Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 245. (Read 1032481 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
George Residence wan become first hotel wey go accept Bitcoin in Nigeria

One Naija hotel for Lekki don dey plan to accept Bitcoin as a payment method and to be 50% of their reserve. Na the Chief Executive Officer CEO, ‘Yanju George wey talk ham. He talk say the company reason to go for bitcoin na to be hedge against the country's inflation.

‘‘We have allocated around 50% of our cash reserves to Bitcoin…We hope to increase that as time goes on,’’ he revealed. “Bitcoin is the currency of the future and it is only right that we are strongly positioned so we do not get left behind.

Waiting be your opinion about this? Nigeria CBN no support cryptocurrencies, hope this no go be a drawback for hotels that wan use Bitcoin as reserve and for payment in our country?

The thread about this don dey Bitcoin discussion
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5333383.new#new
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na for Telegram group abi na for here i hear am, I no wan take eye fine am but the yarn be say, the papa for the group born some more local boards put for ground some days ago. That na to tell us say, e dey work, the guy don open eye if e bin day close before. I even see some of the work way e do for gambling section, way e lock con even move some kind topic way e feel say no suppose dey there, go where e belong. Even en right hand man too. I no just one mention names make una no reason am. All that na to tell us say, e dey on top this other languages corner and as e be, we need to dey work, dey make sure say, we stay top make we be  the baba for here and as e be so eh, na to keep our character and talk talk in check make e be things way go qualify us. That na the language, how we many for here and how the place dey busy with plenty talk talk. Una dey try but, make we dey do more, na more them need.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no understand watin you dey try talk for here o and u for like make you clear me small because, I believe say talk dey here way fit give person hope.
Waiting I mean be sey the resistance for a price above $60000 dey too much, and big institutions no dey try at that level. You know sey institutions tried as bitcoin price dey increase, especially the ones that cause fomo buying. Grayscale and microstrategy try push the price upto $40000, while Tesla push the price to over $58000. Although, no be sey na wating they invested push the price, na because sey the amount huge and cause people to fomo and bought more bitcoin at the time, which made the price to over $58000. News sey miners dey hold and whales no dey sell again push the price from $45000 when the price falled, it increased to $62000, the price drop again, the same news of whales and miners dey hold cause the last bull market again before the last crash. And the price not get upto to $70000 yet having resistance at $60000. Na why I say e go hard for the price to reach $70000, but over long time, as we know how bitcoin dey deflationary and people will buy more, will make the price increase above $70000 certainly, but I dey guess not now.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
As for getting beyond $70000, e go hard for now as all those big institutions still dey look for now,
I no understand watin you dey try talk for here o and u for like make you clear me small because, I believe say talk dey here way fit give person hope. Although, me no dey fear bitcoin shah, no matter how e fall, e go stil rise. Na the business way we dey be that. If you fit build in yourself say, the market no go fit crash, na so the fall no go worry you. If you no be regular trader, your stronghold na to hodl your coin till e gain value, especially when e be say, na custodial wallet your coin dey and you no dey fear hacking because,  na the matter for there be that. If you be person way sabi too and you wan get value on top your coin, you fit trade am or exchange am fir stable coin make e maintain en value then, you buy when e start to rise from the lowest low. Na so the matter just be.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na fear dey make most of us make mistake, regrettable once.
You dey correct, fear dey make traders make mistakes, but no be only fear, emotion generally dey there. If some trader dey see the market dey fall, and come dey rise back, they go still dey fear the market no go still dey fall further, and the best time to enter market na such time. But, this dey specific to trading.

For me, I dey predict bitcoin market price no go fall below $50000, and if the price fall below $50000, e no go fall below $45000 for now, $50000 na strong support, the good reason Microstrategy put money for bitcoin at the price. As for getting beyond $70000, e go hard for now as all those big institutions still dey look for now, but sure that the price over long time period go go beyond $70000, that one dey certain.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Few weeks i b tell some of my pesin sey dis market go soon shake nd dis shake na 2 remove some people 4rm de mottor car wey carry bitcoin lovers. Dem de whales undastand wat can reduce people 4rm dis market, imagine dis crash just happen suddenly( i mean dis current one now) many people panic sell nd dem still dey sell till now, even wen de market show some strong resistance at $52k+. me as pesin, nothing wey i dey fear again 4 dis market becus i don see many bad animals for my hunting in dis bush nd i no dey fear either na RED or na GREEN.
Green or red na just colour them be, nothing again. E no get anything to do with the market except say, e dey give people some kind sentiment on how things be. So, either red or green abi black cef,na you dey run your thing and you fit decide say, you wan enter or commot for the market. Nothing spoil for there.
The fact say, people dey fear way con make them dey sell na em me i no dey understand sometimes. The fear eh, that na to say, the market wan abi go crash or watin? Because, person way don dey hear for some months and e active suppose know how the crypto space be. Na fear dey make most of us make mistake, regrettable once.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Like somebodi bin yarn here sey dis predishion thing nor go eva end, especially when market begin move. For me ehn, I think sey Bitcoin supposed begin major correshion by now as the dominance don drop, but for where! The thing still dey creep go up. Well, e still good like dis as alts dey rise with am. I sabi sey the real alts bull go start only wen Bitcoin drop enter correshion and depression. BTW, I hope una dey utilize dis moment dey gather alts oh. So dat once alts rally begin una go begin enjoy am. Make una nor do d same mistake wey I do for 2017 believing sey na so e go continue dey sweet go. Nor be so oh. 2022 go red oh. Spend small and invest more now, you go enjoy am later Na so I dey spend my campaign money den with little to invest. How many of una key into dat Safemoon and Safemars projects sef?
member
Activity: 672
Merit: 29
Bitcoin price go decrease back $50000 or increase go $70000

I don dey wonder why bitcoin price no go further beyond $60000, although the price this time before the recent bear market wey happen overnight rose well even above $63500, but still the price decreased and decreased more abruptly over night for Naija time (GMT +1) to $50500. The price don rise back small and dey around $55000 now or slightly higher price.

I notice sey some institutions dey try, but after Tesla invested $1.5 trillion in bitcoin, na waiting carry the price go $40000 and yet carry ham go over $50000 because sey people fomo and invested along. The price later gotten to $58000 around that time and later decreased, as e decreased to around $50000, Microstrategy invested $1 billion, but the bear no gree end at the time, the price decrease go around $45000 but rose back above $50000. After that time, waiting I noticed be sey the price no go below $50000 and no dey near $70000, even not slightly e rise pass $60000 recently but no still near $70000. So, I come know sey the support na $50000 while the residence na around $60000.

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.
Em go be difficult thing to predict bitcoin price now. Nobody fit control the market as em be so. Wetin i know be sae bitcoin no fit fall below $40k ever again. This year bullish market looks very extraordinary wey be sae big investors don enter crypto market and almost everyone no wan miss the golden opportunity to secure their assets
full member
Activity: 756
Merit: 231

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.
Few weeks i b tell some of my pesin sey dis market go soon shake nd dis shake na 2 remove some people 4rm de mottor car wey carry bitcoin lovers. Dem de whales undastand wat can reduce people 4rm dis market, imagine dis crash just happen suddenly( i mean dis current one now) many people panic sell nd dem still dey sell till now, even wen de market show some strong resistance at $52k+. me as pesin, nothing wey i dey fear again 4 dis market becus i don see many bad animals for my hunting in dis bush nd i no dey fear either na RED or na GREEN.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
More input to speculate waiting go happen about bitcoin price still dey active, you fit scroll go up, the first post wey dey this page.

E go make sense if people dey come here to make such announcement I wan make now, to let our brothers wey dey this forum not to lack info about important announcement that dey very important. I believe sey some Naija go dey bustadice campaign, see yahoo62278 (the campaign manager) recent announcement about the campaign.

Just letting everyone know now this campaign will be ending May 16th.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
<...>
This prediction of a thing no go ever end, weda the support level dey $50k or resistance level dey $60k, e no concern me, wetin I know be say bitcoin go do marvelous things, people go regret why them never get btc an na why analysts don talk say the price go reach $100k this year, I no be analyst but the time to buy more btc na now than ever because of all this so called Institutions wey don show face for the currency.

but the thing be say the price no dey go down be low $50k anytime soon
No talk like that oh, wetin pandemic do us na pepper, no body know say na so e go be, anything fit happen wey go crash down the price now now, we never know the next pandemic wey go happen soon.

I no be prophet or prayer warrior
Grin
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Bitcoin price go decrease back $50000 or increase go $70000

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.

Bitcoin beyond $80k in July na fud to be honest. Because many institutions done pack their money put for crypto. The awareness really serious gan. New people no dey stop to dey come in to buy one or two things. This time no be like the 2017 bull run. the resistance just happen. Me I no really Sabi analysis and price prediction but the thing be say the price no dey go down be low $50k anytime soon
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
You are welcome to the forum, and welcome to our local thread. Know sey this na still thread, we dey hope for local board in the future, and e fit be anytime soon. Your post for here go dey useful towards us having Nigeria local board, and English boards should dey your mind very well and dey post there often.

First of all, never mind me sey I go correct you to dey proofread waiting you wan post. Before posting, read waiting you wan post, after you post ham finish, read ham again to check  for errors.

Nothing dey hard about crypto if you are patient, just take ham slow for this forum, learn about bitcoin and crypto generally. With time, you go dey happy sey you dey here. I checked your posting history and I saw a topic asking for what to do about this forum. Try read waiting them post you.

But, I go add you some useful information

  • try download Coinmarketcap to check crypto price
  • read about bitcoin wallet
  • read waiting crypto exchange be
  • read the difference between custodial and noncustododial wallet
  • dey read the post wey you see for this forum (that interest you) to understanding
  • take it step by step, you go be better than before

newbie
Activity: 7
Merit: 1

[3]: First timers should introduve themselves in this manner;
  • Username:
  • Gender
  • State of resident (optional)
  • Skills (Incase a project is looking for someone from the country for that particular job you get hired)
.
philips@3112
Male
ADAMAWA
Home care products production/forex.
Wuna well don my naija people. I dey new here and I wan use dis opportunity introduce myself as pesin wey just enta ino tey. I wan use wuna advise and support so I fit make am for the forum..
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
~Snipped
Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate dey the price go still go further below $50000 resistance.

I no be prophet or prayer warrior but I dey get better feeling say today dump no be the end of the road for Bitcoin as more upside moves still dey come. My personal bias is that we go still reach $70K and surpass it; then go beyond it and break pass that price zone. Since this level na very strong resistance, once price break am, we go most likely see it move past that level convincingly. But the way crypto work, you fit talk a and e go do be. So we fit see the price dip towards $48K momentarily before resumption of the original trend.

Short term prediction - some blood towards $48K - $51K.
Long term bias - $76K - $98K.

I assume that the price would drop closer to a milestone price like $100,000. I know plenty of people go stack sell orders at that price.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Bitcoin price go decrease back $50000 or increase go $70000

I don dey wonder why bitcoin price no go further beyond $60000, although the price this time before the recent bear market wey happen overnight rose well even above $63500, but still the price decreased and decreased more abruptly over night for Naija time (GMT +1) to $50500. The price don rise back small and dey around $55000 now or slightly higher price.

I notice sey some institutions dey try, but after Tesla invested $1.5 trillion in bitcoin, na waiting carry the price go $40000 and yet carry ham go over $50000 because sey people fomo and invested along. The price later gotten to $58000 around that time and later decreased, as e decreased to around $50000, Microstrategy invested $1 billion, but the bear no gree end at the time, the price decrease go around $45000 but rose back above $50000. After that time, waiting I noticed be sey the price no go below $50000 and no dey near $70000, even not slightly e rise pass $60000 recently but no still near $70000. So, I come know sey the support na $50000 while the residence na around $60000.

Waiting you people suggest, you think sey the price of bitcoin is going over $60000 and surpass $70000, because this has been the greatest resistance for now. Or, you speculate sey the price go still go further below $50000 resistance.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
~Snipped
These are the p2p exchanges that provide service for Nigerians. Which ones do you think are the best?
You can choose maximum of three exchanges.

I know say I dey late to the party but make I just drop my input anyhow e be:


P2P exchange service is one of the few crypto service I have always appreciated. The first P2P exchange I ever used was localbitcoins. I can't say the service was bad but I didn't have any issue with my trades. Then I used both Remitano and paxful about twice just to taste their service and later moved back to localbitcoins. Didn't take long before I moved to selling p2p to my friends on WhatsApp as I assumed that it was much more faster.

The P2P exchange wey I don come to appreciate recently na that of Binance. Simple and straight to the point plus them get plenty of p2p pairs - sometimes localbitcoins been lack. Compared to others na Binance be #1 for me.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
This fee thing fit dey avoidable especially, when your funds dey with escrow site already. The next thing na say, make the escrow dey offer those services like card as you talk. E go make people dey realise, the value of bitcoin no start from the value way dey attacked to 1btc, say with the #1k, you don transact with Btc and this fee thing no for worry, e go just be swap of funds between you and the escrow.
You dey correct that if bitcoin dey with escrow provider, fee no go dey there. But e depends on the type you dey use, you dey talk about custodial escrow provider. If na noncustodial, 2 of 2 or 2 of 3 multisig approach will be used, which go even take up more fee. But, you dey correct as na custodial service escrow provider you dey talk.

Waiting me dey think be say I still like the approach in which you will need to pay an address, it dey risky more than your opinion, but privacy go dey. As some platform don dey support bitcoin lightning, e make sense in my opinion. Litecoin transaction too make sense, e get a coin wey I like for such low fee which is digibyte, e make sense too, but no yet dey supported for many platforms. But your opinion to be an alternative na good suggestion because many people no even care if na custodial or noncustodial, but they just prefer there transactions to dey safe and secure.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na that charge be the real matter. Sometimes cef eh, charge way be say you wan pay on one service fit small o but, to transfer am, the mining fee go con wan even big pass am.
For the charging fee, bitcoin, ether or any other coin wey get high fee no dey encouraging. But you fit use bitcoin lightning, or altcoin wey get low fee for transaction, like litecoin.
I no know but, one truth remain say, people dey see this our bitcoin thing as 1 big thing way be say, small person for street no fit involve. Because, when you hear the value way follow 1Btc fir body, e go shake your leg. Even me cef, I go wake up some days like this eh, especially when my campaign week just run out den, I go check the value of BTC for coinmarketcap.com watin I dey see some of those days eh, e dey tire me. I dey like am to drop on those kind days but, watin I dey try talk here be say, for people way no get idea, e dey do them like say Btc na bigman something. Na currency e be and e no suppose get anyhow to worry person. This fee thing fit dey avoidable especially, when your funds dey with escrow site already. The next thing na say, make the escrow dey offer those services like card as you talk. E go make people dey realise, the value of bitcoin no start from the value way dey attacked to 1btc, say with the #1k, you don transact with Btc and this fee thing no for worry, e go just be swap of funds between you and the escrow.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Na wah oh, wetin person no go see for this country wey we dey. Wetin concern us with their useless guidelines, who dey give dem hope say we dey reason wetin dem dey talk? Abegi make dem comot for road and which market dem obstruct?
Nothing Musa no go see for gate way him dey oh😂, this country na just cruise las Las, the guidelines sef no mean anything, the only thing dis our current leaders Sabi na to embezzle money, we get clowns🤡 as leaders, and the market way them dey talk oabout sef dey still do well without the  banks, P2P dey work well so far, make dem dey deceive themselves say them dey stop the market.
Yuguda says the recent decision CBN made to close accounts of crypto exchanges wey dey Naija to protect the financial system from abuse don disrupt the market.

Omo make this people just get out😅, disrupt wetin?, this our leaders na LMAO😆
Jump to: