Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 169. (Read 1026929 times)

hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Our new user eddith1994got banned yesterday for those still wondering why I excluded newbies from my https://bitcointalk.org/index.php?topic=5357434.40 stats here is one of the reason, these users come to the forum with the wrong motive and got banned before they even started their journey. Make we dey try dey use our head and make we be good example to other upcoming newbies. I talk about am sometimes ago.


I don warn una before especially the newbies here say e no dey necessary to dey create topic If you want to grow your account, contribute positively to existing topics. Forcing yourself to create a topic about which you have no knowledge will always result in plagiarism. There are numerous topics on each board, and if you must create one, make it of high quality.
He ignored all the advice. Cookdata bring him matter come here make he correct am him no still hear word. All of us na newbie once upon a time, I don make mistakes too and I don face the music na with that experience we take dey advice newbies but sometimes newbies go dey see am as nothing until he go happen. I nor dey surprised about this account make others use am learn. Those newbies way just enter forum dey create 10 topics once for b&h I greet una
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Our new user eddith1994got banned yesterday for those still wondering why I excluded newbies from my https://bitcointalk.org/index.php?topic=5357434.40 stats here is one of the reason, these users come to the forum with the wrong motive and got banned before they even started their journey. Make we dey try dey use our head and make we be good example to other upcoming newbies. I talk about am sometimes ago.


I don warn una before especially the newbies here say e no dey necessary to dey create topic If you want to grow your account, contribute positively to existing topics. Forcing yourself to create a topic about which you have no knowledge will always result in plagiarism. There are numerous topics on each board, and if you must create one, make it of high quality.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Make I tell you one tin, ASUU no be better body for University oooo them dey kill education system all say them dey fight for their members were I know na my school then when the school comot from ASUU na then the school get level now students dey comot every 3+ years asap

Na here you talk better thing weh enter person ear. ASUU na hypocrites dem be. Once the leadership see money deh will sell out and call off the strike only for the same problem to resurface a few months later. How many of their members self deh enter class teach weh no be when them like? To intimidate students with handouts and missing scripts nah their calling. Education tire me for Nigeria. If you put head for private universities, those ones go use knife cut your head in the name of school fees.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
See cruise asuu and federal government don use students dey catch. I nor fit laugh wen I read the post online wetin small pikin go do when elder go knock him head nai elders come dey do. It is embarrassing...I dey shame the kind news way dey come out nor be reasonable something at all. We get problems for this country but government nor dey see am like that. "Nigerians are strong people" I don taya to strong I wan weak

hero member
Activity: 966
Merit: 701
NEW TOPIC: How ASUU strike is killing campus businesses.

This matta na to bring this ASUU discussion come table fully, no be lie say na businesses wey get their daily bread form campus dey surface pass after the students for this strike something. I understand some of us here na student and nothing pain past to dey to dey for school when you supposed dun pass out and face real life. This ASUU matta dun too dey resurface every now and then. if you been dey incharge, how u go Carey resolve this mata or which advise you feel go go a long way to prevent this strike if a thing or eliminate am totally wey be say we no go dey here ASUU strike and eat again.

Another mata I wan ask na how far fuel for your area, wetin be d price you dey buy. Small small this country dun dey finish. Country wey dey expert petrol dey get fuel scarcity. Wetin dey stop us form refining our own petrol to get all the product e dey offer including fuel. How the country wan take go forward abeg?.
ASUU do this every year then strike pass Balotelli. Na so then take extend my stay for university course way be 5 years I do am 6 years.  You nor fit resolve wetin don become way of life, strike na ASUU culture. The worse part be say nor be all the lecturers dey support the strike na mostly senior men for the top nai be orchestrate this movement nai make ASUU dey get division once government settle these men strike don end. The main issues why them strike them nor go handle am, them go leave am till another time then they continue again. Na just cat and rat race. The elites don’t care their children are in private university or studying abroad.

Fuel dey my side no much queue everybody don carry am for mind say na 200naira per litre them dey sell. You know naija na, once price go up it can never come down. 
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
NEW TOPIC: How ASUU strike is killing campus businesses.

This matta na to bring this ASUU discussion come table fully, no be lie say na businesses wey get their daily bread form campus dey surface pass after the students for this strike something. I understand some of us here na student and nothing pain past to dey to dey for school when you supposed dun pass out and face real life. This ASUU matta dun too dey resurface every now and then. if you been dey incharge, how u go Carey resolve this mata or which advise you feel go go a long way to prevent this strike if a thing or eliminate am totally wey be say we no go dey here ASUU strike and eat again.

Another mata I wan ask na how far fuel for your area, wetin be d price you dey buy. Small small this country dun dey finish. Country wey dey expert petrol dey get fuel scarcity. Wetin dey stop us form refining our own petrol to get all the product e dey offer including fuel. How the country wan take go forward abeg?.
Boss no be lie say ASUU collect almost two years plus for my hand when I be undergraduate and the tin na one of the most depressing mata 4 students most especially dey 1 were no get any tin to fall back to when skul go strike. The koko be say make government deregulate education 4 9ja in the sense say make universities dey spent the moni were them dey generate to pay staffs I know say that one too go lead to hyke in tuition fees them but if the skull fit manage him own resources rather say them go send give government the skull go know how to manage them self properly.
Make I tell you one tin, ASUU no be better body for University oooo them dey kill education system all say them dey fight for their members were I know na my school then when the school comot from ASUU na then the school get level now students dey comot every 3+ years asap
NEW TOPIC: How ASUU strike is killing campus businesses.
This matta na to bring this ASUU discussion come table fully, no be lie say na businesses wey get their daily bread form campus dey surface pass after the students for this strike something.
Me no see any full time biznes  4 campus environment oooo becus dey environment no dey stable most especially 4 place like 9ja were if you no go on strike school go just take one excuse chase you comot from campus, me na born hustler I be that year I dey do barbing saloon to take support my self but my brother las las na me dey support the buzines I come see say the matter don cast I naso I take sell all my things b4 I go run into debts, imagine were u go lock shop for six month sake of say ASUU/NASU Strike or one illegal break. Skull environment no good for business at all e no make sense.
Another mata I wan ask na how far fuel for your area, wetin be d price you dey buy. Small small this country dun dey finish. Country wey dey expert petrol dey get fuel scarcity. Wetin dey stop us form refining our own petrol to get all the product e dey offer including fuel. How the country wan take go forward abeg?.
Baba some people dey sell black market 4 #500 or even #1000 for liter for some place for my town here, but me I go NNPC filling station around 4a.m yesterday and after I spend about one hours for Que I come get fuel I buy amm the same price 162 but the mata no easy oooooo.
1 tin I go correct u be say 9ja no dey export fuel PMs but na crude oil we dey export so we still dey buy pms from other country since say our 4 refineries no dey work but them still dey get budget for every year 9ja don cast finish.
Thank you na my own contributions this.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NEW TOPIC: How ASUU strike is killing campus businesses.

This matta na to bring this ASUU discussion come table fully, no be lie say na businesses wey get their daily bread form campus dey surface pass after the students for this strike something. I understand some of us here na student and nothing pain past to dey to dey for school when you supposed dun pass out and face real life. This ASUU matta dun too dey resurface every now and then. if you been dey incharge, how u go Carey resolve this mata or which advise you feel go go a long way to prevent this strike if a thing or eliminate am totally wey be say we no go dey here ASUU strike and eat again.

Another mata I wan ask na how far fuel for your area, wetin be d price you dey buy. Small small this country dun dey finish. Country wey dey expert petrol dey get fuel scarcity. Wetin dey stop us form refining our own petrol to get all the product e dey offer including fuel. How the country wan take go forward abeg?.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
Them nor dey know the consequences until it is too late. Plagiarism you commit when you be newbie the day you become legendary your past go find e way to the surface to disgrace you. I go sound am again you nor need to dey create topics to get merit. I go see one person go get 3 topics in less than 2 days for the first page of b&h. Very unnecessary

He no really dey funny make person lose account after him don rank up finish, what I notice be say most people are in rush to rank up which is very bad, what's the use of ranking up then later you end up lose your account, I believe it's better you take your time, understand the way the forum works then you can start thinking about ranking up and even if you are posting you shouldn't be in rush.
I believe even if you are active in this board alone people will definitely assist you with merit so why will you rush.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Una welcome new people them, .na gud tin say una locate this place but the look as others been don talk na to focus and to dey learn every day did place be like school person dey change class but waiten go carry go dey next class an knowledge so I go advise make we dey all learn to obey the rule so we no go get problem. As e be made we dey work nd pray e to be God we're dey help person.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
~snip~
Women don dey choke for here. I welcome you @Rich222 to Bitcointalk and I welcome you to our very own Nigerian community. Abeg read the Unofficial list of (official) Bitcointalk.org rules, guidelines, FAQ make you no do mistake by mistake. You get the point.
I don warn una before especially the newbies here say e no dey necessary to dey create topic If you want to grow your account, contribute positively to existing topics. Forcing yourself to create a topic about which you have no knowledge will always result in plagiarism. There are numerous topics on each board, and if you must create one, make it of high quality.

This kind startup dey hurt person tomorrow because those posts were quoted and dey fit use am against am tomorrow. Abeg we dey support ourselves here and dey try grow together too but anybody wey dey find way to cheat the system dey on his own.
Them nor dey know the consequences until it is too late. Plagiarism you commit when you be newbie the day you become legendary your past go find e way to the surface to disgrace you. I go sound am again you nor need to dey create topics to get merit. I go see one person go get 3 topics in less than 2 days for the first page of b&h. Very unnecessary

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I don dey see your post but I get one comment way I Wan make and he go make sense if you correct yourself to avoid ban, you know say all this people just dey after us,
I don see like two of ur post way be say na only source link you put, abeg incase you copy person post always make sure say you quote the person and always make sure say you add source link to be post to be at a saver side.
I don warn una before especially the newbies here say e no dey necessary to dey create topic If you want to grow your account, contribute positively to existing topics. Forcing yourself to create a topic about which you have no knowledge will always result in plagiarism. There are numerous topics on each board, and if you must create one, make it of high quality.

This kind startup dey hurt person tomorrow because those posts were quoted and dey fit use am against am tomorrow. Abeg we dey support ourselves here and dey try grow together too but anybody wey dey find way to cheat the system dey on his own.



Take your journey in this place very serious because the benefits wey follow too much ooo
No be lie you talk. The benefit yafuyafu. But na for senior men like una e sure pass for. Me self I deh imagine wetin I go deh do with that kind weekly pepper weh una deh get if e touch my hand. Na real enjoyment una deh.
More money more responsibility brother nowhere dey easy, everyone go reach there too.


~snip~
Welcome to Bitcointalk!
newbie
Activity: 14
Merit: 12
Username: Rich222
Gender: Female
Country: Nigeria
Skill: TRADER also Training for the future on BBCODE

I dey very happy to bcum a member of dis wonderful family bitcointalk forum, I don go through the rules and regulations e tight Sha but I go try my best not to go again am even if na to dy read am every three times in a week I go do am so that I no go make mistakes where go make me regret. My people I hail  ooh.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
My people, I greet una.
E don tai way I com dis side o or evn cef, 2 dey day active 4 d forum bt anyhow e be, I remain Mr.right85 nd I don show back. I wan dey try 2 dey do as una dey do bt, e no easy 4 me at allll. Dem say watin u no sabi, e big pass u and as by d gud tin there be say, u fit still learn am.

Here sure for you pass na unto say local posts no be problem for the campaign weh you deh. I no come know wetin make you no deh frequent here. Na the same campaign we deh. Anyhow weh e bi e go bi make you deh show face here now well well as e go help your people deh sabi you well deh go.



Take your journey in this place very serious because the benefits wey follow too much ooo

No be lie you talk. The benefit yafuyafu. But na for senior men like una e sure pass for. Me self I deh imagine wetin I go deh do with that kind weekly pepper weh una deh get if e touch my hand. Na real enjoyment una deh.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
Name: Edith1994
Gender: female
State of resident: imo state, Nigeria
Skill: trader in crypto currency ( apart from being a trade I'm into cosmetics and wines)

I dey very happy when my friend tell me about dis platform, when I con become member I con see am well well say everything wey  e talk about the platform e worth am.

You are welcome, I dey see your post but I don't even know say na from thesame country we commot, I dey like make I dey see my country people for forum, he dey always give me joy and I believe say you go benefit from the forum well just make sure say you read and understand the forum rule.
I don dey see your post but I get one comment way I Wan make and he go make sense if you correct yourself to avoid ban, you know say all this people just dey after us,
I don see like two of ur post way be say na only source link you put, abeg incase you copy person post always make sure say you quote the person and always make sure say you add source link to be post to be at a saver side.
https://bitcointalksearch.org/topic/m.59327331
https://bitcointalksearch.org/topic/m.59322552
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Abeg, I wan mk somebody put me true on how 2 start new topic 4 dis naija forum, I no wan mk mistake again b4 people go think say I purposely Dy do am. I won take my time.
Just follow the format used by brainboss https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.2280 just make it simple since we are using a single thread just make it brief and add a reference link for further reading, if you want to add a picture just make it small too.

Make it interesting make we discuss, just make am quality small.
newbie
Activity: 14
Merit: 16
Abeg, I wan mk somebody put me true on how 2 start new topic 4 dis naija forum, I no wan mk mistake again b4 people go think say I purposely Dy do am. I won take my time.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Name: Edith1994
Gender: female
State of resident: imo state, Nigeria
Skill: trader in crypto currency ( apart from being a trade I'm into cosmetics and wines)

I dey very happy when my friend tell me about dis platform, when I con become member I con see am well well say everything wey  e talk about the platform e worth am.
You do well by reaching out to your Naija brodas and sisters here. You are welcome.
I know the kind of joy wey em d give for body getting to know about this forum. But dey matter be sae everybody for dis forum suppose not to review his or her real identity. To avoid make person no trace you tomorrow cos na digital world we dey.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
My people, I greet una.
E don tai way I com dis side o or evn cef, 2 dey day active 4 d forum bt anyhow e be, I remain Mr.right85 nd I don show back. I wan dey try 2 dey do as una dey do bt, e no easy 4 me at allll. Dem say watin u no sabi, e big pass u and as by d gud tin there be say, u fit still learn am.

I dey see am say, dat our new 16teen no know how e dey be so, we fit still help her pm those men dem to do as e go sure 4 her bt, dat go be wen she don put d 1 way dey her okay.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Name: Edith1994

Our people say anywhere you go do not leave anything behind because nobody knows tomorrow this na internet space so make you try hide your identity it matters a lot I for like make you edit that your name then ask other to requote you. We are not here to expose anyone identity.

And yes I'm glad we are having the female gender for our midst e make sense, I just look through your post history now and I get only one advice for you, if you want to grow please ignore the off-topic board unless you are just here for fun and also try and stick to the rules, we also support our own that's one thing you should know.

Take your journey in this place very serious because the benefits wey follow too much ooo
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Name:
Gender: female
State of resident: imo state, Nigeria
Skill: trader in crypto currency ( apart from being a trade I'm into cosmetics and wines)

I dey very happy when my friend tell me about dis platform, when I con become member I con see am well well say everything wey  e talk about the platform e worth am.
I welcome you. We don dey get women for here and I dey happy about am make we get diversity small. I don see your topics for beginners and help your face don dey show for there. As you dey learn, take am small small nor rush. If you get any issues you fit talk am here make we put heads together solve am
Jump to: