Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 3. (Read 9498 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 04, 2024, 08:04:17 AM
Man wey dey beat him wife na wetin him dey eat him dey pour sand sand put.
Meaning: You don't do things that will be to your detriment, no matter how angry you're.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
January 02, 2024, 11:38:55 AM
Verse 1

Proverb: No call forest wey give you shelter jungle...

Meaning: Never insult anybody who takes care of your responsibility...

Verse 2

Proverb: Hot anger no go fit cook yam...

Meaning: No matter how someone has angered you it must surely come down...
Haba, my sister dis one you drop verse, abeg you for tell us say you be musician nah Grin.. regardless, all you drop nah beta yarn and I fit relate with some of them. Especially as you mention hot temper because weda we like or not, hot temper no dey solve anything, e no dey even win award so before we carry temperament spoil beta tin, e wise to just take ice water calm ourselves.
 I really happy say place like this dey to help us keep in touch with proverbs wey our parents bin dey sama us with. These wise sayings of our parents be like torch to take guide our paths so I dey happy. Make I drop this one here, person fit don tok am but the understanding fit differ.

Proverbs; Pikin fit play with him mama breast but no fot play with him papa testicles
Meaning ; It's not everything that is for child's play; just because there are things that a within reach doesn't mean you have to joke with it.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
January 02, 2024, 11:23:20 AM
What goes around comes around.

Zillamos, you go try step up your game nah, as you don try locate this our corner, first of all you need to start from the beginning read and learn from wetin oda people write so  you fit learn from them. This corner na African proverbs in pidgin, wetin you need to do na just to write your proverbs in pidgin then you fit use big big grammar come interpret the meaning of your Proverbs.

Make I also use this medium advise you to stop to dey drop one one line write up e rit no worry you now but later e go fit affect your account, you fit gum body with person wey show you dis corner make em fit give you small expo on how this area dey be or you just take small time go round only our naija board make you fit observe how things dey go here. No forget say pikin wey go sabi something no dey waste time take correction so try sleep four side make you observe as things dey go.
newbie
Activity: 6
Merit: 0
January 02, 2024, 03:10:13 AM
What goes around comes around.
full member
Activity: 462
Merit: 145
December 31, 2023, 06:29:17 PM
E don try wey I visit this thread and I no really go through the previous replies
But my people talk say No Matter How teeth decay, tongue go still lick am
meaning: No matter how bad a child is, the family will still accept him and this parable suppose be one of the major things wey suppose to Dey guide us here as to try cover our yans, that one no mean say people go do anyhow or wan spam the board with shit post as my people also talk sayPikin wey say mama no go sleep, him too no go sleep
Nor be small things I dun read for here ooo, my head just dey burst! Idey very impressed, body dey sweet me. Wisdom Choke from different people side oooo. I go like add my own.
PROVERB- The same traffic wey dey vex driver, nai dey sweet who dey hawk gala.
E mean say something wey  nor favour another person, fit favour you if you put hand.
jr. member
Activity: 34
Merit: 14
December 30, 2023, 06:51:27 AM
My people talk say; them go look big heaps finish, plant am big yam
Meaning: Before a task be given to you, you're already equal to the task

Dog go dey chop shit, goat teeth go dey decay
Meaning: you're enjoying your life, people are busy castigating you

Eagle perch, kite perch. The one wey say the other one no go perch, em feather go break
Meaning: you can't oppress any one of your kind and go scot free

Pikin wey him father send thief dey use leg break door
Meaning: no child is scare having the backup of his father no matter how wrong he may be.

Person wey me and am follow dey hunt antelope done say my leg look like antelope own
Meaning: betrayal

Chicken feather no dey ever lack for kite nest
Meaning: something does not lack where it's suppose to be

I wish I can say more 😺

newbie
Activity: 9
Merit: 0
December 30, 2023, 06:13:01 AM
"When one finger dey touch oil, e no go ever remain clean." E mean say, if you dey do something wey no pure, e go always show.
newbie
Activity: 10
Merit: 0
December 30, 2023, 06:00:06 AM
Proverb: If ruggedity na beans moimoi no go done

Meaning: It’s not by Working Hard but by Working Smart
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 30, 2023, 04:31:06 AM
Verse 1

Proverb: No call forest wey give you shelter jungle...

Meaning: Never insult anybody who takes care of your responsibility...

Verse 2

Proverb: Hot anger no go fit cook yam...

Meaning: No matter how someone has angered you it must surely come down...
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
December 30, 2023, 01:03:48 AM
E don tey wey I visit this thread and I no really go through the previous replies
But my people talk say No Matter How teeth decay, tongue go still lick am
meaning: No matter how bad a child is, the family will still accept him and this parable suppose be one of the major things wey suppose to Dey guide us here as to try cover our yansh, that one no mean say people go do anyhow or wan spam the board with shit post as my people also talk sayPikin wey say mama no go sleep, him too no go sleep


full member
Activity: 266
Merit: 113
December 29, 2023, 02:30:00 AM
I



Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

make I yarn my own with my local dialect.

omonimu ikare awor
Meaning: when you grow up you will face reality, and it's not a course

Most parents in my locality will tell their children that might not be taking their lives seriously this proverb just so they know that it's not easy to take care of the home.

As a child if you being too demanding, our parents will tell you this implying that you will grow up to facing similar situation and that they hope you would be able to thrive throw it.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 29, 2023, 12:22:44 AM
Proverb: Two elephants wey meet for small bridge no go go anywhere unless one lie down.

Meaning: Sometimes people need to make way for others to succeed.

Very funny meaning there 🤣 e come be like say the meaning get something to do with some political matters because na them dey like make person go down for them to climb or succeed but oncrhe contrary, i believe we can actually succeed together without bringing anyone down if we don't let envy, greed and selfishness take over our thinking.

You see that greed selfishness you yan so, hmm... E be like scar wey no fit comot from our oga at the top there body oh, e go hard to comot from their body becos that passage them dy money dy come out from their so e go hard.


Proverb:  When you dey cry for rain make you know say you dy cry for mud too.

Meaning: If you're looking for something good be ready for the consequences.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
December 28, 2023, 05:19:58 PM
Proverb: Two elephants wey meet for small bridge no go go anywhere unless one lie down.

Meaning: Sometimes people need to make way for others to succeed.

Very funny meaning there 🤣 e come be like say the meaning get something to do with some political matters because na them dey like make person go down for them to climb or succeed but oncrhe contrary, i believe we can actually succeed together without bringing anyone down if we don't let envy, greed and selfishness take over our thinking.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 26, 2023, 01:42:24 AM
Proverb: Two elephants wey meet for small bridge no go go anywhere unless one lie down.

Meaning: Sometimes people need to make way for others to succeed.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
December 24, 2023, 11:17:14 AM
Proverb: Na chicken wey walka anyhow them carry cook Christmas rice

Meaning: You must learn how you moved and attracts with people because you never can tell who is your enemy or that wants to bring you down. Mostly some people would want you down by all means seeing you stands and make progress doesn't bring happiness to them so we must be cautious on the way we walk and involved ourselves with people around us.

Proverb: Na only God wey know how our women dey take see their period

Meaning: People will always want you to do right thing without them know what you are passing true if it is convenient for you or not, but what they wants is for you to please them and displeased yourself.
member
Activity: 140
Merit: 92
Eloncoin.org - Mars, here we come!
December 24, 2023, 10:26:20 AM
What am elder see while sitting down,  pikin sitting at the tallest tree can not see it.

Sew your cloth according to your size

Toad no dey run for day time is either something dey poshuam or in dey poshu something

newbie
Activity: 29
Merit: 0
December 22, 2023, 03:41:50 PM
Person wey dey sell charcoal no dey wear white clothes
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 20, 2023, 03:10:30 PM
Proverb; Them no dey stand one place dey look masquerade
  Meaning ; You should not stay at a place and expect opportunity to come knocking, rather you create it or go look for it.

I greet una inside this cold harmattan morning Grin
Na true talk be dat. Make I use dis ur proverb remind all of us sey now na dat time not to stand one place and dey wish sey Bitcoin increase in price. Make we use dis opportunity to also keep som Bitcoin aside. Dis coming bull season go dey crazy. If ur power fit carry am, make you find som credible alts too put som cash for dem head. Nor too lavish cash dis period. Na future we dey look so, nor be immediate gratification.

I greet all man. One luv 😘.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 15, 2023, 05:31:08 AM
Proverb: pikin wey dy always ask wetin kill em papa b4 em get strength to take revenge fit dy ask for em papa fate.

Meaning: You should never start a battle if you're not ready or old enough to be a winner.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
December 14, 2023, 04:34:44 AM
 Proverb; Them no dey stand one place dey look masquerade
  Meaning ; You should not stay at a place and expect opportunity to come knocking, rather you create it or go look for it.

I greet una inside this cold harmattan morning Grin
Pages:
Jump to: