NEW TOPIC:
How ASUU strike is killing campus businesses. This matta na to bring this ASUU discussion come table fully, no be lie say na businesses wey get their daily bread form campus dey surface pass after the students for this strike something. I understand some of us here na student and nothing pain past to dey to dey for school when you supposed dun pass out and face real life. This ASUU matta dun too dey resurface every now and then. if you been dey incharge, how u go Carey resolve this mata or which advise you feel go go a long way to prevent this strike if a thing or eliminate am totally wey be say we no go dey here ASUU strike and eat again.
Another mata I wan ask na how far fuel for your area, wetin be d price you dey buy. Small small this country dun dey finish. Country wey dey expert petrol dey get fuel scarcity. Wetin dey stop us form refining our own petrol to get all the product e dey offer including fuel. How the country wan take go forward abeg?.
Boss no be lie say ASUU collect almost two years plus for my hand when I be undergraduate and the tin na one of the most depressing mata 4 students most especially dey 1 were no get any tin to fall back to when skul go strike. The koko be say make government deregulate education 4 9ja in the sense say make universities dey spent the moni were them dey generate to pay staffs I know say that one too go lead to hyke in tuition fees them but if the skull fit manage him own resources rather say them go send give government the skull go know how to manage them self properly.
Make I tell you one tin, ASUU no be better body for University oooo them dey kill education system all say them dey fight for their members were I know na my school then when the school comot from ASUU na then the school get level now students dey comot every 3+ years asap
NEW TOPIC:
How ASUU strike is killing campus businesses. This matta na to bring this ASUU discussion come table fully, no be lie say na businesses wey get their daily bread form campus dey surface pass after the students for this strike something.
Me no see any full time biznes 4 campus environment oooo becus dey environment no dey stable most especially 4 place like 9ja were if you no go on strike school go just take one excuse chase you comot from campus, me na born hustler I be that year I dey do barbing saloon to take support my self but my brother las las na me dey support the buzines I come see say the matter don cast I naso I take sell all my things b4 I go run into debts, imagine were u go lock shop for six month sake of say ASUU/NASU Strike or one illegal break. Skull environment no good for business at all e no make sense.
Another mata I wan ask na how far fuel for your area, wetin be d price you dey buy. Small small this country dun dey finish. Country wey dey expert petrol dey get fuel scarcity. Wetin dey stop us form refining our own petrol to get all the product e dey offer including fuel. How the country wan take go forward abeg?.
Baba some people dey sell black market 4 #500 or even #1000 for liter for some place for my town here, but me I go NNPC filling station around 4a.m yesterday and after I spend about one hours for Que I come get fuel I buy amm the same price 162 but the mata no easy oooooo.
1 tin I go correct u be say 9ja no dey export fuel PMs but na crude oil we dey export so we still dey buy pms from other country since say our 4 refineries no dey work but them still dey get budget for every year 9ja don cast finish.
Thank you na my own contributions this.