Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 90. (Read 1021058 times)

hero member
Activity: 952
Merit: 742
Those wey get better posts and activities but lack merit to rank up, make una check that link below:

https://bitcointalksearch.org/topic/--5410264

The Pharmacist wan make e jollof for una. Where I come from, they say na only bad person go see better road nor gree show im brothers.
Thank you for the update sir, at least people wey they lucky among us go get chance ease their work to the next rank.

Make una dey seize any opportunity una see to grow your account, nobi everybody go use their hustle rank up. Some go need additional help and reviews threads like shoudn't be ignored. No over spam/beg there oh or people go put you for blacklist, everything you do here use your head as entering blacklist fit spoil your progress here. I see somebody just publicize him ignore list and plenty Nigerian full am, e no give me joy as e no talk good about us. Make we try abeg. Happy weekend and TGIF.
Thank you for the advice boss @CryptopreneurBrainboss, it's always good to have leaders wey go they show and tell us the right thing to be doing, for all una effort, we they appreciate una, and we go try they keep to una advice always.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Yea, na good opportunity and I see e don bless one or two Nigerians too, him dey try. But make we still use no 6 follow am small small.
No be small joy e wan give people like this o but person gats carry for mind say, matter ft sup normally so that number 6 na dey very important for this matters. Omo, if you see or know road way pass this one, try show me o. Make I no lose like this with torchlight for my hand like this.

I don go to the banks oftentimes and they been get shortage of cash. Banks d refused to give amount wey pass 200k to their customers no matter d money wey you get for your account.
Ah! E don reach like that!! E don tay I go bank I no go lie you and I no even like the idea again but on a normal, na bank go advice you to withdraw money above 150k way some cards no go fit collect via daily limit inside bank for security reasons and say, make you for fit collect your money. This one way dem don dey hoard money like this, na wahala too for them o because, when person finally fit collect money way e go use dey run en matters, no need to dey work with bank again na. Nobody like that stress!

Hoarding the money no be the best strategy for the banks, na to upgrade there services. ASAP everything and end that there join line matter.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Those wey get better posts and activities but lack merit to rank up, make una check that link below:

https://bitcointalksearch.org/topic/--5410264

The Pharmacist wan make e jollof for una. Where I come from, they say na only bad person go see better road nor gree show im brothers.

Nice update from our brother @Mpamaegbu, out of all the merits source wey get plenty smerits like 1k+, @The Pharmacist na person wey dey help Nigerians pass wella on the low so if you see any update from am no use am play. Many people wey dun rank up from this our side, that guy play better role for their rankup story. Just dey very constructively for your post, try talk sense no just dey talk generic things (like average spamming just for your weekly quota). Even though the guy no see you now but any day your village people forget to put you for bottle then your own dun better because the guy sabi review post history and merit worthy posts.

Make una dey seize any opportunity una see to grow your account, nobi everybody go use their hustle rank up. Some go need additional help and reviews threads like shoudn't be ignored. No over spam/beg there oh or people go put you for blacklist, everything you do here use your head as entering blacklist fit spoil your progress here. I see somebody just publicize him ignore list and plenty Nigerian full am, e no give me joy as e no talk good about us. Make we try abeg. Happy weekend and TGIF.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
E be like say children of Adam don hijack this thread o, I dey try to understand wetin dey happen here but I no dey try understand and confusion dey my head. Agbe you say you don invent bitcoin wey dem go dey send with Nokia torch?  Grin

For any innovation wey concern bitcoin, I dey always dey happy, especially dis one wey Africa people do. Make people get dem connect make dem come lunch am for this forum e go make sense pass all these plenty scam projects wey Oyibo dey bring come here. Who get link to the whitepaper make I read.

Everything wey you say for this post dey off me. From the Nokia torchlight to 3310 lol. That whitepaper too me self dey expect am make I see whether dem go even write naija for there. I don dey even look that thing make e no resemble scam, e dey smell fish fish for my nose.

Lolx... as I type finish read am e follow off me o. Even Agbe sef don commot him head say him no invent anything o Grin. Agbe you wey get superpower try invent one thing na make we carry proud as Nigerians. How you see am na??

Those wey get better posts and activities but lack merit to rank up, make una check that link below:

https://bitcointalksearch.org/topic/--5410264

The Pharmacist wan make e jollof for una. Where I come from, they say na only bad person go see better road nor gree show im brothers.
Yea, na good opportunity and I see e don bless one or two Nigerians too, him dey try. But make we still use no 6 follow am small small.
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Bitcoin Casino Est. 2013
I don go to the banks oftentimes and they been get shortage of cash. Banks d refused to give amount wey pass 200k to their customers no matter d money wey you get for your account.
I dey reason say POS still join cause this one when you talk so, you know say many people don dey use their money run POS business and also most person's nor dey even bother go bank to deposit again.
If anybody wan deposit nah just to stroll go one POS pay Dem 200 naira before you even know Dem don print receipt give you instead for you to go lineup for bank queue dey wait for your turn.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Hello guys, I'm new to the forum. I'm Finbar from Imo state. I just found about this Naija section. How una deh?  Just mek una put my through. Thanks.

You are welcome, but please obey the rules in the forum wey also apply in this thread. make u no go quote di whole comment of a pesen and also make u no go comment after ur comment again. weti i mean bi say, wen u comment, u go wait make anoda pesen coment b4 u coment again. I discovered u just dey come d forum sef. so please calm down and learn from others
newbie
Activity: 7
Merit: 0
Hello guys, I'm new to the forum. I'm Finbar from Imo state. I just found about this Naija section. How una deh?  Just mek una put my through. Thanks.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Those wey get better posts and activities but lack merit to rank up, make una check that link below:

https://bitcointalksearch.org/topic/--5410264

The Pharmacist wan make e jollof for una. Where I come from, they say na only bad person go see better road nor gree show im brothers.

Dis na sure plug him try abeg e no easy for dis please I like de restrictions wey him put based on say na only post wey make contribution to forum him go fit give.. so if anybody na bounty hunter no even waste time go apply bicus notin go come out for dem.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Those wey get better posts and activities but lack merit to rank up, make una check that link below:

https://bitcointalksearch.org/topic/--5410264

The Pharmacist wan make e jollof for una. Where I come from, they say na only bad person go see better road nor gree show im brothers.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
If you don ever check, you go notice sae, most of the 1k naira note wey we d use today, na this year d print am.

Una think na joke? the former Deputy Governor of Central Bank wey be Kingsley Moughalu don lament say the CBN d currently print haira and em be the major courses of inflation.

The small economics wey I did for Secondary School d still work in my brains. No value. No production. Nothing nothing. Borrow and share govt na wetin d APC government d do.

Secondly...

I don go to the banks oftentimes and they been get shortage of cash. Banks d refused to give amount wey pass 200k to their customers no matter d money wey you get for your account.

They just d announce if anyone wan deposit cash. Like, bank d look for cash to deposit.

I no d understand the kind of inflation Nigeria d currently undergo.
Wetin d cause all this? Is it too much money dey in circulation or lack of money dey in circulation? Because I no understand all this

Stagnant economy. Stagnant policy.

APC d like a child crying make dem given am kola but dem don give am kola nut already. Ok. Chew am. Em put am in his mouth and spat it out, into the abyss.

APC na abysmal government of incompetent buffoons.
member
Activity: 756
Merit: 30
ENaira will never and ever reduce poverty in Nigeria. The problem in Nigeria is this CBN President, Lai Mohammed, and Adamu Adum (Education Minister). Now in what way ENaira will reduce poverty in the country?. 840000 have downloaded ENaira app? and 270000 users are active?  No wonder the country can't develop. So those active users are using it to do what? That is an exaggeration. 
Nigerians and wahala na 5&6 Grin Adamu Adamu dey him thing you just carry stray bullet go hit the werey man. We know say the man no try at all in fact na he be the most useless education minister so far for this country but wetin concern him for this Enaira Mata now? 🤔
As for me na the CBN governor no know wetin he dey do. Dey just create that thing without even know the purpose e suppose to serve, habba! To even get yourself registered on that app na shege you go see.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
E be like say children of Adam don hijack this thread o, I dey try to understand wetin dey happen here but I no dey try understand and confusion dey my head. Agbe you say you don invent bitcoin wey dem go dey send with Nokia torch?

Abeg no confused di tin no dey confused pesen, abeg calm down nd readam again. Abeg ooo no bi me invent oooo na South Africa software developer do am. Dat mata dey tire me 2. Lol Adam children. We are from Adam ooo. Don't worry just follow up u go dey understand den small small.

Gozie51 my man abeg make di tin no off 4 u. Di mata I talkam straight.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
E be like say children of Adam don hijack this thread o, I dey try to understand wetin dey happen here but I no dey try understand and confusion dey my head. Agbe you say you don invent bitcoin wey dem go dey send with Nokia torch?  Grin

For any innovation wey concern bitcoin, I dey always dey happy, especially dis one wey Africa people do. Make people get dem connect make dem come lunch am for this forum e go make sense pass all these plenty scam projects wey Oyibo dey bring come here. Who get link to the whitepaper make I read.

Everything wey you say for this post dey off me. From the Nokia torchlight to 3310 lol. That whitepaper too me self dey expect am make I see whether dem go even write naija for there. I don dey even look that thing make e no resemble scam, e dey smell fish fish for my nose.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Now in what way ENaira will reduce poverty in the country?. 840000 have downloaded ENaira app? and 270000 users are active?  No wonder the country can't develop. So those active users are using it to do what? That is an exaggeration. 
I am still thinking how eNaira would lead to poverty reduction but I see no connection too, eNaira is naira, nothing different. Said to have low transaction fee, which I do not see to be true.

The first phase, focusing on banked users,
The second phase, its objectives borders around financial inclusion
Why the third phase not mentioned, to be poverty reduction.

He said 'NO' to bitcoin, but 'YES' to what is the same as naira, a significantly depreciating fiat. Do not get me wrong, I only meant naira is eNaira, a lot of money was spent on eNaira development, but he said no to what people can hold and make money that the CBN do not need any development about before Nigerians can hold and earn passive income.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
CBN governor's speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale

I watched the CBN president speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale, you can see what CBN president said:

Around 30 minutes 48 seconds of the video, he said:

Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
Once the government realized how they have been losing, they will not have another thought than to regulate cryptocurrencies. But from the look of things, this Emefiele time would not be positive for crypto regulation.



ENaira will never and ever reduce poverty in Nigeria. The problem in Nigeria is this CBN President, Lai Mohammed, and Adamu Adum (Education Minister). Now in what way ENaira will reduce poverty in the country?. 840000 have downloaded ENaira app? and 270000 users are active?  No wonder the country can't develop. So those active users are using it to do what? That is an exaggeration. 
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
CBN governor's speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale

I watched the CBN president speech at 2022 eNaira Hackathon Grand Finale, you can see what CBN president said:

Around 30 minutes 48 seconds of the video, he said:

Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
Once the government realized how they have been losing, they will not have another thought than to regulate cryptocurrencies. But from the look of things, this Emefiele time would not be positive for crypto regulation.

hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
E be like say children of Adam don hijack this thread o, I dey try to understand wetin dey happen here but I no dey try understand and confusion dey my head. Agbe you say you don invent bitcoin wey dem go dey send with Nokia torch?  Grin

For any innovation wey concern bitcoin, I dey always dey happy, especially dis one wey Africa people do. Make people get dem connect make dem come lunch am for this forum e go make sense pass all these plenty scam projects wey Oyibo dey bring come here. Who get link to the whitepaper make I read.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I dey ponder on am for sometime now for my head,since El Salvador get something like a Bitcoin City, Nigeria no fit get something Like a Bitcoin Village ?
Maybe e dey like fantasies to me buh, I feel say make I share the idea... Chances of getting this are slim buh, how or ah see am ? Put cap on top the matter weh I play! Ornah Greetings n Good Evening.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Dem Wan Send Bitcoin Tro Sms

South Africa software developer don go do (create) one software wey go send btc from botton (Nokia tourch) 2 anoda pesen nd e dey like normal text message wey we dey send everi time. Me, I don talkam say, dat tin go affect pipo.
   I no think say e go fit work becos u go need Internet to do your btc transaction, u dey forget as network dey dull you when u won change moni.so dat Nokia torch light no go fit access your wallet. That USSD code transfer thing na e worst pass e dey dull pipo just for dem to transfer money base on bank network and d rest.
   Even though dat software fit do am but I doubt becos na block chain,my advice to pi po here be say make Una no use am bcos everybody know d danger of your private key when e don cast to anoda person. Yahoo boys dey find maga all d time o
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
On a more serious note, naija don Do e citizen watin men dey do most women.
Omo! Heaven is very far from you 😂 na una type dey give ladies mouth to say men are wicked.
You no suppose complain again cus na karma dey hunt you and you sef Don know 😂
I pray make the weekend favour all of us 🙏
Hahahahahaha, omo, see as I carry myself put for wahala. I don correct am o, I don write watin I bin wan talk well make e clear for eye. Yawa2020, e be like you be babe o. If na so, sorry for your gender o and if na man you be, na em be say you dey that circle too. No com claim church for me as, people way dey church cef na em dey run am pass. Them go carry God put front of billing, make e turn brother and sister hood. Mean while, on the main matter, I sure say you get the point now and karma no come out anywhere o, watin some of these ladies dey do men them no be here. Ladies dangerous kwa, very very but, no be the topic be this shah.

The fact say, person fit just get up for naija con believe say, na en time to rule just show how backward we don fall. No be watin en wan offer or gain, possibly e fit gain something but to reason say, na en turn to enter the history books, e no soft at all. E commot power for the people hand to make choice and that on na very bad signal and e go make leaders dey behave anyhow, together with there godfathers them.
Pages:
Jump to: