Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 173. (Read 1027165 times)

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
My people make I bring one matter here small make we chuck mouths, this Abba Kyari matter tier me oooo, person were still get case still dey hustle for black market were on a norms him na police officer in fact in head SARS we're them ban and also contribute to all the cryptocurrency wahala for 9ja.

I wan Yan waiten dey my mind now but make the discussion cash fire first.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I know of an Alt-Coins made by two Nigerians and it's listed on coin market cap first 100 coins from the last time I checked but this could be possible because them be Nigerian wey no base for Nigeria

Na Wakanda Inu you deh refer to here? E don teh, no be today matter say Nigerians no deh like support the one weh be dem o when investment matter deh concerned. You no go too blame us because anything money issue deh make people open eyes. Money hard to get and nobody go want waste the little weh he get. Most developers for Nigeria deh completely after how them go take blow from the project and not how the project go become prosperous.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Zugacoin dey popular scatter but the issue be say, we, no be only Nigerains but Africa as a whole, we no dey fit support ourselves. Today like this, I don see the Zugacoin sign post like 2 big once and the price way this coin carry for body go surprise you but, many of us no get am. Even me like this, I no still get am!

The little I bin know about the coin be say, na watin we go use for Africa and to raise money way them fot use support charity small.

Na the faer we still dey get within ourselves dey make we no fit support ourselves and we no fit blame the next man because, 2 seconds, man fit betray. Na small small we go take build the trust. We still dey try.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
@BIT-BENDER make I ask somtin sharply abeg any body don hear about zuga coin were dey claim African first cryptocurrency own by Bishop Zuga I never really know how this coin take manages to get that price and how e blockchain dey work. I for like here from we 9ja people got knowledge about the coin.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
@Ruchi man it really doesn't make sense dey Nigeria as big as we dey and as we dey involved into crypto-currency we no dey support our own, doing my research I know of an Alt-Coins made by two Nigerians and it's listed on coin market cap first 100 coins from the last time I checked but this could be possible because them be Nigerian wey no base for Nigeria, it's time to promote our own, but even if we one do am we go do am wisely, no be to go Chuck head for any how coin or project, as always make you fess do your research and from there would know what to do.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
...why because we no dey value or regard our own.
My brother, this matter of not regarding our own, nor be today e start. The mentality wey most persons get for this side na say anything wey black man start for Africa nor fit dey compare with the one white man go start, and e nor go well. Na inferiority complex be that. Na the same thinking dey make people nor dey too wan buy this IVM motors, na same reason you go call Italian shoe original, and associate fake shoes with Aba people forgetting say if same Aba people get good support, dem fit outperform and compete with the international market with their own originals. My brother, our mentality need to change.

crypto-currency still struggling in Nigeria and Africa at Large.
Another reason na say we too get rigid thinkers for this side wey nor like new things. Civilization and exposure never reach some people, so some people believe say some kind things like crypto na wayo and e nor dey possible.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
We dey find am hard to support our own, many Nigerians dey into crypto-currency many of which they buy multiple coins here and there, this no bad ohh, infact na investment and as we all know all investment dey risky, but my point be say we no dey buy Nigerian project and e no blend at all, davido release him project after him do birthday, with the whole influencer wey this Manny get, e be like say the project self do go down to the extent him don forget am, why because we no dey value or regard our own, which make crypto-currency still struggling in Nigeria and Africa at Large.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
life isn't fair, so if it gives you little you make something out for your self.

Na here you talk wetin enter brain as to say make person make out something out of wetin life throw give am and na wetin make so many Nigerian youths run enter crypto. I listened to Buhari one time weh the old man dey talk say make graduates no count on government for jobs. Na that kind talk a president supposed deh talk? This country na big mess. I salute the courage and smartness of youths weh don enter crypto and other genuine businesses already and not waiting for government for anything. One day, Baba God go crown our efforts.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

My brother, those people weh you think say get those jobs easily like that no be so. Go and investigate, you go see say connection join the matter. But them no go tell you the truth. No be this same Nigeria weh person weh study Religion or Food and Nutrition deh work for bank while those weh study related courses for banking sector no get the same job for the same interview. I mean second class upper graduates o.
Brother don't underestimate the power of hard work, yes I no see our country no to dey try for it's citizens but they get people who got jobs due to their hard work and consistent attitude, even in crypto you have to work hard and also smart to that's how the world works, no place all over the world is perfect, life isn't fair, so if it gives you little you make something out for your self.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
And many more people still deh believe government to give them job after them graduate. I just deh laugh them weh never realise say job no deh for Nigeria. Just find wetin you fit do for yourself na wetin deh now. Nobody supposed deh look certificate to engage themselves for any job. Even okada riders now sef some be graduates. I wish say these people go know about bitcoin and join us for this online move to benefit themselves too.
The economy is bad though very bad, but no discourage other people's believe, I think I don see some even for our country wey get better job, they went to school studied a good course came out and had the believe and it work for them, I no gbadu our government one bit, but I always respect other people's believe, if you work hard and believe something go work out even if everyone dey complain e fit sure for you.
One truth way follow the matter be say, e get how you go scatter paper reach for some companies written interview eh, them no go get any other choice than to collect you. Sometimes, these corrupt men way dey head companies dey reasons too. No be everytime dem dey rubbish people way their brain dey work wonders to go employ olodo, abi you wqnt make company fold...

Though, another thing be say, when you good but, you no too good, na there you go need person to at least, protect your interest. Like, even if w no help push you go front, at least if slot dey and your qualifications fit give you the slot, the person go just put eye to make sure say, them no carry am give another person.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The economy is bad though very bad, but no discourage other people's believe, I think I don see some even for our country wey get better job, they went to school studied a good course came out and had the believe and it work for them

My brother, those people weh you think say get those jobs easily like that no be so. Go and investigate, you go see say connection join the matter. But them no go tell you the truth. No be this same Nigeria weh person weh study Religion or Food and Nutrition deh work for bank while those weh study related courses for banking sector no get the same job for the same interview. I mean second class upper graduates o.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
And many more people still deh believe government to give them job after them graduate.
Maybe the person no be Nigerian  Grin

Ahhh baba I no wan go there, the koko be say many of us don suffer for dis strikes wahala, me na 6 years I spend for course were normally na 3+  years for University I see pepper for school walahi, but e no suppose be like dat
I spent 6 years as well, PD join making 7 years. This is Nigeria, nothing dey go good as e ought to be. There was a time I was thinking if blacks dey primitive to whites, even here, we are Nigerians, but far beyond obvious, na due to our (local) environment.

if you work hard and believe something go work out even if everyone dey complain e fit sure for you.
Diligence, patience and opportunity. Exposure may bring opportunity. Hard work with little profitability dey. Na another discussion this can lead to.

Nigeria universities nodes denied anybody admission just because the child is under age normally at the age of 17 you should be through with your elementary classes except those olodo wey repeat classes or didn't start school when they were supposed to start.
I no get what you meant here, what age you dey term as underage? Below 18? Read the OP by Wiwo. The girl na 16 years and she don get PHD.

Made a mistake for my last post, I post Nigeria Universities no dey accept below 14, it is Nigerian universities no dey accept below 16. Even for JAMB (UTME) self.

Senate mulls amending JAMB Act to limit age of writing UTME
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Abeg my people make una no vex say I want bring mata outside dey tin we bin dey talk before, I see something we're make me come dey reason some kind things. This mata na about 16 year old 9ja girl were don barge Ph.D. abroad ooooh.
If na Nigeria universities now dem go tell her parents say she never reach to get admission. We just deh like slow things for Africa. Oyibo no get time for all that.
Nigeria universities nodes denied anybody admission just because the child is under age normally at the age of 17 you should be through with your elementary classes except those olodo wey repeat classes or didn't start school when they were supposed to start.

The main education starts from Basic one, Nursery school can easily get skipped because an only to know alphabets and numbers wey you fit learn in Nursery school and these things some parents fit keep their kids at home and teach them better.

The famous phrase wey say everybody brain na the same na pure scam ooo our brain are not the same, some people are born genius, if you see wetin 3 years old Chinese kids dey do you go bow.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
And many more people still deh believe government to give them job after them graduate. I just deh laugh them weh never realise say job no deh for Nigeria. Just find wetin you fit do for yourself na wetin deh now. Nobody supposed deh look certificate to engage themselves for any job. Even okada riders now sef some be graduates. I wish say these people go know about bitcoin and join us for this online move to benefit themselves too.
The economy is bad though very bad, but no discourage other people's believe, I think I don see some even for our country wey get better job, they went to school studied a good course came out and had the believe and it work for them, I no gbadu our government one bit, but I always respect other people's believe, if you work hard and believe something go work out even if everyone dey complain e fit sure for you.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
why be say na only 9ja children abroad dey break dis kind record and only exceptional ones for 9ja fit get this doings

You go notice say those ones weh deh make us proud abroad for education na south if Nigeria them they always come from. I never hear of any northerner breaking records academically. This na observation weh somebody make and I agree with that 100%. Yet na these same people weh no too sound academically deh rule us for Aso Villa like say we be mumu.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Normally, even 4 year school no be 4 year exactly, should be around 3.5 years, but Nigeria go make ham 6 or more years after many ASUU strikes. This na just a painful discussion I no go like to discussed more further. Even, no job for Nigerias that spend the years dey study for school.
Ahhh baba I no wan go there, the koko be say many of us don suffer for dis strikes wahala, me na 6 years I spend for course were normally na 3+  years for University I see pepper for school walahi, but e no suppose be like dat, I don learn something say make u no go school sake of say you wan get job wen you graduate but try learn skills and hand work so that when you finish school we go fit be employers of Labor.

E possible oh, I no know for her case but e get people wey dey talented like mad to the extent dem dey dey like 9-12 years for college wey be our own university. This people get high IQ abi u never see small children wey Sabi maths to the extent dem fit multiply any number you give them even though na thousands or millions. I dey watch YouTube steady and they see this children doings.

For this our sister matter; congratulations to her, make she keep am up, e no easy oh.i hope say dem go put her for better school so she fit train her well.

I no say dis gal dey gifted me sef don see many like this girl but dey tin were dey wonder me be say why be say na only 9ja children abroad dey break dis kind record and only exceptional ones for 9ja fit get this doings nd e dey very rear to see amm 4 we country. I done conclude say no be say we no dey gifted for 9ja oooo but the problem na dey system. Our educational system needs a revamp. E don expire just like our Constitution don expire so.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Even, no job for Nigerias that spend the years dey study for school.

And many more people still deh believe government to give them job after them graduate. I just deh laugh them weh never realise say job no deh for Nigeria. Just find wetin you fit do for yourself na wetin deh now. Nobody supposed deh look certificate to engage themselves for any job. Even okada riders now sef some be graduates. I wish say these people go know about bitcoin and join us for this online move to benefit themselves too.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
As many people dey congratulate here others come dey talk say the gal achievement good but say e fit make here jump some kind childhood sense were she sopus get because of her age
What matters most? No be achievement. You know say some people that got the childhood experience no even dey experienced, many broken homes, poorness and the likes after the whole childhood thing.

I wonder when she start school actually be because, e no look possible or doable.
Yes, e no dey doable, but the girl story dey different, e no go school like other people, when her mum know she is grasping math easily, she dey teach her for home, na from home to tertiary school.

For this our sister matter; congratulations to her, make she keep am up, e no easy oh.i hope say dem go put her for better school so she fit train her well.
Congrats to her

If na Nigeria universities now dem go tell her parents say she never reach to get admission. We just deh like slow things for Africa. Oyibo no get time for all that.
Africa dey primitive, but I think this na exceptional case, but that Africa mentality go dey there, which go be a blocking wall for the girl success. Even some universities in Nigeria don make it compulsory for 13 years and below not to come school if they pass JAMB and UTME until dey are 14 years (I do not know how true this is anymore though).

Normally, even 4 year school no be 4 year exactly, should be around 3.5 years, but Nigeria go make ham 6 or more years after many ASUU strikes. This na just a painful discussion I no go like to discussed more further. Even, no job for Nigerias that spend the years dey study for school.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Abeg my people make una no vex say I want bring mata outside dey tin we bin dey talk before, I see something we're make me come dey reason some kind things. This mata na about 16 year old 9ja girl were don barge Ph.D. abroad ooooh.

Esther story na very impressive one. I don follow the matter online and she na pikin weh deh confident. Una see now say age no really get wetin e deh do brain. When you wan to teach small pikin something some people go say make you leave am, say the brain no go carry am. But all na lie lie. Even me weh be adult my head no carry maths pass the level of secondary school. Make we tell ourselves the truth. If na Nigeria universities now dem go tell her parents say she never reach to get admission. We just deh like slow things for Africa. Oyibo no get time for all that.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I wonder when she start school actually be because, e no look possible or doable. How can  person in just few years go archive watib on a normal, e ho take you at least 22years to archive normally. If we take eye look am or reason am on a normal level, e go way am gor real.

Jump to: