Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 87. (Read 1020763 times)

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
This one when I dey see cake for chairman @CryptopreneurBrainboss profile so una sure say today nor be him birthday so??? Huh

If you see a cake, yes you are very right. Happy birthday chief CryptopreneurBrainboss   MGL!!!
Na location remain laidis chief.

EDIT: Ah don see the cake too hehe
For clarity sake since both of you are new members, the cake on cryptocurrencybrainboss forum profile shows that the user brainboss has completed another 365 days cycle on this forum and that is the forum way of celebrating members here who set their date of birth on the profile setting. But in-between note that bitcointalk is an anonymous forum so the individual behind the account cryptocurrencybrainboss may not be celebrating his real-life birthday unless he set it to represent his real-life date of birth.
But whichever way happy birthday to user @cryptocurrencybrainboss may heaven shower you with all the wonderful things you deserve as you have continued to be a light and a guide to others. Am proud of you bro.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Happy Birthday CryptopreneurBrainboss

I waka for telegram group today, I come see where person yarn say today na CryptopreneurBrainboss birthday, incase anyone wants to wish him well. Na there I come sabi, just say I dey busy since, I say if I come online I follow wish him Happy birthday for here. But as I reach here, I no see such post. I come dey reason whether e dey against the rule here to wish person Happy birthday. Even if na rule, abeg make una forgive me.

Happy birthday CryptopreneurBrainboss, we the Nigerian community for Bitcointalk dey proud of you and wish you well.
member
Activity: 421
Merit: 47
This one when I dey see cake for chairman @CryptopreneurBrainboss profile so una sure say today nor be him birthday so??? Huh

If you see a cake, yes you are very right. Happy birthday chief CryptopreneurBrainboss   MGL!!!
Na location remain laidis chief.

EDIT: Ah don see the cake too hehe
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Bitcoin Casino Est. 2013
This one when I dey see cake for chairman @CryptopreneurBrainboss profile so una sure say today nor be him birthday so??? Huh
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Make you love your neighbour as yourself. As we dey consider the current state of this our able country, any Nigerian wey no d support Peter Obi d simply hustle for his or her daily bread. We understand sae d country d hard.


The tori about peter Obi be say in the midst of all the people wey him dey contest with, him dey miles away from dem and e just be like say persin go dey inside ocean make soap com enter him eyes. So no be about loving your yourself or neighbour but to see the facts and acting on it. At least we see how the NBA conference 2022 go wey peter obi dust all of dem collect award.

hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Make you love your neighbour as yourself. As we dey consider the current state of this our able country, any Nigerian wey no d support Peter Obi d simply hustle for his or her daily bread. We understand sae d country d hard.

Wetin the person no d do correct na the willingness to sacrifice the wellbeing of all Nigerians for his/her daily bread.

That kind mindset d exactly wetin "blood money" be. You know d care who dies or who lives, as long as money d enter your pocket.

Being OBIdient be loving your neighbour as you take love yourself.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
CBN governor's speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale

I watched the CBN president speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale, you can see what CBN president said:

Around 30 minutes 48 seconds of the video, he said:

ENaira will enhance financial inclusion, support poverty reduction...

...since the launch of this great initiative, the eNaira has attained 840000 downloads with about 270000 active wallets...

Please, how would eNaira support poverty reduction?

Most Nigerians are using Android, only 100000+ of downloads on Android while I was not able to see eNaira Marchant wallet again both on their eNaira official website and on Playstore. Is it true that the total downloads is up to 840000?
D truth 4 d matter be say, eNaira no gt any direct impact way e go mak on d poverty of d nation, only watin ft change situation na 4 us to dey produce most of watin we dey consume bt no b so d kontri b. We no dey see value our products. Naija nd Naigerians na kontri way lik ready made, to leave on a borrowed standard nd wth borrowed money kwa.

Dis people jst wan use any tin way dey enta dere mouth promote eNaira nd no mined to crush anytin way dey in-btwn. D idea way dem dey try pass wth eNaira be say, e go reduce printing of notes nd frm dere, them go carri money way dem suppose use print notes, con invest am 4 orda capital intensive projects way go help d kontri. E fit happen lik da o bt d matter b say, dem no go do am. Na jst mor money 4 dem to chop.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
There is no place like home, so on that note, I am here to officially announce that I got ranked as a Sr. Member yesterday, haven acquired the required merit due for the rank. And I am really grateful, because i know that wouldn't have been possible without the support from members of this board and the forum at large. I am really grateful, and I promise to offer my very best to the forum and humanity at all times.

Thank you... Thank you.. & Thank you..


The joy I felt for you was overboard when I see sae you don enter senior member. I was happy for you, you know why? Because I know how hard you don work to get that position(senior member) and how em take start. Nevertheless, this journey na turn by turn. All man go get to their own higher level someday with time. Anyway, I say make you enjoy and flex cos em no d easy
sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
CBN governor's speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale

I watched the CBN president speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale, you can see what CBN president said:

Around 30 minutes 48 seconds of the video, he said:

Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
Once the government realized how they have been losing, they will not have another thought than to regulate cryptocurrencies. But from the look of things, this Emefiele time would not be positive for crypto regulation.


Me I been don post something about this E-Naira before for this forum

I been they ask before how Dem go ban crypto for the country come they launch something way them call E-Naira say nah their digital currency say eh go better pass crypto how?
The problem way this our government get be say them always wan they control anything way them see.. something way them self no understand them wan put body.
Assuming say eh they possible for them to manipulate the download record for playstore them for do make eh just be say them mislead the public say them get plenty users.
Nigeria people self way try download the app, nah so so bad feedback them carry full for the Dre.
Poverty eradication for the country them know watin them suppose do to settle that matter but them no go do am, watin them always want nah how them wan carry chop money eh don finish.
Onah go see very soon them go bring account of how many billion them don spend for this their E-Naira Project.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Oboi eh see levels! My mind bin tell me say 9ja people must dey here! Na now I see this board oo. So all this big names like @Cryptoprenuerbrainboss, @Charles-Tim na 9ja people. I tuale for una. He mean say my way for here Don clear be that na. God go bless everybody wey put hand wan make this board go forward. The way una Unite for here Baba God go unite our country in peace and Harmony, Come help us rescue am from all this yamama and durty durty politicians

My info's be

Forum name : ZAGURU12
Gender : Adam's gender   Grin
Skills: Graphics design, content writer and comics creator

u dey welcome. so, how  u take come reach here? na ur mind just tell u say 9ja pipo dey nd u quickma come here come see am. oboy u bi prophet. Abi u dey si double. ur way e clear o but u go still work clearly.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
casinosblockchain.io

U no say many pipo tink say here na just place wey man fit come cap anyhow miss but forget every body here start from somewhere. Even me wey don spend close to 1 year never grow pass dey I suppose self, thu na my fault sha I no too put eyes to know how tins nd tins de run.
Abeg make una put for us bicus new pipo tink na to come here make noise run and com back again ask for something den miss again.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
This Fani Kayode Self

             

After I read this post finish and the way Fani Kayode wey be confirm Nigerian Political Psychopath dey criticize PDP and NNPP northern tickets, I come dey tink say wetin him for dey call Tinubu now if him still remain for PDP. If we remember say Fani Kayode na PDP turned APC becos of belle since work no also dey. Our politicians no get any stand na so dem dey support where food dey come from.
Very funny as our politicians no get base again because of belle , definitely them go wan reason well which party go come on board next year so that they will be favored  when there party win so that they go fit fund there expensive lifestyle the more  , flying there private jet buying of expensive properties but local and international so them self no go wan do two zero na politicians for you be that.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624


Bro you go still calm down and work things out oo. Make you no go that way oo things no too easy as e dey appear for face, if to say e easy you for don see too. Na wayo wayo , you get everything you need to reach where you dey go. That thing wey you dey call name, if na so e be na you self for don see am. Make you no give up concentrate on where you get better knowledge and one day rain go begin fall. Believe yourself and be consistent.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Our politicians no get any stand na so dem dey support where food dey come from.

Of lately i come understand sometin from this our politician say na greed make dem keep our country for dis kind bad situation onto say na my party member go enta seat or na dis nd dat go rule, all dis tin be say make money follow dey flow into their pesina bag no be to even put their citizen for front but only their own. I com also discova say dem dey fear make powa no remove from dia hand as well, bicus if dem no get powa dem no fit tok anyhow for country so all the political party just dey struggle to those tin instead them go think develop dey country make e open eye like abroad dem dey inside just dey circle powa among dia selves dey share money. If you cough dem EFCC take follow you up to empty little ones wey you manage collect from dem, after which dem still circle again share dat small one dem take from you.

na belle dem day follow my broda.
So like dis me no too put eyes dia, only i get to do is to keep my PVC Safe and ready to vote right pesin to rule us.

I greet all the elders on this forum, una boy dey hail o, Ekale, inauni, ehihe oma. Glad to be here.

Abeg follow wetin oda's do make e no be say we no kia for u. use de normal introduction methods make we know your side and ur units so i go recommend u go de first page make u see the instructions b4 u go follow up.

thank you
member
Activity: 295
Merit: 98
There is no place like home, so on that note, I am here to officially announce that I got ranked as a Sr. Member yesterday, haven acquired the required merit due for the rank. And I am really grateful, because i know that wouldn't have been possible without the support from members of this board and the forum at large. I am really grateful, and I promise to offer my very best to the forum and humanity at all times.

Thank you... Thank you.. & Thank you..



E really sweet 🧁 me say you done reach this rank, at least e also give me hope say one day we go reach that lader too. I also happy say place like this they for inside this forum way people fit carry one language communicate.
Congratulations 🎉 to you bro, congrats.
Leo
member
Activity: 620
Merit: 10
Trident Protocol | Simple «buy-hold-earn» system!
Baba sorry but I no go welcome you here oooo, sake of say e get somethings were we no like for here and as I put eye for your mataz I discover say you make waiten we dey do here look like childs play, e better make you start small than to jump start come hang for road. This my statement so e get why ooooooooo and you know, this na local thread soon to be local board and from you history you no belong here oooo, no reason my matter ooo but na the truth be that. E go make sense make we dey enter house through the door because my people talk say pesin were enter house last na him suppose close door and persin were enter 2ru widow him na ole be that, abeg try reason this matter well. Small beginning dey make sense.
Boss I no take this forum as child play o, as I talk am before this forum Don help me wella, but parables too much for ur talk o, abeg he go make sense if you help clear ur comment plainly I go really appreciate so that I go understand wetin you dey talk, even if na tru personal message biko help clear ur statements, because everyone dey learn ni one or two things fit dey wey I go learn there
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
(--)
I give you the maximum salama. I might call you the best graphics designer. In ur member rank u com dey create graphics that were Super gud with d post but as a low rank memba no 2 much Mani merits we're given. Bt I dey remember someone in tell u say u go get am wen u become Sr member nd 2day ur dream e don enter. I dey jolificate..with u.
Nor be only dat wan sef. Another wan wey d dude do wey enta my head na Touching the life of random poor kids with all my 3wks campaign BTC. Abeg, those of us wey get colele wata for fridge make una go pour am. It's an effort worth emulating. Also, rememba dat we rise by lifting others. Senior men supposed show there to show am love. E nordn't easy a thing to do at all as coWtry red like dis but somebodi still fit comot weeks of pay to do unto others dat better thing. Dat action is worth emulating. I salute you once again, broda.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Baba sorry but I no go welcome you here oooo, sake of say e get somethings were we no like for here and as I put eye for your mataz I discover say you make waiten we dey do here look like childs play, e better make you start small than to jump start come hang for road. This my statement so e get why ooooooooo and you know, this na local thread soon to be local board and from you history you no belong here oooo, no reason my matter ooo but na the truth be that. E go make sense make we dey enter house through the door because my people talk say pesin were enter house last na him suppose close door and persin were enter 2ru widow him na ole be that, abeg try reason this matter well. Small beginning dey make sense.
Leo
member
Activity: 620
Merit: 10
Trident Protocol | Simple «buy-hold-earn» system!
I greet all the elders on this forum, una boy dey hail o, Ekale, inauni, ehihe oma. Glad to be here.


Welcome bro, e nice as you find us come here hehe. and una no need panic at all. Na all of us be elders. no forget to make contributions and share opinions too. one love
Thanks boss, mehn this place sweet, expressing one self for this kind language dey sweet, u na agba me still dey 10 merits lol
Leo
member
Activity: 620
Merit: 10
Trident Protocol | Simple «buy-hold-earn» system!
I greet all the elders on this forum, una boy dey hail o, Ekale, inauni, ehihe oma. Glad to be here.

Oga Leo, e be like you wan set us up o...
You carry account wey start forum together with Satoshi enter come dey call people here elders. For here, elders no be by age o, na people wey don tey here gather experience be elders. So, you self na elder. Very big welcome and I believe say your ride here go go well.
I take style check your post history, e be like you dey post for areas wey no dey too visible for the forum. E go make sense to dey post were men go see you and send merit give you. Your name sef too sweet and e no suppose hard fly for the forum.
Thanks boss, you na agba o, me still be member fa, boss the thing just weak me I dey post wella before but as I see say guy man no dey rank up for the forum I just relax, as I no dey receive merit the thing just weak me boss I will be glad if you share some places wey I fit dey post wey dem go dey see my post wella and give me this stuff to go up, this forum Don really help but he just get as he b with those top accounts their itk too much, and most of the signature stuff na big accounts he require
Pages:
Jump to: