Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 9. (Read 9496 times)

member
Activity: 159
Merit: 39
June 02, 2023, 12:45:36 PM
I dey troway salute to all the senior men Dem for dis side. And special salute to d person wey reason to open dis place. As naija babe wey I be, E sweet me to see place wey my fellow naija pipo dey dey hit beta proverbs. E jus be like say we carry a little of home come dis side. Dis na beta tin bcos proverbs jus be like salt, without am, flavor no go dey. Make I drop dis one wey my mama dey use nack me

Proverb: Wisdom be like underwear; e gud to get, but no gud to show off
  Dis one dey easy to understand but I go appreciate more meaning to am.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 02, 2023, 10:05:50 AM
Proverb: Na person wey like you go tell you say your mouth dey smell.
Thank you for dat proverb. Dis days sef, na to hand d persin tomtom or menthol. No too much talk sef again. I hope sey people wey dey back seat for hall dey hear am, ba or make I increase d amplifier for una?

On a serious note, a lot of people this day nor dey like correction no matter how subtle or soft you deliver am to dem. Everybody dey form "I've arrived, you can't talk to me that way." E worse pass for dis social media space.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 01, 2023, 02:03:10 PM
Even as we don enter anoda chapter for we country naija I wam yarn una one ogbobge proverb wey my grand mama yarn me before she kick bucket I feet say e go help us wey be elders for here.

Proverb: Na person wey like you go tell you say your mouth dey smell.

Meaning: It takes love to correct a bad child. Imo don't see correction as insult because he who corrects you wants the best for you.

Proverb: Na person wey first start to dey use pot cook go first get old pot.

Meaning: You can not be wiser than someone who taught you what you know when you are new to the system. You can not be older than your senior.

I fit no give you the meaning wey enter your body but you fit still add your own meaning(s) make we learn together.
@GiftedMan, you nack beta proverbs for dia, Esp the first one. Life dey easy wen we dey surrounded by pipo wey fit de honest with us, not to laff wit us for front, but wound us for back.

 

You do well my broda Majestic as you take make my head swell and my body sweet me well well you try well well. Your word remind me wetin our elders talk wey be say if you praise person wey pound yam well you dey give am more strength to pound weller weller next time. I no go slack I go dey drop more beta proverb because na my grand mama train me.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
June 01, 2023, 01:27:36 PM
Even as we don enter anoda chapter for we country naija I wam yarn una one ogbobge proverb wey my grand mama yarn me before she kick bucket I feet say e go help us wey be elders for here.

Proverb: Na person wey like you go tell you say your mouth dey smell.

Meaning: It takes love to correct a bad child. Imo don't see correction as insult because he who corrects you wants the best for you.

Proverb: Na person wey first start to dey use pot cook go first get old pot.

Meaning: You can not be wiser than someone who taught you what you know when you are new to the system. You can not be older than your senior.

I fit no give you the meaning wey enter your body but you fit still add your own meaning(s) make we learn together.
@GiftedMan, you nack beta proverbs for dia, Esp the first one. Life dey easy wen we dey surrounded by pipo wey fit de honest with us, not to laff wit us for front, but wound us for back.

 
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 29, 2023, 03:23:52 PM
Even as we don enter anoda chapter for we country naija I wam yarn una one ogbobge proverb wey my grand mama yarn me before she kick bucket I feet say e go help us wey be elders for here.

Proverb: Na person wey like you go tell you say your mouth dey smell.

Meaning: It takes love to correct a bad child. Imo don't see correction as insult because he who corrects you wants the best for you.

Proverb: Na person wey first start to dey use pot cook go first get old pot.

Meaning: You can not be wiser than someone who taught you what you know when you are new to the system. You can not be older than your senior.

I fit no give you the meaning wey enter your body but you fit still add your own meaning(s) make we learn together.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 27, 2023, 02:04:15 AM
Una know say when hunter comot from bush, na so him mouth go dey sharp say him do animal this and that but the true picture of wetin him eye see nko
Dis na true. Proud people like to boast of things wey dem do and even add the wans wey dem nor do especially wen dem know sey nobody dey there to contradict dem.

OP abeg no vex, na only dis two na im  I go fit to drop for this naija proverbs thread.
Even those two wey you throw enta na ogbenge talk dem be. Dem be real grassroots yarn. You deserve my colele wata but na as e dry for my fridge na im make we nor pour you any.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
May 24, 2023, 01:22:28 PM
Monkey get skill be say tree near tree.

Meaning: you're making progress because you're surrounded by the resources and what it takes to make progress.


Your fowl don de born Turkey.

Meaning: your little resources is yielding plenty gains.


OP abeg no vex, na only dis two na im  I go fit to drop for this naija proverbs thread. Members don talk almost the whole proverbs wey I know.
hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 24, 2023, 08:54:05 AM
E get our provide wey say “Until the lions have their own historians, histories of the hunt will glorify the hunter.”

Meaning : E no easy ehh..... smiles. Anyway I believe say this proverb just sum up fair hearing. Hear both sides before you commit yourself. Una know say when hunter comot from bush, na so him mouth go dey sharp say him do animal this and that but the true picture of wetin him eye see nko, you no go hear am because you no dey there with am. Make we dey wise.


hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
May 23, 2023, 06:35:42 PM
Egg 🥚 wey them cook no dey be the same with the one them fry because fried egg must need oil other ingredients to sweeten am.

Meaning: Good characters can never be compared with bad, a bad characters carries all manner of bad luck and hatred. Hence good characters are rear to find.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 20, 2023, 06:50:27 AM
1. Na fly wey no dey hear word dey follow dead body enter for grave oh.
Meaning: When a fly fails to hear words it follow the corpes to the grave

2. Pikin wey don say him mama no go sleep for night make eh also ready for night vigil.
Meaning: When a baby fails to sleep at night both mummy and child stays awke till dawn.
Nor vex sey I single your post out to point out certain things. Na the desire to set things right make me dey do am. Those ur explanations na just transliteration of the proverbs wey you throw there. Nor be the real meaning. You fit ask any elderly person around you.

The first wan mean – reaping the consequences of one's stubbornness or recalcitrance.

The second wan mean – talks about retributive justice or karma. Whatever we wish unto others is what we should expect in return.

Make we try dey use pidgin even as the corner na African Proverbs in Pidgin so that every bodi go flow 2geda.
God bless you for dat talk. I don even post my comment on dis kain talk before I com see dis ur own. I suppose pour you colele water but my fridge dry up now.
member
Activity: 213
Merit: 12
May 19, 2023, 04:32:41 PM
It's good for us to talk in our forefathers dialect,to prove to us that we are really born and brought up by the lineage of our ancestors.

Provable is the Igbos language,,,,

No matter how hard the jungle is,a Lion can never eat grass,,it means that no matter how bad leadership or the whole world turns into we must try to survive...
An old woman says if the hill learns to break her waist she will learnt to walk and take rest,it means that when the journey of life begins stressful we learn to apply wisdom to it..
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 18, 2023, 01:10:58 PM
The boat that sail on the sea or an ocean doesn't know it doesn't have an end.
Meaning; No matter how your are suffering or hustling know that one day your maker (God) will answer your prayers. So don't give up keep pushing to get to your destination.

Haba baba abeg make una try dey calm down with dis big big grammar Dem nah, here now we African proverb we no need to blow big big english so dat our elders go hear and follow us chuck mouth. Make we try dey use pidgin even as the corner na African Proverbs in Pidgin so that every bodi go flow 2geda.

No carry dis talk for mind because my people talk say no be only papa and mama wey born pikin dey train am because pikin na every bodi own once Dem give birth to ram.
hero member
Activity: 2450
Merit: 616
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 18, 2023, 03:02:33 AM

3. Pu--y dey sweet oh, but signature campaign sweet pass
Meaning: Women is sweet but money is sweeter.


Guy this your own quote na wa oo. Definitely na your own personal quote no be African quote  Grin. E just be like the kind of quote wey the late Zimbabwe president, Robert Mugabe dey give.

Anyway, make I drop my own quote, hope say dem never splash am here already...

Stealing the village drum is easy but finding a place to beat it peacefully is the problem.

Meaning:  “Stealing the people's mandates is easy, but governing peacefully with the consequences of your actions thereafter is the problem.” I think this na quote wey dey online, I use Google check the meaning com see say e relate to the past election wey de matter still dey court.

But apart from that meaning, me I for still say e mean say anything wey belong to the village, you no fit thief am and still use am for the same village make men no catch you.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
May 10, 2023, 04:24:11 PM
It feels good to finally drop my first African proverb in pidgin for this board wey we dey so, and dey go like this;

1. Na fly wey no dey hear word dey follow dead body enter for grave oh.
Meaning: When a fly fails to hear words it follow the corpes to the grave

2. Pikin wey don say him mama no go sleep for night make eh also ready for night vigil.
Meaning: When a baby fails to sleep at night both mummy and child stays awke till dawn.

3. Pu--y dey sweet oh, but signature campaign sweet pass
Meaning: Women is sweet but money is sweeter.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
May 09, 2023, 08:14:13 PM
The boat that sail on the sea or an ocean doesn't know it doesn't have an end.
Meaning; No matter how your are suffering or hustling know that one day your maker (God) will answer your prayers. So don't give up keep pushing to get to your destination.
newbie
Activity: 38
Merit: 0
May 09, 2023, 10:14:28 AM
If breeze blow wella, foul yansh go open. ( Meaning )   "If person go through difficulties too much, people will see your secret"
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
May 05, 2023, 05:39:49 PM
Our people say any discussion them discussed for night morning na to nod head.
Meaning: always work on your life the way you planned it out and whenever it works people will come jubilating with you thinking it was that easy without planning.
I say make I carry this one come here.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 05, 2023, 02:52:34 PM
but e pain me say she kick bucket when tins no soft for me...
I feel you on dat. Somehow somehow we nor need to dey wait until things soft because things nor go everly soft for dis life oh. As life don programme be sey "the more money we make the more problems we get." Those small small things wey we fit do fit go a long way in other people's struggling life.

Oyibo dey call am "once a man, twice a child.
Na dat koko don dey as my avatar text for long oh. Na true principle of life be dat and as dem dey play am, e dey show korokoro.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
May 05, 2023, 02:13:18 PM

No how wey you go take torchlight old woman wrapper wey you nor go see shit there.
Meaning: In life, everyone has their own shortcomings. Sometimes, it's good to look pass these inadequacies.

 Oga boss, no be lie you talk. Mesef no nid torchlight sef and just like @Giftedman tok, e good to do those things seeing as their age don go plus nah two times person dey be small Pikin. (Newborn and old age). Oyibo dey call am "once a man, twice a child. No be to dey shout for them, but rather follow them wit understanding and nah dia blessings dey. At least @Giftedman dey reap am.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 04, 2023, 07:10:17 PM
but on a normal I go just help her tidy the stuff like say nothing happen because I know say old age go reach everybody unless person wey die before em time...
I sure sey granny go don pour ororo for your head join too.

She pour me better ororo for my head no be small but e pain me say she kick bucket when tins no soft for me but I dey happy say I dey alive dey see tins and tins wey she bin pray for me dey show face wella, tears dey drop for my eyes now but I no fit shout because na oluwa Sabi why beta people dey go home early.
Pages:
Jump to: