Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 4. (Read 9496 times)

member
Activity: 129
Merit: 16
December 13, 2023, 09:14:29 PM
Proverb; The thing that killed a mother rat will always be there to make sure the young ones never open their eyes.
MEANING; Wicked people are always at work.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 07, 2023, 03:32:45 AM
Proverbs: na where dey pain person, naim dem dey put near fire

Meaning: People will take whatever action necessary to resolve an issue troubling them.

This your proverb just remind me of something wey happen to me this year😅.


Proverb: d vex you vex for your broda nah for flesh him go feel am no be for bone.

Meaning: you should forgive and forget whatsoever your relatives have done to you.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
December 06, 2023, 09:04:46 AM
 Una good day for this ogbonge cabal. I say make I throway salute since e don tey wey I reach dis side. Make I drop wetin I get for here

Proverbs: fly wey no dey hear word go follow dead body enter grave

Meaning: when you choose to pay deaf ears to instructions and warnings, whatever the consequences of your actions, you're the only one to blame

Proverbs: na where dey pain person, naim dem dey put near fire

Meaning: People will take whatever action necessary to resolve an issue troubling them.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 06, 2023, 08:35:38 AM
Proverb: No expect to find any virgin woman for maternity ward.

Meaning: You can never get pregnant without having sexual intercourse. Also means that you're the cause of your problem.
member
Activity: 196
Merit: 25
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
November 29, 2023, 05:16:12 AM
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.

— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.

Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations.


All these Proverbs have many way of communicating to our society to caution and to improve knowledge. OP I commend you for once again bring to the table in order to enhance us more "mine" is pikin wey dey in mama or papa shoulder don't know how far the journey be meaning that one who is not taking responsibility don't know what it take to provide another is person wey fall with basket for play ground tell public what she carry meaning person who exposed his secret and problem give room for mocking and criticism
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 29, 2023, 03:58:17 AM
I believe say this section no get restrictions for rank or levels...
No rank restrictions at all, provided everibodi stick to making dem proverbs for pidgin and give d explanations for real English.

This ones na me be the author..
Anyhow wey e bi, you for try put explanation down so dat others go flow with you.
sr. member
Activity: 308
Merit: 448
Math + Code = Blockchain 😁
November 28, 2023, 10:08:42 AM
I say make I add some proverb way I form by myself

No b to carry de shout Bitcoin u no watin BTC b?
Meaning:not all who talk about Bitcoin know about it

Naira de rise naira de fall but Bitcoin ge level pass am
Meaning: Bitcoin is immune to inflation

Bitcoin no de heavy who hodl am
Meaning: Bitcoin is virtual and therefore does not have physical weight.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
November 26, 2023, 06:36:25 PM
Proverb: When man make fence you go know how high em wisdom be.

Meaning: Your knowledge always reveal in your activity.
full member
Activity: 294
Merit: 215
November 26, 2023, 06:39:44 AM
when handshake don pass elbow, e don turn to insult

Meaning that you should know when to draw the limit in any form of social interaction because there is a level a joke will get to, it will become like an attack in personality. Another meaning to this is to never abuse privileges as that can backfire.

cricket dey burn them say e dey bring oil
Meaning someone might be going through a difficult time yet some person might think he is enjoying and pretending.
newbie
Activity: 18
Merit: 0
November 25, 2023, 10:18:32 PM
Even a baby can percieve his mothers breastmilk from afar

This adage means that even the youngest or least experienced individuals can recognize or long for something essential, like a baby recognizing the presence of its mother's breast milk even from a distance. It highlights the innate or intuitive understanding or attraction to something important.
member
Activity: 168
Merit: 75
November 20, 2023, 03:06:04 AM
One thing I love the most about African/Nigerian proverbs is that it carries message and humor, you can't help but laugh and learn at the same time when you read through them, I just bumped into this threat and while reading the proverbs it just cracked my ribs, I couldn't stop laughing, I can't just read and pass without dropping mine. So here goes.

Woman wey never see problem.. Na im dey still hold breast run.

This proverb conveys the idea that someone who has not faced significant challenges or difficulties in life may still take certain things for granted or not fully appreciate the gravity of certain situations.


Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
This means you shouldn't always make assumptions based on the current situation or facts that surrounds the the situation.



Person wey don faint before no be
stranger to death.
This proverb means that people who has experienced worse situations in the past are no more afraid of what might come in the future.



No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
 just because someone benefits from a situation or gains something doesn't necessarily mean they will be generous and share it with others so be cautious and not expect reciprocity or fairness from everyone,



Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
This is a cautionary reminder that one should always consider the potential consequences before engaging in any erratic or irrational behavior
jr. member
Activity: 135
Merit: 6
November 19, 2023, 06:02:35 PM
I must commend this post, it's really funny.

Waiting old man go siddon see even if small pikin climb leather him no go fit see am

Meaning say knowledge or wisdom no by how you tall reach or how you big reach
newbie
Activity: 13
Merit: 1
November 19, 2023, 11:28:38 AM
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.

— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.

Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations.


When a blind man tell you say him go stone you make you already know say in feet dey mach stone.


Meaning: when someone way you done big pass dey tell you say him go deal with you make you know say e get waiting dey bit drum for am.
newbie
Activity: 50
Merit: 0
November 18, 2023, 08:51:31 PM
Na Rat wey dey inside, tell the one wey dey outside say fish dey for cage
newbie
Activity: 50
Merit: 0
November 17, 2023, 08:52:07 PM
Na small pikin dey call im mama boyfriend, Uncle.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
November 17, 2023, 05:36:49 PM
Proverb: Send your pikin go where him wan go, nai dia you go see speed.


Meaning: Passion must always drive our actions.
full member
Activity: 280
Merit: 190
The great city of God 🔥
November 13, 2023, 08:11:55 AM
Person wey marry 2 wife's be like who dey ride two tires at once.

person wey dey hungry no they think of sex.

Person wey want make in future bright, make e stop to dey shift pant anyhow.

Person wey dey go visit him wife from far journey dey prepare for war. So make sure you drink agbo jedi make you no go fuck up.

This ones na me be the author..
newbie
Activity: 32
Merit: 0
November 13, 2023, 07:40:52 AM
Proverb: Anybody wey fetch firewood with Ant 🐜🐜🐜 has also invited Lizard 🦎🦎 🦎 for a feast/merriment.

Meaning: There is a repercussion for any decisions you take.
newbie
Activity: 22
Merit: 4
November 11, 2023, 01:17:38 PM
I greet una oo senior men and women dem abeg make una no next as I carry my leg come here I believe say this section no get restrictions for rank or levels based on say as 9ja we be person for chuck mouth this section, and I carry small tori come here as provab.

Proverbs: Any fish wey dey chop em fellow for water no know say na human being dey chop am too.

Meaning: stop to dey look on people based on say you get pass no mean say another person no get pass you.
full member
Activity: 224
Merit: 195
November 11, 2023, 12:56:14 PM
Make hunter way carry bag for back not feel superior way him non know wetin dey the other hunter bag.
Abeg senior man make u try explain wetin e mean, make u no just drop proverb cos I sure this one na u bring am and e get wetin u want pass across abeg make u try explain am well I don even dey try rack my head but to no avail.
Pages:
Jump to: