Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 91. (Read 1021048 times)

hero member
Activity: 2520
Merit: 624
@ Agbe Wetin me I get to talk for the matter be say that thing no go work because sabi btc dey function via blockchain and transactions dey stored or reflect dere simply from a common man idea and you go need network to access blockchain too , so e no be just one way thing. The guys dem don try oo but internet network follow for wetin go still worry the creation.
hero member
Activity: 910
Merit: 582
Dem Wan Send Bitcoin Tro Sms
South Africa software developer don go do (create) one software wey go send btc from botton (Nokia tourch) 2 anoda pesen nd e dey like normal text message wey we dey send everi time. Me, I don talkam say, dat tin go affect pipo. Bcos, yahooboys go dey use am dey send fake alert give pipo dey collect money. Mostly pipo wey dey do POS, wey dey acept bitcoin nai go suffer pass. Me, I no support dat tin 4 9ja wey I kno.
https://bitcointalksearch.org/topic/bitcoin-without-internet-sms-service-allows-sending-btc-with-a-text-5409627
https://cointelegraph.com/news/bitcoin-without-internet-sms-service-allows-sending-btc-with-a-text
No be bad idea as him dey try find way make more pipo 4 di African continent begin dey use Bitcoin without internet for dia toi toi phone, Imagine say 96% of financial transaction wey pipo dey do 4 we Africa say na via ussd code while 6% na only 4 mobile App according to the post bcos of d internet wahala. di tin wey make am bad be say e go against Bitcoin ethos wey be "not your crypto not your keys" (a.k.a centralized).if dem go fit make am dey secure pipo go only dey put /recharge small moni for d phone and make sure say dey take all necessary security measures to dey secure dia moni mak our smart guys no run dem street e go help some pipo a bit.
di bottom line be say dey no dey becos of di heat wey dey for kitchen come avoid to cook for kitchen.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Agbe my broda, you sure say this one nor be duplication of topic so. Because, you even don put the original link sef. Anyways wetin I fit talk be say this kind thing nor go fit work for Naija just yet. Because of many factors some of which wey you don already mention for the post. Personally, I nor even support am at all at all. For example, like yesterday now, person send me phone number via text message for morning. Before I recieve am na almost 7pm. Now, imagine say this kind this happen when you send bitcoin. Mistrust and distrust comes easily to the average Nigerian due to several lessons that have been learned the hard way.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Dem Wan Send Bitcoin Tro Sms

South Africa software developer don go do (create) one software wey go send btc from botton (Nokia tourch) 2 anoda pesen nd e dey like normal text message wey we dey send everi time. Me, I don talkam say, dat tin go affect pipo. Bcos, yahooboys go dey use am dey send fake alert give pipo dey collect money. Mostly pipo wey dey do POS, wey dey acept bitcoin nai go suffer pass. Me, I no support dat tin 4 9ja wey I kno. Bt I go fit supportam if di pipo wey create di new idea make am secure nd make dem use am 4 dia kwatri 4 like some time nd wen we see say, di tine good well well b4 we go do am. If not, yahoo boys wey dia eye dey red 4 money everi time go chock nd shock some pipo. Weti una go fit talk 4 dis kind mata now?




https://bitcointalksearch.org/topic/bitcoin-without-internet-sms-service-allows-sending-btc-with-a-text-5409627

https://cointelegraph.com/news/bitcoin-without-internet-sms-service-allows-sending-btc-with-a-text
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
I no go lie you, once Naija person start crypto, him eye they on how them go use the network make money, in the long run, other ideas fit enter, like to use am evade tax, but not at the beginning.

For me oo I no tink say men dey do crypto things just to run fm tax payment. How many naije dey even drop for tax?
The issue of tax invasion for 9ja done tey oooo but as recently many things dey happen were come make it impossible for cryptocurrency traders to avoid taxation, as the CBN stamp duties is already taking a tole on the people who are engaged with electronics transfer which the major tool for cryptocurrency traders because na bank transfer p2p dey use to make payments. Let say you make 10 trades in a day which are above #10,000 you pay #50 naira on each of those transactions which is already a huge tax.
But say 9ja government to make direct tax on cryptocurrency transactions it will be difficult and almost impossible for now.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
I no go lie you, once Naija person start crypto, him eye they on how them go use the network make money, in the long run, other ideas fit enter, like to use am evade tax, but not at the beginning.

For me oo I no tink say men dey do crypto things just to run fm tax payment. How many naije dey even drop for tax? Naija govt self sabi say guys no dey pay tax even with fiat. That one don make dem dey increase the price of some services to directly some tax money from there like the telecommunication area wey dem won increase call rates and data usage. Anyway make we still dey look how dem Minister for communication and digital economy wey be Isa Ali Ibrahim Pantami go battle am because him dey battle dem say make dem no from his ministry come dey increase tax .
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
No be lie. U knw say, d way forum b, no b evry mata way persn dey easily cari com drop 4 forum nd as e b nw, e don giv us tip way b say, persn ft use head follow up aside frm d pple way b say, e relate wth directly.

Inside all d secret nd pple way understnd kwa, I lyk d follow up way una giv Agbe. E dey vry encouraging nd na watin shw say, we no b jst Nigerians 4 d forum, say we don dey be d family way we suppose b, dey care 4 each orda nd dat 1 mata well well 4 watin we dey try build.

I still dey say sori w Agbe nd tank u 2 all of us way don see say, we dey inside each orda 4 here. Una weldon.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives. Mostly Davidvictorson, Wiwo, Zlannta, CryptoHeadlineNews,Adbitco, My boss Smartvirus, CryptopreneurBrainboss etc, please if I did not mention your name that does not mean that your condolence message was not received but I can not compiled all the names which the message were sent and called, it is only this few ones that are familiar with me and some of the people who called were having no name so please. I received all the condolences. You really show love and respect. It was really weighed down throughout the weekend but your calls and text encouraged me and wake me up. Untimely dead will never come near your families. And also to those who are not here yet but have shown love from one way or the other here, may his glory shine in your families. Amen.
Baba I don try scroll up to see where you post wetin happen to you but I no see. You know say na only one thread we dey use, before I come back after I post last, three pages done convert. From your post e be like say you lose special person for your life. Take heart brother and for everyone of us wey try reach out to him in his trying time una don try well well. We no go lose our special ones and we self no go die. Amen
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives. Mostly Davidvictorson, Wiwo, Zlannta, CryptoHeadlineNews,Adbitco, My boss Smartvirus, CryptopreneurBrainboss etc, please if I did not mention your name that does not mean that your condolence message was not received but I can not compiled all the names which the message were sent and called, it is only this few ones that are familiar with me and some of the people who called were having no name so please. I received all the condolences. You really show love and respect. It was really weighed down throughout the weekend but your calls and text encouraged me and wake me up. Untimely dead will never come near your families. And also to those who are not here yet but have shown love from one way or the other here, may his glory shine in your families. Amen.
   My guy(guy) sori for did strong tin wey happen to u,e really touch me especially wen u explain to me how e happen. I just want you to know say baba God know why e happen like dis so take heart and hold God Strong so that e go give us d grace to bear our lost.May God cover your family with the blood of Jesus so dat dis kind thing no go happen for your family again.Na long life we want. Kpele
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives. Mostly Davidvictorson, Wiwo, Zlannta, CryptoHeadlineNews,Adbitco, My boss Smartvirus, CryptopreneurBrainboss etc, please if I did not mention your name that does not mean that your condolence message was not received but I can not compiled all the names which the message were sent and called, it is only this few ones that are familiar with me and some of the people who called were having no name so please. I received all the condolences. You really show love and respect. It was really weighed down throughout the weekend but your calls and text encouraged me and wake me up. Untimely dead will never come near your families. And also to those who are not here yet but have shown love from one way or the other here, may his glory shine in your families. Amen.

Agbe I dey veri sori 4 d lost. I am sorri 4 d late sympathy. Dead dey inevitable, di untimely dead e dey very bad because person has not done or fulfill her mission on earth which God sent her 2 do bt We cant question God 4 d dead. Weti dey ground bi say, make u no reason am. Make u dey encourage urself to come out 4rom d pain. I feel ur pain.  Accept my condolence...
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives. Mostly Davidvictorson, Wiwo, Zlannta, CryptoHeadlineNews,Adbitco, My boss Smartvirus, CryptopreneurBrainboss etc, please if I did not mention your name that does not mean that your condolence message was not received but I can not compiled all the names which the message were sent and called, it is only this few ones that are familiar with me and some of the people who called were having no name so please. I received all the condolences. You really show love and respect. It was really weighed down throughout the weekend but your calls and text encouraged me and wake me up. Untimely dead will never come near your families. And also to those who are not here yet but have shown love from one way or the other here, may his glory shine in your families. Amen.
Amen!!! And yours too. We say no to untimely death to our family IJN.
Am so sorry for your loss. I know how it feels when someone loses someone close to him. Na God d give, na God d take. May God give you and your family the fortitude to bear the loss. Please accept my condolences once more. 
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives.
Nor be small thing oh as I read about d misfortune wey befall you and your family members. My guy, na God go give una d strong heart to bear am. It's well. Just remain gidigba. Accept my condolences.
member
Activity: 295
Merit: 98
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives. Mostly Davidvictorson, Wiwo, Zlannta, CryptoHeadlineNews,Adbitco, My boss Smartvirus, CryptopreneurBrainboss etc, please if I did not mention your name that does not mean that your condolence message was not received but I can not compiled all the names which the message were sent and called, it is only this few ones that are familiar with me and some of the people who called were having no name so please. I received all the condolences. You really show love and respect. It was really weighed down throughout the weekend but your calls and text encouraged me and wake me up. Untimely dead will never come near your families. And also to those who are not here yet but have shown love from one way or the other here, may his glory shine in your families. Amen.

My brother 😶, seeing you mentioned untimely death just got me dumb folded. Losing people we love in an untimely manner is usually painful but what every it is, I just want you to put your self together and move on, things at times happens for reason that is beyond our understanding. Accept my sympathy Brother man.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC: UN urges Nigeria, others on crypto regulation Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
E get any policy way we naija no dey open hand to...? So long as dem beliv say, dem ft get add thru pledged loyalty. D only policy way I sabi wella say we naija bin reject na wen our Jona no gree accept gay marriage way Obama propose dat yr.

Dis crypto regulation matta, I beliv say, we naija go open hand for ram bt d issue be say, we naija no strong rch to say dem go lik tak up regulation mata. We naija cef, na only civil servants dey pay direct tax as dem dey collect am frm dem salary mean while, d rest na indirect tax frm things way we dey buy. D Nepa bill way dem dey see 4 eye na em dem never fit collect talk more of tax on crypto way dem neva evn understand. E go wayh dem if not, na dis kind policy naija dey like.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
I really appreciate everyone of you who picked their phone bought card and called me to have empathy and sympathy. I always found belonging in this forum even than some relatives. Mostly Davidvictorson, Wiwo, Zlannta, CryptoHeadlineNews,Adbitco, My boss Smartvirus, CryptopreneurBrainboss etc, please if I did not mention your name that does not mean that your condolence message was not received but I can not compiled all the names which the message were sent and called, it is only this few ones that are familiar with me and some of the people who called were having no name so please. I received all the condolences. You really show love and respect. It was really weighed down throughout the weekend but your calls and text encouraged me and wake me up. Untimely dead will never come near your families. And also to those who are not here yet but have shown love from one way or the other here, may his glory shine in your families. Amen.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
I no really know if our Naija government so go follow this advice, though wetin i know be say even if them go do like that, the thing no go happen soon, maybe sometime later sha. Having said that, Nigerians no they run enter crypto because of tax, we know say with or without crypto many Nigerians tay tay don they evade tax in one way or another, so they really no need crypto to do that, maybe the thing go they easier for them to do with crypto, but tax evaders plenty for our nation for a long time now. I no go lie you, once Naija person start crypto, him eye they on how them go use the network make money, in the long run, other ideas fit enter, like to use am evade tax, but not at the beginning.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
I slept with light although it was not stable. But to some extent, it is better off. If na like dis light go dey let Dem do indefinite strike. Bt wait o. I think say NEPA sef e don privatized who Dem dey strike give again? I come understand d whole thing again def. No wonder I like d song Nigeria Jaga Jaga. E no dey straight attol.

Privatization wey na still dem d government still buy am as individuals or group of individuals. Dis light mata no affect only your state oo. Naso dem give light steadily for some states recently wey people com dey surprise d way dem dey see light as unusual. Can you just imagine how d country be ba lol, we talk say we no dey see light plenty, as d light come com e come dey look unusual to us again. But e better make we dey see d light small small dan to dey total black out for days sha. If d repercussion of having light steadily na to dey go indefinite strike den we no need am lyk dat, make we dey manage am small small.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Una dey think weti I dey think. Me I never sleep with light for 24 hours in my state, Bayelsa. Bt from on Saturday I come dey hear say PHED Dem don go strike nai light come dey steady light weti I no know.


I slept with light although it was not stable. But to some extent, it is better off. If na like dis light go dey let Dem do indefinite strike. Bt wait o. I think say NEPA sef e don privatized who Dem dey strike give again? I come understand d whole thing again def. No wonder I like d song Nigeria Jaga Jaga. E no dey straight attol.
member
Activity: 756
Merit: 30
Having gone through the whole thing I realized that the UN or whatsoever its called are not being sincere with their analysis.
Quote
The agency’s recommendation reads, “To improve taxpayer compliance rates and combat tax evasion, tax authorities should clearly define the legal status of cryptocurrencies and require crypto exchanges, e-wallet providers, and DeFi platforms to report gross inflows and outflows on all business and personal accounts.
How can someone evade tax with something regarded as an illegal especially in a country like ours. Something is there that they're not willing to disclose to us, it can not be tax evasion. I don't know from which angle they're trying to bring the argument but I can assure them tax evasion is not part of it all.
Quote
Financial institutions in Nigeria are currently banned from facilitating crypto transactions by the Central Bank of Nigeria. Despite this ban, Nigerians traded at least N497.35bn ($1.16bn) worth of Bitcoin between January 2021 to June 2022.
I no understand this part, shey na punch add this statement abi na the UN give the data? How them take know this amount despite the ban still dey effective? Abeg make we no dey deceive each other na.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
 My pipo make una no mind dem,den get reason wet make den dey talk like did but den just dey cover am up with tax BC os den c say wen den say tax e go make sense for other pipo to reason say na for we country.
  The truth b say dis pipo wey won tax crypto users get dem personal reasons and interest in mind maybe den won use dis way scam we country 2Ru crypto matter. No fear nothing dem fit do. Tax ke wey even civilized country no fit collect tax from crypto users becos den no say e no go fit work come be naija dead government na e go fit. I so me I reason am o.
Pages:
Jump to: