Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 6. (Read 9496 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 04, 2023, 01:12:44 PM
Old woman nor dey old for dance wey she sabi dance.
Meaning: No one forgets what they're skillful at doing.
full member
Activity: 238
Merit: 151
September 28, 2023, 05:15:29 PM
Yes o African proverbs dey sweet well well o especially when you know their various meaning. Me I know so many African proverbs o but since Una don mention most of them make I mention the ones wey Una never mention.

African proverbs:
1. Before you see a blind man kon dey halla know say him don match stone for ground- meaning before someone is threatening you they have an evidence to use in fighting you.

2. Monkey dey smart na only when tree near tree -- meaning people seems to be smarter than you when they know your secrets or when they're close to you.

3. Any body wey dey ready for wrestling should also be ready to be falled by his opponent- meaning if your are ready for anything also be ready for the outcome.

4. Person wey kari bag no no wetin dey the other person bag -- meaning if you are confident of yourself your opponent is also confident of himself.

5. Lizard know dey talk no mean say in no no wetin to do -- meaning don't take people's silence for cowardice

6. No be who call police dey win case-- meaning sometimes we claim we're right when we're wrong in the sight of the law.

7. No body be Chike Obi--- meaning no one knows it all

8. Fly wey stubborn dey folo dead body enter grave --- not listening to advice can make one do lots of mistakes.

9. People wey dey dance surugede should know that surugede is the dance of the spirits--- meaning if you're taking critical decisions also be ready for the outcome.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
September 28, 2023, 11:21:20 AM
I hope una dey use am for real oh and nor be to just post to increase post count.


Baba dis one na big question o but I no fit answer for everybody because na only my self I know I no no how every other person take dey relate for the proverb matter. Yes I dey use am on daily basis but I dey only use am if I dey with men wey get akonuche and my fellow elders wey fit understand and relate because my people talk say person wey dem speak parable to come explain am the money wey dem use marry the person mama na waste.

Like yesterday wey I been dey with some elders for office, e get something wey we bin dey discuss as another person come inside the room all of use come dey use proverbs dey talk instead of the normal English language wey we been dey communicate with and we still understood each other.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 26, 2023, 12:15:18 PM
...the proverbs wey Dobabe and Roseline492 drop don already dey for here I understand say dem no no.
Na true you talk. Thank you. I see am too and nor be only dem I don observe wey don do am. I get some people wey dey my radar. I nor wan rush enta dem, make e nor come be like sey we dey hammer dem harshly. My investigation dey on. The main purpose wey I take create dis thread nor be to dey spam put; but na so we go dey share proverb ideas so dat any time wey we talk for where elders dem dey, dem go confirm sey we sabi wetin we dey do. I hope una dey use am for real oh and nor be to just post to increase post count.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
September 26, 2023, 11:30:00 AM
~snipped~

~snipped~
I take my last muscles hail una. Una too much. The only gbege wey I see for wetin una do be sey una use English write una yarns. For here, we nor dey use English drop proverbs. Na strictly pidgin things here but you fit explain d proverbs for English. Na so we dey take run am here. Una go try adjust.

My chief your observations dey always dey legit and I dey also like the way you dey advice and encourage the younger elders dem wey dey gather here you do well Baba.

I get small thing to add here based on wetin you don already yarn, abeg help us address this matter so that new elders wey dey come dis we corner go notice am, make dem try dey read the previous proverbs before dem drop new one because the proverbs wey Dobabe and Roseline492 drop don already dey for here I understand say dem no no.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 24, 2023, 01:50:36 PM
~snipped~

~snipped~
I take my last muscles hail una. Una too much. The only gbege wey I see for wetin una do be sey una use English write una yarns. For here, we nor dey use English drop proverbs. Na strictly pidgin things here but you fit explain d proverbs for English. Na so we dey take run am here. Una go try adjust.
full member
Activity: 252
Merit: 157
September 22, 2023, 04:06:56 PM
Picking way them carry for head no no say road far.
Meaning: a child that always depends on the parents for everything doesn't no what it takes for the parents to bring food on the table.

Don't put all your eggs in one basket.
Morning: channeling all your investment on one direction is very bad were as if anything happens to it all your hard labour will be gone.

Cut your coats according to your size.
Meaning: don't try to leave another person lifestyle when you cannot.

What an old man can see while seating down a young man cannot see it even climbing a tree.
Meaning: an old man has seen life and experience before you were born
newbie
Activity: 28
Merit: 6
September 22, 2023, 12:49:22 PM
THE STURBBON FLY FOLLOW THE CORPSE TO THE GRAVE
Meaning: he that does not listen follows the corpse to the grave

HE WHO FIGHT AND RUN, LEAVES TO FIGHT ANOTHER DAY
Meaning: we didn't win this time, but live to fight another day
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 22, 2023, 09:46:22 AM
Na from kneeling down goat dey take suck im mama breasts
Meaning: You've to stoop to conquer
full member
Activity: 294
Merit: 215
September 15, 2023, 02:06:34 AM
Na small small dem dey take lick hot soup
Meaning: delicate and complex tasks or situations require gradual and strategic approach
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 14, 2023, 08:17:03 AM
Dem sey persin wey go frog house to ask for stool whether im see the one wey the frog sitdon put?
Meaning: You've to be circumspect while asking people for help.
jr. member
Activity: 78
Merit: 6
September 06, 2023, 03:22:43 PM
better kola last in the mouth of those that values it.
meaning:: anything wah you dey do, and put more effort on it. you we sure progress on it.

Never you troll stone inside market, E fit go touch your mother.
meaning::: any bad thing wah you do, must surely come back to you
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 06, 2023, 03:09:53 PM
Man wey get faulty gun, na from far wey im dey take shoot.
Meaning: A man who is incapacitated financially (or in other ways) always plans ahead of time.
jr. member
Activity: 39
Merit: 7
September 04, 2023, 05:56:42 PM
Proverb: The frowning of a he goat no go stop the owner from taking it to the market.

Meaning: There are things or situation you can't change by what ever means.

The only situation wey I fit say person no fit change right now na death but even as e be now people still dey use money dey change some kind death situation but e no dey work always.

For some oda situations, baba I fit say na only person wey no get money wey no go no wetin to do in any situation but if money dey ground na to just put calls connect with the right person or people wey fit help sort the situation out no matter how hard e be. No forget the oyibo wey Dem say money answerth all things I believe say any situation wey you no no wetin to do na situation wey never come your way because right now people don see shege tire and e don make dem zero mind to accept any situation wey come their way.




I'm sorry to use him as an example, do you remember Senator Ike Ekwere mmadu, the former Deputy Senate President?

He's in prison now. Do you think he wants to be in prison?
jr. member
Activity: 39
Merit: 7
September 04, 2023, 05:51:21 PM
Proverb: If you no want your friend to become a king, you no go become friend to a king.

Meaning: If you're not wishing your friend well, indirectly you're not wishing yourself well.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
August 30, 2023, 06:53:44 PM
Proverb: The frowning of a he goat no go stop the owner from taking it to the market.

Meaning: There are things or situation you can't change by what ever means.

The only situation wey I fit say person no fit change right now na death but even as e be now people still dey use money dey change some kind death situation but e no dey work always.

For some oda situations, baba I fit say na only person wey no get money wey no go no wetin to do in any situation but if money dey ground na to just put calls connect with the right person or people wey fit help sort the situation out no matter how hard e be. No forget the oyibo wey Dem say money answerth all things I believe say any situation wey you no no wetin to do na situation wey never come your way because right now people don see shege tire and e don make dem zero mind to accept any situation wey come their way.


Baba no vex but at some point I no think say money fit solve everything because I know people wey get all t money wey fit buy their lives but at the end them still die and remember say bible talk say my people perish for lack of knowledge not money and the truth be say me I agree with Okwara say e get some situations wey we no go fit change except God come down come intervene and I don also see people wey get money yet ten Dey under one serious spiritual attack or the other.

E don tay wey I drop parable for here so make I drop small

Proverb: my people talk say woman wey Dey run for her life no Dey hold breast

Meaning: when there is trouble, there is no dignity in shame.

Even me no believe say na me drop that grammar but no worry I try.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
August 30, 2023, 01:12:07 PM
Proverb: The frowning of a he goat no go stop the owner from taking it to the market.

Meaning: There are things or situation you can't change by what ever means.

The only situation wey I fit say person no fit change right now na death but even as e be now people still dey use money dey change some kind death situation but e no dey work always.

For some oda situations, baba I fit say na only person wey no get money wey no go no wetin to do in any situation but if money dey ground na to just put calls connect with the right person or people wey fit help sort the situation out no matter how hard e be. No forget the oyibo wey Dem say money answerth all things I believe say any situation wey you no no wetin to do na situation wey never come your way because right now people don see shege tire and e don make dem zero mind to accept any situation wey come their way.


jr. member
Activity: 39
Merit: 7
August 30, 2023, 07:33:31 AM
Proverb: The frowning of a he goat no go stop the owner from taking it to the market.

Meaning: There are things or situation you can't change by what ever means.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
August 25, 2023, 08:48:17 PM
Mehn this thread na one of the thread wey i like pass for this forum ah done read many make i share my own too as e they hot

Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
Meaning: It means that it's easy to act crazy or pretend to be insane, but the real trouble comes when you have to deal with the consequences or challenges that arise from your actions.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 25, 2023, 02:26:28 PM
I get one important question to ask even though say e no relate to wetin we dey talk here, abeg na how we fit take make we oga dem ontop see reasons to legalize bitcoin for we country Naija since dem no dey create any employment opportunities for we youth.
Yes, true true ur question nor relate to dis threat at all but I go talk put make e for nor be like sey I jaw am. As d matter be now, e nor get anything wey we fit do bc d man wey eyeneck select put for us as presido and his cabinet know next to nothing about cryptos. Dem be traditional old men wey nor even know jack about using d internet. I go stop here. You fit start a thread on dat, we go chook mouth there. For now, make we just keep here pure with owa proverbs. Thank you.
Pages:
Jump to: