CBN TO REDESIGN NIGERIA CURRENCIES
The Central Bank of Nigeria said dem dey prepare to redesign the N200, N500 & N1,000 notes. However, both the new & existing currencies go remain legal tender & circulate together until Jan 31, 2023 when the former currencies shall cease to be a legal tender. History Don repeat itself again as Buhari changed national currencies in 1984 and now in 2022. I dey shame for all this clueless people leading us for this our country. Our currency wey don lost 70% of its value instead of them to think on how to regain it value dem dey think of how to rebrand it. Very disappointed! Wetin una think on top this matayas fellas?
You don see where we land ourselves for this country. Do we need our naira currency to redesign or na to find ways to regulate the dollar against naira so that our economy go fit stand gidigba. I no know why be sae, the people wey d lead this country d clueless and the CBN governor don d reason one kind one kind for sometimes now. Emefiele don become CBN for years and this na the kind thing em go fit think of for Nigerians. Few days ago na scraping of ATM cards. Today na redesigning of naira notes. Peso no know what next em go bring up tomorrow.
As the matter be so for this country. So wey no get another peso wey d capable again to take the position of that CBN governor cos em don mis-reason. Em d too bad to place a such person in a such precarious position
Sometimes we need to think twice before we go conclude say the leaders dey clueless. I no say dem be thieves, but that one no come mean say dem.no sabi something. E no mean say dem no go school. Those men go school, some go for big school for outside country like Howard and Cambridge.
Na government decision be that, before them make that decision, one or two committees don sit down weigh the matter well. All of them no go make mistakes at the same time.
We too wey be youths, we go school and even if we no study economics, bitcoin don teach us well.
You fit still use Google search for importance of redesigning currency. Especially for this election wey dey come. E go even help strengthen naira because the old money fit expire for illegal hoalders hand and many more.
Many advantages dey to redesign currency.