Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 31. (Read 10492 times)

legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
February 01, 2022, 03:58:52 PM
Senior Man I dey loyal, I dey under ur bonnet like this!

lmao, inside bonnet dey hot ooo, you nor go like dey under umbrella, lol.

Our people say , Kolanut & palmwine wey dem go take serve elders for evening, na for morning dem buy am, because you fit nor see am buy later.

Meaning - Make proper preparations always.
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 01, 2022, 10:34:31 AM
Proverb: The same turning garri( eba turner) way them dey use bake eba for good pikin na them go still flog pikin way stubborn
Meaning: Good deed is rewarded handsomely and bad deeds are punished with the same hand
Proverb: Man way get work no dey do aproko for compound
Meaning: a busy man cannot be found gossiping others
member
Activity: 98
Merit: 36
February 01, 2022, 08:41:19 AM
Gasty4 you go identify yourself oo shuoo. I don confirm say na grammar school you go. You dey drop proverb like DJ Khaled I comot cap for you
Proverb:who never sidown for chair nor dey lap person
Meaning: poverty nor go fit help poverty comot for poverty

Senior Man I dey loyal, I dey under ur bonnet like this!
Boss Mpamaegbu , I dey loyal,you dey do more than enough for here
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
February 01, 2022, 03:54:45 AM
Una d moda proverbs for here badly. I say make I follow una drop one for here.
Proverb: The Yoruba people say "if we don't have bats, we can make sacrificial offerings with other birds"
Meaning: if what you hope for, didn't come your way, make use of the available one.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
February 01, 2022, 12:30:05 AM
Gasty4 you go identify yourself oo shuoo. I don confirm say na grammar school you go. You dey drop proverb like DJ Khaled I comot cap for you
Proverb:who never sidown for chair nor dey lap person
Meaning: poverty nor go fit help poverty comot for poverty
member
Activity: 98
Merit: 36
January 31, 2022, 09:05:34 PM
IF YOU TAKE COW EYE LOOK GRASS, NA ONLY GRASS GRASS YOU GO DEY SEE!
MEANING: How you see life does really matters, at times you need to change your mentality and look further than you think.

FIREWOOD WEH DEM DEY USE FOR RAINY SEASON, NA FOR DRY SEASON DEY DEY GATHER AM!
MEANING: Humans should plan good, planning for the bad days too,coz their comes bad days after them good one's.

IF GIVER NO DEY CAREFUL, BEGGER GO FIRST AM BUILD HOUSE!
MEANING:You'd shouldn't be a fool while trying to be a cheerful giver, always do this with disipline,humans abuse good things.

Ornah good morning and happy new month!! 🖤
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
January 27, 2022, 11:12:49 AM
Proverb: Person way you sabi dem nor dey use torch find am for night.
Meaning: A true friend is known in times of difficulty.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 26, 2022, 04:49:18 PM
Persin wey nor dey where dem fight war nor dey know sey war na die.
Meaning: Those who don't know what they enjoy in moment of peace take it for granted.
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 26, 2022, 04:11:12 PM
Proverb: na rat way dey inside house nai dey show outsider where to enter
Meaning: There is no enemy greater than the one within

Make we dey help each other make we no scatter the small tin we get. Who dey outside no suppose know our weak point. Na we go use our hand promote our own e get why I yan this one this night. Na food for thought I drop here.
legendary
Activity: 1694
Merit: 1168
January 26, 2022, 04:03:05 PM
Proverb: Na presence of lazy man them take dey kill strong man
Meaning: survival is not dependent on strength but wisdom
Mpamaegbu we dey see you. This thread no busy like before again proverb don finish for mouth? Or na poor visibility dey worry us I go post am for our local thread make others know say we dey here.
Nor worry, una dey talk talk for here. Omo, Mpamaegbu, this thread way you bin start eh, e sure die. Watin I dey see here na stuff way be say eh, I no dey hear on a normal day. E generic die and e all make sense. E dey surprise me say, no matter how we advance for  the  life, many of us still carry our tradition join body. That na to say, una be Ogbenge for this corner. Plus, I like the growth via the new new faces way don de burst in the corner. Even at that too, I still get joy for the old faces way there hand never tire to dey make here dey bubble. I salama for all of una. We ho dey run am dey go. Bless up!
member
Activity: 98
Merit: 36
January 26, 2022, 01:13:35 PM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.

Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
These guys, una sure sey we nor go run MRI test or something to find out if una nor be old men so? 😅😅 Kai, una yarns really crack me up. Nice ones. So true.

Na the matters senior man, you dey hear ohhh!!!
We go ey give or ah back to back for this matters.
hero member
Activity: 1176
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 26, 2022, 07:50:32 AM
Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
These guys, una sure sey we nor go run MRI test or something to find out if una nor be old men so? 😅😅 Kai, una yarns really crack me up. Nice ones. So true.
Oga mi, no be old man I be o😅😅 but I don follow old men chop food for table.
African Proverb say: Pikin wey wash hand well go follow elders chop food.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 26, 2022, 03:02:39 AM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.

Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
These guys, una sure sey we nor go run MRI test or something to find out if una nor be old men so? 😅😅 Kai, una yarns really crack me up. Nice ones. So true.
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 24, 2022, 05:58:19 PM
Proverb: Who build glass house nor dey throw stone
Meaning: a wise person will not do something that will affect him negatively.
hero member
Activity: 1176
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 24, 2022, 05:15:12 PM
Proverb: Them say na small-small he goat dey use scale en mama kpekus.
Meaning: that na to say, before person go start to disrespect you, e been don dey attempt some funny-funny behaviour since way, you no gree stop when e early. The next thing you go see say, e don start to fall your hand on a major and by that time, nothing you fit do way go shake am again.
Na true, e no deh start suddenly. Na small small e dey take start. Person no fit disrespect you if you no permit.


Make I drop the one wey motivate me this year. Na this one be my new year resolution. I no need explain the meaning because everybody go fit understand am.
Proverb:
If you wan FLY, no follow people wey go dey comot your feathers dey clean ear.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
January 24, 2022, 02:43:38 PM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.
No be play o, if them no been commot body for some of us, e for hard us to wise o. No be say, the things we dey see no sweet person or been motivate person but, the comfort go dey make you feel say, you dey alright mean while, na die you dey because, na time dey uo so.

Anyhow na, make me cef drop una small something to carry reason the life dey go.
Proverb: Them say na small-small he goat dey use scale en mama kpekus.
Meaning: that na to say, before person go start to disrespect you, e been don dey attempt some funny-funny behaviour since way, you no gree stop when e early. The next thing you go see say, e don start to fall your hand on a major and by that time, nothing you fit do way go shake am again.
legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
January 24, 2022, 07:20:48 AM
My people! i dun miss una for this corner o, hope say everywhere maramma! Make una nor vex for me unto say i never dey add my own curry to the pot of stew for this way o, many many bush meat dey wey  man dey pursue. But unto say i dun pass this way, i dun tear one sachet of curry to pour for the stew.
Proverb: Na overconfidence make goat wey suppose dey run pass highway, dey waka.
Meaning: Don't let over confidence kill you, exercise caution where and when necessary.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
January 24, 2022, 04:09:44 AM
Proverb: Who get only kobo for pocket nor dey jump for public if not people go hear the sound know say he nor get paper money.
Meaning: A man doesn't show off his poverty.
Kobo na physical coin we dey use transact in the old days. That time money get value for naija. Now e better to get crypto coin than to hold paper money  Wink
hero member
Activity: 1176
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 22, 2022, 04:15:43 AM
My people, na today I discover here.
I know say I dey welcomed.
I thank all of una wey done dey make here happen before now. Una too much.
Proverb: Na foolish person wey no know say em brother na visitor.
Meaning: Some people dey regard strangers pass their people. As you get visitor, entertain your brother join. Anything you do for stranger or visitor do more for your brother because African proverb talk say "if corpse begin smell, friend wey big pass brother go run"
member
Activity: 98
Merit: 36
January 21, 2022, 08:43:18 AM
Proverb: Pikin weh dey suck breast, na no know say milk cost!
Meaning: You no go value wetin you no hustle for.
Pages:
Jump to: