Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 29. (Read 10230 times)

hero member
Activity: 966
Merit: 701
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 24, 2022, 09:25:46 AM
I greet una my poeple. As I enter our local board I discover something. Many new accounts just dey pop up they create plenty topics and dem go ban dem because of plagiarism.

Igehh don already advice them not to dey open plenty and careless topics wey dem never get better experience use tall for here.

Me I go drop proverb for our newcomers here and I go try explain the proverb join.

Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.

I go contribute to wetin Uchegod don highlight. Igehhh gave a sound warning about plagiarism a day before.
Proverb: our people say when stranger enter new community he nor dey go price chieftancy title
Meaning: when you come to a new place you need to be careful, learn the way of life there before you can blend in
hero member
Activity: 1134
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
February 24, 2022, 08:53:14 AM
I greet una my poeple. As I enter our local board I discover something. Many new accounts just dey pop up they create plenty topics and dem go ban dem because of plagiarism.

Igehh don already advice them not to dey open plenty and careless topics wey dem never get better experience use tall for here.

Me I go drop proverb for our newcomers here and I go try explain the proverb join.

Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 24, 2022, 05:46:03 AM
Proverb: you nor go fit run leave your yanch for back  
In English: Because you want to run it doesn’t mean you should leave your buttocks behind Lips sealed
Meaning: You should not  kill yourself because you want to gain something
Disclaimer: this proverb get many meaning una fit talk Wetin una know am to mean
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
February 21, 2022, 05:48:26 PM
O Bobbb, e be like say the tung dey everybody body this evening o. All una yarn just dey enter brain finish.
Na that small snake turn python own dey enter my head pass becuase if you look am, na so e be. Watin you dey underrate say na small matter way no touch anywhere, na that same matter people fit rise way be say eh, e go choke you. You no go know how to go round am again than to beg. So for the life, no underrate something or even person because, e fit turn python if you give am the chance way e need. This life now, e be as e get and na head we dey carry follow things, no be power again. Una too much.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
February 21, 2022, 03:36:45 PM
Proverb: when corruption favor person e go say na connection
Meaning: Human being go only call something bad when e nor dey work for am
Dat na true. But sha nor be every connection dey be through magomago oh.

Proverb: Small snake wey one person see fit turn to python.
With dis your proverb, I can confirm sey you be Igbo. Our people nor dey joke with dat proverb, especially when dem wan judge matta for community or elsewhere. Dem go want make d accused chook mouth for the matta and explain them own side of wetin happen.

Meanwhile, make I drop una one.
Proverb: When eye dey cry, nose dey follow cry too
Meaning: if you really dey close with person, watin dey worry am or happen to ram, e suppose happen or wayh you too.
Na so e bi.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
February 21, 2022, 02:21:49 PM
meanwhile make I for drop one proverb here...Pikin no dey use him papa blokus play o,na him mama breast e dey use
I don dey reason this proverb since shah but, I no fit really come up with better interpretation for the thing except say, I dey reason am as:

Meaning: even for family or for life cef, levels dey to how persin fit free reach. Make your play no carry you go where e go choke you. Na just my reasoning shah.

Meanwhile, make I drop una one.
Proverb: When eye dey cry, nose dey follow cry too
Meaning: if you really dey close with person, watin dey worry am or happen to ram, e suppose happen or wayh you too.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
February 20, 2022, 04:53:35 PM
Pikin no dey use him papa blokus play o,na him mama breast e dey use
lmao, anytime new person play come this our corner, i dey always expect to hear new talk wey go burst my head, i nor dey ever dey disappointed, but you nor cun drop wetin the proverb mean bros.
That na the legit via say, them new person for we corner no dey disappoint and the proverb way mimiklinton drop so, e no add am meaning. Maybe e want make we reason am ourselves (but if na so, e suppose cap us) or encef nor even know abi e never sabi our way wella for this place. That one dey shah but anyhow e be, you got still edit am con put meaning or you go just tell us say eeh, na like this you want am. I no know if you grab!

As I don yarn you that one finish @Mimiklinton, I carry kolanut dey say welcome for inside this we corner. Na we-we zey here and the idea na to show say, we get culture and our people carry sense join body even before them oyibo people come jam us. Make we dey promote the legit background way we born on top. Una na dey do well.
legendary
Activity: 1456
Merit: 1108
Use chips.gg
February 20, 2022, 12:33:57 PM
Pikin no dey use him papa blokus play o,na him mama breast e dey use
lmao, anytime new person play come this our corner, i dey always expect to hear new talk wey go burst my head, i nor dey ever dey disappointed, but you nor cun drop wetin the proverb mean bros.

Proverb: Small snake wey one person see fit turn to python.
Meaning: One person's account of an ordeal or situation is not enough
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 20, 2022, 05:45:09 AM
Omo,the crypto stuff no be beans o..I don dey try since to run am,but e either be say my head no carry am or na wetin I no know sef...meanwhile make I for drop one proverb here...Pikin no dey use him papa blokus play o,na him mama breast e dey use
Crypto no be anybody mate ooo today na your friend tomorrow e don send you go village. Mimiklinton I welcome you to this lga. He get as we dey arrange our proverb and their meaning for format make everybody fit catch am once. When I first show I dey use English before them correct me to pidgin. When we dey write proverb we dey put am for bold like this
Code:
 [b][/b]
member
Activity: 77
Merit: 10
February 20, 2022, 05:38:08 AM
Omo,the crypto stuff no be beans o..I don dey try since to run am,but e either be say my head no carry am or na wetin I no know sef...meanwhile make I for drop one proverb here...Pikin no dey use him papa blokus play o,na him mama breast e dey use
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 20, 2022, 04:40:10 AM
Uche and Smartvirus, una try. At least after two days. E bi like sey una go consult village people for expo on dis one sha 🙊.
Lol,,, the matter no be like that o... you, you know say this proverb soft normally but, we abo make I say me, i bin dey try reason how I go carry polish am make the pighin for sweet for ear. I no even sabi say, the tin don dey for like 2 days cef but anyhow e be na, e still sweet me for body say, I chest watin come out for the doings. You know this matter na!
Nor worry, I go soon drop una something to carry enrich this our corner. I dey with una normally. I greet una my people!
I no know where una sabi this things from. I don learn some kind things for here where I go take shine for my house.
Proverb: when corruption favor person e go say na connection
Meaning: Human being go only call something bad when e nor dey work for am
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
February 19, 2022, 02:44:38 PM
Uche and Smartvirus, una try. At least after two days. E bi like sey una go consult village people for expo on dis one sha 🙊.
Lol,,, the matter no be like that o... you, you know say this proverb soft normally but, we abo make I say me, i bin dey try reason how I go carry polish am make the pighin for sweet for ear. I no even sabi say, the tin don dey for like 2 days cef but anyhow e be na, e still sweet me for body say, I chest watin come out for the doings. You know this matter na!
Nor worry, I go soon drop una something to carry enrich this our corner. I dey with una normally. I greet una my people!
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 18, 2022, 01:14:47 PM
Proverb:no matter how mess silent reach the smell dey always loud
Meaning: you no go fit hide your sins one day them go come out
English: Nothing can be hidden under the sun forever
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
February 18, 2022, 09:45:43 AM
Proverb: make I sleep small tomorrow still far na make okoro poor
Meaning: Laziness is a poor man's best friend
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
February 18, 2022, 09:06:57 AM
Uche and Smartvirus, una try. At least after two days. E bi like sey una go consult village people for expo on dis one sha 🙊. Make una two share the spoil. We don wrap that one. Enjoy.
hero member
Activity: 1134
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
February 18, 2022, 05:40:56 AM
This one na very popular one. Na wetin people wey go school dey call, "sing song". Make I drop am here. Any persin wey get d interpretation wey jam am or wey jam my head go get colele wata to baff for this hot weather.

Cow wey nor get tail, na God dey drive am fly
Na true say the proverb dey popular, and e be like everybody go understand am because e dey sef explanatory. But I go try give am short interpretation wey get swag see weda e go please oga Mpa.
Proverb: Cow wey nor get tail, na God dey drive am fly
Meaning Person wey no get connection, na God be em connect.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
February 17, 2022, 01:51:09 PM
This one na very popular one. Na wetin people wey go school dey call, "sing song". Make I drop am here. Any persin wey get d interpretation wey jam am or wey jam my head go get colele wata to baff for this hot weather.

Cow wey nor get tail, na God dey drive am fly
Na true say e common o and the interpretation many well well but, one meaning carry say;
Person way no get people, na the grace of God dey carry am along for the life.

Time go always come when e go be like say, your wahala wan swallow you, you go look left and right then, that passage for bible way say, 'from where cometh my help' go enter your mind and at that point, na only God you fit look up to as person way no get anybody. The life no fit swallow you with God by your side.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
February 15, 2022, 04:42:02 AM
This one na very popular one. Na wetin people wey go school dey call, "sing song". Make I drop am here. Any persin wey get d interpretation wey jam am or wey jam my head go get colele wata to baff for this hot weather.

Cow wey nor get tail, na God dey drive am fly
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
February 12, 2022, 04:02:38 PM
You sure sey you hear dat proverb well so? I know sey I dey hear am as – "Old man nor fit dey for house, make goat born with rope wey dem tie am." Wetin make me bother give you dat version na because of the meaning wey you give of am. If you speak am for Igbo (may be you na Igbo too), both dey wan sound alike if persin nor listen wella. But if you dey sure sey na so you hear am, no shaking.
E be like the version for this proverb plenty because, e get another one way I sabi too say, the meaning no far from watin the we dey talk for this one although, no be goat them carry talk am shah. The proverb say,

Proverb:
For we Pighin: adult no go dey for market and pikin neck go come bend.
Meaning: e dey relative shah but the main thing be say, adults go always try to make sure say, nothing go wrong under there watch. Once them see say, the matter wan go out of hand, them go sharply correct am.

Still on still, I go like carry this small chance way I get congratulate you my own person. Mpamaegbu, you na big name and now like this, you do  Legendary up, no be chaise. Watin sweet me for body be say, na the same week way me turn Hero na em you Legendary up. That na to say, we dey together and e go touch everybody. Cheers!
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
February 11, 2022, 04:45:36 PM
E get proverb way cap say,

Old man or adult no fit dey for house, then rope way them carry tie goat for neck go choke am, con kill am.

Jump to: