Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 200. (Read 1029239 times)

member
Activity: 686
Merit: 19

but I realize something we no be better supporters, nigeria don win two of their last qualifiers but you no go see any body say congratulations super eagles but once them lose e go be as if we dey wait on them to lose before now, omo make we dey support dem, even PSG lose their last league game, so did Baryern Munich, na football be that.

The problem no be say we lose for the match, no be that one at all. The problem na the kind small country we beat us. If we lose to Ghana, Cameroon, South Africa or Senegal, Côte d'Ivoire, person no go complain at all na. Who be Central African Republic if to say our boys de highly committed to the game. To de carry mind put for Nigeria match na for person to de give himself better heart problem. Even Gernot Rohr we be our coach, I no understand wetin dem de pay am for.

My niqqa you don talk wehtin sweet my Belle now, them dey pay that old man way suppose to dey go fishing too much money but yet h team still dey under perform.......9ja tire person no be lie.
member
Activity: 67
Merit: 10
Well done my country people e take me time to fit find una for this place. Why we hide here na anyhow sha I thank God say I don finally bsee my people. I nor too dey active for here but as I don see una so believe me I go dey enter wella. My calling na to dey play chess na my favorite thing for the world be that. Anybody way sabi play here make e send me message make we connect for LilChess
I buy my first Bitcoin this year as I see how much those boys way get Patricia dey make.  Now I know say something dey special about this Bitcoin something
 Username: KarpovE4
Gender: Male
Skills: Chess Player
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
The coin dey coinmarket cap, and their telegram group dey very active, but I still no see the coin as one wey get or go get value, forget sey na Bishop get am with is team, crypto-currency matter no be by Bishop, I don even see there vendor stands for my area where you fit buy or even sell zuga coin, I no know the coin much but the enthusiasm from the team and hard work are much, but the koko now be sey person no fit predict what the coin go do in future, the coin has its own special wallet join, but the thing still looks like something wey a low budget Dev organise for them.

The Way dis kin coin be now, person never too sure about the coin and forget say na our own coin anything fit happen, the coin fit do well and he still fit fall person hand so my suggestion be say if you wan invest for this kind coin make you no too put plenty money like that.
full member
Activity: 140
Merit: 128
according to wetin we bin dey read ontop zugacoin mata dem talk say na him be d numba 1 ogbonge crypto to get launch in dis awa afrika so, d amount he take worth is around eighty sometin thousand dollars but pipu con yarn say e no mean say as him prize berekete for group no mean say na him get value pass other Cryptocurrency, and dey talk say d coin now dey kampe 4 any form of crypto exchange.

wetin be na say to me i tink zugacoin is coming up with something big o but e no go dey eazi 2 counter d Bitcoin and d likes ogas, i recal say d man don dey work tehteh ontop him zuga project o nd d tin be say pesin fit giv trial if u bin get any smal change u no make use of sha.... but d man jst dey come up sha but make him no reason say him tilte as Bishop get related to crypto make e no go loose guard.
som of him tori plenti ful hia
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
The coin dey coinmarket cap, and their telegram group dey very active, but I still no see the coin as one wey get or go get value, forget sey na Bishop get am with is team, crypto-currency matter no be by Bishop, I don even see there vendor stands for my area where you fit buy or even sell zuga coin, I no know the coin much but the enthusiasm from the team and hard work are much, but the koko now be sey person no fit predict what the coin go do in future, the coin has its own special wallet join, but the thing still looks like something wey a low budget Dev organise for them.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
         Samzuga coin
I greet the house, I no go use any big grammar for this mata wey I won bring up now, for some weeks now I been dey follow this alt-coins wey the name be samzuga coin, the price of this coin high die, but we know for crypto-currency the value for e coin to end for the price of the coin, due to my curiosity I been dey search for more information about the samzuga coin mata, I don follow them for telegram and even whatapp, and them dey talk many positive things about this coin wey the owner na Anglican bishop I think for nigeria, and the man no dey stop to hyping the coin. I one know wetin una think about samzuga coin.

Omoh this kind coin self only the name dey even fear me self cause I never come across for this internet space but I go look up and make some research and come back to this topic make I fit throw more lights to it. This one I dey hear Bishop matter for crypto matter so e go pure so. So many coins for martjet now an pure scam oo e plenty die even the ones you put hope self
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
         Samzuga coin
I greet the house, I no go use any big grammar for this mata wey I won bring up now, for some weeks now I been dey follow this alt-coins wey the name be samzuga coin, the price of this coin high die, but we know for crypto-currency the value for e coin to end for the price of the coin, due to my curiosity I been dey search for more information about the samzuga coin mata, I don follow them for telegram and even whatapp, and them dey talk many positive things about this coin wey the owner na Anglican bishop I think for nigeria, and the man no dey stop to hyping the coin. I one know wetin una think about samzuga coin.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928

Nigeria go better, but I believe say no be now so make we just dey leave am the way he be, make we just they survive.
How nigeria one take better if we leave am, if to sey those who fought for set make the slave trade end talk like this by now that thing for dey go on, we be nigerians and if we continue to dey talk like this, not voting, supporting evil, selfishly surviving because we can, and those that can't go dey suffer then I no think sey this whole thing go end, make we stand up and do wetin we fit do, and even though e no go end now but we go dey part of the change wey go bring am to an end in the future.

Me I get what you're saying, but it's been a long time since Nigeria has been spoiled, and one person no fit just stand up one day and repair am, or we no fit just vote person enter one day and him go repair Nigeria. because even our youths way people dey talk about are corrupt, most of them are after money na why even yahoo don plenty be that if Nigeria go better, I believe all dis generation way dey go don clear because most of us way dey dis generation now don corrupt and imagine you dey hold position and you no corrupt and your other members corrupt they will definitely be looking for your downfall some will even want to kill you so me I believe Nigeria go better but he go take time.
Because one person no fit just come change Nigeria, if Nigeria go change na gradually because na gradually he spoil and no be one person spoil am,  no be one year dey use spoil am. So if Nigeria go better he go still take time. But make we continue to dey pray and try our possible best to influence people around us positively and with time Nigeria go better, Nigeria will be great again.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Nigeria go better, but I believe say no be now so make we just dey leave am the way he be, make we just they survive.
How nigeria one take better if we leave am, if to sey those who fought for set make the slave trade end talk like this by now that thing for dey go on, we be nigerians and if we continue to dey talk like this, not voting, supporting evil, selfishly surviving because we can, and those that can't go dey suffer then I no think sey this whole thing go end, make we stand up and do wetin we fit do, and even though e no go end now but we go dey part of the change wey go bring am to an end in the future.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

but I realize something we no be better supporters, nigeria don win two of their last qualifiers but you no go see any body say congratulations super eagles but once them lose e go be as if we dey wait on them to lose before now, omo make we dey support dem, even PSG lose their last league game, so did Baryern Munich, na football be that.

The problem no be say we lose for the match, no be that one at all. The problem na the kind small country we beat us. If we lose to Ghana, Cameroon, South Africa or Senegal, Côte d'Ivoire, person no go complain at all na. Who be Central African Republic if to say our boys de highly committed to the game. To de carry mind put for Nigeria match na for person to de give himself better heart problem. Even Gernot Rohr we be our coach, I no understand wetin dem de pay am for.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I just dey laugh when I dey listen to radio station this morning wey some guys come dey talk about bitcoin investment program lol.
Dem dey advertise dey ask people to send YES to the numba wey dem call out for interest and seat reservation. As usual with Nigeria stuff na, greedy people wey think say na them first sabi new thing go like go public to collect public money take join there own take travel outside  Grin

I dey wonder wetin dem want tell the participants wey no go end for register with certain money and invest with another money and within one month, gbemu or big alert go begin show up but them go forget say bear dey oo, that one go dey hidden from participants. And finally finally, dem go chop people money waka. No be today wey ynash don dey for back oo. We wey dey here dey privileged and know better.


Unfortunately my brother, the people wey be the organisers of all those kind parole dey still dey cash out. Truth na say, as you talk am say we wey dey here dey privileged, my brother plenty people still dey wey nor get that privileged ooo, and based on poverty dey our country well well, people wey dey find way to get from bitcoin sake of say dem dun hear the story, go still fall prey to all this kind people wey dey take advantage of them. Na the sad reality be that. Information dey free now to a large extent, but many people still nor know where to get am from.
hero member
Activity: 1484
Merit: 928
I just dey laugh when I dey listen to radio station this morning wey some guys come dey talk about bitcoin investment program lol.
Dem dey advertise dey ask people to send YES to the numba wey dem call out for interest and seat reservation. As usual with Nigeria stuff na, greedy people wey think say na them first sabi new thing go like go public to collect public money take join there own take travel outside  Grin

I dey wonder wetin dem want tell the participants wey no go end for register with certain money and invest with another money and within one month, gbemu or big alert go begin show up but them go forget say bear dey oo, that one go dey hidden from participants. And finally finally, dem go chop people money waka. No be today wey ynash don dey for back oo. We wey dey here dey privileged and know better.

My people perish becos dem no wan sabi sometin. Far back self, I no tink say those kind tin fit catch me make e come be now. Flex guys, who go take me out dis weekend joor Roll Eyes
Baba, e be like say na the eastern part of NAIJA you dey ooh, cus me lodge for asaba currently and na almost everyday I dey hear that their advertisment ontop wazobia Fm onitcha, if I dey hear that their ad, I dey always dey laugh too, and sincerely, I dey always dey pity people wey go believe that their crap come dey send yes yes, those scammers go just use them chop.


By the way guys, una see the latest wey happen on Thursday,? Nigerian army arrest popular Nollywood actor, Chinwetalu Agu say because him dress in Biafra outfit... Though through the help of Ohaneze ndi igbo, they don release am today, my question now be say, where Nigeria really dey go???

Follow the news here*** https://punchng.com/agn-commends-ohanaezes-efforts-towards-chiwetalu-agus-release/?utm_source=auto-read-also&utm_medium=web

***https://punchng.com/this-is-rising-sun-not-biafra-not-eastern-security-network-actor-chiwetalu-agu-defends-outfit/?utm_source=auto-read-also&utm_medium=web

***https://punchng.com/chiwetalu-agu-dons-biafra-outfit-after-release-from-military-custody/?utm_source=auto-read-also&utm_medium=web



Nigeria go better, but I believe say no be now so make we just dey leave am the way he be, make we just they survive.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I no go really blame those people wey day believe the advert for radio, many of them been don dey watch that radio station for years and many times e never fail them, me I go blame the radio station wey let those people advert, I know the advert na how this radio station dem dey take maintain themselves, but wen e don enter finance and health advert I go think say radio stations suppose dey very careful so dem viewers no go suffer.

About chiwetalu agu matter, I think say the army don release am, and that be say him be popular, legendary actor if no be so e for really bad for am, am happy say the old man is out and this kind of thing no go for the image of we own country military.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I just dey laugh when I dey listen to radio station this morning wey some guys come dey talk about bitcoin investment program lol.
Dem dey advertise dey ask people to send YES to the numba wey dem call out for interest and seat reservation. As usual with Nigeria stuff na, greedy people wey think say na them first sabi new thing go like go public to collect public money take join there own take travel outside  Grin

I dey wonder wetin dem want tell the participants wey no go end for register with certain money and invest with another money and within one month, gbemu or big alert go begin show up but them go forget say bear dey oo, that one go dey hidden from participants. And finally finally, dem go chop people money waka. No be today wey ynash don dey for back oo. We wey dey here dey privileged and know better.

My people perish becos dem no wan sabi sometin. Far back self, I no tink say those kind tin fit catch me make e come be now. Flex guys, who go take me out dis weekend joor Roll Eyes
Baba, e be like say na the eastern part of NAIJA you dey ooh, cus me lodge for asaba currently and na almost everyday I dey hear that their advertisment ontop wazobia Fm onitcha, if I dey hear that their ad, I dey always dey laugh too, and sincerely, I dey always dey pity people wey go believe that their crap come dey send yes yes, those scammers go just use them chop.


By the way guys, una see the latest wey happen on Thursday,? Nigerian army arrest popular Nollywood actor, Chinwetalu Agu say because him dress in Biafra outfit... Though through the help of Ohaneze ndi igbo, they don release am today, my question now be say, where Nigeria really dey go???

Follow the news here*** https://punchng.com/agn-commends-ohanaezes-efforts-towards-chiwetalu-agus-release/?utm_source=auto-read-also&utm_medium=web

***https://punchng.com/this-is-rising-sun-not-biafra-not-eastern-security-network-actor-chiwetalu-agu-defends-outfit/?utm_source=auto-read-also&utm_medium=web

***https://punchng.com/chiwetalu-agu-dons-biafra-outfit-after-release-from-military-custody/?utm_source=auto-read-also&utm_medium=web

hero member
Activity: 2520
Merit: 624
I just dey laugh when I dey listen to radio station this morning wey some guys come dey talk about bitcoin investment program lol.
Dem dey advertise dey ask people to send YES to the numba wey dem call out for interest and seat reservation. As usual with Nigeria stuff na, greedy people wey think say na them first sabi new thing go like go public to collect public money take join there own take travel outside  Grin

I dey wonder wetin dem want tell the participants wey no go end for register with certain money and invest with another money and within one month, gbemu or big alert go begin show up but them go forget say bear dey oo, that one go dey hidden from participants. And finally finally, dem go chop people money waka. No be today wey ynash don dey for back oo. We wey dey here dey privileged and know better.

My people perish becos dem no wan sabi sometin. Far back self, I no tink say those kind tin fit catch me make e come be now. Flex guys, who go take me out dis weekend joor Roll Eyes
full member
Activity: 140
Merit: 128

NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.

I swear dis na raw beans ... Imagine dem go dey pay undergraduates moni wen d graduate sef wey dey work neva get gud package arrange for am, nawaooooo right from the time i bin dey hear dis news i don knw say e no fit possible, else dey wan cos kasala, y dey go dey pay som undergraduates without paying other graduates studying other courses.

Anoda tin be say there's no gud schemes of service/proper condition of service put in place 4d existing teachers, i can remember d one dem do for feeding primary school pupils wey no dey effective at all, some sef don stop dey giv d children d food, see d mata 4 exited npower pipu wey no get head and tail dey are still hanging around, dey bin promise to giv dem fed. govt job as permanent but till d present regime go finish we no go hear anytin, and nex govt go scrap d whole thing.

Still on d mata 4 d said amount sef he dey do me one kind oooo minimum wage 4 govt wonker bin 30k nd u wan dey give undergraduates 75k na 4 wia dem dey do dat, abi na kaikai dey wori dem all 4 d fed govt. Npower sef na 30k dem dey kolect and most of them be graduates, awa corpers na 33k be dem allawee. Must dey fool d pipu wit unrealistic jagons and dead mata wey dem no fit realise or achieve?...dis one heavy me o.

No be all of us be illiterate o walai..... Na so yoruba pipu dey yarn dey talk say "ko si oboh (monkey) ni idanre mo" meaning no more monkey 4 idanre land, all of dem don wise up be dat. Awa govt no knw say we don pass dat kind level wey dey go dey tell us papa ajasco tori 4 film.
God no go shame us o.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Omo bigman, na true you talk for here o, we no dey sabi clap for better and no be just we, na the society we find ourselves. E dey and before you see person appreciate better, except the better na the type way too good. Na that kind time you fit see one or two person go say you try. Oya na, try do one small thing way bad, na once many many people go just chop you for mouth finish con carry tooth peak clean mouth. Na so the life just be.

Though, in this case eh, our team no do well o. To loose no sure normally but, e get teams way you go loose to and people go understand say, e hard but, no be this kind one. Them suppose win this one at least and for our ground for that matter, na fk na.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Una see how the thing come be this night again as our super chickens no fit beat common Central African Republic for Nations Cup Qualifier for our home ground o. Our home ground o. When this people go stop to de disgrace this country like this sef. The thing na big shame. I hear say Karl Namnganda, the player we score against us na for 2019 na him e score last for their national team. Na for Nigeria we match rusty players de become active players and sharp shooters. We don suffer.
I really dey disappointed with the nigerian football team, how we go dey think to qualify to the world cup and dey lose at home to central republic, I no sure say majority of the players from that country na full time professional footballer, e really dey choke me as I dey talk am, but I realize something we no be better supporters, nigeria don win two of their last qualifiers but you no go see any body say congratulations super eagles but once them lose e go be as if we dey wait on them to lose before now, omo make we dey support dem, even PSG lose their last league game, so did Baryern Munich, na football be that.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

Una see how the thing come be this night again as our super chickens no fit beat common Central African Republic for Nations Cup Qualifier for our home ground o. Our home ground o. When this people go stop to de disgrace this country like this sef. The thing na big shame. I hear say Karl Namnganda, the player we score against us na for 2019 na him e score last for their national team. Na for Nigeria we match rusty players de become active players and sharp shooters. We don suffer.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
NEW TOPIC: Undergraduates studying education in public varsities to get N75K per semester Una people dun come with another fake promise, and if den go even do am e no go last like N-Power. Wetin una dey think of this news like dis.
One thing for life be say, e dey very easy to talk than to do. That na normal thing, matter like this for we country eh, I no mind who talk am via say, them no go do am. Las las, one government go propose the matter, the other one go commot am for ground. Na so we country just be. Besides, how them wan even raise the money cef, abi na with all this borrow-borrow way them dey do... omo, the matter don weak me for the baba them way dey seat down for our chair.
If e possible cef, China go just come carry this country for head carry go drop inside there fence. Because like this eh, them don sell this country finish. Anyhow shah, that na under graduate students matter, make una try.

On the language matter, I get watin Brainboss dey talk but the thing be say, e no just dey inside the guy. Pighin writing na for hard-core pighin users I tell you. If na watin the G dey form, we for don confirm am by now. On the stats matter way Igehhh dey talk and Brainboss don recap so, na true. Stats go sure for one person when the others no dey put effort to improve on posting, I no commot myself for the matter.
Make we dey try shah, we go reach one day!
Jump to: