Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 32. (Read 9496 times)

member
Activity: 67
Merit: 10
December 04, 2021, 04:11:36 PM
This one na yanings wey parents dey drop when them wan carry their pikin boast
Proverb:Monkey nor dey born goat
Meaning: A child is like his father
hero member
Activity: 966
Merit: 701
December 04, 2021, 01:16:35 PM
Proverb: He whose house is on fire does not chase rats
Meaning: Set your priorities straight. Do not fiddle with useless things
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
November 29, 2021, 08:37:52 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
Welcome, time dun reach sef for woman to dey we side small for this corner, you nor need to dey old SatoPrincess to share small wisdom, e fit still be wisdom wey your parents give you or wey person tell you, anyhow wey e be , as far say e get meaning, we for this corner go chest am.

Our people say;
Proverb: Shark wey dey stay for small water nor fit big pass wetin e dey see.
Meaning: You cannot grow bigger than your mindset.

Proverb: Pikin wey dey play for dustbin, go march cheat one day.
Meaning: Luck may save you a couple of times from events, but don't take it for granted. consistency yields results.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
November 28, 2021, 02:02:07 PM
~snipe ~
But shey dis princess na female abi na male–female? Anyway, like owa correct man @CryptocurencyKing talk, we nor too go school for dis we corner na im make we dey use local yarns follow am up as per pidgin oh. Feel at home but make you nor spoil remote sha.
Na legit them relate you so, you carry eye check am. No be sat na matter o, no where e touch normally but na say, make we corner for be our own and make e for dey sweet when we enter na why, we dey reason am. On that note, I welcome you specially to come share this our small corner with us  the house never full until everybody come, e go enter us, no worry.
Oya na, make we for carry this one hold body for the day.

Proverb:
For we Pighin: Them say, bird or person way go like fly, e no go stay near people way dey plug or commot en feather to use clean ear.
Meaning: This means, if you ever have any wish or hope to progress in life, you ought to hangout with like-minds, those that encourages you and avoid people with negative vibes or energy.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 27, 2021, 04:03:23 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
What good is the morning without the sun
This also can be rephrase what good is money without health
Meaning: We need good association to be balanced in life
I welcom you wit two hands like Bubu dey do owa politicians. Later make you surrender d break wey you carry enta house sha. But shey dis princess na female abi na male–female? Anyway, like owa correct man @CryptocurencyKing talk, we nor too go school for dis we corner na im make we dey use local yarns follow am up as per pidgin oh. Feel at home but make you nor spoil remote sha.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
November 27, 2021, 01:31:32 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
What good is the morning without the sun
This also can be rephrase what good is money without health
Meaning: We need good association to be balanced in life
First eh, na to welcome you say, you don fine road lap for this our small corner and as e be so, we don dey one person stronger. I like  say, e give you joy say, you ball in here and watin we dey do con sweet you for body. Na that one mean say, we no just dey throw-way careless capping but still, me go still like make you for put eye for ground. Follow us as we follow dey go. The best way to enjoy our proverb na when we use we pigin dey drop am, na that time e dey sweet both for mouth and for ear. Just try eh,,, I know say;

Proverb:
Brocos-broco (prick-prick), no be the same.
That na to tell you say, even if na the same thing you carry na em the next man carry kwa, one still pass one.

I grab the fact say, no be every body from we naija dey sabi speak the pigin and as e dey hard some kind men them but then, we go dey try.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
November 24, 2021, 04:53:48 PM
~snipe~
E dey happen like that sometimes shah. Some mama and papa dey like act like say, them know there pikin finish. Forgetting say, this pikin you think say you sabi, no be everything e dey display for your front and as e dey grow, na so e dey change, dey follow things way e dey observe for the area. Person just need wise for this life way we come o, na who die na em loose o. Make person no go die for one useless matter way no suppose reach anywhere. You dey avoid disgrace but still, con go chop major disgrace (that na for the pikin side) and mama don turn lesson to people way sabi jump swear... power of tongue, e strong o!
hero member
Activity: 966
Merit: 701
November 21, 2021, 07:55:29 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
What good is the morning without the sun
This also can be rephrase what good is money without health
Meaning: We need good association to be balanced in life
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
November 21, 2021, 02:31:04 AM
This matta com remind me of something wey happen for my area for Lasgidi so many years ago. The short story be sey somebodi wey dey owe one fishseller money bin give d fishseller pikin d money to give im mama but the girl nor deliver d money to her mama. She just die d money. Even when argument com for d matta she still deny am sey nobody give am money to give to her mama and her mama stood by her, saying she trust her pikin. Sey if to sey dat woman truly give d pikin d money sey d pikin for deliver am to her. She com swell on top sey if to sey her debtor truly give her pikin d money, make she (fishseller) die. Na so d matta end there oh. Like play like play, few weeks later d fishseller died.
Eweeeeeeeeeeew! nor be small thing ooo:o na so the woman take die for yeye matter ooo, how much be the money sef....na wa, i wonder how the girl go fit leave with herself for causing the death of her mother.

To raise everybody morale for the house, make i drop one wisdom.

Proverb: You nor fit play ball for 90minutes say ball nor go touch your leg once.

Meaning: Your consistency will pay you, don't quit if you get unlucky a few times.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 19, 2021, 11:50:16 PM
Proverb:
For we Pighin; Them say na only pikin way dey for belle you fit say, e no do.
Meaning; Never be so sure and ready to advocate or stand for a person based on his or her past behaviours not to have done or committed a particular thing. In life, people change!
This matta com remind me of something wey happen for my area for Lasgidi so many years ago. The short story be sey somebodi wey dey owe one fishseller money bin give d fishseller pikin d money to give im mama but the girl nor deliver d money to her mama. She just die d money. Even when argument com for d matta she still deny am sey nobody give am money to give to her mama and her mama stood by her, saying she trust her pikin. Sey if to sey dat woman truly give d pikin d money sey d pikin for deliver am to her. She com swell on top sey if to sey her debtor truly give her pikin d money, make she (fishseller) die. Na so d matta end there oh. Like play like play, few weeks later d fishseller died.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
November 18, 2021, 03:55:39 PM
Anoda proverb wey resemble dat one be – No matta how careless wey a man wan sit, im nor fit sidon on top im blokos.
Hahahahahaha, jeez! Omo, you na correct deede no ne lie. But no be play o, person no fit make that mistake o, you wan crush your generation before,,, and the pain no be here o, na die hard something.
Proverb: Dem nor dey roast corn for fueling station.
Meaning: Do the right thing at the right place, not all characters are suitable to be displayed everywhere you find yourself.
Men way dey run am, I swear una dey finish work for here. Bless up my people, una too much. Make we just dey carry am dey go. Make I drop small something...

Proverb:
For we Pighin; Them say na only pikin way dey for belle you fit say, e no do.
Meaning; Never be so sure and ready to advocate or stand for a person based on his or her past behaviours not to have done or committed a particular thing. In life, people change!
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
November 14, 2021, 09:31:31 AM
Anoda proverb wey resemble dat one be – No matta how careless wey a man wan sit, im nor fit sidon on top im blokos.

Wahala Grin, this your proverb chairman, na confirm one, lol.
I salute una well well. Unto contribution matter i dun come to drop my own wisdom, make all of we for smile wella.

Proverb: You nor go fit run pass your yansh.
Meaning: Don't be in too much of a hurry in life, take things easy.

Proverb: Dem nor dey roast corn for fueling station.
Meaning: Do the right thing at the right place, not all characters are suitable to be displayed everywhere you find yourself.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 10, 2021, 05:41:22 PM
No matta how craze worry crazeman, nor be wen im wan cross express road.
Meaning: There is limit to our excesses, otherwise they get us into trouble.

Anoda proverb wey resemble dat one be – No matta how careless wey a man wan sit, im nor fit sidon on top im blokos.
newbie
Activity: 9
Merit: 0
November 09, 2021, 06:36:14 AM
Proverb :
Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap

Meaning :
Keep calm! Nothing last  forever
member
Activity: 67
Merit: 10
November 08, 2021, 04:31:50 PM

Proverb:
Them say, when dog start to dey bark for the owner, that one mean say, another person don dey feed am be that.
Meaning: Your value is rated in the things you do, no one is truly loyal forever.

Una dey do well, I sight una.
Dog way go bralama bite him owner na calabar them go send am for holiday make e know wetin life dey talk
Proverb:Pikin way go know book nor be by size of head them dey know am
Meaning: You cannot tell content by looking at outside
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
November 08, 2021, 02:44:43 PM
Rruchiman this your proverb nor be here o be like you be Edo guy.

lol, i nor be from Edo State gee,  Grin e be like you dun hear say Edo People dey like all those kind parole?

Anyhow anyhow make i drop small wisdom.
Proverb: if snake nor do wetin make am be snake, small pikin dem go think say na rope, use am tie firewood.
Meaning: At you level, act the way you should.
Senior man like snake na em person wan use play... that gee dey rep en level everytime o. Adults self no fit near. Na real matter shah, person gat carty eye look in age then, e position encef in place of respect way dey deserving. I gret you bigman. Make me kwa throway small something.

Proverb:
Them say, when dog start to dey bark for the owner, that one mean say, another person don dey feed am be that.
Meaning: Your value is rated in the things you do, no one is truly loyal forever.

Una dey do well, I sight una.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
November 05, 2021, 04:43:09 PM
Enuf oil dey your head, wella. But na married people go fit understand dis part pass. E bi like sey you get wife, ba?

lol, seniorman wifey never dey the background yet, we still dey hustle that side, na street wisdom wey me dun contact normally nai me dey relate. As e be say i near the village side recently, i follow old men dem yan well well and na some of the Ogbonge wisdom i dey drop for the house. But lately i cun dey observe say activity nor cun too dey dey this our corner.

Wetin dey really sup?

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 05, 2021, 04:04:32 AM
This week get as e be for me, i go person wey i know well well her burial, see as she dey successful dun do everything wey person fit do with money, but she still dun die and she nor too enjoy dem.
So sad. Death na the dance wey every man go dance if Jesus tarries. According to people wey go school, dem sey "death is inevitable." Sorry about your friend.

Make i drop one wisdom for the house;
Proverb: Woman wey dey find pikin, nor dey wear pant sleep.
Enuf oil dey your head, wella. But na married people go fit understand dis part pass. E bi like sey you get wife, ba?

Anyhow anyhow make i drop small wisdom.
Proverb: if snake nor do wetin make am be snake, small pikin dem go think say na rope, use am tie firewood.
Dat na true yarns.


I been dey search everywhere since I join the forum, I sha know say I go surely find my naija pple as we no dey carry last.
Na two hands I take welcome you my Naija blood. I hope you bring Agege 🍞 enta house sha.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
October 31, 2021, 05:52:24 PM
Rruchiman this your proverb nor be here o be like you be Edo guy.

lol, i nor be from Edo State gee,  Grin e be like you dun hear say Edo People dey like all those kind parole?

Anyhow anyhow make i drop small wisdom.
Proverb: if snake nor do wetin make am be snake, small pikin dem go think say na rope, use am tie firewood.
Meaning: At you level, act the way you should.
member
Activity: 67
Merit: 10
October 29, 2021, 04:10:40 AM
I been dey search everywhere since I join the forum, I sha know say I go surely find my naija pple as we no dey carry last.

Welcome brother to this our corner where everybody dey follow contribute ogbonge wisdom. Make e nor be say na only once once you go dey enter here.

Make i drop one wisdom for the house;
Proverb: Woman wey dey find pikin, nor dey wear pant sleep.
Meaning: Person wey dey find something, na e hand dey long pass



Rruchiman this your proverb nor be here o belike you be Edo guy.
Proverb: Man wey nor get money nor dey shook hand for pocket
Meaning: Do not spend more than you earn
Proverb: Who nor get nor do form big man
Meaning: cut your coat according to your size
Pages:
Jump to: