Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 247. (Read 1032481 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
My people how Una dey for here?
Which projects Una dey hold for a longer-term benefits as BNB, cake and some other ones with good use cases done already dey over pumped?
I dey reason
CNS
MX
HT
CRO and few others. Wetin be your observations?
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I prefer to use remitano any time any day, it gives me the sense of home since it is run by Nigerians. Binance nice anyways but when it comes to exchanging crypto to naira remittano is the best for p2p trading.
No be naija dey run am you know say remitano nodey plenty country and as you select nailja as your preferred country nain make you see say na only naija buyers and sellers you dey see and as remitano nodey accept PayPal payment e come make scammers no too dey the site.. I like this site pass my girlfriend na me dey tell you.
member
Activity: 504
Merit: 57
I prefer to use remitano any time any day; it gives me the sense of home since Nigerians run it. Binance nice anyway, but for exchanging crypto to naira remittano is the best for p2p trading.

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Username                                                       Exchange chosen

Josefjix                                                           Binance

igehhh                                                             Remitano, Binance, Paxful, Locolbitcoins

CryptopreneurBrainboss                              Binance

Lordhermes                                                    Remitano

Becky666                                                        Remitano, Binance

posi                                                                  Binance, Remitano

Smartvirus                                                      Remitano, Binance

Obi theo                                                           Binance

Charles-Tim                                                    Binance

BIN-BIN                                                            Remitano

nelson4lov                                                      Binance
 
To check the poll result:
https://bitcointalksearch.org/topic/m.56718637

Thanks to all that participated

Charles, you 4 add anoda option — Telegram/WhatsApp P2P. Na dat one me dey use. I neva use any of those wans wey you be list there.
Sorry, I will not be able to add Telegram/WhatsApp P2P due to obvious reasons.

Me never really use any one o but, I bin only register for Remitano though, I don hear more about binance say, na them be the ogbonge,
Your input is valid, and thanks for being part of this. Because you have not used any exchange p2p before, that is why I did not include you along. Although, you can try and use one frequently and edit your post about it so I can add it later.
member
Activity: 123
Merit: 25
I like these hangout, am new here, and i need your support your encouragement and method of communication and I know that  soon I will coup with the language use here
Welcome , boss abeg I one ask you be Nigerian? If yes we dey introduce our self b4 anything
You give us ur name
State
And any other information you go like share once again welcome.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
When it comes to binance p2p trading I be big-time novice. How I wish person go kukuma teach me how to use am wella without stress.
If you dey use binance app, e no hard at all. I dey wonder when my friends here and some of us dey talk sey biannce p2p trading hard, some even dey talk sey binance hard generally. Binance no dey hard like that. For the p2p, all you need to do na to:

  • click on 'wallets' on binance
  • click on p2p at the uppermost part
  • you go see the coins and tokens you can trade using p2p
  • but before the listed coins are, 'transfer' and 'p2p trading'
  • click on 'transfer'
  • you go see 'send' and 'transfer'
  • sending means sey you wan transfer coin to another person using binance, but the transfer na to transfer your funds from spot wallet to p2p wallet
  • click on transfer
  • transfer the coin from spot wallet to p2p wallet
  • go to p2p trading
  • at the uppermost part, you go see p2p, but click on it you go see the two type of p2p (p2p and express)
  • p2p type will list many people with their ads and different buying and selling prices
  • express na for fast selling, you go see the exchange rate, but na zero fee too

So, you can make use of any, but make sure sey you no release bitcoin from escrow if you no see funds on your account balance (no be text message but checking your account balance). Also make sure sey if the seller no release bitcoin in time, report.
member
Activity: 672
Merit: 29
Except for ethereum and Bitcoin transaction, other transaction fee are relative low compare with other exchanges and I consider it as the main selling point for binance among others. Have u tried their P2P transaction compare with other local exchanges, fast, secure and low transaction fee. It provide a good exchange rate and can trade as high as 50 million naira in one transaction. Interesting I still some people looking for where to sell their bitcoin within the country with such provision available
For binance p2p (express and normal p2p), the transaction na zero (0) fee. You dey right about the altcoin withdrawal fee wey dey very low on binance, except ethereum. Bitcoin and ethereum fee for most others exchanges high too, binance still better many exchanges self, while many just dey like binance.
When it comes to binance p2p trading I be big-time novice. How I wish person go kukuma teach me how to use am wella without stress.
Almost all the top coins dey do well. So many coins dey my mind to buy but much chedah (money) no dey. I just d manage myself small small
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Except for ethereum and Bitcoin transaction, other transaction fee are relative low compare with other exchanges and I consider it as the main selling point for binance among others. Have u tried their P2P transaction compare with other local exchanges, fast, secure and low transaction fee. It provide a good exchange rate and can trade as high as 50 million naira in one transaction. Interesting I still some people looking for where to sell their bitcoin within the country with such provision available
For binance p2p (express and normal p2p), the transaction na zero (0) fee. You dey right about the altcoin withdrawal fee wey dey very low on binance, except ethereum. Bitcoin and ethereum fee for most others exchanges high too, binance still better many exchanges self, while many just dey like binance.
hero member
Activity: 2436
Merit: 516
Enterapp Pre-Sale Live - bit.ly/3UrMCWI
For me eh na binance oh
Binance na ogbenge exchange and I nor think sey e get any Naija peep wey dey trade crypto wey nor get account with dem. My main problem with dem be the high fees wey dem dey take to transfer BTC out. Dat standby commission wey don dey since long time Imo River na die! If you convert am for naira na almost N12k oh. But me I nor know wetin dem dey collect for escrow sha as I never use Binance for P2P before.
Binance na iron hand for the crypto matter, for the 9ja sef e nor get who dey follow am drag. But their fees dey tear shirt normally nai make me dey taya for them. Make them try review their high fees o. You don try BrainbossExchange? Na blast for the p2p life normally, no long story...btc for fiat instant payment
Except for ethereum and Bitcoin transaction, other transaction fee are relative low compare with other exchanges and I consider it as the main selling point for binance among others. Have u tried their P2P transaction compare with other local exchanges, fast, secure and low transaction fee. It provide a good exchange rate and can trade as high as 50 million naira in one transaction. Interesting I still some people looking for where to sell their bitcoin within the country with such provision available
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Funny enough eh, fir all this una altcoin talk way una dey talk here many times, I never hear una for once mention BitcoinCash. E be like something dey really bad about that coin. Me no be altcoin man shah, I never know how to follow una hustle that side so for now, I dey very okay with Bitcoin and Ethereum though, with the way the matter be for BNB now and to think say, na there exchange @Binance be the standard, na only better fit dey meet them, no be play. But then, watin really sup for this BitcoinCash way be say, e just be as if, e no dey exist as coin at all because, me no just get at all and na so the price high kwanu. Watin sup the coin.
Binance coin na good coin, I like the concept how certain part of the token will be burned after certain period of time, 100 million of the coin is said to be burned and yet little has been burned, less than 4 million but I no dey completely sure about the amount wey don burn already. Na why you see people dey rush dey buy the coin while the price dey increase lately. Never forget sey if you wan hold BNB, noncustododial wallet na the best for privacy.

About Bitcoin cash, you know sey na hardfork of Bitcoin, the man behind the fork who also own bitcoin.com try everything to make sure sey people think bitcoin cash na bitcoin, but see waiting happen in the process, bitcoin no dey replaceable. Bitcoin cash no do well for last bull run, make we see how e go be,
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
$ROPE wey we get  for discord airdrop just dey pump very hard today, this life no really balance. My people how the matter dey be how the movement be wetin be discussion of the week? How we go take achieve wetin dey hungry us for here?

I no sell my ROPE bro. I just keep am since them gimme. I no even get chance to even look at am much. I just dey focus on writing exams finish. Anyhow sha, I think I go sell my own if e get to like $1 each. Na cope airdrop I miss wey pain me. Guys for school wey collect am dey worth 5M - 10M free.  Well opportunity no dey finish for crypto so I believe say my tike dey come too. When you dey consider to sell?

Funny enough eh, fir all this una altcoin talk way una dey talk here many times, I never hear una for once mention BitcoinCash. E be like something dey really bad about that coin. Me no be altcoin man shah, I never know how to follow una hustle that side so for now, I dey very okay with Bitcoin and Ethereum though, with the way the matter be for BNB now and to think say, na there exchange @Binance be the standard, na only better fit dey meet them, no be play. But then, watin really sup for this BitcoinCash way be say, e just be as if, e no dey exist as coin at all because, me no just get at all and na so the price high kwanu. Watin sup the coin.

Why them no dey talk about am be say since Bitcoin cash been break away from bitcoin during that hard fork, people always dey see am as second to Bitcoin.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Funny enough eh, fir all this una altcoin talk way una dey talk here many times, I never hear una for once mention BitcoinCash. E be like something dey really bad about that coin. Me no be altcoin man shah, I never know how to follow una hustle that side so for now, I dey very okay with Bitcoin and Ethereum though, with the way the matter be for BNB now and to think say, na there exchange @Binance be the standard, na only better fit dey meet them, no be play. But then, watin really sup for this BitcoinCash way be say, e just be as if, e no dey exist as coin at all because, me no just get at all and na so the price high kwanu. Watin sup the coin.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
$ROPE wey we get  for discord airdrop just dey pump very hard today, this life no really balance. My people how the matter dey be how the movement be wetin be discussion of the week? How we go take achieve wetin dey hungry us for here?
Yes, na so. Life no balance. About waiting dey happen for this week, I think make we continue dey post here actively make sense enough. According to your last post about binance coin, the coin dey one of the coins wey increase for price well well recently. Waiting I see about binance coin be sey, na ethereum rival. Even, Binance smart chain dey also compete with ERC20 now.

Binance na iron hand for the crypto matter, for the 9ja sef e nor get who dey follow am drag. But their fees dey tear shirt normally nai make me dey taya for them. Make them try review their high fees o. You don try BrainbossExchange? Na blast for the p2p life normally, no long story
Binance withdrawal fee for altcoin no much, na one of the best for altcoins. The withdrawal fee for bitcoin much though, but people wey dey sell bitcoin, no be problem on their side. And he get ways people that wan withdraw dey use altcoins manipulate.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
For me eh na binance oh
Binance na ogbenge exchange and I nor think sey e get any Naija peep wey dey trade crypto wey nor get account with dem. My main problem with dem be the high fees wey dem dey take to transfer BTC out. Dat standby commission wey don dey since long time Imo River na die! If you convert am for naira na almost N12k oh. But me I nor know wetin dem dey collect for escrow sha as I never use Binance for P2P before.
Binance na iron hand for the crypto matter, for the 9ja sef e nor get who dey follow am drag. But their fees dey tear shirt normally nai make me dey taya for them. Make them try review their high fees o. You don try BrainbossExchange? Na blast for the p2p life normally, no long story...btc for fiat instant payment
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
$ROPE wey we get  for discord airdrop just dey pump very hard today, this life no really balance. My people how the matter dey be how the movement be wetin be discussion of the week? How we go take achieve wetin dey hungry us for here?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I like these hangout, am new here, and i need your support your encouragement and method of communication and I know that  soon I will coup with the language use here
Na Pigin be the language for here, though English no dey bad.

You are welcome, know sey Naija people for here ready to help newbies, but newbie need to know sey quality post dey needed. Try make researches about bitcoin, post for the English boards too, and no forget here, post here often for more bonuses.

The thing be sey, you can also make researches, post ham for here in Pigin, although if you know sey na core Naija matter, you can use English. If you post dey quality, know sey you go achieve your aim here too.

Hope you done know the Telegram bot wey you can use dey receive notification for merit and mentions?
Hope you know sey you can use your email to dey receive notification for tracked topics and boards?

You are welcome to this local thread. Hopefully we go get local board as time goes.

You don dey use p2p exchanges? You too can check the recent poll using below link to post the ones wey don satisfy you before.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56718552
member
Activity: 868
Merit: 38
Join hands and help me to grow everybody...
I like these hangout, am new here, and i need your support your encouragement and method of communication and I know that  soon I will coup with the language use here
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
I never use any exchange p2p before na my bros @obi theo wey d run am for me
Ohh, this no go well bro, abi you no wan learn how to do am, every person suppose sabi how e go do about him own buying and selling cryptocurrency to Fiat, I got tell you say make you learn am how to run p2p on your own, that go make you good in the space and have more knowledge better than your bro too., how you see am? e no make sense like that?

I have used it once before, I think 2 years ago but I went there to sild their native token which I got working for them during their bounty and the token was wonderful so is their service. However, I don't know how their service now.
Hmmm, 2 years ago and me never hear about this p2p exchange, e shock me, no be lie. I just fee say them go struggle to get large volume on the exchange by now, make I search about am anyway.
member
Activity: 62
Merit: 14
I never talk since unto say I never use any exchange p2p before na my bros @obi theo wey d run am for me
Honestly I thank all of una wey the reply this topic especially Person wey start am because e the help me choose which 1 I go go for
I don see as my bros the run am for binance so binance go b my first choice and una the talk of remitano and as una the talk of am I d feel say e d go but I go first research on am before I go use am
Brainboss exchange na one of the trusted members of the forum so his exchange will b Worth a try someday in the future

hero member
Activity: 2268
Merit: 579
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
It all depend on what you mean by the best because all the p2p exchange have there own unique features but in terms of best market price I believe Binance is the best and in terms of secure trading platform Remitano have that. Those are the p2p exchange I like the most but localcoinswap is not included in your list.
I have added localcoinswap, I checked about it, and I see it to be decentralized, have you used the exchange before? Or you know some Nigerians that are using the exchange? Decentralized exchanges are just the best for p2p trading with privacy not compromised.

Jump to: