Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 242. (Read 1032218 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
That one week make sense and make we try put the date wey e go end so every pesin go follow up and mak we make sure say if we close the date
I later included the date. Thanks for the suggestion.

Payment time range is within a week and some days (from 12th of May to 22nd of May, that is 10 days from now).
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
-snip-
Oga Charles-Tim you don talk everything finish nothing dey to add again na just for us to start to pay, I just pray everybody comply pay within the estimated time, so that we fit give the family something.
Bro according to boss @brainboss him say them don do burial already oh, so like this na to just contribute give him family way him leave behind. 😔💔
Na here the matter reach con tire me, say, we dey hear after every every don sup finish. Anyhow e be, e get why. From watin e cap, e come out say, the mama still come board, though she don see her grandchildren but then, say you dey alive and your pikin con kick bucket and e dey mortuary guy, e be as e get.
My mama dey tell me say, 'Na only parents dey understand watin sup when pikin misbehave or jakpa'. Na this kind thing them bin dey avoid and as e be so, we go still do watin we suppose do.

Make we try dey visit both here and telegram group chat to dey get informat detailed and clear. As e be, we dey try drop something to help the family and na only one week we get. Make we try support them anyhow we fit. Una do well.
I hear about the part way them say him mumsy dey alive sha, and na true the tin no go nice if she dey alive her son come dey for mortuary, e good as them do am so to avoid something way the mama go come think too much, anyway e be God know the best.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Guys, na nice idea say we dey rally on top our late brother matter. That one week make sense and make we try put the date wey e go end so every pesin go follow up and mak we make sure say if we close the date, we don close am be dat and any further 30 billion dolls wey dey come , no go dey accepted. Dis go mak the package legit.

Rip Becky666
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Bro according to boss @brainboss him say them don do burial already oh, so like this na to just contribute give him family way him leave behind. 😔💔
Na here the matter reach con tire me, say, we dey hear after every every don sup finish. Anyhow e be, e get why. From watin e cap, e come out say, the mama still come board, though she don see her grandchildren but then, say you dey alive and your pikin con kick bucket and e dey mortuary guy, e be as e get.
My mama dey tell me say, 'Na only parents dey understand watin sup when pikin misbehave or jakpa'. Na this kind thing them bin dey avoid and as e be so, we go still do watin we suppose do.

Make we try dey visit both here and telegram group chat to dey get informat detailed and clear. As e be, we dey try drop something to help the family and na only one week we get. Make we try support them anyhow we fit. Una do well.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigeria Bitcointalk Community Hangout, First Purposeful Donation [2021]

As some of us see this title, you go think say we go wan dey donate for any other reason, the 'first' up there na just serial number to indicate the numbers of time we don donate in a particular year, that no be say we go continue to dey donate by having second or third. But, with this, you go know say this na the first time we dey donate this year.

The donation na for our recent deceased Bitcointalk brother's family as a means to provide support and relieve during this painful time and as a mean of condolence. If the donation/contribution is not beyond your capability, it will be good to provide support.

Procedure
Payment time range is within a week and some days (from 12th of May to 22nd of May, that is 10 days from now).
Payment will be in Naira or USDT (TRC20) (if you have any other suggestions, please do not hesitate to post about it)
Minimum of $10 to be contributed per each person, no maximum amount if not beyond capability
All members rank can contribute (from Newbie to Legendary)
The money will be paid into three members accounts (Smartvirus, igehhh and Charles-Tim)
People that pay and the amount paid will often be indicated it below
After contribution is over, we will discuss how the money will get to the Becky666 family member.

Note: Please, if you have paid, you can indicate that on this thread including your txid or contact igehhh or Charles-Tim about the payment. If the payment has reflected and seen by igehhh and Charles-Tim, then it will be updated. If you want to be anonymous, please do not pay into Naira account, pay into either BTC or USDT (TRC20) which we can have the payment tixd or track the transactions using the addresses.

Smartvirus
BTC: bc1q8mvnr3actrxn97v3pxn28tly9yu0yw5mpvxhts

igehhh
USDT (TRC20): TP4kLhXxQwy1MppaSSQPyi2vyeeK1YC83p (TRC20)

Charles-Tim bank account details
GTBank (please, make sure it is Guarantee Trust Bank)
0049732936
PM me (Charles-Tim) if you think the account name is necessary.

Bitcoin
1. Rollbit team: 0.01058000 BTC



USDT (TRC20)
1. posi: 18.57 + 12 (30.57)  USDT
2. Mpamaegbu: $12
3. Anonymous: 300 USDT

Naira
1. Josefjix: 9,900 naira
2. Lordhermes: 6,000 naira
3. nelson4lov: 10,000 naira
4. Charles-Tim: 10,000 naira
5. Igehh: 6,000 naira
6. Gozie51: 5,000 naira
7. CryptopreneurBrainboss: 12,000 naira
8. gabbie2010: 6,000 naira
9. Upgrade00: 10,000 naira
10. Smartvirus: 5,000 naira
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Damn, 😭omo i see the news for telegram yesterday, Mehn this kin bad news 💔, we don loss one soldier 😢, so like this we no go dey see our brother for this our small hangout again, God know why him allow our bro die sha,but e dey really heartbreaking 💔, RIP Becky666 till we meet again 🙏, things like this they always remind me say life dey short to dey take everything too serious, but anyhow God dey, anyway we fit contribute give him family make we do am abeg🙏.
If anybody done try reach out to the deceased family make una give us updates about the burial and how we'd support with our different resources and manpower.
It is very saddened to be honest.
RIP, Becky66
Bro according to boss @brainboss him say them don do burial already oh, so like this na to just contribute give him family way him leave behind. 😔💔
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
Kai which kind wahala be dis morning on top this kontri that na hustle everibodi dey take back up na im we come loss Becky666 walahi I weak as I hear this bad news may God Almighty give his family the fortitude bear the loss I was always thinking the user name na female, my contribution be sai make we use NAIRA help his family using USDT may delay all of us get bank account he go easy make we just transfer the funds into a single dedicated account
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
By the way, I support the motion of donations to be in naira. If we go still donate (after we get more information), I suggest e be for both naira and USDT - TRC20 preferred for cheaper fees. At least anybody wey no get usdt fit use naira to contribute.
I believe if donation go come, we will have to make suggestion and decide which currency to be used. But in my opinion which I will still stand on at the time, I will support the donation to be in Naira. We are all making use of Naira, even converting crypto to Naira for daily living. Naira donation will be the best.
Naira abi USDT o, e no really matter. Infact cef, most of us no dey use to naira again, na Bitcoin and USDT just full our mouth and anyhow e be, watin each person need drop, we fit still decide the value no matter the currency way we carry talk am. The point still remain say, we gets drop something except say, na just to use language decorate our corner make e be our talk dey here na em the naira thing go be something.

On the matter say we gets reach out to the family first before we start to dey show ourselves, that one na real matter o. We never know how there customs rights be like either them go accept our not or e get matters way come board way we never know and again, when them plan to put the bigman for ground. All those small details go help us prepare better and we go know how much time we get for hand. Anyhow e be, make dey put eye for here and Telegram so we for dey know watin dey sup on the matter.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
By the way, I support the motion of donations to be in naira. If we go still donate (after we get more information), I suggest e be for both naira and USDT - TRC20 preferred for cheaper fees. At least anybody wey no get usdt fit use naira to contribute.
I believe if donation go come, we will have to make suggestion and decide which currency to be used. But in my opinion which I will still stand on at the time, I will support the donation to be in Naira. We are all making use of Naira, even converting crypto to Naira for daily living. Naira donation will be the best.

The usual currency most of us are receiving for payment is Bitcoin, I do not think there are Nigerians that are receiving payment in USDT, even if some are receiving payment in USDT, it may not be TRC20 USDT and they may no be receiving payment on exchanges but on noncustododial wallet. Some people no dey use exchange, but use noncustodial wallet for their payment, which may be the reason why they no go get access to USDT easily, not to talk of TRC20 USDT. The second we can suggest which I know all of us can easily access na Bitcoin because nearly all of us are paid in Bitcoin, but yet not all of us, and the high transaction fee is an obvious reason we may not consider using it when we have access to Naira that every one of us can easily have access to and use it for the payment.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Make una no vex but no be so dem dey do something. Anybody don reach the family, I believe not. Storey wey reach me besay dem dey Becky burial for village. I still dey try contact the wife and brother to know how things dey go. Any contributions gaz dey debated on no be just to drop address wey belong to you. If need arising and community decieve then you need create new account so you fit give proper account.

I Know say blood dey hot but easy pressure, make we hear from family come see how things dey go before we know where we fit step in and I for like make donation be for Naira since na local thread be this.

No too rush if not we no go go anywhere remember one or two people no fit make decisions for community. We gas tidy the mata for table come reason am before we make any final conclusion.

Omo brainbox... Na better talk you just talk be that and I dey in support. Since Becky666 family and loved ones are unavailable now, make we hold off until more information come to light. E just dey sad say Becky666 wey follow start this our community no go dey alive to see it through. By the way, I support the motion of donations to be in naira. If we go still donate (after we get more information), I suggest e be for both naira and USDT - TRC20 preferred for cheaper fees. At least anybody wey no get usdt fit use naira to contribute.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Make una no vex but no be so dem dey do something. Anybody don reach the family, I believe not. Storey wey reach me besay dem dey Becky burial for village. I still dey try contact the wife and brother to know how things dey go. Any contributions gaz dey debated on no be just to drop address wey belong to you. If need arising and community decieve then you need create new account so you fit give proper account.

I Know say blood dey hot but easy pressure, make we hear from family come see how things dey go before we know where we fit step in and I for like make donation be for Naira since na local thread be this.

No too rush if not we no go go anywhere remember one or two people no fit make decisions for community. We gas tidy the mata for table come reason am before we make any final conclusion.
member
Activity: 70
Merit: 19
I no bin reli sabi dis person bt, d few times way I jam en username 4 forum, e bin do me like say na babe e be bt, e shock me now say na man e be. Las las, e con be say, e don carry waka live us go join en maker.

Chaiii, death na waa o, na sone just make life be like nothing, just like that e just collect family man commot with en family without any permission. Na God go see en family thru for this kind thing wah happen to dem so.

May his soul RIP @Becky666
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Official Payment address

TZCtxP6nW79EHawdmnRXzxRoVMedRptBqG  (TRC20)

Min $10

No Max.

Abeg make we try comply with the payment abeg..nothing is too small. We can do this.

Note: I currently have $200 in this account for record sake.

 
Is the payment going to be in Naira? This is local thread, I am suggesting it to be paid in Naira for ease. Or, what do other people think about this.
E go dey easier for USDT make some of us no come dey reason the amount in naira  Grin
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
If anybody done try reach out to the deceased family make una give us updates about the burial and how we'd support with our different resources and manpower.
It is very saddened to be honest.
RIP, Becky66
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Little Contribution to The Deceased Family(Becky666)

Death is inevitable; as a community who care for ourselves as foe suggest say make we put head together contribute little support to the family of Becky666 since we no go fit meetup the funeral, at least make him family members know say Becky get better friends for the forum him been dey work. Our pipo talk say rain nodey fall ontop one roof, my wish nobe say we go contribute money for only funerals,  No!!. Some of us fit get wedding, Birthday, child dedication wey as a community we go support too, like it or not we are family now..

My suggestions
I know say we pass 10 wey dey active for here and wey dey campaigns too..
$20
$25
$30
These na the money I for like make each of us contribute so I go leave for the house to deliberate on it.


Brainboss endorsed the idea so make I see wetin una think.
E make sense, I am in. But we need to be organized about this.

When the payment go start?
When the payment go end?
Also, maybe there should be lists of those that paid, and amount paid by each person (though, amount paid not necessary to me)
$20 and up should be the amount to be paid, but anyone that is not able to pay upto $20 can pay less than $20 (any amount should be welcomed, but the recommended payment should be $20 and up).
Is the payment going to be in Naira? This is local thread, I am suggesting it to be paid in Naira for ease. Or, what do other people think about this.
member
Activity: 812
Merit: 13
Crypto bookmaker and casino
Why is it that you have go, why is life so cruel? I which that you could stay with us forever. Gone yet but not forgotten brother, although we are apart, your memories lives in us.

On the sand of time, you have left your footprints with glory, everyone will know your name and shall recall your story...Rest In Peace brother Becky666
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
It's hard to say goodbye to someone we cherished and loved like a brother. It weakens my heart we have loss a brother, father, and uncle. We gonna miss his impact a lot in this forum.
My God gives his family fortitude to bear the loss (amen). Wherever he's now he should continue to rest in peace #Becky66
sr. member
Activity: 966
Merit: 421
Bitcoindata.science
What a great loss, an icon with uniqueness is gone. This news came as a great shock. With a heavy heart I have to say goodnight to you with a wet eye trying hard not to believe the news.

Our creator knows best and I pray you find rest and peace with him who knows made you for his pleasure

RIP Becky666


hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Death your full of surprises!

The news caught me inn a spotlight as I never hoped on such neither would I have liked to believe its true but sadly, this is no prank as Becky666 has left us. He was one of the best of persons in this group that even his inactiveness at a time was noticed by those of us who has known him for his  contributions in the forum. Thats to say, he identified and was vividly recognised and appreciated by Nigerians in the forum.

Now, the cold hands of death has snatched him away from us living us in wonder ad the void he has left in us that seeks to hear his call once more. May the good lord grant the family you left behind the courage and strength to bear this lose and provide needed fiance to run  the family.

RIP Becky666
hero member
Activity: 1498
Merit: 711
"Play Poker on Telegram"
RIP to one of our own Becky666: https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732

Death na bastard, our brother wey been dey handle this account wey I write above don just go like dat. When I hear am I no believe, I try to reach am but e number no dey connect again, I check e WhatsApp and account for forum and dem no dey active again.

Quote from:   date=08/05/2021
Good morning sir, I lost my elder brother day before yesterday 😭 I don't know how to get your contact now so that we can talk well sir, this is my phone number 🙏

As the message come, I no believe then now I recieved another message na e I know say the mata don serious and no be joke again. I sabi Becky666 (as account) well well. I know when e start to dey hustle for the growth of the account. E dey pain me say e just go like dat. E family (children and wife) go don here about me and everybody here because e sabi talk good about the forum and how e don help am.

Abeg if anybody fit reach e family for here make dem send mine and our condolences, our prayers and love dey for dem. I go still try reach e family and if we fit organized any small thing for the family e go make sense.

Quote from: date=10/05/2021
Good day Bros, sad to bring to your notice the demise of my friend and former colleague  whom I introduced here in this forum and he is your good friend here too.

The owner of Becky666 https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732 died last week Tuesday at Wuse General Hospital Abuja.

I just go through our chat come remember this message,
 

RIP brother.

Very sad news that one of reputable member of this community has gone, becky666, many your soul rest in peace (RIP), i support the motion of contribution so that we shall honour our brother, our friend for eternity.

Rip bro.
Jump to: