Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 75. (Read 1019899 times)

hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
(~)

Frankolala which one is your comment here? I know that you quote someone and made a comment but your comment e dey another person's statement so at the end ur own come dey like copy nd post. pls make u try edit am so we go know which one be ur own.

Good observation@ Mate2237 I believe say Frankolala never still know how to doam well so that em comment go dey separate from person wey em quote.@ Frankolala edit your post check for the place wey quote dey you go see say you dom do mistake clean something for dia, e fit be one alphabet wey you mistakenly erase as you dey try to cut some word comot for person wey you quote, once you add that alphabet back before you post try preview your work before you post so that you go know if e dom dey separate or not, laslas you sabi doam well.

legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Weti make di Merge come dey necessary?
Enviromentalists don they complain say mining they affect/destroy the enviroment, you know say this miners they use better sophisticated machines wey they consume quite a lot of energy/electricity wey community suppose use, so na the reason why ethereum comot from the POW consensus mechanism wey be say miners dy 'rugged' themselves so them go get Eth reward, and for them to be the winners of it more often than not, they gats buy better machines and run sophisticated mining farms wey people they complain about, that is why they don move go POS wey no require all of that, but just users staking their ethereum so them go fit participate for the ethereum network, though that one get im own cons sha.

Having said that, so the reason for the merge is just because them wan try an eco-friendly method to they create new ethereum. People don dy para say make Bitcoin too follow that same direction, but me i no believe say Bitcoin developers go leave POW to POS, rather than that ehn, miners go just reason better alternatives wey fit reduce the effect of POW on the enviroment.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I know sae, we as Nigeria citizen like a higher pay jobs but no be each time you hear sae there's a business or job wey better pass the one you d do or think of doing, that go make you abandon the one you dey do already and ask about "how I go take do am?" No be hustling be that; na lack of focus. You no d kind to yourself.

Anytime wey em be, you go find job or business wey go better pass d one you d do or thinking of doing.

The goal no be to have the best job or business but na to do and make the best of your chosen job or business.

Abegy focus, my friend!
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Your Identity Na Him Be You Always

Wuna welldone my pple. Dis matter wey I wan yarn today don dey my mind to talk am since but I just neva manage talk am. D tin wey dey wonder me for dis our local board be say na d language wey some people dey use here. As I find dis our local board (thread) wey our Oga @CryptopreneurBrainboss start for three years now. For d description him talk say d official language here na pidgin nd oda local dialects wey dey we country. As I con dey here I see say some people dey use English talk for here without any pidgin, ahbi dem no sabi speak pidgin lyk odas?

Ahbeg make we try dey use pidgin here so dat anybody wey come here go know say na we dey here all, na d language wey we dey understand pass between ourselves for here be dat. Dis na sumtin wey we suppose dey proud of, make person dey ask for translation of wetin we dey discuss for here, just lyk d way if we go oda local boards we no dey understand wetin dem dey talk. I feel say if we continue dey use dis our pidgin wela for here, dey fit consider giv us our own local board make e no be just normal thread again. Even if we no too sabi, we fit learn for here and dey add am small small for our mata here.

Na wetin I get to yarn be dat my people. I dey hail all of wuna for here for wetin wuna don contribute for dis our local board. All of wuna face show nd wuna shoe shyn too.

weti u tok ecorrect, make we try 2 use d pidgin language so dat di forum look look pipo no go come here dey undastand weti wi dey tori nd tok here. Bt u no say pidgin na join nai dem join am with di oyibo language so some pipo no fit tok am di way u sabi am. so allow dose pipo 2 tok di language dem fit tok am 1st na small small nai dem go take learn bi dat.

A major concern of ASUU is not just for staff and lecturers welfare but also the welfare of students. if you follow closely on the news and some of the major reasons why ASUU is still on strike, you see that it is traced down to a breach in contract by the government on an agreement they had with them about pumping some certain amount of money (in billions) yearly for the rehabilitation of school facilities in the country as they are in a sorry state.

According to ASUU, the agreed amount was only paid once during the Jonathan administration and since the buhari administration, the government have been unable to meet up with the agreed amount for a year and have not paid for a couple of years hence the decision to go on strike. I watched and heard this from an interview ARISE TV had with one of ASUU's officials during their regular Morning show, and the amount stated that was agreed was about 250billion naira yearly for like five years, since the government said they couldn't pay all at once. Jonathan paid one of the first deposit completely to ASUU, but since Buhari's Administration, they have not been able to pay 200 billion completely, how poor and unconcerned!!!

Federal universities in Nigeria are in a sorry state, old dilapidated small and uncomfortable lecture halls, classrooms and other structures, we have dilapidated student hostels with no or poor toilet facilities, as well as empty school laboratories...So how can students learn comfortably? Our Federal higher institutions cannot compare with that of some other African countries, If we really pride ourselves as the giant of Africa,  our government needs to be held to responsibility.

When an illiterate rules Literates this would definitely happened. As 4 me I no dey suprise at all. Di education Minister did not read Education in university. Read this Adamu Adamu []/url] Nigeria is a fail state.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Binance/Ethereum Merge Completed

Weti bi meaning of Merge?

Merge na part of di upgrades wey Binance do 2 join Ethereum network  nd make it more available for everibodi. Di Merge come move di network 4rom a proof-of-work blockchain 2 a proof-of-stake blockchain.

Weti make di Merge come dey necessary?

Na proof-of-work like Bitcoin nai dem do - dem built Ethereum on a proof-of-work blockchain:  nai bi network of computers wey dey solve cryptographic problems nd come dey verify di transactions on di blockchain.

Ethereum is a decentralized system like Bitcoin. Me, I neva no Ethereum like Bitcoin, so make our profs tok something here.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Teaching suppose be somtin born out of passion nd no b jst regular job else, person no go fit teach anytin nd dem go dey jump at any opportunity 2 strike.
A major concern of ASUU is not just for staff and lecturers welfare but also the welfare of students. if you follow closely on the news and some of the major reasons why ASUU is still on strike, you see that it is traced down to a breach in contract by the government on an agreement they had with them about pumping some certain amount of money (in billions) yearly for the rehabilitation of school facilities in the country as they are in a sorry state.

According to ASUU, the agreed amount was only paid once during the Jonathan administration and since the buhari administration, the government have been unable to meet up with the agreed amount for a year and have not paid for a couple of years hence the decision to go on strike. I watched and heard this from an interview ARISE TV had with one of ASUU's officials during their regular Morning show, and the amount stated that was agreed was about 250billion naira yearly for like five years, since the government said they couldn't pay all at once. Jonathan paid one of the first deposit completely to ASUU, but since Buhari's Administration, they have not been able to pay 200 billion completely, how poor and unconcerned!!!

Federal universities in Nigeria are in a sorry state, old dilapidated small and uncomfortable lecture halls, classrooms and other structures, we have dilapidated student hostels with no or poor toilet facilities, as well as empty school laboratories...So how can students learn comfortably? Our Federal higher institutions cannot compare with that of some other African countries, If we really pride ourselves as the giant of Africa,  our government needs to be held to responsibility.
member
Activity: 854
Merit: 13
Your Identity Na Him Be You Always

Wuna welldone my pple. Dis matter wey I wan yarn today don dey my mind to talk am since but I just neva manage talk am. D tin wey dey wonder me for dis our local board be say na d language wey some people dey use here. As I find dis our local board (thread) wey our Oga @CryptopreneurBrainboss start for three years now. For d description him talk say d official language here na pidgin nd oda local dialects wey dey we country. As I con dey here I see say some people dey use English talk for here without any pidgin, ahbi dem no sabi speak pidgin lyk odas?

Ahbeg make we try dey use pidgin here so dat anybody wey come here go know say na we dey here all, na d language wey we dey understand pass between ourselves for here be dat. Dis na sumtin wey we suppose dey proud of, make person dey ask for translation of wetin we dey discuss for here, just lyk d way if we go oda local boards we no dey understand wetin dem dey talk. I feel say if we continue dey use dis our pidgin wela for here, dey fit consider giv us our own local board make e no be just normal thread again. Even if we no too sabi, we fit learn for here and dey add am small small for our mata here.

Na wetin I get to yarn be dat my people. I dey hail all of wuna for here for wetin wuna don contribute for dis our local board. All of wuna face show nd wuna shoe shyn too.
I don join you with this mata some time I go dey go through de board I go dey ask myself say this one no be 9ja again, some people dey speak hard English wen I no understand I come dey question myself say this no be pigin wen I no ooo. I dey beg some people make dey come down to our level for English na pigin I sabi weller.
member
Activity: 742
Merit: 30

E no get as e wan be, we contri no dey value teachers lai lai. Imagine wetin prof wey be d highest in educational ranking dey collect #332k. Make I fes ask, wetin that one wan do for dem?
 And lecturer no dey collect reach #200k nai make joy nor dey dey dem bodi to teach. And somtimes govt go still owe.

 Dis nah falling hands na if dem no fit invest well in education, becos nah one of our rights be dat na. Sha dem no go kia afta all dia pikins dem dey obodo the world.
Wetin de pain me 4 d mata be say, all dis people wey de up de call dem selves Government, na dis teachers and profs teach dem oo, but as dem de see money dem no wan increase dis old people and young lectures own. Even as people talk am sey dere reward dey heaven, dem too go chop now, and d way tins de even add money self normal worker no go fit afford to buy self and still government no wan increases money.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
Your Identity Na Him Be You Always

Wuna welldone my pple. Dis matter wey I wan yarn today don dey my mind to talk am since but I just neva manage talk am. D tin wey dey wonder me for dis our local board be say na d language wey some people dey use here. As I find dis our local board (thread) wey our Oga @CryptopreneurBrainboss start for three years now. For d description him talk say d official language here na pidgin nd oda local dialects wey dey we country. As I con dey here I see say some people dey use English talk for here without any pidgin, ahbi dem no sabi speak pidgin lyk odas?

Ahbeg make we try dey use pidgin here so dat anybody wey come here go know say na we dey here all, na d language wey we dey understand pass between ourselves for here be dat. Dis na sumtin wey we suppose dey proud of, make person dey ask for translation of wetin we dey discuss for here, just lyk d way if we go oda local boards we no dey understand wetin dem dey talk. I feel say if we continue dey use dis our pidgin wela for here, dey fit consider giv us our own local board make e no be just normal thread again. Even if we no too sabi, we fit learn for here and dey add am small small for our mata here.

Na wetin I get to yarn be dat my people. I dey hail all of wuna for here for wetin wuna don contribute for dis our local board. All of wuna face show nd wuna shoe shyn too.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
ASUU lag behind since then wey they suppose negotiate their salary but for now e no fit possible again. So literally, ASUU na their own problem.

Me I no really understand you for here. Na how Asuu take be their own problem wey dem don go strike for more than 6 months. Government strategy and aim na to break Asuu into units but dem never fit do am becos this time dem really mean business. Them self don see say government want to stop dem from lecturing in different universities and getting paid differently na the coco be dat wey make the two people dey fight and no want gree. Them go tell us say dem no want make government spoil the public school system for tertiary level like dem don do for secondary but dat one no be the real struggle, na money matter.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Shey na dem talk say teachers reward dey heaven, maybe that an why our nails government dey do backhand on top matter wdy concern lecturers and professors salary. This Asuu matter big pass this salary something. Firstly dem dey complains say dey want new payment processors to dey handle their pay, next a gratuity wet government owes dem for some time since that Oga Jonathan era. The main one wey be the Koko na this change or upgrade of salary structure wet everybody dey aware of so.
Seriously, make the Naija government dey serious about giving adherence to these striking sectors. Na the future of our development dem dey play with so o.

Naija government need to restructure everything so that things go fit work well. The type of education and the structure white men give them na wetin dem dey use till now and those things were not designed to favour Nigerians and her cultures and norms. Common constitution no way, na amended decree we still dey use. Our leaders still dey lead us by proxy. The white man still dey influence with his implanted ideas. Na only God go help us
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
(~)

Frankolala which one is your comment here? I know that you quote someone and made a comment but your comment e dey another person's statement so at the end ur own come dey like copy nd post. pls make u try edit am so we go know which one be ur own.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

 Dis nah falling hands na if dem no fit invest well in education, becos nah one of our rights be dat na. Sha dem no go kia afta all dia pikins dem dey obodo the world.
Our government na bad pipl,during dem time for school Nigeria provide dem with the best education but now wey na dem dey in power to make our educational system strong instead,dem dey vex say the youths for we country dey rush into university. Them no wetin dem dey do jare abi shey na Buhari we no go university na e won talk for d strike issue. Government don see say university dey bridge the gap between the rich and the poor by 50%. Imagine professor wey read book to the highest level dem dey pay am change but common Local government chairman wey some no even go school dey collect pass a whole professor wey be education itself.

 Nigeria government no want make our brothers and sisters go skool again, instead dem want make only their children and the rich go school,so that tomorrow the poor no go fit get mouth for the country again,but God pass dem because na God be the father to the poor. We get swegbe government and politicians as bab Fela talk since. The government no know the important issues to tackle for we country sometimes I dey wonder if dem really know their work self or na wickedness make dem dey behave like dis.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
Make una see how much our university lecturers the earn as salary. Wey be our politicians and government appointees the earn more than that. Our professors salary no even reach $500 but you go see minister wey d eat more $1500 as monthly salary

You dey wonder why ASUU still dey on strike? This is one of the reason.

The government suppose do something for ASUU member's salaries, asin their welfare them suppose to look into am asap

E no get as e wan be, we contri no dey value teachers lai lai. Imagine wetin prof wey be d highest in educational ranking dey collect #332k. Make I fes ask, wetin that one wan do for dem?
 And lecturer no dey collect reach #200k nai make joy nor dey dey dem bodi to teach. And somtimes govt go still owe.

 Dis nah falling hands na if dem no fit invest well in education, becos nah one of our rights be dat na. Sha dem no go kia afta all dia pikins dem dey obodo the world.
full member
Activity: 882
Merit: 207
Shey na dem talk say teachers reward dey heaven, maybe that an why our nails government dey do backhand on top matter wdy concern lecturers and professors salary. This Asuu matter big pass this salary something. Firstly dem dey complains say dey want new payment processors to dey handle their pay, next a gratuity wet government owes dem for some time since that Oga Jonathan era. The main one wey be the Koko na this change or upgrade of salary structure wet everybody dey aware of so.
Seriously, make the Naija government dey serious about giving adherence to these striking sectors. Na the future of our development dem dey play with so o.
member
Activity: 756
Merit: 30
Make una see how much our university lecturers the earn as salary. Wey be our politicians and government appointees the earn more than that. Our professors salary no even reach $500 but you go see minister wey d eat more $1500 as monthly salary

You dey wonder why ASUU still dey on strike? This is one of the reason.

The government suppose do something for ASUU member's salaries, asin their welfare them suppose to look into am asap

This one no be their actual salary sha na after dem deduct all those small small dues including taxes e dey remain like this. Besides almost all lecturers dey lecture for 2 or more institutions wey dey make dem earn extra money at the end of the month. Na the government of wey change Nigeria salary structure get the blame. ASUU lag behind since then wey they suppose negotiate their salary but for now e no fit possible again. So literally, ASUU na their own problem.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Snip

Is of no doubt seeing that those politicians are trying all their best to make sure power remains in their hands. How can a lecturer paid 120k per month while they steal our funds to buy all expensive ride and houses abroad, if politicians salary can be sliced down to same as lecturers I bet none of them will come out to fight I will be president and I will be minister or that, those positions will be empty and no one would to occupy it for any reason. Those listed amount is not even 10 percent of politicians waldrop allowance ect.

How would they be so naive to down pay their lecturers someone who tutored them to be what they are today and by right all teachers are meant to receive a minimal of 5m per month, this would make lecturer be more serious to strive their best to raise good student. Instead is students that teaches their selves what lecturers does is to stretch hand to steal from the poor student who can't afford to even pay their school fees.

This is very bad and I think if all those nonsense and Injustice should stop the better our country would be for us. Imagine in abroad no politicians uses convoyed but in our country they made available those things wasting our resources.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
~snip~
Although I don't question the list, I believe it to be relative. What I'm trying to say is that academics' wages in private colleges could be higher. We should also be aware that some of our academics hold teaching positions at other universities, as I hope we are. That is, it is possible that they will make twice as much. I believe that one of the FG's reasons for the IPPS is that it would eliminate the need for academics to work at two different institutions. However, if these lecturers in our public universities are paid properly, there won't be any need for them to do so. That is what ASSU counters.

Asuu members for no dey worry if to say the government people wey dey for chair no dey too corrupt. Na that money wey dem dey waste make Asuu want make dem also collect from the national cake. Since wey I take dey follow Asuu things na this strike wey deir mind don come together pass to see say them get government to change the narrative becos this government too corrupt and nothing dey move just to stop youths from daily bread and release corrupt governors from prison. But for another side, I no believe say Prof pepper be that oo bcos some of our men here go dey hammer pass Prof lol
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Make una see how much our university lecturers the earn as salary. Wey be our politicians and government appointees the earn more than that. Our professors salary no even reach $500 but you go see minister wey d eat more $1500 as monthly salary

You dey wonder why ASUU still dey on strike? This is one of the reason.

The government suppose do something for ASUU member's salaries, asin their welfare them suppose to look into am asap

At least, dem get job way dey pay dem. Both dem way b govmnt nd ASUU suppose learn hw 2 dey manage dem cef. Govmnt dey tell us say, evn if we finish school, we no go see job yet, dem get job nd salary grade in 6digits nd dem dey complain.
Shah, d matta 4 ground b say, no b only dere salary bt still, watin dem dey use d moni do wen dey release am nd if dem release am, we no dey see am. Teaching suppose be somtin born out of passion nd no b jst regular job else, person no go fit teach anytin nd dem go dey jump at any opportunity 2 strike.

Who go save us cef 4 dis we naija. Mak dis our PO beta b d guy o nd dat na if e win first shah.

What if him no be the one ? Wetin go be your plan B ? I dey always laugh when ornah dey talk PO! PO! C'MON, be realistic,this nah Nigeria ohhhh. We need a more agressive and coordinated plan than PO if you ask me.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673

Jump to: