Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 83. (Read 1020385 times)

full member
Activity: 882
Merit: 207
Why some elements no just like this country to move forward in a positive way? E no make sense to carry hooliganism go another man land na. Abi no be because of greener pasture una go Dubai?
It's very disheartening reading or hearing such of Nigerians at this time wey things like banditry, terrorism and kidnapping dey make wave for our local news channels everyday.
The age restriction is, however, too extreme. Persons of good character and pedigree and below the age limit of 40, still live in this country and do travel or intend to travel to Dubai, due to its attractions and commerce. Make dem resolve their issues quickly ahbeg, make dem no use their reggae spoil another man blues.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
~snip~
My broda, watin you talk make brain wella. I discredit cultism or any form of hooliganism and see those involved to have been misinformed and needs proper rehabilitation but still, e dey outrightly wrong say, the UAE go put this kind restrictions on Nigerians. If you look, e no affect the elites o. I sure say, na them join body with the UAE government to map out that age limit as most of them don cross am. Make them dey get access to UAE.

The truth still remain say, they take cases with Nigerians too seriously and to an extreme.  So many cults dey glorified over seas. Like the Yakuza for Asia, the ms 13 for US and plenty others day way dey exist and accepting members way be foreign nationals but, no ban of this nature. Na just Naija and e show how much let down we don give ourselves else, them no for fit try am.

Mean while, we don pass this era of cultism. Even for we naija cef, e hard to see person way dey carry cult for head not to mention people abroad. These people no do well o, e no soft at all say, them don manage cross border, con dey drag the nation name down.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
A part of me wants to blame the whole hullabaloo going on with Nigerians in Dubai on the government, especially the leadership of the Ministry of Foreign Affairs and the Nigerian in Diaspora Commission. But for today, I won't. The average Nigeria has no sense of pride in being a Nigerian. Little wonder why Nigerians would drag themselves so low as to drag the country's name into muddy waters. Cultism outside the country is the most ludicrous thing one can ever hear of. It is simple-undocumented Nigerians who have no busy being in the country should be sent back home.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
I don't support the actions of those Nigerians who when to Dubia and took Hooliganism to great heights amongst them selves. It's totally unwelcome and unnecessary, but I also believe this is all about the countries reputation. Nigeria is a country already having bad reputation especially in terms of terrorism. If tables turns and it's was another country in the western world that did what those Nigerian did I believe the law would walk on those who carried out the act.

Senior man, honestly I shock as one of my guy wey dey enter Dubia come back dey yarn me wetin dey happen for there. Baba, I was totally dumbfounded. The thing wey my guy tell me just be like the level of cultism wey bin dey Port Harcourt like 5 to 10yrs ago when men no sabi anything. My guy been dey gist me how dem dey kill person, dey chant cultism publicly for another man country. Sotey e tell me about their point 1 wey dem kill, we get wife and children for house and wey start building project. But the whole story no clear me first, like if I leave Naija now I go dey play cultism for another country,  shebi I no know wetin carry me commot ni?

Make dem do anything to protect the reputation of their country make Naija boys no hijack their fine country. Shebi we like this our own country like this?
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I don't support the actions of those Nigerians who when to Dubia and took Hooliganism to great heights amongst them selves. It's totally unwelcome and unnecessary, but I also believe this is all about the countries reputation. Nigeria is a country already having bad reputation especially in terms of terrorism. If tables turns and it's was another country in the western world that did what those Nigerian did I believe the law would walk on those who carried out the act.

I don't think thousands of Nigerians should suffer and be harassed at the embassy just because they are Nigerians, is already though even before the incident for Nigerians to be giving entrance to access many countries so this is just another reason for them to even stifle their law against Nigerians. And I don't this our minister of foreign affairs or ambassadors are really doing the best in helping Nigerians trapped in this situation.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
For naija now people eye done they open when the matter come to bitcoin plenty people for our country both politicians , celebrities and every individual done get interest people they buy and hold , i happy as I see this post he show say my people done they actually invest, if na before people no they wan hear any thing bitcoin them they always see am as scam say they no believe but now you go even hear news about bitcoin for news so is actually a step forward in the industry , that’s nice I believe say with time self then go start collect bitcoin for shoprite.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Base on the katakata(cultism) wey d happen for Dubai from Nigerians wey d live there.

Anyone wey wan go Dubai for Tourist Visa: Must be above 40 years up, if you dey under 40 years, you are not allowed in United Arab Emirates (UAE). - FG Inform Nigerians.

Full report link: https://gazettengr.com/tourist-visa-fg-says-nigerians-under-40-years-not-allowed-in-uae/
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows

watch carefully there is no place you would not find any Nigerian doing business or involved in one or two activities. Nigerians are more freely to associate with any kind of people, diversify in any other activities which Nigerian must be found. Secondly our country has positioned us in way to work without looking for any free maner.
Na true you tok. E remind me of 1 mc way tok say, anywher way u wan sabi say life dey, say u go see Igbo man. Say if u enta anywher nd Igbo man no dey around der dey do business, mak u carri urcef commot 4 der becus, na dead zone u dey so.
Dat na 2 say, Nigerians na hustlers. E dey our body bt some people own never activate. Those people rear small shah as na mainly people frm d upper echelon becus, once u b common man, na 2sec ur hustling spirit dey activate via say, u nid survive nd no bodi go giv u chop if u no put bodi for 1 hustle or anode. Social media nw don con open our eye way be say, so many people don turn CEO online wth Pre Order!
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows


Well brodaly, see ehh as so far with our country we are always paving ways for things not only on crypto's but for another aspect of life. watch carefully there is no place you would not find any Nigerian doing business or involved in one or two activities. Nigerians are more freely to associate with any kind of people, diversify in any other activities which Nigerian must be found. Secondly our country has positioned us in way to work without looking for any free maner.

So far, i really love Nigeria because is a place you can live freely without much low abiding you couple with other countries where you have to study their laws before you can go live over there.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows

Naija nor dey carry last. My belle sweet me wella for the news wey I read so for Bitcoin.com The truth be say nor be even sapa dey make us dey obessed with all these new technologies and the rest of them. I just feel say na so God just manufacture us come from heaven. I sure say e nor go too taye before we go dey read say "Nigeria Stands at the Number Spot for Crypto Owners in Africa". My brothers and sisters make we dey push for our crypto journey one dey we go reach the promise land. I nor get too much to talk. You fit shook mouth for the matter.

No be lie man we Nija people they learn things in the hard way, na place wey u no even expect us we they show. just imagine as we all now say we no get enough technology resources but anything technology for Africa or worldwide you go see us among the top 10, I just they see as a gift wey God don already give us.
Even as our Government no gree legalize cryptocurrency, we still they use strong head they run am, very soon we go they very viral in terms Bitcoin Adoption and cryptocurrency and Nigerians go soon own Big crypto company owners in the world.
full member
Activity: 882
Merit: 207
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows

Naija nor dey carry last. My belle sweet me wella for the news wey I read so for Bitcoin.com The truth be say nor be even sapa dey make us dey obessed with all these new technologies and the rest of them. I just feel say na so God just manufacture us come from heaven. I sure say e nor go too taye before we go dey read say "Nigeria Stands at the Number Spot for Crypto Owners in Africa". My brothers and sisters make we dey push for our crypto journey one dey we go reach the promise land. I nor get too much to talk. You fit shook mouth for the matter.

Quote
With an estimated 53 million cryptocurrency owners, the African continent now accounts for 16.5% of the global total, a study has found. The study findings suggest that Nigeria, which has more than 22 million crypto owners, currently accounts for more than a third of the continent’s total number of holders.

Nigeria Accounts for Over a Third of Africa’s Crypto Owners
According to Triple A’s latest crypto ownership data, the African continent now has an estimated 53 million cryptocurrency owners. This constitutes about 16.5% of the estimated global total of 320 million. Out of all the crypto holders in Africa, Nigeria accounts for over a third of the total, or just over 22 million.

Globally, Nigeria has the fourth-highest number of crypto owners, while the United States is the top-ranked country, with 46 million cryptocurrency holders. According to the data, India and Pakistan are the next top-ranked countries with 27.4 million and 26.4 million crypto owners respectively.
You sabi say Nigerians sabi survive well well, mostly proven when them go abroad. With the way things for the country be right now based on unemployment, Asuu strike, kidnapping and banditry for some corner, the news make sense well well. That na why e dey good make we get better president o. If no be ex-president Obasanjo wey use I.Q introduce mobile phones then, maybe as the country be now, tins for worse. As we dey see the growth of cryptocurrency, mostly Bitcoin, with opportunities wey dey inside, e make sense say we no sit down dey wait for the government to come spoon feed us. We dey observe how the world trend dey go and the importance of good knowledge of web applications and other internet services. The way we take like flexing, na so we still take like money. We no fit carry last at all.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows
D mata pass 2 dey updated wth watin dey sup 4 d world becus, na life  b watin we dey try deal wth here 4 we naija. D pple jst wan survive nd dem no mind do anytin 2 mak sure say, dem see watin 2 chop last last.
Naija na kontry way go moni, moni full dis kontry bt d pple way hold am dey few nd our govment don carry der mouth tell is say, work no dey anywher, mak we hustle ourcefs out nd as e be like dat, naija pple don carry 4 mind say, opportunity no fit fly our window nd we no catch am.
I commend evry Nigerian, we dey try nd sabi tak up challenge. E sweet me say, as we carry dey rank 4 d bad, na so we carry rank for d gud too. D futur sure 4 us nd wth time, all dis bad story go b tori 4 b4.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows

Naija nor dey carry last. My belle sweet me wella for the news wey I read so for Bitcoin.com The truth be say nor be even sapa dey make us dey obessed with all these new technologies and the rest of them. I just feel say na so God just manufacture us come from heaven. I sure say e nor go too taye before we go dey read say "Nigeria Stands at the Number Spot for Crypto Owners in Africa". My brothers and sisters make we dey push for our crypto journey one dey we go reach the promise land. I nor get too much to talk. You fit shook mouth for the matter.

Quote
With an estimated 53 million cryptocurrency owners, the African continent now accounts for 16.5% of the global total, a study has found. The study findings suggest that Nigeria, which has more than 22 million crypto owners, currently accounts for more than a third of the continent’s total number of holders.

Nigeria Accounts for Over a Third of Africa’s Crypto Owners
According to Triple A’s latest crypto ownership data, the African continent now has an estimated 53 million cryptocurrency owners. This constitutes about 16.5% of the estimated global total of 320 million. Out of all the crypto holders in Africa, Nigeria accounts for over a third of the total, or just over 22 million.

Globally, Nigeria has the fourth-highest number of crypto owners, while the United States is the top-ranked country, with 46 million cryptocurrency holders. According to the data, India and Pakistan are the next top-ranked countries with 27.4 million and 26.4 million crypto owners respectively.
No be you talk am. Nigeria no d carry last for anything good dem find themselves on. As far as d thing d legit, worth doing and em d pay, you go see us there with our full strength, giving it our best shot.

Our government think sae, dem go fit stop our shine for crypto by banning any account connecting to crypto. They no sae, the harder d try to put a stop, the more exposure crypto gets for Naija.

I just d wonder, if em come be sae, d next government come d in full support of crypto, how em go take be? we go fit land ourselves for 2nd position after the USA
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
More Than a Third of Africa's 53 Million Crypto Owners Are From Nigeria, Study Shows

Naija nor dey carry last. My belle sweet me wella for the news wey I read so for Bitcoin.com The truth be say nor be even sapa dey make us dey obessed with all these new technologies and the rest of them. I just feel say na so God just manufacture us come from heaven. I sure say e nor go too taye before we go dey read say "Nigeria Stands at the Number Spot for Crypto Owners in Africa". My brothers and sisters make we dey push for our crypto journey one dey we go reach the promise land. I nor get too much to talk. You fit shook mouth for the matter.

Quote
With an estimated 53 million cryptocurrency owners, the African continent now accounts for 16.5% of the global total, a study has found. The study findings suggest that Nigeria, which has more than 22 million crypto owners, currently accounts for more than a third of the continent’s total number of holders.

Nigeria Accounts for Over a Third of Africa’s Crypto Owners
According to Triple A’s latest crypto ownership data, the African continent now has an estimated 53 million cryptocurrency owners. This constitutes about 16.5% of the estimated global total of 320 million. Out of all the crypto holders in Africa, Nigeria accounts for over a third of the total, or just over 22 million.

Globally, Nigeria has the fourth-highest number of crypto owners, while the United States is the top-ranked country, with 46 million cryptocurrency holders. According to the data, India and Pakistan are the next top-ranked countries with 27.4 million and 26.4 million crypto owners respectively.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Please, the congratulatory messages are getting out of hand; there is a thread for this. This is a single thread, and there was a discussion prior to the congratulations messages burying it.

And there is something else I've noticed, those of us who aren't here for genuine discussion and are only looking for activities should stop, we will have activities but not in a shabby way, this thread is monitored each month, and I post our weekly activities here.. 

Abeg make we no cast this small thing we dey manage for here e don tey I receive negative information about Nigerians for my inbox as compared to last year. We are all experienced now and the rate of plagiarism and other sort of nonsense don stop too. Abeg we want our topics to be more on Crypto and Politics because you can not talk about Nigeria and not talk about politics BUT bring a good discussion to the floor and let's tackle it together. Una welldone.

I agreed with you. plenti pipo dey post now 4 here 4 2 reasons as 4 me o! 1. dem dey post 2 enta dat ur weekly or monthly (di time wen i talk about weekly someone told say, no bi weekly na monthly, so as u dey say weekly, I dey confused sef, since na u get di project nah ur own i go follow) list 2 bi regoganaized, den mam karamuyeme (secondly) dem dey do am 4 dia Qatar post. For the congratulation issue. Na here nai we know ourselves. 4 di tred wey dem create 2 discuss any achievement, many pipo no kno am. nd evn u post 4 dat tred, pipo no dey comment. Na onli 1 or 2 pipo na go coment 4 a post. Nai make pipo dey do am 4 here, na so I am. As 4 me I dey post 4 dere well well. For di genuine discussion, I also supportam, make una dey bring beta discussion, like politics and crypto. Igehhh u r very gud in crypto so bring some topic den we can learn 4rom dere. I don talk dis dis b4. Political discussions 2 dey bring argument, I no 2 like am again. Bcos everybody kno nd nobody wan 2 learn 4fom oda.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Please, the congratulatory messages are getting out of hand; there is a thread for this. This is a single thread, and there was a discussion prior to the congratulations messages burying it.


No be lie bro. I been want talk too say make we reduce the way we go just use full post to congratulate one of use. Yes e good say make we let the person sabi say him face show and him don try but we fit still join am shortly for the discussion wey we want drop. Or beta if one or two people don congratulate, then no need to flood the thread with that, you fit show love ontop the post and that one pass and we move.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Please, the congratulatory messages are getting out of hand; there is a thread for this. This is a single thread, and there was a discussion prior to the congratulations messages burying it.

And there is something else I've noticed, those of us who aren't here for genuine discussion and are only looking for activities should stop, we will have activities but not in a shabby way, this thread is monitored each month, and I post our weekly activities here.. 

Abeg make we no cast this small thing we dey manage for here e don tey I receive negative information about Nigerians for my inbox as compared to last year. We are all experienced now and the rate of plagiarism and other sort of nonsense don stop too. Abeg we want our topics to be more on Crypto and Politics because you can not talk about Nigeria and not talk about politics BUT bring a good discussion to the floor and let's tackle it together. Una welldone.
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Bitcoin Casino Est. 2013
Big congratulations to me so far finally climb the hills of the Hero's.

At this point decided to say thank you to does who encouraged me, putting fire on me that i can make it while i keep saying menh is very high to climb that Hills of a Hero's Minds. Thought it wasn't easy all the way but i have some strong poineer's who kept rekindling me when the fire is put to off most especially our 001 (Oga brainboss), Agbe, igehhh, Oluwa-btc, Cryptoheadlinenews also one of our secret oga wey no gree show face (Smartvirus) many more make i no call everybody, I say thank you for the energy you gave me both calling.

I say congratulations to me and i want to also use this medium to encouraged those of our brother's who are just coming up to keep the fire burning without looking at any limitations, obstacle or hindrances from any edge of the forum. i will say these are being implemented to squeezed out the best from You and I.

Good Luck!
Congratulations on your newly acquired rank. I dey always get joy when I see sae another person for we naija community don rank up. He nor easy brotherly, but as Dem talk am " If you want to be quick go alone, but if you want to go far go together." As he be say you dey always carry us wen be newbie alone so the sky nor go be your limit, the sky go be your starting point.
Before you know you go come back again come celebrate for your Legendary rank.

Once again congratulations @Adbitco
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Big congratulations to me so far finally climb the hills of the Hero's.

At this point decided to say thank you to does who encouraged me, putting fire on me that i can make it while i keep saying menh is very high to climb that Hills of a Hero's Minds. Thought it wasn't easy all the way but i have some strong poineer's who kept rekindling me when the fire is put to off most especially our 001 (Oga brainboss), Agbe, igehhh, Oluwa-btc, Cryptoheadlinenews also one of our secret oga wey no gree show face (Smartvirus) many more make i no call everybody, I say thank you for the energy you gave me both calling.

I say congratulations to me and i want to also use this medium to encouraged those of our brother's who are just coming up to keep the fire burning without looking at any limitations, obstacle or hindrances from any edge of the forum. i will say these are being implemented to squeezed out the best from You and I.

Good Luck!
Congrats my broda... Na small small all man d push. It is a good thing sae you don reach hero member. I d happy for you. As you d keep your own firing burning, make you no relent sae hero member na final bustop. We still get legendary rank also.
Wetin I understand for this life be sae, wetin you made up your mind sae you go accomplish, na wetin you go accomplish.

Na higher higher we d go, make no peso relent
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Big congratulations to me so far finally climb the hills of the Hero's.

Congratulations brother man, your face show and your shoe shine too. E no easy to climb the ladder from zero merit to hero. Many hero people wey dey now been recieve Airdrop merits when dem been introduce the merit system newly. I join the forum members for this we thread dey salama you congratulobia for your rank up. Continue dey keep the vibe going as I wait to tell you another congratulations when you go enter legendary.
Pages:
Jump to: