Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 93. (Read 1021315 times)

member
Activity: 756
Merit: 30
You fit add am small yoruba pepper make e for hot wella and gradually, you go improve. Just dey push.
if you add yoruba pepper everywhere go bust  Grin the truth be say determination and encouragement na dem be the key. I Don talk am before and I dey always repeat am. I remember the day I earn my first merit from our boss here na since then I begin dey active for forum and na me know wetin I Don learn from that time till now. As one padi Don talk am above say na who give up na that person lose. Na the truth be that. Make we dey continue to push.
@Agbe please accept our sympathy for the irreplaceable lose. May God comfort you and your family.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If you no mind I go like translate this your comment into simple English language

Permitted, if you think say e go dey easy for you to translate am then no issues but try check if anoda pesin don already do similar tin make e no be say you go against the forum rules so dat e no go attract restrictions or permaban. Remember say na small small dem dey carry lick soup wey dey for fire.

@Ihugbogo dis ur name no be here o, how come you be Ogba 1stson come dey answer community name wey dey for Ekpeya land abi only you na community?
Anyway welcome onboard me too na Egi product. We move ✊
member
Activity: 81
Merit: 11
Finally our brother don create room for us.
Me nah Rivers Pikin.
Ogba 1stson..

Make we carry this thread hold body.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
casinosblockchain.io
This account building no be here o nd another thing wey me observe be say e dey somehow to carry phone explore everything so like this we need laptop or any device wey go give us clear view of this site make we for understand sharp sharp, thou me neva show face for long onto say I dey work to try get one so that tins nd tins go pure for me if I finally come standby here.
Abeg make una no vex say I just fly com shuck mouth.

Una apy Sunday.
Life supposed easy and solf.
hero member
Activity: 1022
Merit: 723
Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
Agbe once again sorry for your lost and accept my condolences
My deepest condolences Sir Agbe, I am very sorry for the death of your younger sister, because I know how it feels to loss a love one, because the forum has made us family, and as such it is rightful to celebrate and mourn with anyone in need. So once again, may her gentle soul R.I.P..
 Amen 🙏
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Bitcoin Casino Est. 2013
~snip~
~ snip~
Everything when una talk enter finish.
I be just get this mindset of I need to know everything before I go fit grow for the forum, nah now the thing just clear for my eye say nah small small Dem take dey do am.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
Agbe once again sorry for your lost and accept my condolences, na so the life be sometime you win some and other time you lose some. Your sister lost the battle to the cold hand of death but am sure she is spending eternity in the bosom of God, just as I told you before pray for her and move on.
E dey painful to lost a love one but then death is out of our control, as @CryptopreneurBrsinboss write for him profile: there is nothing like death, only a better place after Earth.
Be strong and have believe your sis is still around she will come back in a better form, maybe through you or any other family member Na Africa I be and I believe in regeneration.
full member
Activity: 882
Merit: 207
Las las, the only person wey chop breakfast na d person wey give up o...
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Get your own identity.
I dey always tell people wey never too dey forum and dey find am hard to get merit say make dem nor dey discouraged but continue to write and observe so dem fit discover their writing pattern wey dey unique to them and wey go give them merit. For our brother Agbe, na wetin do am be that...e nor mean say if you follow e pattern e go give you merit, you gats discover your own identity like Brainboss dun yan, then dey follow up. E go good for everybody last last.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.
~snipe~
Na the one thing way people no too grab be that. Say forum no get a particular pattern way them dey take follow am up. No be routine something, na you go crack brain see watin u ft drop way go come out wella. This na global forum and many highly intelligent people dey here wella. So no expect say, you go just do any jaguda drop and people go show you love. As we dey talk like this, e go be like say we dey ask una of too much but the thing be say, that small way you sabi, you ft develop am well. Exhaust am in a way wey be say, person no go need think plenty to understand watin you dey talk except na the pattern to the post be that. You fit add am small yoruba pepper make e for hot wella and gradually, you go improve. Just dey push.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.

No be so by brother, you no need all those things wey you dey talk about and if you make am like say you really dey hungry for the merits people no go give you oh. Growing your account involves just using your brain. Oya check people wey dun grow their account from the country and reason how dem do am. Read their merited post and see how e be. Just use your imagination, dey creative. Get your own identity. Check Agbe,  tell a story through him post dem on how him dey use Bitcoin dey help children for him area and evidence dey to back am up. People give am merits as a means of encouragement to continue him good work.

Look Kingsden, the guy dey calm down write him replys dem before him drop am. Him go explain every single sentence to make you understand wetin him dey write. Check others too, dem get something wey identify them for the forum and since everybody na human here, people go easily fall in love with your style and the merits go come your way. Merit no scare again unlike before, e plenty now people just dey wait make you dey productive for the forum make dem stone you am so use your head. Calm down and write.

Boss you done talk am finished. Na so di forum be. E bi like say my story e no dey motivate this newbie Dem oo. I don tell you how I take suffer 4 d forum. Ok. Let me tell una d secret since na di secret una need. Weti una go do bi say make una dey read Oda pipo threads, post . Read! Read!! Read!!! More than post as a newbie. Nd 1 tin webi say una most Kno, make una no dey rush. If rush Forum, my brda, forum go rush u go home (ban), in 1 of d thread I created, I call it WAF as education thread.
Abeg I no wan talk plenti dis evening. Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.

No be so by brother, you no need all those things wey you dey talk about and if you make am like say you really dey hungry for the merits people no go give you oh. Growing your account involves just using your brain. Oya check people wey dun grow their account from the country and reason how dem do am. Read their merited post and see how e be. Just use your imagination, dey creative. Get your own identity. Check Agbe,  tell a story through him post dem on how him dey use Bitcoin dey help children for him area and evidence dey to back am up. People give am merits as a means of encouragement to continue him good work.

Look Kingsden, the guy dey calm down write him replys dem before him drop am. Him go explain every single sentence to make you understand wetin him dey write. Check others too, dem get something wey identify them for the forum and since everybody na human here, people go easily fall in love with your style and the merits go come your way. Merit no scare again unlike before, e plenty now people just dey wait make you dey productive for the forum make dem stone you am so use your head. Calm down and write.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
The issue wen I dey face be say I nor know where I go see better tutorials, I dey try watch YouTube videos once once but the ones when I dey see nor good, I nor know how I go take get better one.
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.
Relax my guy. Everibodi wey dey from full member go up sabi how you dey feel now. Cool your mind down. Google na your best friend. Those small small gist wey you and your paddy dem dey talk knack about bitcoin and cryptocurrency still follow for the materials wey you tink say you need. And many other ways too. E nor too hard like that if you try bend down understudy some of the big names for the forum. Make I live you with the oyibo quote wey I like well well - By the yard it's hard but inch by inch life's a cinch. Just enjoy the process now.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.

Building your account no be to go watch video or finding any PDF file, just stick around the forum read things and see how them carry do am, this forum big enough to get all information you need to build your account. Basically i no think say our brother here wey try enter sir member no just go search videos but na to read wetin other pipo dey talk from forum there him begin get idea on how the forum they work.

The forum dey section by sections
Section 1. Na about bitcoin > Meaning say any information you wan sabi about Bitcoin dey inside there but na for you to bring out your mind to read and learn how e dey work.
Section 2. Economy > Any thing wey concern economy dey inside that section, settle down or develop the heart of reading like say you still dey school.
Section 3. Others > Which involved many other tori wey concern country wahala, politics and many more thing like country development ect.
Section 4. Alt coin( Alternate cryptocurrencies) > This place now na anything out of bitcoin wey only concern anoda currencies like ETH, BNB and new coins to come
Section 5. Locals > Here na about places like to locate your countries and place you go deal with pipo wey from de same side with you and many more. All na just time

For all this sections try bring down your brain make you understand how dem dey work before you go fit grow here if not e go still hard you, even though na 2 weeks each bring am make you learn how them dey work then apply for anything you wan do here then you go boom just like that.
Adbitco thank you very much for this truth wey many of us wey just enter the forum the always run away from but just want find loophole to tk jump jump the ranking ladder just overnight.

If you no mind I go like translate this your comment into simple English language for beginners and help as I feel say this your comment go go a long way helping many of the newbie's, junior members, and members rank users like me, especially to those wey no dey in tone with this our NAIJA pidgin, to know and follow the right better way to take get knowledge and growth inside the forum instead of thinking say their growth fully lye for materials and info outside.

As for the first three lines of ur comment I get intention to handle am in a systematic manner.

Abeg u go need ur reply here, ASAP.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.

Building your account no be to go watch video or finding any PDF file, just stick around the forum read things and see how them carry do am, this forum big enough to get all information you need to build your account. Basically i no think say our brother here wey try enter sir member no just go search videos but na to read wetin other pipo dey talk from forum there him begin get idea on how the forum they work.

The forum dey section by sections
Section 1. Na about bitcoin > Meaning say any information you wan sabi about Bitcoin dey inside there but na for you to bring out your mind to read and learn how e dey work.
Section 2. Economy > Any thing wey concern economy dey inside that section, settle down or develop the heart of reading like say you still dey school.
Section 3. Others > Which involved many other tori wey concern country wahala, politics and many more thing like country development ect.
Section 4. Alt coin( Alternate cryptocurrencies) > This place now na anything out of bitcoin wey only concern anoda currencies like ETH, BNB and new coins to come
Section 5. Locals > Here na about places like to locate your countries and place you go deal with pipo wey from de same side with you and many more. All na just time

For all this sections try bring down your brain make you understand how dem dey work before you go fit grow here if not e go still hard you, even though na 2 weeks each bring am make you learn how them dey work then apply for anything you wan do here then you go boom just like that.
member
Activity: 756
Merit: 30

Omo no be small thing but I tap into una blessings for this forum. The truth be say for person to balance well and do some kind things for this street ehh you gat to need equipments like laptop and other necessary things. If to say comedy board dey ehh I fit reach legendary in a day 😹 but I neva see am. But I sha believe say gradually person gat to adapt.

@Yawa2020 my broda make you forget that bounty thing and unto say man go chop, wake up no sleep.
I don forget about it sha but I go finish the ones wey I dey do presently. And if I see better ones from the like of our boss I go tap in. Na just trial and error sha.
Anyday I worship any politician because of chewing gum money make I coil. I no dey send dem, dem wicked people. I no dey wear their cap or polo. Dem be wash all of them. The process wey pit them there corrupt, so all na the same.
No be everybody understand this thing sha! I be student of politics but I don't see any politician worthy of my respect. If I see people hailing any of them I go just shake my head and Waka pass 😂
If you know wetin dey their mind ehh even to greet them you go avoid am.

On a more serious note, naija don Do e citizen watin me dey do most women.
Omo! Heaven is very far from you 😂 na una type dey give ladies mouth to say men are wicked.
You no suppose complain again cus na karma dey hunt you and you sef Don know 😂
I pray make the weekend favour all of us 🙏
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Omo, the way you just dey run for this forum dey fear me oh,  because even Ferrari and Cheetah never fit run reach the way the merit for your account dey run here oh. How you take dey do am nah? Abi you no go give us latest update🤔🤔..

The guy impressed me and e dey very creative the way him do am. From my experience, him capitalized on wetin him see say give am the most merit. After him observe the merit a particular trend give am him continue on that path and na wetin most people dun use grow their account here. E get people wey start statistics thread and as them see say e dey give dem better merit dem invest more time into am and e dun pay them as in dem get better reward based on merit.

Just dey smart and you go get merit, e no matter to know everything, just seized any opportunity wey you see to use grow and dey comment for other qualify thread make e no dey like say you just dey hungry for the merit. Agbe see opportunity use two hand grab am and today him fit relax small but no too relax oh or you go fall off form hahaha.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
To get hope for this country eh, e hard well  well o because, e don tay way we naija people don dey hope and pray for better and e go con turn out say, the person we carry get hope go just break our heart. On a more serious note, naija don Do e citizen watin me dey do most women. No 2nd class citizen for naija go tell me say, e never experience heart break because, eh government dey serve us breakfast before e commot and the worst be say, EFCC dey free them. No fear at all for the wickedness way them dey show us an e dey very painful.
One thing remain for sure, we go try again. We go dey vote them in and out until we go get watin we dey fine. You no fit say you go avoid am as far as you dey the country, you vote or you no vote, the policy way anybody them vote come with go still affect you. So just vote who dey your mind make we see how e go be.  Na the forward be tha now.

When I look the brain of people wey do rule us, I go shake head coke cry ontop. Most of them na no brain people, based on say dem get mind to kill, rig, shoot, sacrifice and loot money, people go come dey worship dem. Anyday I worship any politician because of chewing gum money make I coil. I no dey send dem, dem wicked people. I no dey wear their cap or polo. Dem be wash all of them. The process wey pit them there corrupt, so all na the same.

Na wetin I dey pray God say the manipulated man wey dey Aso Rock, make God help him make him no go back for the electoral process reformation him dey do. If na the only thing e achieve for us, e go good. Make our vote count first, we know wetin we go do.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
To get hope for this country eh, e hard well  well o because, e don tay way we naija people don dey hope and pray for better and e go con turn out say, the person we carry get hope go just break our heart. On a more serious note, naija don Do e citizen watin me dey do most women. No 2nd class citizen for naija go tell me say, e never experience heart break because, eh government dey serve us breakfast before e commot and the worst be say, EFCC dey free them. No fear at all for the wickedness way them dey show us an e dey very painful.
One thing remain for sure, we go try again. We go dey vote them in and out until we go get watin we dey fine. You no fit say you go avoid am as far as you dey the country, you vote or you no vote, the policy way anybody them vote come with go still affect you. So just vote who dey your mind make we see how e go be.  Na the forward be tha now.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
I understand the sadness and the pains we Nigerians are all experiencing in the hands of our leaders in the federal level, state level and all other levels the matter reach to cry I swear, but my guy I go encourage make we no give up on the country, if we give up now after suffering this whole thing it doesn’t make any sense rather we go even Dey suffer they go, Wetin I go advice be say as election Dey reach make we carry our PVC for hand and vote wisely.
I agree with you. Naija na we own. No matter how bad e dey now, hope still full ground remain. For instance, I read say one Cameroonian relocate from Poland to Naija. Him even do video. According to am him dey come find greener pastures and peace of mind here. So we naija never spoil like that finish. Plenti good news yakpa for the country. This website PositiveNaija dey always talk about the positive things wey dey happen for the countri. Las las na who get PVC be sure person. Next year no sleeping on top bicycle.
Pages:
Jump to: