Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 78. (Read 1020156 times)

hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Today market price wey I dey see self, the price just dey jump like frog since morning and the way wey I dey see am, the thing come dey look up like say na bull all the way. The price still dey 22k but soon the tin fit to fly enter inside 23k , the thing wey dey push price today na im me sabi.. That 23k be like say him get a kind of wedge for there wey be say when price reach there im go waka go back but make we dey look for this time wetin go happen.
Your comment remind me of one of my guy point wey him make when him check Binance to see how bitcoin is doing. Even me sef shock - I come dey ask myself say nor be this price wey be been dey predict say na for December e go reach $23k - $25k? Anyways, the market na the market. Wentin all men dey hope and pray for now na for the price to steady.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

The current pump will hit $23k and then fall back to $16k- $17k low. The bear is not over yet it's just starting. Buy
wisely.

Weti u tok na di truth oo. Na u be our Oracle 4 we 9ja now, wey dey predict crypto 4 us, but small still remain for di prediction to be completed. Yesterday when I checkam , di market been dey 21k and today I come check am again and I saw 22k. I come dey say weti Igehhh tok na true took.

Today market price wey I dey see self, the price just dey jump like frog since morning and the way wey I dey see am, the thing come dey look up like say na bull all the way. The price still dey 22k but soon the tin fit to fly enter inside 23k , the thing wey dey push price today na im me sabi.. That 23k be like say him get a kind of wedge for there wey be say when price reach there im go waka go back but make we dey look for this time wetin go happen.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
please before u buy, make sure you understand the next move of the market, or u contact Igehhh or Brainboss to to explain for you. Probably before the weekend the remaining 1% go enter making the total of 23k as it was predicted by Igehhh that the market go enta 23 before di year go end.
My brother, wetin you go understand be say e dy impossible for anyone to master the market, you fit make one or two predictions and analysis here and there, but you no fit ever they completely certain say na this or that go happen, that is why you go always they hear say the market is unpredictable, even the people wey you mention so go tell you the same thing, and even if them share their strategy or what they think with you, them go still add disclaimer put for back, tell you say there is no guarantee oh, make you no come back hold them for neck say wetin them talk no work. My point be say the best thing na to DYOR, advice no bad oh, you fit collect am join the research wey you do, but make your final decision stem from your own research/conclusion.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341

The current pump will hit $23k and then fall back to $16k- $17k low. The bear is not over yet it's just starting. Buy
wisely.

Weti u tok na di truth oo. Na u be our Oracle 4 we 9ja now, wey dey predict crypto 4 us, but small still remain for di prediction to be completed. Yesterday when I checkam , di market been dey 21k and today I come check am again and I saw 22k. I come dey say weti Igehhh tok na true took. As u said earlier if anyone wan buy, buy now that di market dey down but buy it wisely, as it is said, di market go still go down therefore pipo wey want buy, buy am now or wait  the decrease of d market to the 16k, please before u buy, make sure you understand the next move of the market, or u contact Igehhh or Brainboss to to explain for you. Probably before the weekend the remaining 1% go enter making the total of 23k as it was predicted by Igehhh that the market go enta 23 before di year go end.
member
Activity: 854
Merit: 13
Username: Questcry
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, Bounty hunter

I haven't get enough experience but hope to learn more in this forum, i want to know how e dey b to collect merit,

Good day my friend you are welcome to the Forum. Has you dey now to get merit no be by bounty campaign ooo, to get merit you have to live bounty campaign and make meaningful discussions in the forum because merit is not awarded easily, you have to work hard for it. Please don't be eger to get merit be patient gradually it will start coming but you have to be active in the forum. Do not rush or you will land yourself in trouble and here in forum they are notin like sorry, you have to defend yourself if you pass your are safe and if you fail I don't pray that for you. Once again you are welcome.
member
Activity: 756
Merit: 30
I haven't get enough experience but hope to learn more in this forum, i want to know how e dey b to collect merit
I Dey welcome you to our midst here wey 9ja blood dey flush for our body. First of all I go like make you read Forum rules wella before anything else so you no go misbehave for forum wey go lead to your account suspension or ban. The merit Mata wey you talk no be big issue sha. If you yarn better thing wey dey useful for this forum ehh na merit go dey look for you woto woto but no go copy anybody post because Forum dey vex for plagiarism. Na with Caution we dey survive here. Welcome once again 😁
stop posting in bounty thread, there different childboads to contribute to with positive post and you can get rewards which is "merit".
Boss you no get joy ooo  Grin but sha we no fit stop everybody from posting on bounty threads as it one way or the other contribute to our financial means despite be say e no too dey pay again. Na our country I blame sha for not providing youths with better jobs. So the thing be say some people here focus na on bounty while some of us get different focus. I sha say make e dey run the both for the street. Nobody go tell am to stop bounty if e rank up now. Na my own opinion sha. No shade!
hero member
Activity: 798
Merit: 635
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Username: Questcry
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, Bounty hunter

I haven't get enough experience but hope to learn more in this forum, i want to know how e dey b to collect merit, ever since i have been participating in Bounty Campaign all the one have done that benefit me most comes from CryptopreneurBrainboss
All thamks to him
I will happy if my message get to him well
And i really appreciate my pipo wey dey here, their contributions make my belief strong and keep me going, i want to be sure what great thing it will comes out of it
You are welcome on board, just like me, I enta on board just last week. Wetin I go advice u be say make u ask well from the people wey dey do the bounty of thing the bad and good side of it. Na wetin dey make person dey earn fast be that for dis forum, but I no think say na my thing. I no like wetin go dey put me under unnecessary condition and aggression, and intruding my privacy too. I like to do things under nice terms. Just heed to the advice of the senior members here, dem go guide u wella.
member
Activity: 854
Merit: 13
Pipo wey dey interested go nd apply 4 fillipone thread now. Bt pls b4 applying read di rules very well please oo. https://bitcointalksearch.org/topic/merit-share-your-best-poststhreads-with-fillippone-to-be-merit-assessed-5412657 I don't know if he is still doing but try your luck.

wish u all di best gud luck
I dey really appreciate this thing wan you do, thank you for your kindness and support. I will try my luck and see. Anytime I dey local board I dey like I dey house because the kind love wan deg dey see here he dey beyond watin I dey except.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Skills:          freelancer, Bounty hunter
~
i want to know how e dey b to collect merit
Abeg bro no take bounty hunting as skill for this forum, you na our brother and we no go fit mislead you, nothing wey too make sense they for this bounting hunting wey you they do, if you check am well sef, most of these bounty campaigns no they pay their participants, you go work tire, in the end them go yarn you one story or the other. If you wan know how e they be to collect merit, i'm afraid you go first comot from bounty area of the forum oh, come chook your eye for better sections them wey knowledge they fly up and down, from there you sef go they grab your own knowledge come they use am make your own topics, na from there you fit they expect to get merits.
member
Activity: 295
Merit: 98
Username: Questcry
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, Bounty hunter

I haven't get enough experience but hope to learn more in this forum, i want to know how e dey b to collect merit, ever since i have been participating in Bounty Campaign all the one have done that benefit me most comes from CryptopreneurBrainboss
All thamks to him
I will happy if my message get to him well
And i really appreciate my pipo wey dey here, their contributions make my belief strong and keep me going, i want to be sure what great thing it will comes out of it


It's nice you discover this thread, first you should focus on contributing positively in the forum and stop posting in bounty thread, there different childboads to contribute to with positive post and you can get rewards which is "merit".
This thread will guide you to make some good post that may help grow in the forum:
newbie
Activity: 336
Merit: 0
Username: Questcry
Country:      Nigeria
Skills:          freelancer, Bounty hunter

I haven't get enough experience but hope to learn more in this forum, i want to know how e dey b to collect merit, ever since i have been participating in Bounty Campaign all the one have done that benefit me most comes from CryptopreneurBrainboss
All thamks to him
I will happy if my message get to him well
And i really appreciate my pipo wey dey here, their contributions make my belief strong and keep me going, i want to be sure what great thing it will comes out of it
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
~snip~
I have mixed feelings about bitcoin seeing a bull run in December. I predict that the bull run will happen in January. My reasons for this is because of the feds and their anticipated regulations, as well as other very interesting projects that exist in addition to bitcoin.
D dfrent season of d yr get watin dem dey carri 4 bodi cum. December na time way b say, pple dey wan joli, dey wan celebrate say dem survive tru d struggle of d whole 12months nd managing watin dey put food 4 dere belle. Den 4 Christians, 2 celebrate birth of Christ. December, na time to spend, 2 withdraw small frm d plenty way u don gada bt, na stil time 4 pple way dey run seasonal business 2 collect.

January na time way be say, u go dey try recover frm watin u spend 4 December. Pple go like re-invest bt, I no deal say, e go be bullrun like dat, maybe small pump as we dey experience now. Like 12-20% increase.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Pipo wey dey interested go nd apply 4 fillipone thread now. Bt pls b4 applying read di rules very well please oo. https://bitcointalksearch.org/topic/merit-share-your-best-poststhreads-with-fillippone-to-be-merit-assessed-5412657 I don't know if he is still doing but try your luck.
wish u all di best gud luck
This one na correct initiative o. I dey wait the day wey we go get more merit sources for we naija board so that them go dey show we naija people wey dey make better post love. Anyways make una apply.

December and January no be the same thing my guy? Anyway me too dey feel say bull go fit happen around that time no be even because of fed expected regulation but because say since wey btc don drop from $64k to when e reach $50k, $35k just come reach $20k the thing never come up since and the expectation be say altcoins suppose rise and this never happen, so maybe another circle go happen with bitcoin around that time but if we no see am , na halving time we go look.
Oboy eh, December and January nor be the same thing o. And another thing be say shey una know this Fed anticipated regulation na this year wey e strong pass.  Las las like you talk na everybody dey look forward to the next halving.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
~snip~
I have mixed feelings about bitcoin seeing a bull run in December. I predict that the bull run will happen in January. My reasons for this is because of the feds and their anticipated regulations, as well as other very interesting projects that exist in addition to bitcoin.

December and January no be the same thing my guy? Anyway me too dey feel say bull go fit happen around that time no be even because of fed expected regulation but because say since wey btc don drop from $64k to when e reach $50k, $35k just come reach $20k the thing never come up since and the expectation be say altcoins suppose rise and this never happen, so maybe another circle go happen with bitcoin around that time but if we no see am , na halving time we go look.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Pipo wey dey interested go nd apply 4 fillipone thread now. Bt pls b4 applying read di rules very well please oo. https://bitcointalksearch.org/topic/merit-share-your-best-poststhreads-with-fillippone-to-be-merit-assessed-5412657 I don't know if he is still doing but try your luck.

wish u all di best gud luck
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

We have been hearing about the Feds and their regulations and it did not even start this year. It's becoming like a point to just create FUD on Bitcoin. Up till now the FEDs regulations hasn't happened, I think if a Bull run comes this year surprisingly everyone would lie low on the topic about the Feds regulations.
Bitcoin is currently above $21k and not everyone saw this coming. I had over heard a big influencer saying it may never happen this year and he backed his thoughts with prove but as always the crypto-currency market proves to be very much unpredictable.
The Crypto-currency market is volatile and definitely not fixed to history. Many factors affects the market and some can happen at anytime and some are also Unforeseen. So the best way in my opinion to survive in the crypto space is to believe in the coin you're holding and don't get moved by FUDs as for me I believe in bitcoin.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
~snip~
I have pored over series of historical data and charts and have watched the market and no way Bitcoin is going above $24k in my opinion. Historically, bear markets cycles have lasted an average of 220 days. I have mixed feelings about bitcoin seeing a bull run in December. I predict that the bull run will happen in January. My reasons for this is because of the feds and their anticipated regulations, as well as other very interesting projects that exist in addition to bitcoin.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

Yes bear market is an opportunity to buy but this is the worse bear we have seen in recent years and there is a possibility that not all the TOP altcoin will survive it.

We could see a little bear by February next year from my own calculation but I could be wrong.

I really like this your analysis. These are the kind of discussion I love here. So which time u come think say di bear market go end?  Yesterday wen I saw di dip I come dey Powe (Happy), I dey pray say make di 23$ wey u tok stay till next month.

Weti u took na true oo. Everyone be wise about di bear market becoz if you buy bitcoin in dis bear market nd di markt come dey come down well well below ur expectations nd u come need cash seriously at time, oboy dat kind thin e no go gud at tol. So once again be wise.

As previously stated, the bear will run until next year; we will only see some bullish signs around December, but BTC will not go above $25k because the resistance above that point is too strong to break. The next bull run could begin in mid-April to September of next year, as the next halving of Bitcoin will occur in 2024, so expect a lot of buying power before that.

Those looking for buying time this chart from coupon should help.


Not a financial advisor, only for educational purposes. DYOR

hero member
Activity: 952
Merit: 742
I no know watin you dey even said, the way wen market dey behave na him you dey  encourage person make dey buy dip dip, he never long wen luna teach people lessons when people take the advantage of dip wen com result to suicide.
you go do your own research before you buy, but na True dem talk, u go need to take risk for anything wey u wan do, if u talk say u wan follow wetting people they talk about luna or reason how luna takes fall people hand, u no go ever invest in crypto again, but if u wan get profit you need to take risk. Na this time be d right time to buy any coin wey u wan buy because d market de down, so as d market go pump go take your gain.
member
Activity: 756
Merit: 30
  Baba u dey right jars,how person wey dem just employ go get knowledge on how to rig election. INEC themselves na dem be the real riggers and na dem go even teach the new full staff how to rig election. Nigeria na paddy paddy government, even when election no go dey, employment dey go on underground. To work as INEC full staff no be here o bcos this our government know say na flexing work wey be once in awhile.
Una dey talk as if to rig election na big deal  Grin
Something wey kwamrades Don Sabi right from campus politics. The only thing wey go make am hard this time around na because of technology ooo since na through serva dem Wan dey transfer the result and e go dey live for everybody to see with their Koro Koro eyes. I just dey pray make dem no do any how for this upcoming election.
Pages:
Jump to: