Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 73. (Read 1019759 times)

hero member
Activity: 952
Merit: 742
Wetin una go call this level of insults to our African Presidents?

For the Queen's Funeral: President Biden Arrives at Buckingham Palace with em Presidential Armoured Convoy While African President wey come for the burial Were Blocked and Convey inside a Bus.

What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol
Dis tin an pure racism, see as dem disgrace dem 4 God sek, and if them no go now, them go talk say them no go. Me I sha blem dem wey carry dem selves go d burial, and most of dem get issues wey dem never resolve 4 dir countries.
This one go also serve as lesson to dem, mek dem de always mind dir business, anything wey no concern blak mek dem avoid white people.
full member
Activity: 882
Merit: 207
Welcome to this board @knowngunman, your name be like bullseye o. Just try dey make regular posts as your contribution so as to rank up.
Onto the Npower matter wey I dey read so, the irregularities of the APC lead government dey to blame as it concern this matter. Shey because say election don dey corner, that na why them wan use this as distraction take disburse money to youths so as to waive their mind from whom they intend to vote for. Abi no be the same scheme wey almost Nigerian youth register for, wey after 2 or 3 payment they stop the thing. Make them investigate the board of directors wey they in charge of this program because them no they talk the real matter of the intention of the program.
As for Asuu, eastern division get strong head wella o. Whatin IMSU they do na because of the suffer wey both state and federal chapters of the same Asuu they cause.
Make federal government introduce crypto programs wey we the youths go benefit from in the long run, no be all this things fall apart program wey them they use scam us everytime.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
No be wetin you dey reason ooo senior man. The thing wey the gun men dey do us this country too much and our goment dey deceive us say they are unknown. So I use the name to serve as a memory for their activities cux they're known. Nothing is unknown for this country. If you know the reason why I use the name, you fo no blame me. Dem take my better people away from me. I no just fit forget those sheges.
I'm sorry if the high level of insecurity in the country has affected you in one way or another, if you've lost someone or people because of this gun wielding men, then accept my sincere condolences.

Having said that, if me i wan talk the truth as e suppose be ehn, your username no they send the right message wey you wan portray for your mind, any user wey see this username fit come get the wrong impression about you, and even if users no go openly tell you, for their mind them fit no wan associate with you in any way possible on the forum, but as you don choose am so nothing much, everything fit still go well, Good Luck in the forum.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
the Batch C2 Npower beneficiaries' Deployment started on early August 2022 but was slowed by circumstances.

Pipo wey tok dis tin e no do mistake. "Experience is the best teacher". Di beneficiaries 4 di batch A/B go tell u well. Npower na wan of di program wey APC Government take suffer di 9ja youth. Wen Osinbajo was di head of di management team everything was working well, nd wen Buhari come see say Osinbajo dey do di program very well 4 di 9ja youth nai he e go bring dis woman come spoil everything. Oboy come see grammar. Latest, soon, through of stone, close very close, near etc finally nexit till date I don't know where I dey or stand 4 dis nonsense program. NP and covid 19, I no Kno which wan come get word pass. As 4 me I don't know 4 odas, since wen Buhari come enta dis govt I Neva hear any employment 4rom di civil servants perspective. Except di arms forces. Bt Dem don do plenty empowerments. Even di empowerments nothing come out.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
If you guys know you are a participant in the Npower scheme and have not been deployed in Batch C stream 1, kindly stay updated and always check your portal.

I think say this program suppose run for two years per batch so na how dem want take continue the payment after dem don pack their bags waka after 2023 election. Abi APC still dey think say dem go dey power after election with Tinubu as the presidential candidate? This na another scam in waiting, na wetin dem dey call work and no pay go happen. Although the Npower self dem no dey do anything.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
NASIMS prepares for full deployment of Batch C2 Npower beneficiaries
[/b]

As we are hustling here, let's not also forget that the National Social Investment Management System (NASIMS) has kicked-off activities for the full deployment of the Batch C Stream 2 Npower beneficiaries.

the Batch C2 Npower beneficiaries' Deployment started on early August 2022 but was slowed by circumstances. If you guys know you are a participant in the Npower scheme and have not been deployed in Batch C stream 1, kindly stay updated and always check your portal.

Naija I hail thee. This scam project. Project wey dem dey use siphon tax payers money. Dem wan start another one. I remember 2 years ago when I register, write their yeye aptitude test, upload the required documents. I even get 95 marks for the test. Na so everyday I dey check portal. No show. But my friend wey get the same score with me got called up. Dem talk say make we nor worry say dem go call us. Till today, no show. Naija just dey scatter scatter sha - zero accountability, nobody dey audit or checkmate the excesses of these so called National Social Investment Management System (NASIMS). Is there any beneficiary of this scheme that will say he or she has received their stipend consistently every month since they resumed at their place of primary assignment? I don't think so. Payment is always irregular.
hero member
Activity: 798
Merit: 635
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no believe say state universities dey call off strike too, na university authorities dey loud am, but lecturers no dey answer dem. Make dem go teach d pikin na, e easy?
State Universities they pull out true true oh, and for some of them lectures don start, at least i can speak categorically for my alma mater wey pull out from the strike about two weeks ago, and i still get better friends for there wey don update me say lectures don start small small. You sabi as our Nigerian institutions they na, e no get when them go just pull out from strike come start lectures immediately, they go still gats solve some small internal issues, but wetin they certain be say those we don pull out aren't going back, they will try their best to resolve any issues with their lecturers so school go start fully, students don already they on ground, as house don tire them wella.
I know say few schools don comot ASUU strike but not as much as media dey carry am. The IMSU wey cause d lastest tension don come out say dem no dey call am off, say na school PRO sabi wetin e dey talk. The same thing for Gombe state university last month. E dey always be like dis, little school go comot but many still go stay bcos ASUU strong pass each other for schools. I believe say government dey infiltrate universities too to destabilize ASUU and disgrace them.
hero member
Activity: 896
Merit: 612

I been dey see this picture dey trend for social media, but I no get time to read the story behind the picture. Na now wey I get the real gist shaa. Hope say Baba Buhari no dey for the picture. Our Africans dey value dem oyibo while oyibo dey take us anyhow. If say me be Nigerian President or any other African President, na representative I go send. Even for the burial, you fit shock say nobody recognise them.

Africa never dey ready to get independence for real, no be the independence dem write for book.

I go continue dey remember Gadaffi and Mugabe for their firm believe and defence of Afrika.

N/B: Marykeller,  you see as I put width for the images and e come small, e fine like that than to cover everywhere .
Buhari no go o, he dey for USA. Na Osinbanjo they send. The story done generate enough talk for twitter, and seriously I cant understand why they have to do that and if they refused to come, you label them . Will Gadafi or Mugabe accept such treatment from the Government especially from ina side of the world? whereas all these people can afford cars that mete their status.
Even as he go, dem no show he face for the group of pipo dem pack kip for that bus like sardine or he nor folo dem? We dey talk about regard, I no sure say we afrika no say na insult be dat if not dem for react. We afrika leaders still get the mentality of dependency, if not dis behave by d Whites supoz make dem para turn back.
 
 Maybe we presido don too fall im hand for UK nah im gats push vice to go.
sr. member
Activity: 700
Merit: 348
Welcome Knowngunman, thankGod you know say your name get k-leg. There are plenty name wey jakpa where you go chose from answer but na gunman you see to pick. But na your choice, nobody get right to chose wetin you wan answer. But remember say with the present situation of Nigeria and the activities of gunmen everywhere, no single Nigerian go dey happy anytime wey dem see your name. E go remind them the atrocities wey don happen and still deh happen for the country.

Another thing be say dem no dey change username, unless u get strong reason to do so.
No be wetin you dey reason ooo senior man. The thing wey the gun men dey do us this country too much and our goment dey deceive us say they are unknown. So I use the name to serve as a memory for their activities cux they're known. Nothing is unknown for this country. If you know the reason why I use the name, you fo no blame me. Dem take my better people away from me. I no just fit forget those sheges.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

Ahh this our God too wonderful I swear. I just land for place and the first thing na to see my people. Hallelujah! Make I follow introduce myself sharp sharp
Username; knowngunman
Gender: male
State of residence: Lagos
Skills: shoe maker
I beg make una no fear my name at least I no be unknown gun man  Grin make person put me through for this new environment please

Welcome Knowngunman, thankGod you know say your name get k-leg. There are plenty name wey jakpa where you go chose from answer but na gunman you see to pick. But na your choice, nobody get right to chose wetin you wan answer. But remember say with the present situation of Nigeria and the activities of gunmen everywhere, no single Nigerian go dey happy anytime wey dem see your name. E go remind them the atrocities wey don happen and still deh happen for the country.

Another thing be say dem no dey change username, unless u get strong reason to do so.
sr. member
Activity: 700
Merit: 348
[3]: First timers abeg just introduced yourself so we fit relate weller

    Username:
    Gender
    State of resident (optional)
    Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend)
Ahh this our God too wonderful I swear. I just land for place and the first thing na to see my people. Hallelujah! Make I follow introduce myself sharp sharp
Username; knowngunman
Gender: male
State of residence: Lagos
Skills: shoe maker
I beg make una no fear my name at least I no be unknown gun man  Grin make person put me through for this new environment please
member
Activity: 295
Merit: 98
NASIMS prepares for full deployment of Batch C2 Npower beneficiaries
[/b]

As we are hustling here, let's not also forget that the National Social Investment Management System (NASIMS) has kicked-off activities for the full deployment of the Batch C Stream 2 Npower beneficiaries.

the Batch C2 Npower beneficiaries' Deployment started on early August 2022 but was slowed by circumstances. If you guys know you are a participant in the Npower scheme and have not been deployed in Batch C stream 1, kindly stay updated and always check your portal.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Wetin una go call this level of insults to our African Presidents?

For the Queen's Funeral: President Biden Arrives at Buckingham Palace with em Presidential Armoured Convoy While African President wey come for the burial Were Blocked and Convey inside a Bus.

What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol

I been dey see this picture dey trend for social media, but I no get time to read the story behind the picture. Na now wey I get the real gist shaa. Hope say Baba Buhari no dey for the picture. Our Africans dey value dem oyibo while oyibo dey take us anyhow. If say me be Nigerian President or any other African President, na representative I go send. Even for the burial, you fit shock say nobody recognise them.

Africa never dey ready to get independence for real, no be the independence dem write for book.

I go continue dey remember Gadaffi and Mugabe for their firm believe and defence of Afrika.

N/B: Marykeller,  you see as I put width for the images and e come small, e fine like that than to cover everywhere .
hero member
Activity: 896
Merit: 612
Wetin una go call this level of insults to our African Presidents?

For the Queen's Funeral: President Biden Arrives at Buckingham Palace with em Presidential Armoured Convoy While African President wey come for the burial Were Blocked and Convey inside a Bus.

What a shame and letdown give Africans at large. See as our Africa Presidents take d laugh for inside bus. But if una for their for Africa now you for see the number of escorts wey dem go carry d patrol

As 4 me  di West dey use dem (our African  bad leaders) 2 show example 4 other leaders dat maltreating there citizens. Dat one na very big shame as Dem dey do Dem like dis, Dem go learn lesson. Dem dey get strength 4 onli dia pipo. Why dia security personnel no go cause yawa 4 dere. Nai make if u dey do bad tin no come do am 4 ur house and compound becoz if you do am e go affect u one day. Dat laf wey Dem dey laf inside dat bus na di laf of anger/shame. Me I dey like dis kind tins wen oyinbo dey punish our bad leaders.

ASUU Strike Update
9ja students don go blocked Morutala Mohammed airport yesterday. 2day Dem go block, sea ports, nd 3rd Main land bridge all in Lagos State. Imo state University e don pull out from ASUU. Dem come dey tell dem weti happon 4 #endsars protest. 9ja govt understand only protest.
As e take consan d ASSU strike, nah so students dey para dey block block o. All na for say we government resin students o. But dis kain tin dey pain sha, imagine person pikin go dey house over 7 months, tym just dey go.
 
 But with dia decide to block the airport for Lagos so, anytin go come out. We know say we government fit choose to ignore them  like say wen dem tire, dem go go rest, becos as e be nah solution all of us dey find.
hero member
Activity: 784
Merit: 568
Helo Mai pipo
I just sai mek I bring dis  1 to Sav as a reminda 4  dos of us  wey don register and dem neva go collect dia PVCs.

FIRST BATCH 4 AUGUST
All PVC registered from June 2021 to January 15th don de redo 4 collection. Mek una go visit una  LGCA for collection.

SECOND BATCH  4 OCTOBER
Pvcs registered from January 16 to June 30th go de 4 collection in October.

THIRD BATCH 4 NOVEMBER
Pvcs registered from July this year go de ready 4 collection on November.

As we see am, d first tow batches don de redi 4 collection.
Make we try go collect our PVCs so 2geda will can voter our choices.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
I no believe say state universities dey call off strike too, na university authorities dey loud am, but lecturers no dey answer dem. Make dem go teach d pikin na, e easy?
State Universities they pull out true true oh, and for some of them lectures don start, at least i can speak categorically for my alma mater wey pull out from the strike about two weeks ago, and i still get better friends for there wey don update me say lectures don start small small. You sabi as our Nigerian institutions they na, e no get when them go just pull out from strike come start lectures immediately, they go still gats solve some small internal issues, but wetin they certain be say those we don pull out aren't going back, they will try their best to resolve any issues with their lecturers so school go start fully, students don already they on ground, as house don tire them wella.
hero member
Activity: 784
Merit: 568
The Asuu matter don tire person. Make dem kuku turn our tertiary universities to vocational learning centres. E go pay right now pass say students just sit down for house dey put hand inside tins wey no make sense, all because of say dem dey find moni. The truth finally be say, na entering government go fit resolve this issue, because even if this current try resolve the matter, na on top false promise the tin go end. A compromise needs be reached at a quick pace because e get as e go be say dem call off strike but students no gree resume.

As u tok am na Tru,but I no kon blame asuu on top dis Mata bcus most  federal universities are down of dia standards. Check now are  days  universities kon b like secondary skul where practical room no get equipments or practical tools, u na too contribute B4 u get some practical tins 4 practical practical place bcus does 1 wen dey B4 Don spoil and no replace 4 it . Is  beta 4 asuu 2 wait 4 a year or more if dia problems will b solve so Dat they will no even tink of strike 4 good 20years to come, and federal government no get 2 support does Universities make dem hand over to private sectors and nothing will like asuu again and wen u enta skul u go know wen graduate and our parents go Sabi how to find Does money, kuku skul feels for federal go Don increase. Na naija u go see sai mechanical engineering no airbeg B4.
hero member
Activity: 798
Merit: 635
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Imo state University e don pull out from ASUU. Dem come dey tell dem weti happon 4 #endsars protest. 9ja govt understand only protest.
I see say all these state universities dey pull out from ASUU, to me na two things dey oo
1. I agree with state Universities make them no follow ASUU strike if the strike na about salary only, because FG don talk say dem no go put mouth for state universities matter if he concern salary but if na about revitalisation make dem just put body together with ASUU oo.
2. The other thing be say if state universities pull out totally from ASUU, any time wey state government show them shege dem fit no get who go defend them oo.

Them don adjourn court case go 23 this month make we put ear for ground they wait waten go happen. We pray for the best sha

The FG suit no get merit, dem go lose big time. Na ASUU I encourage make dem fight dis fight till last, Naija government no dey serious. Wetin dem dey use our money do? dem no get money, but dem fit do railway line reach inside Niger Republic and fit spend money on frivolities while others dey chop am as dem like.

I no believe say state universities dey call off strike too, na university authorities dey loud am, but lecturers no dey answer dem. Make dem go teach d pikin na, e easy?
full member
Activity: 303
Merit: 136
Defend Bitcoin and its PoW: bitcoincleanup.com

Jump to: