Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 80. (Read 1020172 times)

hero member
Activity: 910
Merit: 686

Nigerian job employments through selection or recruitment are free and fair. And one thing I came to understand in INEC is that, election has come to stay as a democratic state like Nigeria. Therefore, they should permanent the recruited staff to reduce unemployed youths in the country instead of using them and dumped them after the election to suffer and hustle again. Most time before the election ends some staff have already finished their allawee (salary). For those pipo wey dey go for di recruiment, na abeg we dey beg, make una do well, u know how we don suffer 4 di kwantri. No compromise, no bribery, and no fear.

I pray dey don’t discard dem afta d election don end. Becos I get friend too wey don do am before and dem no recruit any of dem, dey dumped dem and paid dem afta d election. D allowance no dey even do dem at all but as hustler you gatz just manage am like dat. D tin be say d recruitment sef na until u know person there wey go fit run am for you, if not nothing for you still oo. Dem dey use am dey get small cash out too for there, as dem no dey carry the number of people wey dey pay dem to recruit.


Quote
weti I wan ask is dat, pesen fit vote 4 him polling unit?

Once you be adhoc staff u no fit vote oo, I don’t think so. Becos dem no go even carry you go your polling unit as adhoc staff sef. So your PVC no fit get use I think. Unless dem go do their own voting after dat which I never hear say e don happen before sef.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
INEC don open portal for Adhoc staff recruitment. Em go start on Wednesday 14 September and em go close on 14 December 2022. Apply if you wan follow for Adhoc staff of INEC.

I can't wait to apply. I don work as INEC Adhoc staff for two consecutive elections but you see this time, I no allow any party to manoeuvre the presidential election result sheet
My brother thanks for the info, I dey wait for this for so long, I dey pray make I dey the among the lucky one. I don apply tired dey no carry me. I am a serving Corper now I dey pray make dey consider also this time, I go dey happy.

Nigerian job employments through selection or recruitment are free and fair. And one thing I came to understand in INEC is that, election has come to stay as a democratic state like Nigeria. Therefore, they should permanent the recruited staff to reduce unemployed youths in the country instead of using them and dumped them after the election to suffer and hustle again. Most time before the election ends some staff have already finished their allawee (salary). For those pipo wey dey go for di recruiment, na abeg we dey beg, make una do well, u know how we don suffer 4 di kwantri. No compromise, no bribery, and no fear.
u don work 4 INEC 2 times, can u tell us how di tin be? pls do well to say no to election maneuver dis coming general election. Do not wori urself 2 much, u r already a staff there. anyone wey get gud heart to do well in di forth coming as a youth or adult is already recruited. e bi like say I go apply for this time oo. make go do well.

weti I wan ask is dat, pesen fit vote 4 him polling unit?
member
Activity: 854
Merit: 13
INEC don open portal for Adhoc staff recruitment. Em go start on Wednesday 14 September and em go close on 14 December 2022. Apply if you wan follow for Adhoc staff of INEC.



I can't wait to apply. I don work as INEC Adhoc staff for two consecutive elections but you see this time, I no allow any party to manoeuvre the presidential election result sheet
My brother thanks for the info, I dey wait for this for so long, I dey pray make I dey the among the lucky one. I don apply tired dey no carry me. I am a serving Corper now I dey pray make dey consider also this time, I go dey happy.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

                          THANK GOD FOR MY NEW RANK


  My brodas from another mother, how una dey for the forum, this forum don help me o,since Agbe introduce me to this forum. I know say I don know small tin about bitcoin. My news be say I don enter member rank yesterday night,so I want make una follow me celebrate my new rank, and also give me advice on how to take survive for the forum to the next rank.

     I need una prayers to help me upgrade to full member as the journey no easy.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I can't wait to apply. I don work as INEC Adhoc staff for two consecutive elections but you see this time, I no allow any party to manoeuvre the presidential election result sheet
The election go even dey too hard to maneuver because of the technicalities wey INEC don ensure to be of effect. If them catch you sef, na em go worse pass. Normally, them dey share money for participant wey help conduct election, but if you check the kind locality wey you dey, ahbeg no fail to use you I.Q o, unless you want get wahala with area boys or persons wey just ready to on a go cause kasala.

Davo, there is no technicality in nigerian election. you go see say dem go still try to manipulate di election, the election go hard but dem go still do am. there are 3 major people wey dey maneuver election and election result. 1. INEC, INEC never and ever conducted a free and fair election in nigeria.  2. police dey always support di politicians wey dey pay them peanut. and finally the worst group of pipo in nigerian election is the Judiciary. I am using last Bayelsa and Imo States Elections as a case study.
    
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
I can't wait to apply. I don work as INEC Adhoc staff for two consecutive elections but you see this time, I no allow any party to manoeuvre the presidential election result sheet
The election go even dey too hard to maneuver because of the technicalities wey INEC don ensure to be of effect. If them catch you sef, na em go worse pass. Normally, them dey share money for participant wey help conduct election, but if you check the kind locality wey you dey, ahbeg no fail to use you I.Q o, unless you want get wahala with area boys or persons wey just ready to on a go cause kasala.
hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death
So OP you mean say if with this current country situation of hardship, politician dash you money to take clean sweat of hard work to manipulate result, you no go take? I like your resolve o, na people like you we need for this country well. People wey go ensure say due process dey followed to the core.
My brother these politicians them dey carry us dey play. Before elections, we no go see that money. Them dey bring am during elections so that plenty people wey hunger don nack wella go sell their vote. My brother everybody go fit reject their money eh go better for the country. But sometimes the money dey very attractive oh. But if people like you stand gidigba say no, then we go get the right person for the job.

Quote
The only problem wey I get be say, wat if them dash you money to maneuver result and you no comply, hope if them turn the matter to fight, you no go stand do gra gra o?
Na my problem with Nigerian politics. If you say you no want collect bring, them go use intimidation and problem to force you to accept wetin them want. Baba no politician worth your blood oh. If don carry gragra come, my brother make you commit body except say law enforcement agencies dey wey go protect you.

Quote
We all pray for a free and fair election in all voting centers across the nation and as such, na only people wey get better mind for this country suppose to participate.
Na wetin every Niaja person dey pray for. Say make that miracle wey happen for Kenya wey even the supreme court no fit change happen for our country. Make the people choice win the elections.
full member
Activity: 882
Merit: 207
So OP you mean say if with this current country situation of hardship, politician dash you money to take clean sweat of hard work to manipulate result, you no go take? I like your resolve o, na people like you we need for this country well. People wey go ensure say due process dey followed to the core. The only problem wey I get be say, wat if them dash you money to maneuver result and you no comply, hope if them turn the matter to fight, you no go stand do gra gra o?
We all pray for a free and fair election in all voting centers across the nation and as such, na only people wey get better mind for this country suppose to participate.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
This narrative mean say mago mago been dey the former election if I understand correctly and you been dey follow dey do, dey take money. Abeg update us hw much you been get from all the runs. Then secondly, wetin you mean by say you nor go allow, what if them bring money come like the last time? you mean say you nor go take am, abi you go take am still do wetin you wan do?

These questions wey you ask op make sense well well I wish say em go fit update us more so that we go watch out for the up coming election make all our struggle for a better government no be in vain. For the last presidential election wey been happen, I been dey suspect say plenty mago mago happened because some of the result dem wey Inec been dey announce been no dey accurate as e be say the number of people wey vote bin plenty pass number of registered voters and so on. Another thing wey I know be say if them give person money to deliver a particular unit, dem go make sure say you doam if not na your head go carry am if dem catch you after result come out.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I can't wait to apply. I don work as INEC Adhoc staff for two consecutive elections but you see this time, I no allow any party to manoeuvre the presidential election result sheet
This narrative mean say mago mago been dey the former election if I understand correctly and you been dey follow dey do, dey take money. Abeg update us hw much you been get from all the runs. Then secondly, wetin you mean by say you nor go allow, what if them bring money come like the last time? you mean say you nor go take am, abi you go take am still do wetin you wan do?
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
INEC don open portal for Adhoc staff recruitment. Em go start on Wednesday 14 September and em go close on 14 December 2022. Apply if you wan follow for Adhoc staff of INEC.



I can't wait to apply. I don work as INEC Adhoc staff for two consecutive elections but you see this time, I no allow any party to manoeuvre the presidential election result sheet
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
We are very pleased with the activeness and ranking; I've been very active on the reputation for the last 6 months and have yet to see any case from this group or accusations against any Nigerian here. There is a negative perception out there, but we prove them wrong every day. Because of the increase in numbers, I'm now putting in more effort to post the monthly stats. If the number continues to rise, I may be forced to reinstate the weekly stats that I used to provide + Merit stats.
Em no d easy to be keeping up with the monthly activeness of every Nigerian wey d for this forum. I d commend you on that. But I wan bring this for your notice sae I don enter full member since last 2weeks now. Em be like you never know cos you still d group me as a member rank.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
We are very pleased with the activeness and ranking; I've been very active on the reputation for the last 6 months and have yet to see any case from this group or accusations against any Nigerian here. There is a negative perception out there, but we prove them wrong every day. Because of the increase in numbers, I'm now putting in more effort to post the monthly stats. If the number continues to rise, I may be forced to reinstate the weekly stats that I used to provide + Merit stats.
You don talk wetin i carry for mind for a while now, i know say as Naija people come they enter here, many people go dy put their eye for our matter make them find something they go take accuse people for our Nigerian community, but as e be so, i never too see situation wey e be say Nigerian break rules or enter problem for here. Better negative perception choke against Nigerians, and we understand why e be like that, so as things be ehn, make we continue to they set good example say better people still they for our country, make we they prove am on a daily say Nigerians they intelligent, resourceful, diligent and honest, make e no come be like say anytime person hear the country "Nigeria", e go begin they fear you. So congratulations all my brothers for here, please let us all continue to be good, and in whatever you do, abeg always follow the forum rules.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The contract wey dem carry give tompolo go even tell us say this thing wey dey for naija no be government but just cabals wey dey control Nigeria.

No be dis same contract i hear say Asiri Dokubo abi how dem spell dat him name again, dey fight for?
say how dem go give tompolo come leave am na so dey tori carry tire me.

D matter b say, no b 2day way we naija don spoil. Politicians don mak d citizens beliv say, na share d money we dey, chop your own and I chop my own.

See na wetin make we no dey push go front since we beliv say we country na share d money, nd e con make us no even get any small savings or even thinking to develop we country for better for good.

E jst bad say, d life abi kontri no b electronics if not, we suppose don restart am.
bros no be only restart but we go format am, mak we get new fresh memory so that things go better pass as e be.

Oh big man like u sef dey zenger 4 award. Y u no allow 2day pikin dey ask. Any way I don fulfill my promises.

My broda no reason am oo, 1 single tree no fit make forest oo and na coperation make rice full cooking pot. So Na same way i go carry grow for the hustle.

Wen I see youth support APC or PDP I dey cry....No good go come out from these parties . I come dey even hear say Nigeria good don dey pamenent 4 di batch c 1 4 d npower scheme. Nigeria youth is for the Politicians mugu.

See i don tok am b4 nd i go still tok am again, our youth no wan tell themselves d truth onto say greed to lose dia political power dey mak dem no reason well nd to remain same spots of life nd same tin dey hinder we country not to grow as we need.
for instance; U nd I know say if Mr. A enta seat him no go do well but base on our interest say if him enta seat we go get chopins, While we know say Mr. P or so, can do well and bring we country back to reality go com make u & i no go vote am put there bcus we want to remain with power so dat dem no go see us as minority for country nai dey cause all dis problems.

Snip

Lastly Congratulation to your for your new frank. I think is highest among all, rock well sir  Kiss.
@Smartvirus don't worry you are already at the promised land, only thing be say broda Moses no gree open door for you, but no worry i go enta 5 days fasting and prayer for you so dat you enta promised land, d land filled with Milk and Honey  Smiley
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Just like you talk igehhh, me too deh happy as our people never enter problem of ban or anything like that for a long time now. It show say we don deh understand the forum movement. We are great people. Make we continue this way.

You observe well and I hope say we go keep the flag high and our increase go reach all over plus our board wey we dey look for go land to our surprise. We naija guys na gud pple na jus d govt make us dey ja.

Broda man you go soon reach dere as you congratulobia igehh and smartvirus, your own pure water go soon catapult you enta ur next ride.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

@igehhh and @smartvirus, I say make I salute una two for this legendary rank weh una enter so. E no easy. Even if una no want to celebrate am, I deh celebrate am for my corner with one cold malt. I deh like clap for other people progress so that my own go reach my hand too.

Just like you talk igehhh, me too deh happy as our people never enter problem of ban or anything like that for a long time now. It show say we don deh understand the forum movement. We are great people. Make we continue this way.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Oga Mpamaegbu been try to carry first make e for fit chop money wey dem promise him Grin but e later come give up. But him really perform well this time around. Him self don nearly pass igehhh and CryptopreneurBrainboss
My broda, na Igehhh praya point hold me down from reaching dat top bc engineer nor want make I chop d bet 🤪. If not, wetin be to carry first na. E nor hard na.

I carry bodi enta ogbe to salute all man wey dey do legit stuff here. E dey sweet my belle die as I dey see how men dey climb go up and change ranks like women wey dem husbands buy new wrappers for. Una too try. I need more men to come join us for dat peak wey only 5 of us dey. Make una continue to dey focus and put in more efforts, soon everything go blend for all man.
Haha, this man Wait! Person been put money for top rank of the month? Make una dey give us update na at least for us wey no get shishi Grin

We are very pleased with the activeness and ranking; I've been very active on the reputation for the last 6 months and have yet to see any case from this group or accusations against any Nigerian here. There is a negative perception out there, but we prove them wrong every day. Because of the increase in numbers, I'm now putting in more effort to post the monthly stats. If the number continues to rise, I may be forced to reinstate the weekly stats that I used to provide + Merit stats.
hero member
Activity: 798
Merit: 635
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Congratulation for locating us, you are welcome to the group.
As i go see your profile am very happy for you with the step you dey carry. With this you can go a long way. In merit you do fine more than me but you still dey Jr member, I dey urge you continue with the activities so that you merit will determine your rank position. Do not engage in bounty like me ooo because am almost a year now in the forum see  wotin bounty do me. In the next 6 months I want to be seeing you in Sr member or Hero member. I am happy for you, at least even though I can make it to that level am happy seeing people behind me succeeding. I wish you good luck and safe journey. Once again congratulation. I salute you.
I appreciate the kind welcome. I go try make I keep the tempo active. Your comment and advice na motivation too.

Welcome bro. It's better late than never to be identified on the Nigerian board. Your candid input is valid. The way I see you so, e be like you go get better yarnings for us. This bitcoin matter, na the way forward as e be like this, and na the future of content writing and online hustle.
Sure, plenty things dey wey we go do together. U fit ask me anything, I dey ready to help. Make you dey ready for my questions too.

Welcome on board man, na we Nija people gather they here oo, as the forum be every community get they own corner we're local related issues they discussed.  Congratulations and welcome to the forum once again, as u talk am say u Don read all the rules and regulations regarding the forum and our Nija Unofficial Thread, I hope you follow the rules so that u go dey safe.
Thank you! I dey happy to be here. Na the rules I kuma read first, na my guide now.

Absolutely bro, you are welcome to the Nigerian part of the forum, e no matter when you join, the main thing na im be say you join, i don notice you for forum for sometime now, and based on your username one part of my mind they tell me say this guy na our countryman, but until person identify himself with us for this thread as a Nigerian, you no go fit address am as that, we love privacy, na why we love Bitcoin join.

Having said that, you don start really well on the forum oh, so no long talk they needed, just continue to they do wetin you they do already, but the only difference now be say you go add the Nigerian section as place wey you go they drop your contribution too, so that we go fit get our local board sometime soon.
Ok, I get am. Thanks for the advice, e go go long way
hero member
Activity: 1022
Merit: 723
Well e no easy oo, i congratulates Agbe for carrying first for last month result, secondly i no believe say i go even near the 2nd position but any away i know say me dey alway dey for 2nd and 3rd position.
So una just dey here dey carry carry 1st abi? 🤔 No wahala, me I don fully show body this month, we go see how the matter go be. But all the same, I dey happy say our Naija community here dey increase everyday, because I can see new new faces here coming up small small, and i go like to tell them say for here eh no dey easy oh, but with time, you go chop the fruit of your labour if you no give up just like me and my brother Agbe dey do now.



Na time like this dey make person dey regret say him no get any start up or better coding skills to use launch one or two as I dey get feeling say blockchain job/business go soon dey very lucrative for this side for the world. Sha any wisdom u wan throw for this matter above?.
Na better tin you talk here oh my brother, but one thing be say I still believe say eh never too late to go learn those one or two skills person need for the Blockchain matter, because as i dey see so, I strongly believe say Blockchain and cryptocurrency go dey till the next 10yrs

So eh get anybody wey know any better company wey dey teach about Blockchain technology for Nigeria here???
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341

Well e no easy oo, i congratulates Agbe for carrying first for last month result, secondly i no believe say i go even near the 2nd position but any away i know say me dey alway dey for 2nd and 3rd position.
abeg Agbe no forget your promise oo, i really need am oo even though say me and you still small deal but e no means i no go follow collect am as you promise.
I neva near for about days now and i just dey see the post now.

See my broda from all technical analysis, current regime dey find all thing to please our Youth, just remember the cases of eNaira as dat one no work them con run go Binance bicus many people dey use binance trade most especially p2p and if dem do people go support dem via dia political movement. Since dem want anoda APC candidate to enta seat so dem go do am make e be say APC don try so make youth support dem. Anoda tin again wey dem give 4 Billion contract to protect against pipeline vandalism, why all this tins dey come now wey be say their tenour wan pass, dis na to show you say na political propaganda nd na eye service dem dey do.

just watch this remaining period make you see tins wey dem go do before dem finally tuama for seat to carry close case say dem do sometin for we country.

Oh big man like u sef dey zenger 4 award. Y u no allow 2day pikin dey ask. Any way I don fulfill my promises.

I want 2 also talk say the newbies or junior members like 2 pesin wey go talk beta beta crypto mostly bitcoin 4 dis month go collect better award. T&C edey, no bi 4 Newbies or Jr member wey just come last month or this month oooo, di pesens we bin dey since nd he never get reward b4. Biko make una no disturb I go dey do am like dis small small dey go.


4 we Politics mata. Na only ignorant youth go fall 4 their nonsense trap. Wen I see youth support APC or PDP I dey cry....No good go come out from these parties . I come dey even hear say Nigeria good don dey pamenent 4 di batch c 1 4 d npower scheme. Nigeria youth is for the Politicians mugu.
Pages:
Jump to: