Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 33. (Read 10492 times)

hero member
Activity: 1288
Merit: 504
December 20, 2021, 05:59:05 AM
Proverb: The leopard cannot hide the colour of its skin no matter how hard it triess]
Proverb: Leopard no go fit hide him colour even if he soak body inside water
Meaning: No one can effectively hide his/her true character no matter how hard he or she tries to.
Na true o because the matter eh, na just say, make you jam that thing way dey trigger person and the next thing, you don dey display watin no good.
Some persons, na poverty or hardship while, to others, na too much money. All of them dey play role to bring watin you cef no been know say, e dey inside you.

Mean while, I see say you don confirm watin Mpamaegbu talk, you go dey try eh. Nothing much come out but you go try. Make we cef dey follow you go as you dey go. We dey together.
full member
Activity: 1470
Merit: 148
December 19, 2021, 05:42:32 PM
Proverb: Pesin were carry mascurate comot no de do am waiting go makam laf
Meaning: Take whatever brings you to the market serious if not you will return home with nothing.
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 15, 2021, 04:57:55 PM
Proverb: The leopard cannot hide the colour of its skin no matter how hard it tries
Meaning: No one can effectively hide his/her true character no matter how hard he or she tries to.
Abeg, as you dey throw the ogbenge yarns dem dey come, you go try dey help us to dey put dem for pidgin. People wey dey dis house nor too go school. Na pidgin we dey try use rub minds here. Thank you. You na correct gee.
Thank you for the correction. Forgive my ajebutter doings I don't speak pigin a lot but I will try to uphold the tradition of this thread
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
December 15, 2021, 03:24:27 PM
Proverb: The leopard cannot hide the colour of its skin no matter how hard it tries
Meaning: No one can effectively hide his/her true character no matter how hard he or she tries to.
Abeg, as you dey throw the ogbenge yarns dem dey come, you go try dey help us to dey put dem for pidgin. People wey dey dis house nor too go school. Na pidgin we dey try use rub minds here. Thank you. You na correct gee.
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 15, 2021, 12:42:24 PM
Proverb: The leopard cannot hide the colour of its skin no matter how hard it triess]
Proverb: Leopard no go fit hide him colour even if he soak body inside water
Meaning: No one can effectively hide his/her true character no matter how hard he or she tries to.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
December 15, 2021, 08:51:06 AM
Proverb: Dem nor dey put curry for soup, nor be say e nor dey sweet.
I nor too gree dis wan oh. Na until you cook Egusi soup with curry you go sabi sey e get something wey sweet pass cocoyam. Na the powdered curry I dey refer to here sha. Based on chef wey I be, curry dey good for Egusi soup. E bi like people wey dey argue sey e nor good to cook okra with waterleaf. Try am, you go confess. Na banker I drop for una here so.

On a more serious note, abeg make una nor follow me vex sey I nor frequent here for some time now. My people, na issues of life dey drag man pikin anyhow oh. Una sabi sey if nor be stomach wahala, all man for just siddon fold hands na. Na off forum activities dey take my time. But anyhow wey e bi I still dey here.

By the way, I hope una dey invest small small from the cash wey una dey make here from campaigns (no matter how small e bi). Next year go dey bloody oh from experience wey some of us here gather for 2018 sha. I dey expect bear season after first quarters of 2022 for all cryptos. I expect sey Bitcoin go end im bull run dis December, then alts go enter bull rally from December ending to first quarters of next year. Make una wear seat belts. E go red like danger oh.
legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
December 13, 2021, 02:10:12 AM
I dun miss this corner well well, for the culture, sake of say make e for nor loss, make i follow contribute small thing.
Proverb: Nipple dun too sweet small pikin for mouth, nai make e bite am.
English: Be careful who you show your sweet side.

Proverb: Dem nor dey put curry for soup, nor be say e nor dey sweet.
English: Know your place.

hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 07, 2021, 06:30:01 PM
A woman that's calls her husband lord does that out of respect because she actually knows her husband's name
Meaning: it is important to get respect for what you do and at the same time give it.
member
Activity: 67
Merit: 10
December 06, 2021, 02:30:01 AM
Proverb: Fowl wey say e wan fly like bird na neck him go break
Meaning: Nor go dey do pass yourself
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
December 05, 2021, 11:30:41 PM
Proverb:
For we Pighin: Them say, bird or person way go like fly, e no go stay near people way dey plug or commot en feather to use clean ear.

Our people say;
Proverb: Shark wey dey stay for small water nor fit big pass wetin e dey see.
Nice ones! Una get old men brain for inside small pikin body. I gbadu una yarns.
member
Activity: 67
Merit: 10
December 04, 2021, 03:11:36 PM
This one na yanings wey parents dey drop when them wan carry their pikin boast
Proverb:Monkey nor dey born goat
Meaning: A child is like his father
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 04, 2021, 12:16:35 PM
Proverb: He whose house is on fire does not chase rats
Meaning: Set your priorities straight. Do not fiddle with useless things
legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
November 29, 2021, 07:37:52 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
Welcome, time dun reach sef for woman to dey we side small for this corner, you nor need to dey old SatoPrincess to share small wisdom, e fit still be wisdom wey your parents give you or wey person tell you, anyhow wey e be , as far say e get meaning, we for this corner go chest am.

Our people say;
Proverb: Shark wey dey stay for small water nor fit big pass wetin e dey see.
Meaning: You cannot grow bigger than your mindset.

Proverb: Pikin wey dey play for dustbin, go march cheat one day.
Meaning: Luck may save you a couple of times from events, but don't take it for granted. consistency yields results.
legendary
Activity: 1694
Merit: 1168
November 28, 2021, 01:02:07 PM
~snipe ~
But shey dis princess na female abi na male–female? Anyway, like owa correct man @CryptocurencyKing talk, we nor too go school for dis we corner na im make we dey use local yarns follow am up as per pidgin oh. Feel at home but make you nor spoil remote sha.
Na legit them relate you so, you carry eye check am. No be sat na matter o, no where e touch normally but na say, make we corner for be our own and make e for dey sweet when we enter na why, we dey reason am. On that note, I welcome you specially to come share this our small corner with us  the house never full until everybody come, e go enter us, no worry.
Oya na, make we for carry this one hold body for the day.

Proverb:
For we Pighin: Them say, bird or person way go like fly, e no go stay near people way dey plug or commot en feather to use clean ear.
Meaning: This means, if you ever have any wish or hope to progress in life, you ought to hangout with like-minds, those that encourages you and avoid people with negative vibes or energy.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
November 27, 2021, 03:03:23 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
What good is the morning without the sun
This also can be rephrase what good is money without health
Meaning: We need good association to be balanced in life
I welcom you wit two hands like Bubu dey do owa politicians. Later make you surrender d break wey you carry enta house sha. But shey dis princess na female abi na male–female? Anyway, like owa correct man @CryptocurencyKing talk, we nor too go school for dis we corner na im make we dey use local yarns follow am up as per pidgin oh. Feel at home but make you nor spoil remote sha.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
November 27, 2021, 12:31:32 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
What good is the morning without the sun
This also can be rephrase what good is money without health
Meaning: We need good association to be balanced in life
First eh, na to welcome you say, you don fine road lap for this our small corner and as e be so, we don dey one person stronger. I like  say, e give you joy say, you ball in here and watin we dey do con sweet you for body. Na that one mean say, we no just dey throw-way careless capping but still, me go still like make you for put eye for ground. Follow us as we follow dey go. The best way to enjoy our proverb na when we use we pigin dey drop am, na that time e dey sweet both for mouth and for ear. Just try eh,,, I know say;

Proverb:
Brocos-broco (prick-prick), no be the same.
That na to tell you say, even if na the same thing you carry na em the next man carry kwa, one still pass one.

I grab the fact say, no be every body from we naija dey sabi speak the pigin and as e dey hard some kind men them but then, we go dey try.
legendary
Activity: 1694
Merit: 1168
November 24, 2021, 03:53:48 PM
~snipe~
E dey happen like that sometimes shah. Some mama and papa dey like act like say, them know there pikin finish. Forgetting say, this pikin you think say you sabi, no be everything e dey display for your front and as e dey grow, na so e dey change, dey follow things way e dey observe for the area. Person just need wise for this life way we come o, na who die na em loose o. Make person no go die for one useless matter way no suppose reach anywhere. You dey avoid disgrace but still, con go chop major disgrace (that na for the pikin side) and mama don turn lesson to people way sabi jump swear... power of tongue, e strong o!
hero member
Activity: 1204
Merit: 802
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
November 21, 2021, 06:55:29 AM
This is a awesome thread. Today is my first time posting here. I'm not old enough to know the proverbs please bear with me
What good is the morning without the sun
This also can be rephrase what good is money without health
Meaning: We need good association to be balanced in life
legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
November 21, 2021, 01:31:04 AM
This matta com remind me of something wey happen for my area for Lasgidi so many years ago. The short story be sey somebodi wey dey owe one fishseller money bin give d fishseller pikin d money to give im mama but the girl nor deliver d money to her mama. She just die d money. Even when argument com for d matta she still deny am sey nobody give am money to give to her mama and her mama stood by her, saying she trust her pikin. Sey if to sey dat woman truly give d pikin d money sey d pikin for deliver am to her. She com swell on top sey if to sey her debtor truly give her pikin d money, make she (fishseller) die. Na so d matta end there oh. Like play like play, few weeks later d fishseller died.
Eweeeeeeeeeeew! nor be small thing ooo:o na so the woman take die for yeye matter ooo, how much be the money sef....na wa, i wonder how the girl go fit leave with herself for causing the death of her mother.

To raise everybody morale for the house, make i drop one wisdom.

Proverb: You nor fit play ball for 90minutes say ball nor go touch your leg once.

Meaning: Your consistency will pay you, don't quit if you get unlucky a few times.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
November 19, 2021, 10:50:16 PM
Proverb:
For we Pighin; Them say na only pikin way dey for belle you fit say, e no do.
Meaning; Never be so sure and ready to advocate or stand for a person based on his or her past behaviours not to have done or committed a particular thing. In life, people change!

Jump to: