Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 74. (Read 1019898 times)

full member
Activity: 882
Merit: 207
What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol
This is not a problem at all in my opinion. Why? due to the fact that they were not made to attend the funeral service. They chose to attend. They had to comply with their rules and regulations as a result. Second, everyone is aware that the Beast follows the US president everywhere he goes. There are those who, in contrast to our African leaders, would kill the US at the least opportunity. Remember JFK? Furthermore, it is not like any African nation is a super power to be able to call the shots.
One thing to note also is this; Britain colonized America in the 16th century and almost half the world. America and Britain are more like siblings, if I may. African leaders mostly those to whom there is little or no control over by the Britain, are supposed to comply to the rules as guests or as trades partners would. It is totally not out of place to be treated in the aforementioned manner, also as rightly quoted, una no be super power na.  See as dem dey happy for inside the bus sef.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
<...>
Welcome my brother, me i like as you take they approach forum matter oh, it is very good to start by reading, because on how you read wella, come garner better knowledge, when e don reach time for you to post, you go always get better quality and constructive posts to make. Thank God say you don locate this our local thread so, we don they here for sometime now, but we they hope say small time we go park comot from here go local board. As your username be Chilwell so, i guess say you be Chelsea fan, make i use this opportunity tell you say this season go hard for una well well, Grin Grin welcome bro.
What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol
It is what it is, nothing much they for this matter, you no go compare any president with that of the U.S.A, their president go always get preferential treatment in any official international gathering. If you be president and you no like the protocols wey they for the burial, then no go, na so the matter be.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol
This is not a problem at all in my opinion. Why? due to the fact that they were not made to attend the funeral service. They chose to attend. They had to comply with their rules and regulations as a result. Second, everyone is aware that the Beast follows the US president everywhere he goes. There are those who, in contrast to our African leaders, would kill the US at the least opportunity. Remember JFK? Furthermore, it is not like any African nation is a super power to be able to call the shots.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Wetin una go call this level of insults to our African Presidents?

For the Queen's Funeral: President Biden Arrives at Buckingham Palace with em Presidential Armoured Convoy While African President wey come for the burial Were Blocked and Convey inside a Bus.

What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol
full member
Activity: 882
Merit: 207
[/url]
Reno used to be a big and respected figure on social media particularly during the #endsars protest, where he was largely and always in support of the youths, and spared nothing in criticizing the excesses of the present APC government. But since recently, he is still big but gradually now loosing any respect he has because of talking too much on the internet. There are many persons like myself who do not take him seriously.
I have no issues with Reno. I always like his yarns but there's also a thin line between overdo and stupidity. Nigeria needs a mouthpiece of some sort to alert other citizens of happenings that concern our government. He was instrumental during the end sars protest and as that subject has seemed to die down, the next item on the list is to find other suitable topics to express himself. There are times when it his story corroborates well with stories from other sources, because he is not based here in the country. The thing is just to filter out whatever gibberish that doesn't rhyme well and also investigate further into whatever light he shares. The same goes for all other political or individual mouthpieces whose sole responsibility is to relate far-reaching or close-quarters headlines. Please filter out only the sense from all the nonsense.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
[/url]
Reno used to be a big and respected figure on social media particularly during the #endsars protest, where he was largely and always in support of the youths, and spared nothing in criticizing the excesses of the present APC government. But since recently, he is still big but gradually now loosing any respect he has because of talking too much on the internet. There are many persons like myself who do not take him seriously.
full member
Activity: 303
Merit: 136
Defend Bitcoin and its PoW: bitcoincleanup.com
Them say them don begin block roads from Lagos Ibadan express road but e be like say dem want touch the government officials directly by blocking the airports. Make we still put ear down to hear how the protest go today.

This one na beta thing oo because he be like the only thing wey this government they hear na protest imagine say common aide to politician dey collect money pass Professor. I bin dey talk say ASUU greedy before but na now my eye clear after I see there salary scale. I pray this protest go comot beta result but abeg if you follow dey protest make una do well not to spoil any properties for road side because na we go still later suffer am
sr. member
Activity: 630
Merit: 453
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
Username: Chilwell
Gender: male
State of resident: Niger state

Good day my country people I dey greet whona, I join this forum since last month but I dey busy dey read the rules for every where I come see 9ja boards, I come use like one week go through 9ja board, I come see say na for here I go do my first post becos na my house be this. I come surprise say this board don dey here like three years now or more. D person wen I just first see na cryptopreneurBrainboss, oga you don try well for us and the hard work wen you dey to make things better. I go try contribute for here too. I am very happy to be home. I dey greet everyone wea dey here again
sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Abeg make onah check diz 2 politicians and their matter.

I say make I enter my fcebok yesterda, Nia I jam diz post, way Reno Omokri talk say nah Obi sponsor lawyer way sue am.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
The Asuu matter don tire person. Make dem kuku turn our tertiary universities to vocational learning centres. E go pay right now pass say students just sit down for house dey put hand inside tins wey no make sense, all because of say dem dey find moni. The truth finally be say, na entering government go fit resolve this issue, because even if this current try resolve the matter, na on top false promise the tin go end. A compromise needs be reached at a quick pace because e get as e go be say dem call off strike but students no gree resume.

Still on still on top the Asuu strike, Nigerian Students want begin the closure of the airports starting with Murtala Muhammad International airport today in solidarity to Asuu and make government for listen and resolve the strike issue but police authorities said the students “are free to come out and see what awaits them.”

Them say them don begin block roads from Lagos Ibadan express road but e be like say dem want touch the government officials directly by blocking the airports. Make we still put ear down to hear how the protest go today.

legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Enviromentalists don they complain say mining they affect/destroy the enviroment, you know say this miners they use better sophisticated machines wey they consume quite a lot of energy/electricity wey community suppose use, so na the reason why ethereum comot from the POW consensus mechanism wey be say miners dy 'rugged' themselves so them go get Eth reward, and for them to be the winners of it more often than not, they gats buy better machines and run sophisticated mining farms wey people they complain about, that is why they don move go POS wey no require all of that, but just users staking their ethereum so them go fit participate for the ethereum network, though that one get im own cons sha.

Having said that, so the reason for the merge is just because them wan try an eco-friendly method to they create new ethereum. People don dy para say make Bitcoin too follow that same direction, but me i no believe say Bitcoin developers go leave POW to POS, rather than that ehn, miners go just reason better alternatives wey fit reduce the effect of POW on the enviroment.

Na so I want dis dis place bi. Where u bin de since? I no de 2 see 4 company, abi u bi new recruit? Who tok dat thin in Nigeria comedy? By d way, u r welcome, although you were in d forum since b4 I even join but dis is di 1st time I de see u. I really like nd love weti u tok. I don promised say, I go give d pesen merit we de tok Cryptocurrencies pass nd de de educate us, dat one na elderly pesen (from Sr. Member Rank) nai go tok who tok am pass so dat we ( eni Oda pesen) go do sharpali sharpali.

As u come tok am I come understand di thing Wella. If na like dat. Me I 4 like bitcoin dey use POS instead of POW. Yestadi sef, I come de ci sunlight we dem dey use dey mine bitcoin. Di environment na one of di tin Miners supposed consider because of living organisms but Dem no de consider bcoz of dia personal interest. Bitcoin developers should look into d mata nd use di best way 2 mine. Egberifa.
full member
Activity: 882
Merit: 207
The Asuu matter don tire person. Make dem kuku turn our tertiary universities to vocational learning centres. E go pay right now pass say students just sit down for house dey put hand inside tins wey no make sense, all because of say dem dey find moni. The truth finally be say, na entering government go fit resolve this issue, because even if this current try resolve the matter, na on top false promise the tin go end. A compromise needs be reached at a quick pace because e get as e go be say dem call off strike but students no gree resume.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Them say when two elephant Dey fight na the grass dey suffer am. This Asuu and Federal government back and forth waka don taya everybody. The lecturers sef don taya but nothing them fit do, the asuu committee get him own Kabal way dey run am and na people way nor even Dey depend on the salary nai full the kabal, their children nor dey public universities and na them dey make decisions for us. I nor know the day Nigeria go better
One of my lecturers say him nor get interest for Naija education anymore. Him talk say education don die for we Naija. According to am, wetin him dey find na Post Doc to Germany. Once him don Japa like this through this Post doc, na to find job and then collect PR for there. Truth be say I nor blame am sha, na the way wey our oga at the top them don turn the countri to. The tin pain me sef because before lecturer go open mouth tell you this kind thing you suppose know say water don pass garri.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Shey na dem talk say teachers reward dey heaven, maybe that an why our nails government dey do backhand on top matter wdy concern lecturers and professors salary. This Asuu matter big pass this salary something. Firstly dem dey complains say dey want new payment processors to dey handle their pay, next a gratuity wet government owes dem for some time since that Oga Jonathan era. The main one wey be the Koko na this change or upgrade of salary structure wet everybody dey aware of so.
Seriously, make the Naija government dey serious about giving adherence to these striking sectors. Na the future of our development dem dey play with so o.
Them say when two elephant Dey fight na the grass dey suffer am. This Asuu and Federal government back and forth waka don taya everybody. The lecturers sef don taya but nothing them fit do, the asuu committee get him own Kabal way dey run am and na people way nor even Dey depend on the salary nai full the kabal, their children nor dey public universities and na them dey make decisions for us. I nor know the day Nigeria go better
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
@Detritus, e be like say you missed it when @Agbe posted this some pages before in this thread, but no wahala as you don already post am, maybe for people wey no see am then too, but if you ask me ehn, wetin i think be say any of our user wey they active for forum go don see that thread where it was posted and sometimes no need to even post am here as fresh information, but nothing much sha, well done.

Thank you Coyster for Noticing.
Na small mistak u mak shah bt, d intention way u carry na beta one except say, d forum no dey smile wth dis act as dem go see am as spam. U don delete am shah bt d mata b say, u ft try 2 dey read few pages up b4 u post some tins nd like Coyster don talk, if u dey activ, u 4 don notice. Dat na to say, mak u dey try com here once once. Na home b dis, mak u no 4get home, put bodi 4 watin we dey do 4 home nd las las, we go dey on joy.
Mena why, I njoy d way u carri follow up d correction. U na correct guy.
member
Activity: 854
Merit: 13
A major concern of ASUU is not just for staff and lecturers welfare but also the welfare of students. if you follow closely on the news and some of the major reasons why ASUU is still on strike, you see that it is traced down to a breach in contract by the government on an agreement they had with them about pumping some certain amount of money (in billions) yearly for the rehabilitation of school facilities in the country as they are in a sorry state.
Oga no allow anybody deceive you with one side story. ASUU no dey fight for any student welfare na just about the welfarism of dem self. Na why dem dey kick against IPPIS, demanding for salary increments and EAA? Now fighting for the salary of the months dem dey strike to be paid. Where dem dey pay workers wey dey strike for this world? That one sef aside, The first batch released by GEJ administration wetin dem use am do? No tell me say TETfund ooo because yes we know say na dem struggle for the establishment of TETfund but na government dey fund am. Our house rent, food stuffs and some of our properties wey Don expire and spoil for school nko? Dem talk about it? Nothing wey you go fit tell me to believe say dem dey fight for students. We know say government dey fuck up tru tru but ASUU sef no be Saint. Dem be bird of the same feather.
My brother na true you dey talk I dey support you, I no say government dey 4cup but asuu no thank God because dey even get opportunity get white collar job dey still dey do enga. Dey no thick say dey dey block our chances say dey dey go do visiting lectures,since when dey start teaching that course dey go don get among is students wen go sabi d course na why dey no one give am appointment make in cover in space. Asuu dey gridi
member
Activity: 295
Merit: 98
@Detritus, e be like say you missed it when @Agbe posted this some pages before in this thread, but no wahala as you don already post am, maybe for people wey no see am then too, but if you ask me ehn, wetin i think be say any of our user wey they active for forum go don see that thread where it was posted and sometimes no need to even post am here as fresh information, but nothing much sha, well done.

Thank you Coyster for Noticing.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
<....>
@Detritus, e be like say you missed it when @Agbe posted this some pages before in this thread, but no wahala as you don already post am, maybe for people wey no see am then too, but if you ask me ehn, wetin i think be say any of our user wey they active for forum go don see that thread where it was posted and sometimes no need to even post am here as fresh information, but nothing much sha, well done, make i show you the @Agbe post wey i they talk about:
Pipo wey dey interested go nd apply 4 fillipone thread now. Bt pls b4 applying read di rules very well please oo. https://bitcointalksearch.org/topic/merit-share-your-best-poststhreads-with-fillippone-to-be-merit-assessed-5412657 I don't know if he is still doing but try your luck.

wish u all di best gud luck
member
Activity: 295
Merit: 98
Happy Sunday to my country men and women, I see something that will help us here so I decided to share.

One respected member in this forum with the name Fillipone and a legendary rank created a thread where he lay down some rules that will enable low rank Members earn merit on their quality post which can allow them rank up. He named the thread "[Merit] share your best post/thread with Fillippone to be a merit assessed".

Abeg unah make una make sure to read the thread very well before unah comment according to his request on the thread.

Here is the thread: https://bitcointalksearch.org/topic/merit-share-your-best-poststhreads-with-fillippone-to-be-merit-assessed-5412657

I just realized this same information has been passed by @Agbe on this page: https://bitcointalksearch.org/topic/m.60921473
member
Activity: 756
Merit: 30

Jump to: