Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 8. (Read 9496 times)

newbie
Activity: 23
Merit: 0
July 31, 2023, 03:23:25 AM
Na money dey make Iron float for water

Meaning: Money creates unimaginable solutions to difficult problems.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
July 28, 2023, 03:19:18 PM
Na true you yarn, Obari. I supposed pour you beta two buta of water but wetin dey my fridge nor reach anywhere, na im make me relax 4 now. You try, nor be small thing.
No worry you good and I don already put you for white list.
I like this your thread and we go dey all put in better effort to grow the thread and with time, we no go dey follow wetin the old talk because most of those proverbs don already dey very out dated and some of them, have been proven wrong but I believe say with time, we go collectively  drop better parables wey generations to come go use talk but until then, I carry am for mind say you dey owe me better water both the one I go drink and the one I go bath😁.

No also forget say my people talk say "elder no fit dey house, goat born for rope
meaning I no fit get you dey suffer stunted growth for here na 😆
Abi "make I dey river make soap enter my eyes ?
I know say you no go gree.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 28, 2023, 03:02:50 PM
Na true you yarn, Obari. I supposed pour you beta two buta of water but wetin dey my fridge nor reach anywhere, na im make me relax 4 now. You try, nor be small thing.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
July 28, 2023, 12:07:48 PM

All 💯. Ur granny train you well. Even if na from ur neighbours you learn dem, you copied well.

Boss i been dey expect say you go do me the least joy via reward because I really crack this head to bring out this qoute and I no know if you still get any in stock but frankly I don try and I deserve am na, if for nothing, atleast  I don drop 3 once.
No reason me abeg
 "my people talk say pikin wey wear white no dey follow others play with charcoal"

Then also talk say who no get anybody suppose fight for himself.
Abeg try bless your boy 👦
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 28, 2023, 05:31:00 AM
~
Baba no worry, even cripple don dey cheat abi you never see cripple dey do gangbang?😁
Well, I neva see sha 🙄. I nor wan even behold such scenario sef make dem nor go spoil my churcheous mind jor. Anyway, as you carry d matta enta ordinary meaning with illustration of physical marriage, Paul too for Bible nor marry but he addressed so many issues in marriage.

Quote
Make I add small of my own talk
My people talk say Elder wey open prick for pikin face,one day the pikin go wan touch wetin him see

our people also talk say, no matter how teeth decay for mouth,  tongue go always lick am

leave wetin them write for motor,  enter motor
All 💯. Ur granny train you well. Even if na from ur neighbours you learn dem, you copied well.
full member
Activity: 308
Merit: 143
July 28, 2023, 04:28:05 AM
U fit bend & break a single broom bt only fit bend bt no fit break bunch of brooms

Meaning there is power in unity
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
July 27, 2023, 10:09:09 PM

Owa people say persin wey marry a crippled persin na only am sabi how to sleep wit am.
Meaning: Only those involved in a messy situation would know how to carve out a way to deal with it by themselves.
Baba no worry, even cripple don dey cheat abi you never see cripple dey do gangbang?😁
The truth  be say, person no need dey messy situation before he fit tell people how to come out of one because now we don see unmarried marriage counselors wey dey settle even some impossible marriage crisis( if you wan see one, then come my prophet never marry but no worry he don settle plenty homes).


Make I add small of my own talk
My people talk say Elder wey open prick for pikin face,one day the pikin go wan touch wetin him see
meaning: only those who respect themselves  will be respected.

our people also talk say, no matter how teeth decay for mouth,  tongue go always lick am
meaning: no matter how bad a child is, he will always be accepted back home.

leave wetin them write for motor,  enter motor
meaning: don't be deceived by looks but go for the content.

I no know if any of these one i post don already dey posted but I don laugh tire with the kind proverbs I don see so far.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
July 27, 2023, 07:32:39 PM
Una good evening I say make I drop wetin I learn today make my fellow elders follow chuck mouth and I go really appreciate if we talk our mind base on weton I won drop.

Proverb: Na when man open door for morning em also open em belle.



Meaning:This is just another motivation reminding us how we need to hustle hard to keep our daily bread flowing because things are getting more difficult everyday. Feel free to drop your own meaning I will really appreciate.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 13, 2023, 03:27:17 PM
~
Baba abeg dash me small wisdom because e full your body.
Dis guy, shey you nor go hype me enta wahala for Wike hand so 🙆‍♀️

Quote
But no forget also say no be everybody wey enter problem dey sabi ways to come out of am as I don see so many people wey dey go meet oda people collect advice on how dem go take come out of some wahala wey dem find demselves into.
Na d persin go still know how to carve d way out by demsef. Abi you nor dey read people wey dey ask questions and pretend sey na their friends or persin wey dem know get d problem?

Quote
e get one cripple fine girl wey I gbadu for my area but na how to start the thing dey hard me 😂😂😂
Nor be sey to start d thing dey hard you but na d shame of wetin people go talk if dem see you rolling wit her dey do you 🤦. My guy, if you dey always wan do things to please people na slavery be dat. Free your mind. Na mindset dem dey look for in friendship/relationship, nor be physical beauty.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
July 13, 2023, 01:50:17 PM
Owa people say persin wey marry a crippled persin na only am sabi how to sleep wit am.
Meaning: Only those involved in a messy situation would know how to carve out a way to deal with it by themselves.

Baba abeg dash me small wisdom because e full your body. But no forget also say no be everybody wey enter problem dey sabi ways to come out of am as I don see so many people wey dey go meet oda people collect advice on how dem go take come out of some wahala wey dem find demselves into.

Abeg about the cripple person matter, na how I do take sleep with them because e get one cripple fine girl wey I gbadu for my area but na how to start the thing dey hard me 😂😂😂
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 12, 2023, 04:46:08 PM
Owa people say persin wey marry a crippled persin na only am sabi how to sleep wit am.
Meaning: Only those involved in a messy situation would know how to carve out a way to deal with it by themselves.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
July 09, 2023, 01:49:56 AM
Persin mama dey turn to winch if una no progress for house.
Meaning: Whenever you are too lazy to make money you finds whom to apportioned blamed on while your mates are making it in life,
and doing things you should be able to do more than them.
Na better quote you just drop so my gee, because this na big problem wey dey our families for we 9ja and beyond, of children blaming their parents when they fail to do well in life, while forgetting the fact that in life, in other to make it, you just have to be the hardest worker or smartest worker, as nothing good comes on a platter of gold.

Quote
E don tey I show face here oo abeg make una vex the industry too large.
Lolz.. I guess what you meant is "Make una no vex" ba? And if so, apology accepted, as long as you go dey come subsequently dey give us better quote for the day.
full member
Activity: 308
Merit: 197
July 08, 2023, 08:19:12 PM
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.

— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.

Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations.


 Op you really try we'll well and this topic sweet me for body because eh dey remind me of back in the days  when my sisters dey get discussion then my younger brother go one engage them and eh go come lead to arguments then my grandmother go begin they advice am and na proverbs she dey always use calm am down, some of them dey funny but I go drop a few wey I remember.
Na only mumu they use two legs test whether river deep
 Eh mean say make people no dey rush into conclusion.
if them tell ears something eh no hear when they cut head comot eh go follow I'm go
Eh mean say make you listen to advise
 And eh also get one my mama dey always talk for igbo when I do something bad, runaway from house then come back to beg, lol eh dey funny
Agbachaa Oso, Aguo Mile
 Eh mean say when a man run race finish eh go come sit down reflect on the distance eh cover.
hero member
Activity: 1400
Merit: 650
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
July 07, 2023, 06:02:06 PM
Persin mama dey turn to winch if una no progress for house.
Meaning: Whenever you are too lazy to make money you finds whom to apportioned blamed on while your mates are making it in life,
and doing things you should be able to do more than them.


E don tey I show face here oo abeg make una vex the industry too large.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
July 07, 2023, 03:12:28 PM
Our people sey wen dey carry persin corpse wey we nor know, e dey be like sey na log of wood dem carry.
Meaning: We feel less concerned when things happen to others that don't directly or remotely affect our peace of mind or happiness.

DIS one na real thing wey dey happen for we everyday life, na person wey get matter dey know how e dey pain am but every other person dey see am as nothing even when dem wam help self e dey be dem like say na one kind difficult something dem dey help the person do. Na em make our people dey talk say I don't care na person wey e never happen for before. Chief abeg no dey run leave us here for long oooo I don miss you.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 07, 2023, 02:30:51 PM
Our people sey wen dey carry persin corpse wey we nor know, e dey be like sey na log of wood dem carry.
Meaning: We feel less concerned when things happen to others that don't directly or remotely affect our peace of mind or happiness.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 10, 2023, 09:13:49 AM
You no fit know how soup sweet reach with one morsel of gari

Meaning: Don't place your judgement based on first meeting because you may get it wrong.

Baba I no go lie you I go fit use the aroma of the soup self know how e sweet reach without using eba run am. My people say dem no dey Carry mirror look Wetin dey hand so I believe say any how e be with one blow of eba we fit know if soup sweet or not.

For the meaning wey you drop, no forget the grammar wey oyibo people talk say first impression matters alot because e get wetin you fit do when person see you for the first time baba dat tin don make dem no go ever gbadu you again.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
June 08, 2023, 04:53:09 PM
You no fit know how soup sweet reach with one morsel of gari

Meaning: Don't place your judgement based on first meeting because you may get it wrong.
Garri matter nai u dey tok for here? Ur proverbs e no go work for di Garri and soup. Tai!!? Di meaning e dey okay but di idiom e no go work. If I use one Garri morsel take test soup I go confam sae whether di soup go sweet or not, me I go know wella. If pepper dey sef I go know, and anything wey pass I go know unless my mouth e no good to know if not one ball or morsel of Garri is enough to know bad and good soup oo
hero member
Activity: 784
Merit: 589
June 08, 2023, 06:31:38 AM
You no fit know how soup sweet reach with one morsel of gari

Meaning: Don't place your judgement based on first meeting because you may get it wrong.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 07, 2023, 02:53:19 AM
The Nza bird talk sey if nor be because of d heart disease wey him dey get, him and cock na mate.
Meaning: If not for inhibitions and life challenges some of us face, we would've achieved more than we already have done.
Pages:
Jump to: