Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 7. (Read 9498 times)

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
August 23, 2023, 04:16:58 PM
Dem sey persin wey know sey im pikin fit from sleep die go nor suppose let am sleep.
Meaning: It's better to nib a problem in the bud before it escalates.

My Chief dis one enter well you no need to loud am too much again because with dis small explanation even person wey no get akonuche go know say true true the best thing to do to stop fire before e burn down house na to stop am before e enter every where.

Elder you do well as you dey continue dey keep dis we corner active for us with your wise proverbs God don bless you more already but I get one important question to ask even though say e no relate to wetin we dey talk here, abeg na how we fit take make we oga dem ontop see reasons to legalize bitcoin for we country Naija since dem no dey create any employment opportunities for we youth.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 23, 2023, 10:13:18 AM
Dem sey persin wey know sey im pikin fit from sleep die go nor suppose let am sleep.
Meaning: It's better to nib a problem in the bud before it escalates.
jr. member
Activity: 39
Merit: 7
August 22, 2023, 10:13:17 AM
Proverb: Road wey you don pass the first time, no dey hard to pass the second time.

Meaning: It's easier for you to do something if you have done it before or have been doing in the past.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
August 21, 2023, 01:59:23 AM
1. African proverb: Sugarcane na for eh joint eh dey always sweet pass
Meaning: That good things of life may appear difficult, but at the end it's always worth it.

2. African proverb: No enter road for night, hoping to drive using another car front light
Meaning: Don't ever put all your hope on someone else in life, hoping to be there for you at all times
hero member
Activity: 784
Merit: 589
August 20, 2023, 07:08:16 PM
 My pipo I salute una. I don dey see many hands for here and I commend the effort at trying to keep the forum lively. E don try wey I drop something wey my elders tok so make I drop one here.

Proverbs: insect wey dey eat kola, nah for the leaf e dey.
Meaning : Most times, your enemy is within
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
August 19, 2023, 06:25:33 AM
Proverb: person wey dey baf for river nor dey complain say soap dey en eye.
Meaning: you shouldn't be complaining when you have the solution by your side.

Proverb: pikin wey dey shoot karterpot for market, one dey the stone go touch em mama.
Meaning: evil practices will surely torment you back.
member
Activity: 784
Merit: 34
👉bit.ly/3QXp3oh | 🔥 Ultimate Launc
August 19, 2023, 12:47:25 AM
Oboy you wan activate that african proverb's inside of us like this i still dey remember some wey my mother been dey tell me wey go like this
 
1. PIKIN WEY NO DEY LET HIM MAMA SLEEP HIM NO GO SLEEP
meaning: If you spend all your time denying people's comfort,  you ultimately deny yourself same comfort.

2. WEYTIN ELDER SEADOWN SEE, PIKIN WEY TALL LIKE IROKO TREE NO GO SEE AM
meaning: what an elderly person has an experience of in life, a child that they gave birth to will not have any experience.

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
August 18, 2023, 06:56:31 PM
The antilope wey grow hurn overnight no dey last long
Meaning: life is a gradual process, if you want to achieve everything in one day you end your life.

You try well well my elder dis your proverb enter body as e be say wetin you talk na exactly wetin dey happen for we society nowadays, you go just see small small boys dey rush to get things fast fast wey Dem never even know how the end go be so baba I salute you because you bring better word of wisdom come.

I go also encourage and iladvice you to take am easy especially as you dey learn make you really understand the way things dey go for here and forum entirely. I see say you don make one mistake because only you write two times when another person never write Dem dey call that one spamming for we forum here so take correction and make you dey always wait when you drop one write up make another person drop before you add another one.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
August 18, 2023, 09:09:16 AM
Proverb: When bird dey alive, the bird go dey chop ant 🐜, but when the bird die, ant go chop am.

Meaning: life and circumstances can change at any time either in your favor or against you.
This your proverb dey well seasoned with salt and nah true mata you bring. Anoda understanding I take attach to wetin you talk nah say make we no go dey raise shoulder come dey look down on others wen small rabas dey our side. E sure for us now mean say e no go stew for the person and since no man knows tomorrow, e fit red. I kuku join my elder statesman @GiftedMan welcome you to the forum and hope to dey see more of your meaningful contribution for this our cabal.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
August 16, 2023, 12:52:54 AM
Our people say foul wey en leg break, Dem no dey sell am give neighbor.
Meaning: what you really know will cause a conflict dont even try it.

Dem say no matter how the jungle be, lion no ft chop grass.
Meaning: there is a limit to one's downfall.

Dem say cameleon no dey change colors, say na environment dey change em color.
Meaning: people don't change carracter environment influences them.

Dem say de day man want to marry, na mad women dey full everywhere.
Meaning: when it's time for your breakthrough, there is always trials that comes your way.

The antilope wey grow hurn overnight no dey last long
Meaning: life is a gradual process, if you want to achieve everything in one day you end your life.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
August 15, 2023, 06:28:16 PM
Proverb: When bird dey alive, the bird go dey chop ant 🐜, but when the bird die, ant go chop am.

Meaning: life and circumstances can change at any time either in your favor or against you.

Dis one go well and I dey see say you just dey join us for dis we corner I salute you my elder and I go like to dey see your face here.

Na ogbonge word na em you give us here but any how e be no ever allow any situation be against you because e no go easy even though some people dey name dia pikin Ezekiel 😂😂😂 welcome once again.
jr. member
Activity: 39
Merit: 7
August 15, 2023, 04:18:47 PM
Proverb: When bird dey alive, the bird go dey chop ant 🐜, but when the bird die, ant go chop am.

Meaning: life and circumstances can change at any time either in your favor or against you.
jr. member
Activity: 39
Merit: 7
August 15, 2023, 02:32:54 PM
Proverb:If you bite me for head without minding my hair, I will as well bite you for nyash without minding your shit.

Meaning: The same way you treat me without remorse, I will also treat you the same way.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 11, 2023, 01:00:20 PM
Pikin wey dey travel every time go get better sense pass an elder wey siddon for one place.
Meaning: Wisdom isn't bestowed based on age but experience.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 03, 2023, 07:47:12 AM
Parable: Pikin wey don too suck breast milk wey refused to stop, look am well e get wetin dey hold the baby down.
Meaning: If you have been working and there is no progress or changes, always back it up with prayers. Many set back today are because of our distance with Christ, call upon him he would answer you.

Dis one enter my whole body infact I salute you and you deserve one bucket of water as my chief dey always talk am but I no get any one for now but make I ask you something I hope say you no go vex , you know say e get so many set backs wey prayers no fit solve like set backs wey stinginess cus? na only de person go fit deliver him self else na instant death e go die without penny OOO make we also learn to dey open hands.

Yes all are being classified as one, Just as we do say go to school but without knowing going to school also connotes you chosing a career. You don't just go to school without you having to chose a course to study. So it's to my parables and meaning, Prayers signifies all things including giving in fact given is the most important things that can easily breaks one out from every hardship be it spiritual or physical we need to release our hands to sow seed in the lives of those we felts we are better of or to those whom we felts are more anointed to attracts a speedy and heavenly blessings from them. Abeg make una no vex say I no flow with the OT but I go try as much possible to dey post with the OT wey we get here.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
August 02, 2023, 05:15:47 PM

Elder Mpa I like as you take explain dis matter give@gotzekrul, you know say some people dey feel say as dem see elders carry cutlas for hand e no heavy for hand. Proverbs dey easy for to talk for mouth but to interpret am dey hard unless you be person wey dey sit down near elders like us hahaha 🤣🤣 you do well baba.

Oga gifted, make I first remind you say me and you get serious two aside and with regards to your birthday, I want make you also know say you dey owe me, so abeg if you dey near elder, try shift comot there because you go certainly bless me weda na by hook or na my crook😁😁

I been dey take time dey read some of the parables for here and my brother i no go lie, most of those parables don ready dey outdated and sometimes cutlass fit heavy for elder hand but no heavy for pikin hand, wait make I explain, pikin of this generation fit don dey shoulder responsibilities wey even elder no fit shoulder easily, hence the cutlas (responsibilities) Don light for that pikin hand pass the elder own.

No mind me abeg I dey catch cruise but the truth be say, most of this parables don dey outdated and them don prove plenty wrong.

Before I go make I drop one :
Plenty fowl for pepper soup no dey too sweet
meaning: having so much talks than actions yields no results.

na person wey baff dey rob cream
meaning: it takes only prepared to be successful.

@smartgold you try abeg I no go lie but if na my breast pikin dey suck and e no gree stop, or even bit me, na to give am better dirty slap make him know say na human get the breast he suck🤣🤣😅
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
August 02, 2023, 12:46:36 PM
~
Nice try but nor be so dem dey take analyse proverbs oh. Nor be plain meaning from d syntactic structure. You get to dig deep and peruse am. For instance now, if I tell you sey "Pikin wey dem carry for back nor dey know sey road far" E nor mean sey dem actually carry pikin for back dey go somewhere but na true if dem still carry pikin for back. Wetin dat particular proverb mean be sey persin wey dem dey help do something nor dey know sey e dey hard. Proverbs get application, nor be d regular talk and just leave am there kind of thing.

Elder Mpa I like as you take explain dis matter give@gotzekrul, you know say some people dey feel say as dem see elders carry cutlas for hand e no heavy for hand. Proverbs dey easy for to talk for mouth but to interpret am dey hard unless you be person wey dey sit down near elders like us hahaha 🤣🤣 you do well baba.


Parable: Pikin wey don too suck breast milk wey refused to stop, look am well e get wetin dey hold the baby down.
Meaning: If you have been working and there is no progress or changes, always back it up with prayers. Many set back today are because of our distance with Christ, call upon him he would answer you.

Dis one enter my whole body infact I salute you and you deserve one bucket of water as my chief dey always talk am but I no get any one for now but make I ask you something I hope say you no go vex , you know say e get so many set backs wey prayers no fit solve like set backs wey stinginess cus? na only de person go fit deliver him self else na instant death e go die without penny OOO make we also learn to dey open hands.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
August 02, 2023, 11:40:42 AM
I say make i come see wetin dey ground here as I never to show up based on one or two matter but e no means say I no go drop something here..

Parable: Pikin wey don too suck breast milk wey refused to stop, look am well e get wetin dey hold the baby down.
Meaning: If you have been working and there is no progress or changes, always back it up with prayers. Many set back today are because of our distance with Christ, call upon him he would answer you.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 02, 2023, 11:19:11 AM
~
Nice try but nor be so dem dey take analyse proverbs oh. Nor be plain meaning from d syntactic structure. You get to dig deep and peruse am. For instance now, if I tell you sey "Pikin wey dem carry for back nor dey know sey road far" E nor mean sey dem actually carry pikin for back dey go somewhere but na true if dem still carry pikin for back. Wetin dat particular proverb mean be sey persin wey dem dey help do something nor dey know sey e dey hard. Proverbs get application, nor be d regular talk and just leave am there kind of thing.
newbie
Activity: 59
Merit: 0
August 01, 2023, 03:02:20 AM

- Man no be God. (Man is not God.)
- E no dey shame monkey say im mama no get tail. (It's not shameful for a monkey to have a tailless mother.)
- Who know go know, who no know go dey learn. (He who knows, knows. He who doesn't know, will learn.)
- When rain dey fall, fowl wey no get house dey hide for burrow hole. (When it rains, a chicken without a house hides in a burrow.)
Pages:
Jump to: