Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 246. (Read 1335402 times)

jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody
I need some BNB...
Who has some for sale...
Sorry I no get time to follow procedure for new topic...
Abeg who get am?
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
This news dey very impressive for all bitcoin men dem for 9ja but one thing wey we go know be say, this government fit do anything to cripple your business. The owner no suppose come out openly come talk about this kind thing but na them Sabi pass us. At least e go give the oyibo them better infomate say Nigerian people no dey left behind for this bitcoin matter.
Waiting I dey think be sey e go hard CBN to do anything, we know how their crypto ban actions na after EndSars and no good reason at all dey get to ban cryptocurrencies payment for the country. And we know CBN no fit ban cryptocurrencies completely, na dem senate fit do that kind thing with president, and that no possible (many no go gree). Waiting CBN fit ban na the money transfer aspect of it. I believe the hotel no go just interact their bitcoin with banks directly, and nothing go happen.
You know say no individual entity fit battle the government and win. E no fit ever happen, if government impose better tax on am. Begin the mount heavy security on the hotel, even customers go fear to come there. Or them begin expose customers wey lodge there personal information. Dem go lose credibility and integrity. Nothing really hard government of a state to do. Our prayers be say make we no see the bad days we always pray against.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I be think sae First bank of Nigeria dey make plans to get Bitcoin atm since last year. Wetin happen to their plan again? Em no work again due to the ban wey CBN place on Bitcoin transaction with bank? This our country matter don tire me. Everyday na different palava we d see
Even before CBN crypto ban, I never heard even rumor about First Bank planing to create any crypto business, I no hear such company planing any Bitcoin or crypto ATM. If you heard anything like that, na just rumor.

The company we are taking about this time around is a hotel, nothing concern such company with crypto ATM which the CBN can have ways to get banks to make it mandatory for users not to use it to buy Bitcoin. But, I still dey look for how CBN can have ways to have influence on a hotel in relation to cryptocurrencies usage when crypto are bannd., I still think it will be hard for CBN to stop such action as the company will not make it connected to bank.
member
Activity: 672
Merit: 29
George Residence wan become first hotel wey go accept Bitcoin in Nigeria

One Naija hotel for Lekki don dey plan to accept Bitcoin as a payment method and to be 50% of their reserve. Na the Chief Executive Officer CEO, ‘Yanju George wey talk ham. He talk say the company reason to go for bitcoin na to be hedge against the country's inflation.

‘‘We have allocated around 50% of our cash reserves to Bitcoin…We hope to increase that as time goes on,’’ he revealed. “Bitcoin is the currency of the future and it is only right that we are strongly positioned so we do not get left behind.

Waiting be your opinion about this? Nigeria CBN no support cryptocurrencies, hope this no go be a drawback for hotels that wan use Bitcoin as reserve and for payment in our country?

The thread about this don dey Bitcoin discussion
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5333383.new#new
Na very thing for our country Naija. Na a very big welcome development.
I be think sae First bank of Nigeria dey make plans to get Bitcoin atm since last year. Wetin happen to their plan again? Em no work again due to the ban wey CBN place on Bitcoin transaction with bank? This our country matter don tire me. Everyday na different palava we d see
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
This news dey very impressive for all bitcoin men dem for 9ja but one thing wey we go know be say, this government fit do anything to cripple your business. The owner no suppose come out openly come talk about this kind thing but na them Sabi pass us. At least e go give the oyibo them better infomate say Nigerian people no dey left behind for this bitcoin matter.
Waiting I dey think be sey e go hard CBN to do anything, we know how their crypto ban actions na after EndSars and no good reason at all dey get to ban cryptocurrencies payment for the country. And we know CBN no fit ban cryptocurrencies completely, na dem senate fit do that kind thing with president, and that no possible (many no go gree). Waiting CBN fit ban na the money transfer aspect of it. I believe the hotel no go just interact their bitcoin with banks directly, and nothing go happen.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
George Residence wan become first hotel wey go accept Bitcoin in Nigeria

One Naija hotel for Lekki don dey plan to accept Bitcoin as a payment method and to be 50% of their reserve. Na the Chief Executive Officer CEO, ‘Yanju George wey talk ham. He talk say the company reason to go for bitcoin na to be hedge against the country's inflation.

‘‘We have allocated around 50% of our cash reserves to Bitcoin…We hope to increase that as time goes on,’’ he revealed. “Bitcoin is the currency of the future and it is only right that we are strongly positioned so we do not get left behind.

Waiting be your opinion about this? Nigeria CBN no support cryptocurrencies, hope this no go be a drawback for hotels that wan use Bitcoin as reserve and for payment in our country?

The thread about this don dey Bitcoin discussion
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5333383.new#new
This news dey very impressive for all bitcoin men dem for 9ja but one thing wey we go know be say, this government fit do anything to cripple your business. The owner no suppose come out openly come talk about this kind thing but na them Sabi pass us. At least e go give the oyibo them better infomate say Nigerian people no dey left behind for this bitcoin matter.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
George Residence wan become first hotel wey go accept Bitcoin in Nigeria

One Naija hotel for Lekki don dey plan to accept Bitcoin as a payment method and to be 50% of their reserve. Na the Chief Executive Officer CEO, ‘Yanju George wey talk ham. He talk say the company reason to go for bitcoin na to be hedge against the country's inflation.

‘‘We have allocated around 50% of our cash reserves to Bitcoin…We hope to increase that as time goes on,’’ he revealed. “Bitcoin is the currency of the future and it is only right that we are strongly positioned so we do not get left behind.

Waiting be your opinion about this? Nigeria CBN no support cryptocurrencies, hope this no go be a drawback for hotels that wan use Bitcoin as reserve and for payment in our country?

The thread about this don dey Bitcoin discussion
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5333383.new#new

Na very good plan from the hotel management to start moving their business to Bitcoin and crypto in the near future because crypto na the future of digital payments. So them dey take a very good step by making the switch to crypto this early. E no go tey now before other hotels and businesses follow them to dey accept bitcoin because whether we believe am or not, our country economy dey in deep trouble and anybody wey never start working on getting reserves in bitcoin yet, never dey serious to survive for this country.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
George Residence wan become first hotel wey go accept Bitcoin in Nigeria
This news now sef dey sweet me for body we know say people wey get sense for the country no reach 5 again despair our bad government some of us wey get sense dey try dey think of the future..e get one guy for my area wey been dey accept payment via bitcoin for him salon... When I lay my photoshoot studio I go dey accept payment via BTC. Na correct development.

I like as you post thread for bitcoin board I go use am werry posts dis week  Grin
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
George Residence wan become first hotel wey go accept Bitcoin in Nigeria

One Naija hotel for Lekki don dey plan to accept Bitcoin as a payment method and to be 50% of their reserve. Na the Chief Executive Officer CEO, ‘Yanju George wey talk ham. He talk say the company reason to go for bitcoin na to be hedge against the country's inflation.

‘‘We have allocated around 50% of our cash reserves to Bitcoin…We hope to increase that as time goes on,’’ he revealed. “Bitcoin is the currency of the future and it is only right that we are strongly positioned so we do not get left behind.

Waiting be your opinion about this? Nigeria CBN no support cryptocurrencies, hope this no go be a drawback for hotels that wan use Bitcoin as reserve and for payment in our country?

The thread about this don dey Bitcoin discussion
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5333383.new#new
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na for Telegram group abi na for here i hear am, I no wan take eye fine am but the yarn be say, the papa for the group born some more local boards put for ground some days ago. That na to tell us say, e dey work, the guy don open eye if e bin day close before. I even see some of the work way e do for gambling section, way e lock con even move some kind topic way e feel say no suppose dey there, go where e belong. Even en right hand man too. I no just one mention names make una no reason am. All that na to tell us say, e dey on top this other languages corner and as e be, we need to dey work, dey make sure say, we stay top make we be  the baba for here and as e be so eh, na to keep our character and talk talk in check make e be things way go qualify us. That na the language, how we many for here and how the place dey busy with plenty talk talk. Una dey try but, make we dey do more, na more them need.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no understand watin you dey try talk for here o and u for like make you clear me small because, I believe say talk dey here way fit give person hope.
Waiting I mean be sey the resistance for a price above $60000 dey too much, and big institutions no dey try at that level. You know sey institutions tried as bitcoin price dey increase, especially the ones that cause fomo buying. Grayscale and microstrategy try push the price upto $40000, while Tesla push the price to over $58000. Although, no be sey na wating they invested push the price, na because sey the amount huge and cause people to fomo and bought more bitcoin at the time, which made the price to over $58000. News sey miners dey hold and whales no dey sell again push the price from $45000 when the price falled, it increased to $62000, the price drop again, the same news of whales and miners dey hold cause the last bull market again before the last crash. And the price not get upto to $70000 yet having resistance at $60000. Na why I say e go hard for the price to reach $70000, but over long time, as we know how bitcoin dey deflationary and people will buy more, will make the price increase above $70000 certainly, but I dey guess not now.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
As for getting beyond $70000, e go hard for now as all those big institutions still dey look for now,
I no understand watin you dey try talk for here o and u for like make you clear me small because, I believe say talk dey here way fit give person hope. Although, me no dey fear bitcoin shah, no matter how e fall, e go stil rise. Na the business way we dey be that. If you fit build in yourself say, the market no go fit crash, na so the fall no go worry you. If you no be regular trader, your stronghold na to hodl your coin till e gain value, especially when e be say, na custodial wallet your coin dey and you no dey fear hacking because,  na the matter for there be that. If you be person way sabi too and you wan get value on top your coin, you fit trade am or exchange am fir stable coin make e maintain en value then, you buy when e start to rise from the lowest low. Na so the matter just be.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na fear dey make most of us make mistake, regrettable once.
You dey correct, fear dey make traders make mistakes, but no be only fear, emotion generally dey there. If some trader dey see the market dey fall, and come dey rise back, they go still dey fear the market no go still dey fall further, and the best time to enter market na such time. But, this dey specific to trading.

For me, I dey predict bitcoin market price no go fall below $50000, and if the price fall below $50000, e no go fall below $45000 for now, $50000 na strong support, the good reason Microstrategy put money for bitcoin at the price. As for getting beyond $70000, e go hard for now as all those big institutions still dey look for now, but sure that the price over long time period go go beyond $70000, that one dey certain.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Few weeks i b tell some of my pesin sey dis market go soon shake nd dis shake na 2 remove some people 4rm de mottor car wey carry bitcoin lovers. Dem de whales undastand wat can reduce people 4rm dis market, imagine dis crash just happen suddenly( i mean dis current one now) many people panic sell nd dem still dey sell till now, even wen de market show some strong resistance at $52k+. me as pesin, nothing wey i dey fear again 4 dis market becus i don see many bad animals for my hunting in dis bush nd i no dey fear either na RED or na GREEN.
Green or red na just colour them be, nothing again. E no get anything to do with the market except say, e dey give people some kind sentiment on how things be. So, either red or green abi black cef,na you dey run your thing and you fit decide say, you wan enter or commot for the market. Nothing spoil for there.
The fact say, people dey fear way con make them dey sell na em me i no dey understand sometimes. The fear eh, that na to say, the market wan abi go crash or watin? Because, person way don dey hear for some months and e active suppose know how the crypto space be. Na fear dey make most of us make mistake, regrettable once.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Like somebodi bin yarn here sey dis predishion thing nor go eva end, especially when market begin move. For me ehn, I think sey Bitcoin supposed begin major correshion by now as the dominance don drop, but for where! The thing still dey creep go up. Well, e still good like dis as alts dey rise with am. I sabi sey the real alts bull go start only wen Bitcoin drop enter correshion and depression. BTW, I hope una dey utilize dis moment dey gather alts oh. So dat once alts rally begin una go begin enjoy am. Make una nor do d same mistake wey I do for 2017 believing sey na so e go continue dey sweet go. Nor be so oh. 2022 go red oh. Spend small and invest more now, you go enjoy am later Na so I dey spend my campaign money den with little to invest. How many of una key into dat Safemoon and Safemars projects sef?
member
Activity: 672
Merit: 29
Bitcoin price go decrease back $50000 or increase go $70000

I don dey wonder why bitcoin price no go further beyond $60000, although the price this time before the recent bear market wey happen overnight rose well even above $63500, but still the price decreased and decreased more abruptly over night for Naija time (GMT +1) to $50500. The price don rise back small and dey around $55000 now or slightly higher price.

I notice sey some institutions dey try, but after Tesla invested $1.5 trillion in bitcoin, na waiting carry the price go $40000 and yet carry ham go over $50000 because sey people fomo and invested along. The price later gotten to $58000 around that time and later decreased, as e decreased to around $50000, Microstrategy invested $1 billion, but the bear no gree end at the time, the price decrease go around $45000 but rose back above $50000. After that time, waiting I noticed be sey the price no go below $50000 and no dey near $70000, even not slightly e rise pass $60000 recently but no still near $70000. So, I come know sey the support na $50000 while the residence na around $60000.

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.
Em go be difficult thing to predict bitcoin price now. Nobody fit control the market as em be so. Wetin i know be sae bitcoin no fit fall below $40k ever again. This year bullish market looks very extraordinary wey be sae big investors don enter crypto market and almost everyone no wan miss the golden opportunity to secure their assets
full member
Activity: 756
Merit: 231

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.
Few weeks i b tell some of my pesin sey dis market go soon shake nd dis shake na 2 remove some people 4rm de mottor car wey carry bitcoin lovers. Dem de whales undastand wat can reduce people 4rm dis market, imagine dis crash just happen suddenly( i mean dis current one now) many people panic sell nd dem still dey sell till now, even wen de market show some strong resistance at $52k+. me as pesin, nothing wey i dey fear again 4 dis market becus i don see many bad animals for my hunting in dis bush nd i no dey fear either na RED or na GREEN.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
More input to speculate waiting go happen about bitcoin price still dey active, you fit scroll go up, the first post wey dey this page.

E go make sense if people dey come here to make such announcement I wan make now, to let our brothers wey dey this forum not to lack info about important announcement that dey very important. I believe sey some Naija go dey bustadice campaign, see yahoo62278 (the campaign manager) recent announcement about the campaign.

Just letting everyone know now this campaign will be ending May 16th.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
<...>
This prediction of a thing no go ever end, weda the support level dey $50k or resistance level dey $60k, e no concern me, wetin I know be say bitcoin go do marvelous things, people go regret why them never get btc an na why analysts don talk say the price go reach $100k this year, I no be analyst but the time to buy more btc na now than ever because of all this so called Institutions wey don show face for the currency.

but the thing be say the price no dey go down be low $50k anytime soon
No talk like that oh, wetin pandemic do us na pepper, no body know say na so e go be, anything fit happen wey go crash down the price now now, we never know the next pandemic wey go happen soon.

I no be prophet or prayer warrior
Grin
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Bitcoin price go decrease back $50000 or increase go $70000

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.

Bitcoin beyond $80k in July na fud to be honest. Because many institutions done pack their money put for crypto. The awareness really serious gan. New people no dey stop to dey come in to buy one or two things. This time no be like the 2017 bull run. the resistance just happen. Me I no really Sabi analysis and price prediction but the thing be say the price no dey go down be low $50k anytime soon
Jump to: