Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 5. (Read 9496 times)

full member
Activity: 462
Merit: 145
November 10, 2023, 03:21:54 PM
Make hunter way carry bag for back not feel superior way him non know wetin dey the other hunter bag.

Nice one, but you go need to dey add meaning so people fit relate.

PROVERB: Sugar sweet pass salt, but nor be for inside soup.
MEANING: There is a place for everyone.
full member
Activity: 308
Merit: 143
November 09, 2023, 09:02:43 PM
Make hunter way carry bag for back not feel superior way him non know wetin dey the other hunter bag.
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
November 09, 2023, 08:45:10 PM
Proverb: You no go fit beat drum with one finger.

Meaning: You have to put a lot of energy and attention to anything you're doing in life.



Proverb: the day I go need wife to marry, na mad people go full market.

Meaning: Whenever you want something you'll never get it.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
November 09, 2023, 09:08:25 AM
Goat wey get mind follow lion go catch fish, make e know sey weda dem catch fish or not, lion food don set.
Meaning: Always keep away from someone who is treacherous and has an advantage over you for you can never please such a person, no matter how hard you try.

Cockroach wey think sey im smart go enter where fowl dey do general meeting don sign im obituary.
Meaning: Never play into the hands of your enemy.



NO matter how hot your temper be,e no fit boil beans
    Meaning:calm down, your temper won't solve the problem.

    Today's news paper na tomorrow suya wrap
      Meaningkeep calm! nothing lasts forever.[/list][/list]
      sr. member
      Activity: 546
      Merit: 418
      November 08, 2023, 10:46:46 PM
      Proverb: No matter how long plank of wood stay inside water, e no go fit turn to crocodile 🐊.

      Meaning: You will always be who you are no matter how long you fake your character/life.


      Proverb: If anybody (men especially) see fowl wey dey scatter excrement (shit) make em stop am, who know who go eat the leg?

      Meaning: Any time you see a girl misbehaving caution her because you will never know who might get married to her. It is either you or a member of your family.
      sr. member
      Activity: 266
      Merit: 276
      November 08, 2023, 08:01:34 PM

      Dog wey go loss no dey hear the whistle of him hunter
      This one wey you taalk sweet me well well. E look so normal but e they pass good message.
      Normally you fot write am like this, Dog wey they always go find in opposite sex no they gree come back house.
      legendary
      Activity: 2674
      Merit: 1208
      Once a man, twice a child!
      November 08, 2023, 08:36:22 AM
      Pikin wey shit bad shit na Sand paper dem go take clean him yansh.

      Fly wey no dey hear word dey follow dead body enter grave.

      Dog wey go loss no dey hear the whistle of him hunter
      You lock door but still carry key throw inside d house. You for try put d meaning of all d yarns wey you drop, make e for tap.

      ~
      You nor supposed drop proverbs here for English. Na pidgin we dey use here. Abeg edit ur stuff. We nor too go skool here. Abi make I report am to mods as spam?

      If you see an elderly  man running, it is either is running after something or something is running after him.
      You forget to put d meaning. Na d proverb you throw alone.
      full member
      Activity: 462
      Merit: 145
      October 27, 2023, 03:49:35 PM
      Pikin wey shit bad shit na Sand paper dem go take clean him yansh.


      Fly wey no dey hear word dey follow dead body enter grave.


      Dog wey go loss no dey hear the whistle of him hunter
      Look how other people dey post their own, make you follow post like that. Nor go dey post proverbs without meaning. Try make the thing dey reasonable make e nor go become spam.

      Proverb- Until lion go sabi write and talk e own story, na the hunter wey go always get praises from the story wey e talk.
      English meaning: When you listen to only one account of a story from someone involving two people, there is always chance that it is not completely true.
      newbie
      Activity: 8
      Merit: 0
      October 27, 2023, 04:35:55 AM
      Na house we dey look before we give child name.
      Meaning: before we give a child name we look at the circumstances around the child or the things that happen before  the child's birth.
      If you see an elderly  man running, it is either is running after something or something is running after him.
      member
      Activity: 213
      Merit: 12
      October 26, 2023, 07:17:28 PM
      Cow wey no get tale na God dey drive fly from am,
      Meaning: someone who has no helper God always become his helper
      A prophet is not known in his community,
      Meaning:you don't value what you have until you lose it.
      What is good for the goods is also good for the gander,
      Meaning:treat others how you want others to treat you..
      One good turn deserve another,
      Meaning:if you are honest with one 's partnership business,you partnership business continues,
      Make a haste when Sun is shining,
      Meaning:you can plan for your greatness tomorrow now that you are still young..
      Live and let live,
      Meaning: don't jealous what others have..
      member
      Activity: 238
      Merit: 54
      October 26, 2023, 01:46:56 PM
      Pikin wey shit bad shit na Sand paper dem go take clean him yansh.


      Fly wey no dey hear word dey follow dead body enter grave.


      Dog wey go loss no dey hear the whistle of him hunter
      sr. member
      Activity: 546
      Merit: 418
      October 26, 2023, 01:00:09 AM
      My big aunty ni drop this one for us when we gather last night and I say make I share am here too...

      Proverb:- person wey fit swallow UDALA seed (Apple seed) go first consider d size of em stomach oh.

      Meaning:- UDALA seed is never digested in the stomach. This means that you must always think about every possible consequences of the actions you take.


      Proverb:- when the greatest/mighty tree fall, all d birds go scatter inside d bush.

      Meaning:- When a great leader passes away, many people loses their way in life if they do not find a successor.
      legendary
      Activity: 2674
      Merit: 1208
      Once a man, twice a child!
      October 25, 2023, 03:41:15 AM
      Make the eagle perch, make the kite also see where to perch. The wan wey talk sey make d orda nor perch, make im wings fall off .
      Meaning: We should let everyone be on their own term without attempting to intimidate them for peace's sakes. Otherwise, let the consequences of hatred be meted on the aggressor.

      Na late China Achebe bin popularize dis proverb for one of im novels and d yarn make sense well well in owa society today.
      sr. member
      Activity: 546
      Merit: 418
      October 18, 2023, 04:23:44 AM
      Proverb:- Na only one time corn dey bear fruit and e go die, bcos e no get root for ground.

      Meaning:- You can never get to the top and stay prosperous without a solid foundation.
      hero member
      Activity: 686
      Merit: 527
      Leo is resting.
      October 15, 2023, 04:39:10 AM
      Make fish sweet for you for soup.
      Meaning: May glad tidings stream your path

      Amen. I believe say this particular proverb wey you give na pure prayer because the blessing wey e carry too plenty. My prayer for you be say make you no see shame and make your family no lack anything good wey go keep the family shinning now and forever.


      Proverb: Dem say pikin wey knife never cut dey always see knife like stick

      Meaning:  Until you witness the consequences of evil you may not stop doing it.
      legendary
      Activity: 2674
      Merit: 1208
      Once a man, twice a child!
      October 11, 2023, 06:54:44 PM
      Make fish sweet for you for soup.
      Meaning: May glad tidings stream your path
      jr. member
      Activity: 39
      Merit: 7
      October 09, 2023, 08:56:14 AM
      Proverb: “Nobody dey go native doctor to find out why he or she dey do well for life”

      Meaning(1): It's only problem that makes you to look for a solution.

      Meaning (2): When there's no problem, there won't be any need to look for solution
      jr. member
      Activity: 42
      Merit: 1
      October 08, 2023, 10:00:04 AM
      E no possible for a water to pass through forest wey e no go bring trees down.

      Meaning: for total cleansing of land, be rest assured even if your flesh are involved they will be cleansed too.
      sr. member
      Activity: 504
      Merit: 421
      Top Crypto Casino
      October 07, 2023, 05:07:22 PM
      E don tay wey I post for this thread and I like how our boss Mpamaegbu and others dey try keep the thread active with words of wisdom. When I see some pidgin proverbs e dey funny me die and at the same time e dey make a lot of sense. So like this, I want drop this one make I see who go get the meaning of the proverb in English language. The proverb get biblical origin.

      Proverb: E no far, e no far... Na wetin Moses been tell the children of Israel, play play dem com spend forty years for wilderness.
      hero member
      Activity: 686
      Merit: 527
      Leo is resting.
      October 05, 2023, 04:45:20 PM
      Old woman nor dey old for dance wey she sabi dance.
      Meaning: No one forgets what they're skillful at doing.

      Deep word of wisdom from our own elder chief MPA. Baba I agree with you because even in old age my late granny been still dey dance waist dance especially when I dash her shine shine money and when she dey dance you seif go contact because she be correct dancer. Make I still relate dis proverb to mysel, I know sure say as I be baller now I go fit forgot how to ball when I become of age that one don become part of me I no fit forget am.

      Pages:
      Jump to: