Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 167. (Read 1026626 times)

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
For Iwofe Port Harcourt, navy people don stand me and others for hold up for over 30mins based on sey dem dey clear road for oyibo people to pass.

For airport for Lagos wey I go pick my brother, na so dem dey queue and all oyibo people clear finish dey go house.

The same thing dey happen for bank everyday. If we no learn our lessons from here, our own worse pass.

Thank you very much. We deh complain of racism but we own na him better pass? The same thing weh we deh do to ourselves here if oyibo do us abroad we go begin complain. Africans are the worst when e reach racism self. Our own na ethnicity and religion. You don ever enter office weh the other tribe be boss? You go hear word if them observe say you no be the same tribe with them. Finally wickedness deh everybody mind. Na opportunities to display am most people never get.
Baba you just speak my mind, I been no wan put mouth 4 dis racism matter becuz y racism plenty for here even pass that place, me self dey applaud oyibo sake of say them even still dey allow our people come there place dey even dey make way for them self, this an war time so any tin fit happen no blame any body blame yourself who tell you say orderliness dey for war, they even thank God say their never kill them. As @ Brainboss been talk if person don dey here say war dey come him supos don japa since na.
SEE THE KIND OF RACISM WERE DEY HAPPENED FOR 9JA NO GET PART 2 EVEN 4 DIS WE FORUM SELF NO BODY WAN SHOW U LOVE 4 NOTHING BUT OYIBO HERE DEY SHOW LOVE STEADY NA WEN YOU FUCK UP DEM NO DEY HERE SORRY WHICH 4 ME MAKE SENSE 100%, I BEEN BUILD COMPANY WITH MY BOSS AFTER COVID 19 LUCK DOWN WE SUFFER DO ALL DEY PAPERWORK TOGETHER ONLY ME AND HIM OOOO, BUT WEN THE COMPANY BEGIN DEY PICK, BABA GO BRING HIM TRIBAL PEOPLE GIV THEM POSITION WERE ME NO SEE 4 COMPANY WERE WE BUILD SAKE OF SAY NA HIM GET AMMM. SELFISHNESS, TRIBALISM AND NEPOTISM FULL WE COUNTRY ND E DEY INSIDE ALL OF US THAT ONE WORST PASS WAITING OYIBO DEY DO.
NIGERIA DON DEY WAR SINCE OVER 10 YEARS NOW OUR PEOPLE DEY DIE EVERY DAY THIS ONE NO BE OUTSIDERS DEY KILL THEM OOOO NA WE WE DEY KILL OUR SELF.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
For Iwofe Port Harcourt, navy people don stand me and others for hold up for over 30mins based on sey dem dey clear road for oyibo people to pass.
This is called privilege it's not racism, only you can create this privilege for yourself, if you have the money there is nothing you cannot command, there are blacks who are also been guarded by white cops and are also enjoying that privilege outside Africa. We still get plenty Oyibo wey dey trek under sun for here. The difference between dem and us na money

Why you dey talk like this na, most of the blacks are Ukraine passport holders they have been in that country all their life, there home is Ukraine and deserve to be treated as one.
I no sure say the president no dey aware of the mata make we no point finger, Maybe e dun give order to evacuate everyone but those in power dey do as dem like. Na war be dis people dey hardly follow order exactly as dem talk. Dem go do wetin you talk but go play small favouritism inside.
There is nothing wrong with Favoritism it happens everywhere but Racism is unacceptable, the videos is everywhere on the internet and I'm very sure the president is aware of what is happening he's not blind, he gave that command, the same blacks are the ones picking up arms to defend Ukraine, the same blacks are being treated like their life is worthless. This is war make den try set carry everybody alone, after dey video was exposed they lost so many supports, people start condemning their actions and the rest.

When you dun see all these kind videos, person go ask e sef say shey if our country good these people go still dey travel out?? cos the thing cun be like you comot your country where you be king cun go where you be slave...  I just hope they will be safe.
Traveling is part of learning, people must travel and not everyone is being treated unfairly, we still get plenty American citizens in Africa den you go ask yourself say why Africa when America is 10x better, this is why we have embassy in different countries because people must travel far and near it's a personal stuff. If you like build paradise people go still travel go see how Hell dey.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
There is horrible video evidence of Africans being mistreated and not being permitted to leave the nation at the Poland-Ukraine border; blacks are requested to walk to the back, and Ukrainian soldiers are utilizing these forms at the crossing: 100 Ukrainians, 30 foreigners, 1 African. Even in times of war, racism is still prevalent; I dislike war but will always oppose racism; I've always been neutral on the Russia-Ukraine conflict until now; the lives of black people do not matter to the Ukrainians..
My guy wey dey Ukraine been dun clear me say for that way, black nor dey carry do as them nor dey too reason blacks and you fit just enter problem for small thing (like black boy dey follow one of their Ukrainian girls) i been know say dem dey run am normally but i nor expect dem to still dey do am and pick preference at a time like this, e nor make any sense at all. When you dun see all these kind videos, person go ask e sef say shey if our country good these people go still dey travel out?? cos the thing cun be like you comot your country where you be king cun go where you be slave...  I just hope they will be safe.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Thanks for this, I really have seen videos concerning this and I was surprised, this act of racism and the world isn't even concerned a bit, the fact is that countries in the middle East are getting bombed, disease are happening in Africa and the world would not be moved or if they are it just going to be partly, I know all this is all am race, so I knew during safety it would come down to race. And the world won't even care a bit, I dey vex for Nigerians, and Africans wey still dey overlook this injustice.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
For Iwofe Port Harcourt, navy people don stand me and others for hold up for over 30mins based on sey dem dey clear road for oyibo people to pass.

For airport for Lagos wey I go pick my brother, na so dem dey queue and all oyibo people clear finish dey go house.

The same thing dey happen for bank everyday. If we no learn our lessons from here, our own worse pass.

Thank you very much. We deh complain of racism but we own na him better pass? The same thing weh we deh do to ourselves here if oyibo do us abroad we go begin complain. Africans are the worst when e reach racism self. Our own na ethnicity and religion. You don ever enter office weh the other tribe be boss? You go hear word if them observe say you no be the same tribe with them. Finally wickedness deh everybody mind. Na opportunities to display am most people never get.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Why you dey talk like this na, most of the blacks are Ukraine passport holders they have been in that country all their life, there home is Ukraine and deserve to be treated as one.

Shey e dun clear for dem eye, if person been tell dem dey no be Ukrainians or na second class citizens them be, dey for gree? If this kind mata sub for Nigeria same thing go happen. Dem go use brother brother sidelines others. This kind thing dey happen everywhere and we too dey guilty make we no do like say na our own bad pass. We Sabi play victim too much when we ourselves they guilty of racism. Well I no happy say e dey happen like this but wetin we go do na?

I no sure say the president no dey aware of the mata make we no point finger, Maybe e dun give order to evacuate everyone but those in power dey do as dem like. Na war be dis people dey hardly follow order exactly as dem talk. Dem go do wetin you talk but go play small favouritism inside.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Russia - Ukraine War- RACISM

There is horrible video evidence of Africans being mistreated and not being permitted to leave the nation at the Poland-Ukraine border; blacks are requested to walk to the back, and Ukrainian soldiers are utilizing these forms at the crossing: 100 Ukrainians, 30 foreigners, 1 African. Even in times of war, racism is still prevalent; I dislike war but will always oppose racism; I've always been neutral on the Russia-Ukraine conflict until now; the lives of black people do not matter to the Ukrainians..
Black lives matter to em fellow blacks?
Wetin dey happen for Ukraine dey happen everyday for Africa and even for Naija we country. We fit talk say Ukraine dey give their real citizens preferential treatment because dem value their own. E no dey vex me, because I believe this na eye opener to our people.

For Iwofe Port Harcourt, navy people don stand me and others for hold up for over 30mins based on sey dem dey clear road for oyibo people to pass.

For airport for Lagos wey I go pick my brother, na so dem dey queue and all oyibo people clear finish dey go house.

The same thing dey happen for bank everyday. If we no learn our lessons from here, our own worse pass.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I oppose war, but I also oppose racism and Ukraine's treatment of black people.

 Russia go show den pepper make den get sense small
No use small group mistakes use judge the whole Ukrainians, those blacks no be correct black lol. A black man dey Japa immediate them hear say casala wan burst. Alarm dun loud since wetin dem still dey do until this time. Dem supposed know say when the rush hour cones, dey will always be last so better to start before anyone else. I no dey say wetin dem do good but every country go put their people first.
Why you dey talk like this na, most of the blacks are Ukraine passport holders they have been in that country all their life, there home is Ukraine and deserve to be treated as one. When the matter been come up most blacks left the country, no be everyone go leave at the same time na. Those were not a small group of people those were soldiers taking command from the President. Yes their citizens were priority and then foreigners but why den separate blacks from the foreigner category?

Russia and China go dey side any dictatorial government while NATO and UN go side democratic.
This is what the Americans and the media want you to believe, and if you don't want them to take over your country, they'll brand you a dictator. Because he refused to surrender their assets to them, they convinced us and the Libyans that Gadafi was a dictator and a rebel, now they are crying. NATO has attacked and killed more civilians than the ostensibly dictatorial countries.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
Even I read of a Nigerian that booked a flight in Poland (to Nigerian) had to walk 11 hours from Ukraine to Poland because of the discrimination, with this, I know say no be only the person go travel with leg, I hate this when I read it yesterday evening.

Let us all dey wish our fellow Nigerians to leave the country in peace.

But if we think this, racism can happen also in Russia.

What I wish na when Africa will stand to have value for themselves which will help them in the world. When Africa that got almost all resources needed to become a great continent no even know how to use ham than to be running to the white countries. The problem comes from within and dey affect us outside the continent.

I can not support anyone, then, after Soviet Union left North country, and the US left South Korea, why Soviet Union allied North Korea so it can take over the whole Korea (both North and South). They failed.

Russia and China go dey side any dictatorial government while NATO and UN go side democratic.

If we should consider this, we no even need to side any country, they have one thing in common for blacks. But I dey wonder how the world will be if the leaders are dictatorial, they like war.

China wan take over Taiwan, a country that is independent, just have the same dictatorial sense of thinking like Russia, I think this people prefer the old (power) way which pays them more than what multitles want. Even Russian president said Taiwan is a breakaway province of China that will still be taken back. Why war? The world can be of peace, but these dictators dey fear NATO.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I oppose war, but I also oppose racism and Ukraine's treatment of black people.

 Russia go show den pepper make den get sense small

No use small group mistakes use judge the whole Ukrainians, those blacks no be correct black lol. A black man dey Japa immediate them hear say casala wan burst. Alarm dun loud since wetin dem still dey do until this time. Dem supposed know say when the rush hour cones, dey will always be last so better to start before anyone else. I no dey say wetin dem do good but every country go put their people first.

I pray nothing happen to anybody there, Dem no deserve within Putin dey put them thorough. People go dey think say this na small thing as we dey quick quick forget history. How world war 2 start na like this too as Hitler invade Poland small small war come start. Now wey Putin dun start e own, Dem dun dey lock up make dem no worry Putin dey come for all man
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Russia - Ukraine War- RACISM

There is horrible video evidence of Africans being mistreated and not being permitted to leave the nation at the Poland-Ukraine border; blacks are requested to walk to the back, and Ukrainian soldiers are utilizing these forms at the crossing: 100 Ukrainians, 30 foreigners, 1 African. Even in times of war, racism is still prevalent; I dislike war but will always oppose racism; I've always been neutral on the Russia-Ukraine conflict until now; the lives of black people do not matter to the Ukrainians..

Watch video here: https://twitter.com/Migiro16/status/1497878616922894338?t=WNL5dQinP5cSBqphqfeOVQ&s=19


Putin was the other leader who opposed NATO invading Libya, killing Gadafi, and leaving the country in poverty and pain. Lybia had $150 billion in foreign remittances under Gadafi, but today America has collected everything and left the country underdeveloped.

I oppose war, but I also oppose racism and Ukraine's treatment of black people.

 Russia go show den pepper make den get sense small
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
Peso don report account connection between Edith1994 and rich222 for meta. His observation na correct. The two accounts d post the same style join. Dey don even introduced themselves for this our board. Na bad vibes give us for here.
Make everybody d mind wetin dem d post for this forum because you know why, d go fit use your past post against you someday
Na the girl fuck up now, they ban her account she come create another account immediately, she come they create post for forum with thesame pathern, before they even go report her self as I see the post me I don know already say na she. As they block her account way she create another account she suppose calm down first now and anytime way she Wan post make she change her pathern na people like this dey spoil our reputation.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I remember how Nathrixxx was corrected, but the correction resulted to mistake for ham, he no come include quote which was pardoned before as the pressure too much as      dey tell him not to quote too much, and if the link embedded under text no dey the beginning, na plagiarism, what got him banned according to my findings.
Make newbies take am easy self o, make them no deh rush open threads, atleast that go remove torch from them side. Maybe na the rush to get better rank deh make them show that level of desperation and them go deh open threads anyhow without links to the source. Some deh open up to two in a day self and those threads no deh get substance and weight self. That one bad. This people forget say no be to open threads go make you chop merit, na post quality. Abeg make who deh bring them play them better tape o.
Nathrixxx got 124 merits or so when he was banned, I no think this na merit issue for him, him never got more than 98 activity at the time, so the story dey different. You talk sense sa if na general opinion you have for newbies, make they no rush because they go get there and besides, this forum is for learning.

But with what happened to the person I brought to this forum, I still no consider better tape you people dey talk, though e dey true but what if the newbie was played better tape but still make mistake. If you be my friend, you go know the length I can go to just make sure you get something right. Make you no dey blame people wey dey here for newbies' mistakes because I see it otherwise if the person that they here for long dey get things done rightly.

Make no forget something person fit be newbie for the forum wey him no go be newbie for crypto-currency,
Even if you nor be newbie for cryptocurrency, as far say you just join this forum, you be newbie for here and you gats act like that for the time being.  Normally sef, when person enter new place, e suppose use small small dey observe, nor be say e go just come there come dey advice all the bros and sist them wey dun dey longer, the thing nor dey normal nai make as newbie, you gats dey act like newbie even if you know pass people wey dey already, nor go dey over do.
Na true, I done dey into crypto for almost a year before I joined this forum, but when I joined I come dey know that I was full of false information, like bitcoin go take 10 confirmations before a transaction go dey successful and many like that, but seeing established members dey correct me. But some people can be good and can do as BIT-BENDER talk, but out of 100% people, less than 0.1% or less go dey like that. Some go come get the confidence to dey argue with established member for the forum, not knowing the established members are correct and their posts be like norm for here which others go support.

I don they see you people dey talk say newbie dey come dey advice, I no dey notice that sa, if na newbie, e dey wrong, if na junior member or member, mistake may still dey the advice, but if na full member, nothing bad there especially like creating it along your ranking up post. But what no make sense be say what is persistent should be avoided, you know say the kind topics too much or one or two people done create ham like 3 months or less ago, why creating topics for repetition, those na low quality topics.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Make no forget something person fit be newbie for the forum wey him no go be newbie for crypto-currency,
Even if you nor be newbie for cryptocurrency, as far say you just join this forum, you be newbie for here and you gats act like that for the time being.  Normally sef, when person enter new place, e suppose use small small dey observe, nor be say e go just come there come dey advice all the bros and sist them wey dun dey longer, the thing nor dey normal nai make as newbie, you gats dey act like newbie even if you know pass people wey dey already, nor go dey over do.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I remember how Nathrixxx was corrected, but the correction resulted to mistake for ham, he no come include quote which was pardoned before as the pressure too much as      dey tell him not to quote too much, and if the link embedded under text no dey the beginning, na plagiarism, what got him banned according to my findings.

Make newbies take am easy self o, make them no deh rush open threads, atleast that go remove torch from them side. Maybe na the rush to get better rank deh make them show that level of desperation and them go deh open threads anyhow without links to the source. Some deh open up to two in a day self and those threads no deh get substance and weight self. That one bad. This people forget say no be to open threads go make you chop merit, na post quality. Abeg make who deh bring them play them better tape o.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
For me I like as dem be real newbies but I no like as those wey dey bring dem cum no dey play dem tape.
I believe say anyone that has been on this forum for long go play tape for any member he bring come. Maybe I go talk ham like this, some people no go rise if they no fail, that is just life. Although, anyone that evade ban will be banned again according to the rules of this forum, and anyone I know, me self go report the person for polluting the forum. No blame anyone, make it evolve as e go be. Talk no go do anything about this, evolving matters. I remember how Nathrixxx was corrected, but the correction resulted to mistake for ham, he no come include quote which was pardoned before as the pressure too much as      dey tell him not to quote too much, and if the link embedded under text no dey the beginning, na plagiarism, what got him banned according to my findings. Person that you can blame but which are also not to be blamed are people that no worth to be on this forum and banned which remain forever as they evade ban and they are banned again for they got nothing to offer. The reward for ban evasion na still ban.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Make no forget something person fit be newbie for the forum wey him no go be newbie for crypto-currency, I f person wey be newbie post suggestions post like that kin one they best wey to judge the person na to check the post by reading it a newbie in the forum will always expose himself or herself for the body of the post and no be the topic.
Regardless newbie can be excited and very curious I know I was so if no guidance they go one show say yes Dem to na Know book.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I don dey observe a preponderance of newbies for dis owa corner now and d kain eye wey I dey take look am e get as e bi. Abeg, make una dey shine una eyes wella. Those wey dey bring these people here make una knack dem scores and tell dem how to post for forum. How persin go sey im be newbie and e dey already open threads to give people advice on Bitcoin and wallet security 😅😅? E show sey nor be newbie na. Some of dem dey even go Meta to yarn. Hia! Meta wey dey even panic me till last year or so.

For me I like as dem be real newbies but I no like as those wey dey bring dem cum no dey play dem tape. Immediately you begin get problem for this forum, e dey hard to recover because your record dun already dey bad books and anyday you mistakenly use am ur own dun finished. Abeg anybody wey dey introduced person come here make una carry dem along. Nobi to dey rush merit be growth here oh  na wetin you know because e go help you wella and dat merit wey you dey find you go get am tire.

By just looking at ur post you go know people wey dun read and understand wetin dem dey comment on and those wey just they fullfil post count. Abeg make una listen to wetin our big bros talk and follow Snr man advice. This constant banning dey spoil our reputation for here.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Our new user eddith1994got banned yesterday for those still wondering why I excluded newbies from my https://bitcointalk.org/index.php?topic=5357434.40 stats here is one of the reason, these users come to the forum with the wrong motive and got banned before they even started their journey. Make we dey try dey use our head and make we be good example to other upcoming newbies. I talk about am sometimes ago.

For sometimes I never show face here due to some personal issues. Sorry for the Edith1994 dem ban. I no even know say the account from our community. When I enter Beginners and Help board, I saw many topics the Edith1994 open. Those topics sef no too get quality.

Even for the post wey make dem ban am, wetin em go copy for internet no even relate bitcoin or any technical something. Na pity say dem ban person for off topic matter.

The two accounts don create plenty topics for beginners and help. I dey ignore the threads because the posts na low quality or e nor interest me. I give them warning yesterday weda them nor dey online to see am I nor know. I hope rich222 can correct his mistakes before it is too late.
Peso don report account connection between Edith1994 and rich222 for meta. His observation na correct. The two accounts d post the same style join. Dey don even introduced themselves for this our board. Na bad vibes give us for here.
Make everybody d mind wetin dem d post for this forum because you know why, d go fit use your past post against you someday
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
My Observation:

I don dey observe a preponderance of newbies for dis owa corner now and d kain eye wey I dey take look am e get as e bi. Abeg, make una dey shine una eyes wella. Those wey dey bring these people here make una knack dem scores and tell dem how to post for forum. How persin go sey im be newbie and e dey already open threads to give people advice on Bitcoin and wallet security 😅😅? E show sey nor be newbie na. Some of dem dey even go Meta to yarn. Hia! Meta wey dey even panic me till last year or so.
This generation of newbies dey make fear catch me. I nor go say them be alts because if na alt he suppose know say na spamming them dey do so. The topics nor dey help anybody better discussion nor dey come out for there. Me I dey avoid them. Them even dey go meta go post.....why? E nor dey funny. I feel like say them be genuine newbies and them nor get orientation na make. After all our talk, the same guys go still open new threads today.
Me no believe this is having effect on the price of cryptocurrencies like that, this time itself no dey favour cryptocurrencies if we check the past. And for analysts, I no dey believe in what they analyze most times.
Wetin me I see concerning Russia and Ukraine, d war go benefit Bitcoin as many go use am as Safe Haven. Maybe na wetin even make am shake up small sef. I expect more spike in days to come.
Bitcoin don dey drop as a result of the kasala way dey hapun. For now I never see how e go take profit Bitcoin. I dey pray make the two countries understand themself before more innocent blood go cry
Jump to: