Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 94. (Read 1021315 times)

hero member
Activity: 1498
Merit: 702
You see Nigeria, i don give up on am.
Our beloved country don finally destroyed under Buhari and APC government:
The best way for the them to prevent the country from imminent economic collapse, state governors don proposed to the FG to compulsorily retire every civil servants wey dey above 50 years and make dem as well levy anyone wey d earn N30,000 and above monthly.
Una don see where we land? The level of the wickedness of our state governors don reach. Issorite, make d continue to reason from their anus, we d watch them. By next year, all this dia rubbish go stop
I understand the sadness and the pains we Nigerians are all experiencing in the hands of our leaders in the federal level, state level and all other levels the matter reach to cry I swear, but my guy I go encourage make we no give up on the country, if we give up now after suffering this whole thing it doesn’t make any sense rather we go even Dey suffer they go, Wetin I go advice be say as election Dey reach make we carry our PVC for hand and vote wisely.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Tell dat your friend sey make im concentrate on building his account to rank up and enta signature campaign. Bounty nor dey rewarding again like in 2017/18. Him go just waste im time finally and waste data unnecessary with am. Most of d projects nor dey like pay once d bounty ends.
Honestly, me sef Don realized say na time, energy and resources person dey waste on top bounty. How person go work for entire one month con get $2 after the work? No be juju be that 🤦‍♂️ some sef you no go get shishi at the end. But person no get choice sha after all na why I still dey participate in some cus man gat to chop.


@Yawa2020 my broda make you forget that bounty thing and unto say man go chop, wake up no sleep. Nothing like that. $2 bounty reward no scratch anything for you for naija today. Time don pass wey some pesin get something from am but not now, even that time na few dey lucky and e no last. Bounty dey stressful becos after you still do your own part you go still com dey wait for distribution and na dere scam go come. Sometimes dem go still ask you to begin go do KYC and change eth wallet. I still get plenty bounty wey I do and no distribute some no enter exchange. Forget oo man don come along way unto dat Mata.
full member
Activity: 882
Merit: 207
I like the testimony I read on behalf of @Agbe
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis. I Kno how I take start am. U know how mani threads date I don create wey mods don delete? U kno how mani threads mods don locked or I don locked? U kno how I take disturb Brainboss, Igehhh, Kenny, Smartvirus (my pioneer boss), Davidvictorson, Zlantann, etc. U kno d thread I created dat I received the highest attacked 4rom d forum? It was Igehhh date helped me out on dat issue. All dis things happen from May dis year and I was a Member Rank. I really struggled 2 enta full member nd Brainboss, Davidvictorson and Zlantann pushed me enta full member nd I say I no go struggle 2 enta Sr Member + and I thank God say I don enta full member make I do my thing small small dey go bt surprisely I come become merit Rascal not only Sr. Member Hero Member merit. Merit dat I was struggling with now I no dey struggle again. Na activities I need. What a blessing from God.

God give u d grace as well.





I tap into your grace o. Na step by step till a thousand and then a million upwards. Na people like you they motivate us to never give up.
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Bitcoin Casino Est. 2013
I go tell any new pesin here to just focus and build account than anything else.
The issue wen I dey face be say I nor know where I go see better tutorials, I dey try watch YouTube videos once once but the ones when I dey see nor good, I nor know how I go take get better one.
If una know where to get better materials even if nah PDF or videos abeg make una help me with the link.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@Yawa2020 even those bounty wey go pay some managers no go pay their hunters. I remember one bounty our 001 for here manage omo him escrowed the payment and they paid in btc so if na that kind of bounty e sweet pesin to join that doing does ones at last pesin end up with just $2 or $10. Although that time I put eyes for bounty's e get some managers I dey do their work oo so I dey selective.

I go tell any new pesin here to just focus and build account than anything else. One day you go collect merits like tomorrow no dey if that your post get attention and meaningful or helpful to the forum.
hero member
Activity: 1022
Merit: 723
Sr. Member Rank
Me till date i no believe say na me e don enta Sr. Member Rank like dis. I Kno how I take start am. U know how mani threads date I don create wey mods don delete? U kno how mani threads mods don locked or I don locked? U kno how I take disturb Brainboss, Igehhh, Kenny, Smartvirus (my pioneer boss), Davidvictorson, Zlantann, etc. U kno d thread I created dat I received the highest attacked 4rom d forum? It was Igehhh date helped me out on dat issue. All dis things happen from May dis year and I was a Member Rank. I really struggled 2 enta full member nd Brainboss, Davidvictorson and Zlantann pushed me enta full member nd I say I no go struggle 2 enta Sr Member + and I thank God say I don enta full member make I do my thing small small dey go bt surprisely I come become merit Rascal not only Sr. Member Hero Member merit. Merit dat I was struggling with now I no dey struggle again. Na activities I need. What a blessing from God.

God give u d grace as well.

Congratulations bro.. 👍👍
Omo, the way you just dey run for this forum dey fear me oh,  because even Ferrari and Cheetah never fit run reach the way the merit for your account dey run here oh. How you take dey do am nah? Abi you no go give us latest update🤔🤔.. But all the same, am happy for you bro. $60 awaits you in Roobet campaign.😋😋🥰


member
Activity: 756
Merit: 30
Tell dat your friend sey make im concentrate on building his account to rank up and enta signature campaign. Bounty nor dey rewarding again like in 2017/18. Him go just waste im time finally and waste data unnecessary with am. Most of d projects nor dey like pay once d bounty ends.
Honestly, me sef Don realized say na time, energy and resources person dey waste on top bounty. How person go work for entire one month con get $2 after the work? No be juju be that 🤦‍♂️ some sef you no go get shishi at the end. But person no get choice sha after all na why I still dey participate in some cus man gat to chop.


I like your spirit,  e dey sweet when person teach, and person learn immediately.
Na una dey ginger our spirit! I really dey appreciate the efforts una dey put to support us wey dey for back. Na that support una go continue to dey give us and we no go make una eyes look ground. One love!
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Boss you too much for this AMA... Person just dey learn new new things every day for this forum. E don tey wey I dey wonder how to make the long quotes short but I no Sabi am. The person wey introduced me to the forum na newbie wey concentrate on bounty and e no even know anything for the forum apart from posting bounty reports 😢 even how to quote a reply e no know until I teach am.
Tell dat your friend sey make im concentrate on building his account to rank up and enta signature campaign. Bounty nor dey rewarding again like in 2017/18. Him go just waste im time finally and waste data unnecessary with am. Most of d projects nor dey like pay once d bounty ends.

Quote
Me I dey try adapt to Forum but e dey difficult since I no get better tutor wey go dey guide me. Everything wey I dey do for this forum na with una help and my own efforts.
Continue to dey learn. Na with small small continual practice persin dey take become expert. Shortcut to dis be to dey watch as people take dey do d thing wey you wan learn.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

Boss you too much for this AMA... Person just dey learn new new things every day for this forum. E don tey wey I dey wonder how to make the long quotes short but I no Sabi am. The person wey introduced me to the forum na newbie wey concentrate on bounty and e no even know anything for the forum apart from posting bounty reports 😢 even how to quote a reply e no know until I teach am. Me I dey try adapt to Forum but e dey difficult since I no get better tutor wey go dey guide me. Everything wey I dey do for this forum na with una help and my own efforts.
Yawa2020 my brother I understand your pain. It's well, what you suffer now is exactly what some of our senior men dem suffer when dem discover this place back in the years. They were in the bounty section without knowing wetin dey sup for other parts of the forum. E been no easy for them, if you hear most of them stories you go understand. People like me come when help don dey around, atleast person go tell you how to quote, the type of post to make and boards to avoid. But e never late, we sama here to help and on your own, use forum search and type any question, you go see answer.
I like your spirit,  e dey sweet when person teach, and person learn immediately.

At hyphen, Wehdone my brother... you make sense.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
You see Nigeria, i don give up on am.
Our beloved country don finally destroyed under Buhari and APC government:
The best way for the them to prevent the country from imminent economic collapse, state governors don proposed to the FG to compulsorily retire every civil servants wey dey above 50 years and make dem as well levy anyone wey d earn N30,000 and above monthly.
Una don see where we land? The level of the wickedness of our state governors don reach. Issorite, make d continue to reason from their anus, we d watch them. By next year, all this dia rubbish go stop

When dey pass dis bill again? E be lyk say tinz don dey fall apart finish oo. Na only politicians go just dey on a lavida for dis country. Because dis tin go affect only dem vulnerable people wey dey work for government but no be dem directly e go affect.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
You see Nigeria, i don give up on am.
Our beloved country don finally destroyed under Buhari and APC government:
The best way for the them to prevent the country from imminent economic collapse, state governors don proposed to the FG to compulsorily retire every civil servants wey dey above 50 years and make dem as well levy anyone wey d earn N30,000 and above monthly.
Una don see where we land? The level of the wickedness of our state governors don reach. Issorite, make d continue to reason from their anus, we d watch them. By next year, all this dia rubbish go stop
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino

Bitcoin will break $25,000 today. Cool

What do you think?
Baba this na over hyping oooo because Bitcoin market price dey very unpredictable and if you say price go pass 25k today that will be over statement, no get me wrong, the price even fit pass 30k today but still know say e fit still drop below 20k, so make we just flow with the market and make we no too put hope for market prediction as all na gamble.
Di bullish market of bitcoin dey very slow, na only di bearish market e dey very fast. So 4 bitcoin 2 enta $25k today go dey hard. Bt make we see weti go happened 2day.
The thing be say if Bitcoin wan make any movement e dey follow pattern and both bull and bearish market na the same pattern them dey follow, e no mean to some $20k Bitcoin price is still a bull market for them let say they bought at $9k years back. And to another person that bought at $60k if price is at 40k he still in a bear market. So the most important thing is your entry and exit price that matters.
member
Activity: 295
Merit: 98
Bitcoin will break $25,000 today. Cool

What do you think?

Market is pumping because of the inflation data, BTC has gained +6.49% today and is trading above $24,000 pick level, I believe there will be more upward movement in the coming days if price can still hold above $24,000.
I don't think it can take $25k today
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Bitcoin will break $25,000 today. Cool

What do you think?
Di bullish market of bitcoin dey very slow, na only di bearish market e dey very fast. So 4 bitcoin 2 enta $25k today go dey hard. Bt make we see weti go happened 2day.
legendary
Activity: 2044
Merit: 1055
Bitcoin will break $25,000 today. Cool

What do you think?
The possibility is slim as the 25k resistance is too strong for now I see it twerking back to 23k, well the current bear market has taught me not to trust in charts as anything is possible in the crypto market.


It's too early to write 25k off. Let's see what the americans do when they wake up!
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Abeg I no dey hash na so my voice dey.  Angry
😂😂😂, I nor even hear your voice oh. Na just your fingers wey dey run freely like Atiku for presidency for the 4th time I sight here 🙄

Unpredictable, Many crypto analyst have predicted it will go below $13k yet it landed at $17k
Nor too dey sure sey e nor go fall enta there this year oh. It's still possible sey $13k fit still happen. Na wen enta November I go begin believe sey $13k nor go happen again dis year.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
How una see deleting of reply that just quoted the whole posts and just drop one or two line reply?

Deleting of long quoted post betta my broda, bicus wetin we dey target na to get our local board so we go try everi tin humanly possible to reach that destination and the rest pipo wey dey come make dem get small patient ask pipo wey dey around to guide dem betta. I believe say plenty pipo dey chuck eye for this we thread like this.

Reminder: EFCC still dey active, dem raid yesterday again, some dem dey update for website others na backyard something.

This one now na to relocate go place wey no open eyes for pipo to dey run intel about our movement go betta o, like for instance many boys don relocate go my LGA buy land build hide inside. even the area no too open like that wey be say EFCC go track dem come easily, anoda tin wey make dem dey put eye for pipo be say dem see pipo with expensive moro wey be say pesin no get physical hustle dey follow cause am too. Bicus of street boys my LGA don develop shapally.
So if e too much my broda make you follow tuama b4 pesin go enter those criminal hands and dem go dey bill you like say tomorrow no dey.

What do you think?

Unpredictable, Many crypto analyst have predicted it will go below $13k yet it landed at $17k and i have learned never to look on bitcoin prices rather than utilizing any given opportunities to hold the quantities i have instead of selling with fear. 
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Bitcoin will break $25,000 today. Cool

What do you think?
The possibility is slim as the 25k resistance is too strong for now I see it twerking back to 23k, well the current bear market has taught me not to trust in charts as anything is possible in the crypto market.

How una see deleting of reply that just quoted the whole posts and just drop one or two line reply?.
Yes please, it burries important discussions and make this place unbearable to have a nice discussion, I name tagged some of them few days ago make dem cut their quote to smaller pieces make others fit see talk too. And for the newbies using here to gain activities points and also multi-posting please stop it. Here is not a chat group, if you do not have a quality discussion please don't copy and paste a random  internet drama here.. Abeg I no dey hash na so my voice dey.  Angry

Lol. I could be wrong though, well I.dont know how you come up with your own numbers, but bear in mine that every month carries 28 max( 14 2weeks) Activity points excluding this month for example from September -December  =112 Activity points. Snr man nodey for calculations ooo I would like to see how you calculated your own.

I know say you too go don calculate your own self keep for one corner deh wait for jungle to mature. E better like that than say na merit hold the person like me.
I can't remember the last time I checked my activities TBH. If I'm lucky enough I will get legendary status by Nov- Dec I guess.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Lol. I could be wrong though, well I.dont know how you come up with your own numbers, but bear in mine that every month carries 28 max( 14 2weeks) Activity points excluding this month for example from September -December  =112 Activity points. Snr man nodey for calculations ooo I would like to see how you calculated your own.

I know say you too go don calculate your own self keep for one corner deh wait for jungle to mature. E better like that than say na merit hold the person like me.

Na April di thing go bi ooo. No bi Bobo juice o. Dis wan na India movie 8 episodes, dat is na 8 months 4rom September dis year.

My brother e good say na activities hodl you down even if na for one year unlike say na merit hold you like e hold me seriously for trousers. You are lucky. Rejoice.

Make una reduce flashy lifestyle and know the friends una dey tell una btt parol and how much una dey hammer because na rat wey dey house dey go tell another for outside say fish dey inside house.

Na better wisdom for that comment you share so and e no go kill you. Na the main gist be that but some people go still deh argue say them get freedom of dressing and association and EFCC no fit intimidate them or force them to dress up without being flashy.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
My boss CryptopreneurBrainboss, you fit do anything to help make the thread they very clean?
I understand say many newbie never know how the forum dey be


Baba you dey really make sense. You get enough wisdom. Obviously na new guys wey still dey find am difficult to use the forum features dey quote post like that. We no go too blame them as some of us too experience things like that. That aspect wey you say self moderation and reporting to you so you go pull such down don end the yawn, kudos sabi.


Reminder: EFCC still dey active, dem raid yesterday again, some dem dey update for website others na backyard something.

Abeg make una stay safe and hide una head from those guys only looking for their pucket and calling themselves EFCC. Make una reduce flashy lifestyle and know the friends una dey tell una btt parol and how much una dey hammer because na rat wey dey house dey go tell another for outside say fish dey inside house.
Pages:
Jump to: