Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 30. (Read 9496 times)

member
Activity: 98
Merit: 36
January 26, 2022, 02:13:35 PM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.

Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
These guys, una sure sey we nor go run MRI test or something to find out if una nor be old men so? 😅😅 Kai, una yarns really crack me up. Nice ones. So true.

Na the matters senior man, you dey hear ohhh!!!
We go ey give or ah back to back for this matters.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 26, 2022, 08:50:32 AM
Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
These guys, una sure sey we nor go run MRI test or something to find out if una nor be old men so? 😅😅 Kai, una yarns really crack me up. Nice ones. So true.
Oga mi, no be old man I be o😅😅 but I don follow old men chop food for table.
African Proverb say: Pikin wey wash hand well go follow elders chop food.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 26, 2022, 04:02:39 AM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.

Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
These guys, una sure sey we nor go run MRI test or something to find out if una nor be old men so? 😅😅 Kai, una yarns really crack me up. Nice ones. So true.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
January 24, 2022, 06:58:19 PM
Proverb: Who build glass house nor dey throw stone
Meaning: a wise person will not do something that will affect him negatively.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 24, 2022, 06:15:12 PM
Proverb: Them say na small-small he goat dey use scale en mama kpekus.
Meaning: that na to say, before person go start to disrespect you, e been don dey attempt some funny-funny behaviour since way, you no gree stop when e early. The next thing you go see say, e don start to fall your hand on a major and by that time, nothing you fit do way go shake am again.
Na true, e no deh start suddenly. Na small small e dey take start. Person no fit disrespect you if you no permit.


Make I drop the one wey motivate me this year. Na this one be my new year resolution. I no need explain the meaning because everybody go fit understand am.
Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
January 24, 2022, 03:43:38 PM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.
No be play o, if them no been commot body for some of us, e for hard us to wise o. No be say, the things we dey see no sweet person or been motivate person but, the comfort go dey make you feel say, you dey alright mean while, na die you dey because, na time dey uo so.

Anyhow na, make me cef drop una small something to carry reason the life dey go.
Proverb: Them say na small-small he goat dey use scale en mama kpekus.
Meaning: that na to say, before person go start to disrespect you, e been don dey attempt some funny-funny behaviour since way, you no gree stop when e early. The next thing you go see say, e don start to fall your hand on a major and by that time, nothing you fit do way go shake am again.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
January 24, 2022, 08:20:48 AM
My people! i dun miss una for this corner o, hope say everywhere maramma! Make una nor vex for me unto say i never dey add my own curry to the pot of stew for this way o, many many bush meat dey wey  man dey pursue. But unto say i dun pass this way, i dun tear one sachet of curry to pour for the stew.
Proverb: Na overconfidence make goat wey suppose dey run pass highway, dey waka.
Meaning: Don't let over confidence kill you, exercise caution where and when necessary.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
January 24, 2022, 05:09:44 AM
Proverb: Who get only kobo for pocket nor dey jump for public if not people go hear the sound know say he nor get paper money.
Meaning: A man doesn't show off his poverty.
Kobo na physical coin we dey use transact in the old days. That time money get value for naija. Now e better to get crypto coin than to hold paper money  Wink
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 22, 2022, 05:15:43 AM
My people, na today I discover here.
I know say I dey welcomed.
I thank all of una wey done dey make here happen before now. Una too much.
Proverb: Na foolish person wey no know say em brother na visitor.
Meaning: Some people dey regard strangers pass their people. As you get visitor, entertain your brother join. Anything you do for stranger or visitor do more for your brother because African proverb talk say "if corpse begin smell, friend wey big pass brother go run"
member
Activity: 98
Merit: 36
January 21, 2022, 09:43:18 AM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
January 21, 2022, 02:57:24 AM
Proverb: Na presence of lazy man them take dey kill strong man
Meaning: survival is not dependent on strength but wisdom
Mpamaegbu we dey see you. This thread no busy like before again proverb don finish for mouth? Or na poor visibility dey worry us I go post am for our local thread make others know say we dey here.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 20, 2022, 05:55:56 PM
I try ask them watin be the vital way really folo the yarn but, them no gree talk shah.
Na because owa people sey persin wey dem throw proverb give and come still explain am to, d money wey dem take marry im mama waste, na im make dem nor gree explain am to you. Dem nor want make your papi money waste 😏

Proverb:
For we Pighin: Them say, e go better make person way don dey chop or drink dey chop or drink dey go. Dan for that person to stop to chop and give way to person way never chop to chop.
Nor mind dem dat yarn na street slang, nor be proverb per se. But e good as you identify am.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
January 19, 2022, 08:12:41 AM
Omo, w get yarn way some men them I bin dey talk with drop for me yesterday. Guy, the tin enter my head no be play and I ron dey try folo up the thing since make I for understand am well. I try ask them watin be the vital way really folo the yarn but, them no gree talk shah. The yarn na people from the east side so, una way dey here fit still talk as e be if una sabi am. Make una hear as them take talk am...

Proverb:
For we Pighin: Them say, e go better make person way don dey chop or drink dey chop or drink dey go. Dan for that person to stop to chop and give way to person way never chop to chop.
Meaning(via my own reasoning): jst like those of us way dey collect small thing with signature now, we no go gree commot make person way never see nothing for collect chop. That na to say, person way don dey on speed, if you cut am short, e fit fail break con cause wahala way fit worry everybody. Na to allow am, make e tire then, e fit tun matters way go better for everybody.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 19, 2022, 04:57:39 AM
I dey sight all d ogbenge yarns wey una dey throw enta here. E dey totori me wella. Make una nor reason am sey I neva sama una colele water. E never dey fridge now but once e show I go baff una. Make una keep up d good work across d forum too. Nor let anybody distract or discourage una or even push una to make irrational decisions. One luv, my people!
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
January 17, 2022, 04:11:48 PM
E get some things way you go hear for here eh, you go know say, some persons leg really touch ground for here. Like, the e unique die and no be something way, you ho dey hear around on a normal day. Na that kind thing I won dey see or hear no be watin, I go carry book read or watch the least movie and 2 seconds e don turn up. Things like, old man way seat down for chair go see far pass young man way stand... omo, this type them don too rampant, infact eh, you fit say na pirated stuff cef. We don too dilute am for the life.
Una dey try for here believe, na here I see say, old age dey for some youthful body too. Una too much.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
January 13, 2022, 02:17:44 AM
Una proverbs na die. I greet una way dey make this place vibrate like torch nokia nor give up na small small that thing you dey find go reach your hand. As you dey here we dey see you...your face dey show so continue to sama better proverb make we share our ancient wisdom. Nor fear na anointing oil dey your head nor be dandruff
hero member
Activity: 966
Merit: 701
January 12, 2022, 05:15:13 AM
Proverb: When small pikin no know the difference between fish and turkey na agidi e go call am
Meaning: a ignoarant person is a like a little baby
Thanks for dropping by but dat ya proverb dey jump my head sha. Abi na old age dey worry me for young age ni. Na d agidi part dey confuse me oh.
Yes you be young dude with oldie wisdom. Agidi na that food way Dem dey put for leaf if you give this 3 food to pikin way never get sense e go call am another name. Because e never get the experience before. After the second time e go know say difference dey
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 12, 2022, 04:45:39 AM
Proverb: When small pikin no know the difference between fish and turkey na agidi e go call am
Meaning: a ignoarant person is a like a little baby
Thanks for dropping by but dat ya proverb dey jump my head sha. Abi na old age dey worry me for young age ni. Na d agidi part dey confuse me oh.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
January 12, 2022, 03:37:23 AM
Proverb: When small pikin no know the difference between fish and turkey na agidi e go call am
Meaning: a ignoarant person is a like a little baby
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 12, 2022, 01:42:28 AM
Wen persin wey thin face barn and begin dey look am, e go be like sey im wan steal yam.
Meaning: A lot of people act on prejudice and that's judging a book by its cover.


Pages:
Jump to: