Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 171. (Read 1026890 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
How far, una dun use enaira app before, if yes how e dey be any experience or you sabi person wey dey use am?
The customer support on the app na support of bank linked to the eNaira account. eNaira na just naira and nothing more other than saying it is designed based on blockchain technology.

I later deleted the app when it was useless on my device.

Na complete failed project make them come up with something better abeg
Over 100000 downloads on playstore, truthfully speaking, no be failed project, but people using it are not (maybe yet) many.

State of origin: cross river State, akpabuyo
omo Rivers State they carry first for this community
You are right about Rivers states, but Cross River na another state entirely.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Any body way never register for voters card before, or you get anybody way never register before, Na now be the time abeg make we try register and get our voters card, make we vote for our person wea we like, time for complain don pass

You deh right about the PVC matter but I hope the person weh you like no go be Bola Tinubu or another oldie politician because na to join hands and beat you go remain ooo. Yes our young people supposed come out especially so we can vote every analogue thinking politician out. Na people weh de digital and weh go help boost cryptocurrency we supposed support for 2023.

Over 100000 downloads on playstore, truthfully speaking, no be failed project.
That no suppose be the parameter to judge the success rate. You forget say only government offices fit download all that number self. Even as you weh download and delete, will it erase the fact that you have downloaded it. Am not sure that the counter does that, or does it? Nigeria government can fake things.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
Any body way never register for voters card before, or you get anybody way never register before, Na now be the time abeg make we try register and get our voters card, make we vote for our person wea we like, time for complain don pass now na time to vote time don reach oh 2023 is here so if you never registered for a voters card before or if you know person wea never register, they can easily register online now and pick up their voters card at any INEC office close to them.
The following link can be use to register for voters card online: https://cvr.inecnigeria.org/

If your Voters Card was registered by 2011, pls try and visit any INEC office close to you to revalidate your voters card, because the new card reader which will be used for 2023 election won't be able to read your card.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
NEW TOPIC
Name: Sandra_Hakeem
Gender: female
Occupation: student
State of origin: cross river State, akpabuyo
I'm really happy to be a part of this forum; I no say we get alot of rules wey we need abide by and I go try as much as possible to stick to am...I want to salute everyone from dis my side cus as e be now our days, crypto dey finally take over every country's economy gradually so na why every body gats Chuck head and body make time for no pass us by..
Thanks for dis opportunity wey una offer me, very grateful...
Well come mate, omo Rivers State they carry first for this community, I like the little orientation you carry enter now na for you to go back go read those rules even if you don read am before. Then follow them, also try dey read, you need to sharpen your knowledge e go help you grow for the forum, once again welcome to the forum.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
NEW TOPIC
Name: Sandra_Hakeem
Gender: female
Occupation: student
State of origin: cross river State, akpabuyo
I'm really happy to be a part of this forum; I no say we get alot of rules wey we need abide by and I go try as much as possible to stick to am...I want to salute everyone from dis my side cus as e be now our days, crypto dey finally take over every country's economy gradually so na why every body gats Chuck head and body make time for no pass us by..
Thanks for dis opportunity wey una offer me, very grateful...

Waw am kind of impressed, na the first time way I go see woman for our local forum be dis, you are welcome and abeg make sure say you avoid anything way go cause problem to your account, incase if you get any problem or anything way you no understand you fit share am for here atleast person go dey way go fit help you out.
hero member
Activity: 798
Merit: 1045
Goodnight, ohh Leo!!! 🦅
NEW TOPIC
Name: Sandra_Hakeem
Gender: female
Occupation: student
State of origin: cross river State, akpabuyo
I'm really happy to be a part of this forum; I no say we get alot of rules wey we need abide by and I go try as much as possible to stick to am...I want to salute everyone from dis my side cus as e be now our days, crypto dey finally take over every country's economy gradually so na why every body gats Chuck head and body make time for no pass us by..
Thanks for dis opportunity wey una offer me, very grateful...
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Them never ever do anything good so why change now. 
You forget say their slogan na change? Them fit start the change now. I just laugh o, no be say me  expect them to do anything better pass as them deh already. This people no get anything to showcase to us again. I no hear about the E-naira matter again until i come read am here now but I no deh surprise as I suspect say na like that the thing go end. People don cash out for long with money weh federal government allocated for the project. Nothing weh this people sabi pass corruption.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
NEW TOPIC: China’s CBDC nearly completes in a single day eNaira’s 3month’s worth of transaction
How far, una dun use enaira app before, if yes how e dey be any experience or you sabi person wey dey use am?. Wetin una think about this enaira something, e go reach time Nigerian go embrace am or the thing go just die out. Nigeria government self no sabi promote something, if dem promote am well like free transaction fees etc or other better offers dem fit pull some crowd but no dem just released within we no know they expect us to use am

To begin with, I believe the timing was off; you imposed a strong ban on cryptocurrency, and that was not the end; you began freezing banks that dealt with cryptocurrency transactions, and that was not the end; you led the public to believe that anyone using crypto-related apps was a criminal, and at the same time, you introduced the E-naira, which is the polar opposite of bitcoin, and you want people to adopt it? Something that is even more traceable than the local bank, despite the fact that Nigerians will never buy the idea

The E-first naira's flaw was that they copied the logo and were sued for copyright just hours after launching. They went back to create a new logo and rebranded the app.

The second E-naira's flaw was the number of bugs in the system, which made it difficult to sign up. As a result, many people lost interest in the project, including myself, who tried but failed to sign up. It had been a national catastrophe.

Last but not least, you will have to fund through your bank, as credit card possibilities have been restricted, making it harder to fund. They've now incorporated the app with our bank apps for quick funding, however the adoption is still low.

Na complete failed project make them come up with something better abeg
The bone of the matter be say at this stage in our democracy and growth as a nation we suppose don grow reach the point where we go fit develop our own things. E-naira innovation nor be bad idea if you check am well na the intentions of the government nai we dey fear, we nor trust those men in agbada. Them never ever do anything good so why change now. 
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
NEW TOPIC: China’s CBDC nearly completes in a single day eNaira’s 3month’s worth of transaction

How una dey see this enaira mata, just imagine the statistics wey dey show face report say, within take enaira almost 3months to transact in value, china dey run am one day. This one show say Nigerian no even dey reason enaira (laugh wan kill me). If e get anything wey I support say 9ja nondey reason na dis enaira bullshit. From the article, dem say na northerns dey use am pass. Our broda for dis side no even dey reason am.

How far, una dun use enaira app before, if yes how e dey be any experience or you sabi person wey dey use am?. Wetin una think about this enaira something, e go reach time Nigerian go embrace am or the thing go just die out. Nigeria government self no sabi promote something, if dem promote am well like free transaction fees etc or other better offers dem fit pull some crowd but no dem just released within we no know they expect us to use am
Baba the truth be say e naira no fit survive the market and to begin with enaira no dey run on blockchain so that tin na nonsense china na big Nation we're get tinz were fit make transaction easy and to say china get the own digital yaun were dey on blockchain 9ja no get level were china dey na. The koko be say even the central bank digital currency don get coma 4 IFM as them been warn say the matter no dey sustainable so the only koko now na Bitcoin and other decentralized moni dem.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
NEW TOPIC: China’s CBDC nearly completes in a single day eNaira’s 3month’s worth of transaction
How far, una dun use enaira app before, if yes how e dey be any experience or you sabi person wey dey use am?. Wetin una think about this enaira something, e go reach time Nigerian go embrace am or the thing go just die out. Nigeria government self no sabi promote something, if dem promote am well like free transaction fees etc or other better offers dem fit pull some crowd but no dem just released within we no know they expect us to use am

To begin with, I believe the timing was off; you imposed a strong ban on cryptocurrency, and that was not the end; you began freezing banks that dealt with cryptocurrency transactions, and that was not the end; you led the public to believe that anyone using crypto-related apps was a criminal, and at the same time, you introduced the E-naira, which is the polar opposite of bitcoin, and you want people to adopt it? Something that is even more traceable than the local bank, despite the fact that Nigerians will never buy the idea

The E-first naira's flaw was that they copied the logo and were sued for copyright just hours after launching. They went back to create a new logo and rebranded the app.

The second E-naira's flaw was the number of bugs in the system, which made it difficult to sign up. As a result, many people lost interest in the project, including myself, who tried but failed to sign up. It had been a national catastrophe.

Last but not least, you will have to fund through your bank, as credit card possibilities have been restricted, making it harder to fund. They've now incorporated the app with our bank apps for quick funding, however the adoption is still low.

Na complete failed project make them come up with something better abeg
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Oga Smartvirus, no vex for me, research don tire me. Na to dey worry people with questions I wan dey do now.

I know say na you him wan quote before e go take sleep eye go misquote our chairmo
Lolx...no be small sleep eyes, him na senior man, even for sleep him dey still complete post. Oga Virus wey sharp, I hail you.

This enaira of a thing no go get head light. Nobody go wan buy wetin no dey appreciate. If you buy enaira keep, e just be like your naira wey dey for bank, e go still depreciate.
The only time people go forcefully put interest, na if government put some kind conditions for the enaira.
Like all the civil servants go recieve their allowie via enaira. If not, that project go fit die.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NEW TOPIC: China’s CBDC nearly completes in a single day eNaira’s 3month’s worth of transaction

How una dey see this enaira mata, just imagine the statistics wey dey show face report say, within take enaira almost 3months to transact in value, china dey run am one day. This one show say Nigerian no even dey reason enaira (laugh wan kill me). If e get anything wey I support say 9ja nondey reason na dis enaira bullshit. From the article, dem say na northerns dey use am pass. Our broda for dis side no even dey reason am.

How far, una dun use enaira app before, if yes how e dey be any experience or you sabi person wey dey use am?. Wetin una think about this enaira something, e go reach time Nigerian go embrace am or the thing go just die out. Nigeria government self no sabi promote something, if dem promote am well like free transaction fees etc or other better offers dem fit pull some crowd but no dem just released within we no know they expect us to use am
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
*yawa*
Thank you my bloda, as the campaign no dey accept post for Beginners and Help, the thing come be like say e wan stress me because my favourite board na Beginners and help. As him dey accept post here, e sweet me well well. For the gambling posts, I no dey use am joke, I dey give him as he wants.

That bloda' weh you write there come jell like Blood oo. Correct man, my broda from another father. The same mama but different papa  Grin. All this restrictions for where to posts and where not to post sometimes no deh get head. Imagine as B&H no come deh included and na weh people deh fall in pass sef. E good as manager still leave local for us anyway. On to another issue. Who don see this blood money (EGOOBALA) plate number? Somebody share am with me for telegram this morn morn. Naija don turn comedy I swear.

Oga Smartvirus, no vex for me, research don tire me. Na to dey worry people with questions I wan dey do now.

I know say na you him wan quote before e go take sleep eye go misquote our chairmo
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Make person wey get idea help me check if the campaign I dey promote dey accept post for local board. For their rule, dem no talk say local board no dey accepted.

Na the same company me with you deh and local board deh accepted well well. If you check well you go see say almost everybody for Gamdam deh put head for local. Gambling na compulsory oo. Make sure you meet cut off for gambling, otherwise our chairmo go hammer you. The guy no deh joke with am at all.
Thank you my bloda, as the campaign no dey accept post for Beginners and Help, the thing come be like say e wan stress me because my favourite board na Beginners and help. As him dey accept post here, e sweet me well well. For the gambling posts, I no dey use am joke, I dey give him as he wants.
Oga Smartvirus, no vex for me, research don tire me. Na to dey worry people with questions I wan dey do now.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Make person wey get idea help me check if the campaign I dey promote dey accept post for local board. For their rule, dem no talk say local board no dey accepted.

Na the same company me with you deh and local board deh accepted well well. If you check well you go see say almost everybody for Gamdam deh put head for local. Gambling na compulsory oo. Make sure you meet cut off for gambling, otherwise our chairmo go hammer you. The guy no deh joke with am at all.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Wow! Congrats for your new rank. I remember you and Cookdata when you both still dey member rank, all I wish for you both na to rank up, now you too don rank up. I think this is just the beginning, you still have a lot to contribute and in the process dey rank up. Seeing your merit history, I know that you no dey fully dependent on us, your quality posts ranked you up, but na my pleasure to see you appreciating us too as the little we contribute to you ranking up. Congrats.

As I see my telegram bot pop your name say you mention me, I think say na time for another lessons Grin, una be icon for people like us and they show good path for junior rank and very soon, I go see you for Mpamaegbu and Brainboss similar rank, we dy una back and we they learn steadily to be like every other reputable member.
Cookdata na big name, Charles Tm, Mpamaegbu and brainboss and the rest of the senior men dem dey steadily give us updates advice and all the other support. Btt na 1 big family for 9ja youth dem and I know say 1 day be 1 day God no go shame us we go reach good height for dey forum as giant of Africa 4 cryptocurrency matazz. 9ja na our own we fit make the change happen if we believe. Make we trust the positive process and follow the system legitly I go make brain 🧠  later.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
Wow! Congrats for your new rank. I remember you and Cookdata when you both still dey member rank, all I wish for you both na to rank up, now you too don rank up. I think this is just the beginning, you still have a lot to contribute and in the process dey rank up. Seeing your merit history, I know that you no dey fully dependent on us, your quality posts ranked you up, but na my pleasure to see you appreciating us too as the little we contribute to you ranking up. Congrats.

As I see my telegram bot pop your name say you mention me, I think say na time for another lessons Grin, una be icon for people like us and they show good path for junior rank and very soon, I go see you for Mpamaegbu and Brainboss similar rank, we dy una back and we they learn steadily to be like every other reputable member.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Nice one brothers, I believe say we all dey learn even me way dey post am brother I no Sabi much about am and that's where we all coming in, as you talk rightly many people go benefit from am, I personally also one learn about altcoin, as we no future investments starts from now, so make we all know how we go take share ideas and make we see how this things call Crypto fit help us especially we from the 3rd world country.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Somebodi calling my name, Showkey! Somebodi calling my name... Mpamaegbu! How many of us still remember that song? As I hear my name na im I quickly show here oh. Nice one Issa56. E dey always sweet my belle weneva I see una dey rank up like dis. Abeg, make una kontinue una good work and steer clear of anything wey go bring yamayama. I need more of una to com join us for meeting ndi legendary. We nor plenty up there and na so cold dey catch us wen harmattan enta. Bravo!
Omooooooo, laugh wan tire me as I hear the lyrics of these song. E don taiii no be chaise. E con get this dance step way dey follow am, the Daddy-shoki dance step. Na there the leg work been start cef but, e no been carry general name the way naira just carry collect am go en side. Omo no worry, we been get legends and we still get legends. 9ja music too sweet!!!

Make person wey get idea help me check if the campaign I dey promote dey accept post for local board. For their rule, dem no talk say local board no dey accepted.
I no sabi you to dey like this o, you na man way dey sabi research. Na just small reading work or pm and e go dey you alright. I greet all of una!
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Somebodi calling my name, Showkey! Somebodi calling my name... Mpamaegbu! How many of us still remember that song? As I hear my name na im I quickly show here oh. Nice one Issa56. E dey always sweet my belle weneva I see una dey rank up like dis. Abeg, make una kontinue una good work and steer clear of anything wey go bring yamayama. I need more of una to com join us for meeting ndi legendary. We nor plenty up there and na so cold dey catch us wen harmattan enta. Bravo!
Oga Mpa, you be correct man. Which song be that? You know say I be song writer  Grin.  Before this year go end, other Nigerians go join una for legend beer.
Issa56 my brother, I no know say you be Nigerian o... congratulobia my brother.  I like this place.

Jump to: