Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 199. (Read 1028948 times)

legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
From what I read today about the case I think it was just an amendment to the previous law on Party choosing their candidate ( now Party can decide whether to use Direct or Indirect Primaries) and also an Appeal to INEC to transmit results online BUT all still dey INEC hand weda to transmit it or not Na just appeal so I no see anything special about this case to be honest na just the same system.
Na true you talk my brother, all na still the same thing and with the way I see am cef eh, na this one worst pass. Them dey fine way to expand there range of excuses when something way no dey alright go sup. E go shock you say, people don dey strategies on how to better utilise the system them aan bring already to use play there wayo. Our Nigerian politicians, them sabi am.

I dey sure say most of us grow up saying and hearing people say you be 419 or you want do me 419. The 419 na a section of criminal code and infact e get 419A and 419B but them dey talk same thing abt taking wetin no be ur own wit wayo way.
Omo, this na confirm. Funny enough eh, we hear this thing, con sabi watin e mean but, na very few people of which, I no follow for inside way sabi say, this code na from constitution e come from. Omo, na so small something dey smart pass person o, I confirm am just now.
member
Activity: 67
Merit: 10
Make I just save this significant and most popular section of the Nigerian Criminal Code Act here.






I dey sure say most of us grow up saying and hearing people say you be 419 or you want do me 419. The 419 na a section of criminal code and infact e get 419A and 419B but them dey talk same thing abt taking wetin no be ur own wit wayo way.
This na konfam number you carry. U go try save am somewhere for history sake cos e make sense wella.
As for Binance wey accept NIN...I go say na welcome development cos na only NIN card I get and I go like create account with binance. This id card thubg don affect many people for our kontri cos many na only NIN dem get. To get voters card  nor easy na only election period person go fit do am. I dey happy as binance change thier policy to accomodate the challenges we dey face.Thank you for the information you do well
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
*Breaking News!!!*

*Binance don  finally decide to dey accept nimc nin paper id as a verifiable document.*

*It has been proven just hours ago...so if you never verify your binance you fit go try verify your binance account if you  are conversant with it.*

*Notify Ur Communities 🎺**Breaking News!!!*

BUT I never still confirm am, anybody dey here way never verify make him give am a trial and me self go dey try get one or two people way never do verification make them try am, I go come back come give feedback.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

From what I read today about the case I think it was just an amendment to the previous law on Party choosing their candidate ( now Party can decide whether to use Direct or Indirect Primaries) and also an Appeal to INEC to transmit results online BUT all still dey INEC hand weda to transmit it or not Na just appeal so I no see anything special about this case to be honest na just the same system.

Quote from: Senate
The bill is titled: “Recommittal of Amended Clauses of a Bill for an Act to repeal the Electoral Bill, 2021 and Enact the Electoral Act, 2021”.

The controversial clause 52(3) is now amended to 52(2), which reads: “Subject to section 63 of this Bill, voting at an election and transmission of results under this Bill shall be in accordance with the procedure determined by the Commission (INEC), which may include electronic voting.”

Full News Here
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Meanwhile i bin dey tink saw na south west dem wan hand over d nex election for presido and dem people for Yoruba land no want Tinubu and com dey claim no election com 2023 in South West, agitating for "Yoruba Nation" even d Tinubu sef dey London since and d old papa sef no dey kampe for bodi o e bin seek with several operations wey he don do.

4d election mata gbege go plenty o bcos pipu dey yarn say no voting again of wich me a beliv its not possible but APC mata 4 naija don finish after buhari.

Make e no shock you oh, na Northerners get presidency, like dem go for their strategy wey be say dem fit win any election free and fair. Who dey vite here nobody, everybody dey claim big people dem but do there ehh, everybody dey come out come vote and provided na their own dem dey vote, every body they put hands in deck. If PDP no gree carry northerner dey no get chance to win as APC go just use their brother again and everybody go queue up for their back.

But another thing wey me now dey beg baba God make him touch our leaders make them do na electronic voting, make people fit dey sit down for their house cast their vote through electronically through internet, this one go really bring alot of good stuffs to the country.

If this one come out then na there dem finish work. The rigging go bloody ehh. You go just see one name wey we no even sabi become president or governments. On paper e for be the best for the country but nothing digital dun work for here. See as bank wahala full everywhere, which day self, I just get debit alert of 10k two times and the person I send am to no receive anyone. We still dey settle the mata sha.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
~snipe~
No be play o, the way our omo naija them dey carry beast up for the forum dey tortori me for body I swear. In that time way you talk eh, I sure say, our canda for the forum ho strong wella and for the crypto matter too. The thing go be say, make we no con use the way Monday dey hungry and call to person, carty dey do some kind bad bad things for here. Make we for dey change the bad name way some person don carty dey tag kontryman. Na small small but, better dey happen.

Omo, for the elcetion matter eh, if I tell you say, I dey expect change eh, that go be say I wan lie to you myself na em be that. Me no fit do that kind thing, I no fit lie yor myself say, outside this forum, naija sure like that. These men them go still find way, even to do am for our koro-koro eye!
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

IIRC, I thought I sent you similar message recently. Continue to post good, can't wait to see you in hero.
Happy to see you guys making it to the top, make we try put better reputation for the forum cause na big advantage to us from what I'm seeing in the next 2-3 years if at all we still dey here I see most of my oga dem
reaching Lagendary status. Keep going we shall all get there

NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

Last election all the results were transmitted electronically to Abuja too I was chanced to handle the card reader and I can body tell you that all the results were sent to Abuja after every voting day and all the message I sent was successfully, I was surprised say INEC denied everything. Well if the bills are passed successfully e go still make sense too at least e go become a law rather than personal decision thing... But nothing go still change.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

See as dem talk am
Quote
The Senate on Tuesday passed a bill to rescind its decision which subjected the Independent National Electoral Commission to seek approval from the Nigerian Communications Commission before it could transmit elections results electronically.

The upper chamber also voted in support of the conduct of party primaries only by direct method.

Still never understand the mata fully sha as things no dey too straight forward for this country although this matter worth our discussion so I say make I bring am come table.
I no know why it dey always take Nigeria time make them move from backwardness carry things go front, Nigeria don big pass old levels of voting, which dey make them no fit give accurate results of people wey vote and the old system they very is for government manipulation, I dey Happy sey this news dey come out, e give me hope sey nigeria go dey get better election soon, but still dem get nothing wey my country no fit do, for their mata when e enter corruption dem fit do anything, we really hope sey the next election go bring small joy to wetin dey happen for we country.
member
Activity: 67
Merit: 10
NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

See as dem talk am
Quote
The Senate on Tuesday passed a bill to rescind its decision which subjected the Independent National Electoral Commission to seek approval from the Nigerian Communications Commission before it could transmit elections results electronically.

The upper chamber also voted in support of the conduct of party primaries only by direct method.

Still never understand the mata fully sha as things no dey too straight forward for this country although this matter worth our discussion so I say make I bring am come table.
Baba na we dey this kontri only we nai know as e dey be. Nor be the same government talk say opposition party don hire Yahoo boys to hack the electronic voting. Before any party dey ginger for something know say them don do underground work for corner. Naija na cruise abeg no permanent enemy no permanent friend. Everything na politics na the masses head them dey use jam. Make election time reach you go see people way carry umbrella and broom go dey fight themselves. I pray make we wake up 2023
full member
Activity: 140
Merit: 128
NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

E for make sense o if dey go folow d nomal protocol but come to tink of it, wat if dem go bring one manipulated result come dey show us say na wetin we vote be dat as u knw say we d masses no get access to dem computer, or better still as pesin dey vote make d results dey show immediately on data and d same day dem go announce d results and winner, if dem no go give room 4 orijo walai e go make pass bcos for computer too orijo plenty yanfuyanfu.

Anoda tin be say dem fit do d election vote as pos take dey operate now, after you vote ur result among other votes go just print out immediately, see if we no go use awa naija orijo e for make sense, or make revolution com make all dis our old leaders dem die all make new political era begins.

Meanwhile i bin dey tink saw na south west dem wan hand over d nex election for presido and dem people for Yoruba land no want Tinubu and com dey claim no election com 2023 in South West, agitating for "Yoruba Nation" even d Tinubu sef dey London since and d old papa sef no dey kampe for bodi o e bin seek with several operations wey he don do.

4d election mata gbege go plenty o bcos pipu dey yarn say no voting again of wich me a beliv its not possible but APC mata 4 naija don finish after buhari.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass
Haha, this one na welcome development oooh, e sweet my belle die, no be say na this one won solve the problem wey we get with bad governance, but as many of us know, rain na drop after drop the water dey take full bucket, this na one step in the right direction, this one if them dey really honest, fit bring alot of good changes to our electoral process as e fit end election rigging for good.

But another thing wey me now dey beg baba God make him touch our leaders make them do na electronic voting, make people fit dey sit down for their house cast their vote through electronically through internet, this one go really bring alot of good stuffs to the country.

In conclusion, them passing this bill na good thing, na good step in the right direction, and like I talk before, na drop after drop rain water dey take full bucket, more good steps dey come wey go really make our country the giant of africa again.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

See as dem talk am
Quote
The Senate on Tuesday passed a bill to rescind its decision which subjected the Independent National Electoral Commission to seek approval from the Nigerian Communications Commission before it could transmit elections results electronically.

The upper chamber also voted in support of the conduct of party primaries only by direct method.

Still never understand the mata fully sha as things no dey too straight forward for this country although this matter worth our discussion so I say make I bring am come table.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
^^

This your message dey relay big message to everyone, no be just the fun fact say that digit merit dy your profile but to understand and digest our naija criminal code dy very important.
Those weh get eye make dem look the section wella, e go save you from future wahala.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624



Gozie51, that your merit number de somehow o. Some people fit begin think say na you be the main 419 kingpin  Grin We fit send this picture to efcc make them follow us look into the matter sef.

Make una see my armpit oo, nothing dey dere. The tin self dey somehow wey make me say make I save am here Grin
 
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The problem no be say we lose for the match, no be that one at all. The problem na the kind small country we beat us. If we lose to Ghana, Cameroon, South Africa or Senegal, Côte d'Ivoire, person no go complain at all na. Who be Central African Republic if to say our boys de highly committed to the game. To de carry mind put for Nigeria match na for person to de give himself better heart problem. Even Gernot Rohr we be our coach, I no understand wetin dem de pay am for.

Our men come beat CAR back. As them disgrace us for our soil na so we disgrace them back for their house. E good like that.



Gozie51, that your merit number de somehow o. Some people fit begin think say na you be the main 419 kingpin  Grin We fit send this picture to efcc make them follow us look into the matter sef.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

IIRC, I thought I sent you similar message recently. Continue to post good, can't wait to see you in hero.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Make I just save this significant and most popular section of the Nigerian Criminal Code Act here.






I dey sure say most of us grow up saying and hearing people say you be 419 or you want do me 419. The 419 na a section of criminal code and infact e get 419A and 419B but them dey talk same thing abt taking wetin no be ur own wit wayo way.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Well done my country people e take me time to fit find una for this place. Why we hide here na anyhow sha I thank God say I don finally bsee my people. I nor too dey active for here but as I don see una so believe me I go dey enter wella. My calling na to dey play chess na my favorite thing for the world be that. Anybody way sabi play here make e send me message make we connect for LilChess
I buy my first Bitcoin this year as I see how much those boys way get Patricia dey make.  Now I know say something dey special about this Bitcoin something
 Username: KarpovE4
Gender: Male
Skills: Chess Player
You do well to don show here las las and e go sure say, we get another person, one of our own way go help carry thusbolace up. Brother, I no ho tell you say e easy for here but, I go say make you dey do that thing way come from you and be you. Na that kind time you go con dey enjoy the life. When you go dey use to the forum, outside life go tire you, e go be like say you go holiday but, na just to ye you say, e don turn  lifestyle and no be hustling o.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
         Samzuga coin
I greet the house, I no go use any big grammar for this mata wey I won bring up now, for some weeks now I been dey follow this alt-coins wey the name be samzuga coin, the price of this coin high die, but we know for crypto-currency the value for e coin to end for the price of the coin, due to my curiosity I been dey search for more information about the samzuga coin mata, I don follow them for telegram and even whatapp, and them dey talk many positive things about this coin wey the owner na Anglican bishop I think for nigeria, and the man no dey stop to hyping the coin. I one know wetin una think about samzuga coin.
I don know about this coin very long time ago, even when I be dey do Uber/bolt driving work for asaba, I dey see their billboard well well, that time, the price of this coin dey between $60 and $80 usd, I no look their way that time cus 1. I no really dey serious with investment in crypto currencies that time, and 2. I feel say the price too dey expensive based on say I no see any utility for the coin.

Na one time this year na im I come read for news say this coin don pass $200,000 usd oooh, omooo, I shock ooo,  Shocked Shocked, but when I come check the coin for coinmarketcap, I see say e never get any better exchange wey list am, and as such, no volume, the price of the coin get huge gap between the exchanges wey e dey trade on...

Long story short be say, I don know about this coin Tey Tey when they price dey way cheaper than it is now, but then, I no regret at all say I no buy this coin that time because the price movement no dey pure at all, and this coin still follow for coins wey I dey avoid at the moment.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The coin dey coinmarket cap, and their telegram group dey very active, but I still no see the coin as one wey get or go get value, forget sey na Bishop get am with is team, crypto-currency matter no be by Bishop, I don even see there vendor stands for my area where you fit buy or even sell zuga coin, I no know the coin much but the enthusiasm from the team and hard work are much, but the koko now be sey person no fit predict what the coin go do in future, the coin has its own special wallet join, but the thing still looks like something wey a low budget Dev organise for them.

Zugacoin advertised last year and come list around December period for exchanges we de both Coingecko and Coinmarketcap. Now, na for only Coinmarketcap de show am. E com be like say e no de Coingecko again o. The price don touch $200k one time too but the thing be like wetin no de pure. Different prices with huge gap for the 3 exchanges we them list am. If una check Coinmarketcap una go see am. Me, I go avoid anything we get to do with that Zuga.
Jump to: