Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 92. (Read 1020993 times)

full member
Activity: 882
Merit: 207
Naija government own na to find way to take collect from the common person always be their concern. Bank dey charge tax, airtime vendors dey charge tax,  even this crypto wey we dey use see front, dey still wan find way to tax am. If them succeed in taxing crypto trade, why una feel say dem no go find way to influence the economic margin wey dey ground so?
Stablecoin as I find out, na one correct tool to use to ensure say all our coins no loss unto market fluctuations. However, e go better make government sponsor more of crypto campaigns if dem get am for mind to collect tax, also proper documentation go come apply which many people no want. Even as unemployment dey high for the country so, many personn no even ready to dash anybody shi shi, let alone tax. Na wa
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Normally self no be that one make people fall enter into crypto, besides tax for 9ja na mainly company dey pay tax with oda industries but individual like me and you no get much tax to pay because na only bank fit dey tax onto say if we transact na from there dem take their own. Like dis we country no pure nd every bodi dey look for alternative wey dem go carry make money so dem believe say if dey go into digital way based on how Bitcoin carry blow pipo before so many carry am for mind say make dem try see weda something fit come out since government no wan make way for us, but if na tax I no sure say na dat one carry dem enter there.

But anyhow pipo never see food chop na wia dem wan see money to carry pay tax, de small money pipo go hustle out dem go wan make dem carry am pay tax who go gree dat kian tin for this we country.
Beside dem go say if dem pay tax na still government dem dey enrich instead de poor go still dey die for hunger while dem carry we money share for top.

My broda de mata too tire pesin oo.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?
Sincerely, I nor reason say many Nigerians dey follow crypto unto say dem fit use am dodge tax matter, na as i dey see this matter like this nai i reason say possibility dey but very slim. More persons use crypto for this way unto the freedom wey e dey provide, and unto say e still get ability to change person life comot from the kind poverty wey e be like our government wan put us. And unto the tax matter sef, if you check am, payment of tax for Nigeria nor too dey serious...Last year, report come out from the Oga of federal Inland Revenue Service ( Mr Muhammad Nami) say out of the 200million people wey dey naija,   na only 41milion dey pay tax ...the report go tell you say people nor get tax paying attitude for this way, na something wey people nor dey too reason, so e nor blend to cun dey reason say for country wey dem nor dey too mount pressure for tax matter, people cun dey follow up crypto majorly because dem nor wan pay tax.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
NEW TOPIC: UN urges Nigeria, others on crypto regulation Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?

I no think say na to avoid tax make people deh run enter cryptocurrency. Na because of the jeje way weh the thing use deh go deh make am enter people eyes well well. Imagine the problem weh deh always deh for banks when person want to do transactions and come compare am with when you want to use crypto for transactions. E deh very easy with crypto and na direct to the person wallet e go enter without anybody worrying anybody for bank sort or swift codes. No restrictions to the amount weh person want to send. Crypto na bae.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
NEW TOPIC: UN urges Nigeria, others on crypto regulation Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?

So I just dey scroll for internet as usual to see the latest development for cryptocurrency matter for we continent and this Nigeria own catch my interest. Make una read am and see if u fit drop small knowledge for the question wey I ask because me just thinking I dey see say with cryptocurency you fit avoid plenty tax and even store your profits for stablecoin and you no go dey affected by the volatility of the market. Wetin you dey think, make wey govern begin dey tasks exchange or any centralized service providers so our tax money no go waste.

The first thing wey enter my mind as I read this topic be say - For we government to collect taxes on top cryptocurrencies them go need to first lift their "bank - crypto business transactions" wey dem put in place since last year. Another thing be say the principle of anonymity wey bitcoin and other cryptocurrencies dey built on go scatter if them really wan task individual (I doubt how possible e go dey) because na KYC wey dem go tell us to do. Lastly, I wan ask in addition to CryptopreneurBrainboss question -  supposing say dem dey serious about this tax thing, shey their E-naira go still follow for d taxation?
full member
Activity: 882
Merit: 207
Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
Brother Agbe so sorry for your loss. Losing a loved one is not easy. I pray God grants you the fortitude to bear the loss. And may her soul RIP.

In other news, my pipo abeg some of the newbies wey dey this forum need some kind orientation because I nor understand why this user, Muzzyart wey I believe say na Nigerian go post this kind topic ASUU STRIKE PART 3 for Economy board.  E nor make sense at all. Any person wey introduce am need to give am proper orientation if him wan enjoy the forum.

Abeg accept my sincerest sympathy brother Agbe, Gods strength dey with you.
Furthermore, I see the 'ASUU STRIKE PART 3' topic...i laf belleful. D matter touch the person, no be small😁
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
NEW TOPIC: UN urges Nigeria, others on crypto regulation Do you think Nigeria will adhere to this, also do you think businesses/individual are intentionally engaging in cryptocurrency to avoid tax?

Quote
The United Nations Conference on Trade and Development has said financial regulation of cryptocurrencies through exchanges, digital wallets, and decentralised finance will enable global authorities to tax digital assets.

The agency said balances presently kept in crypto were untaxed, and most developing countries did not have tax regulations on digital currencies, enabling owners to evade and avoid tax payments.

It disclosed this in its Policy Brief No. 102 titled, ‘The cost of doing too little too late: How cryptocurrencies can undermine domestic resource mobilisation in developing countries.’

UNCTAD explained that while crypto could facilitate remittances, it could also enable tax evasion or avoidance through offshore flows whose ownership is not easily identifiable, curbing the effectiveness of capital controls, a key instrument for developing countries to preserve their policy and fiscal space and macroeconomic stability.

It said, “Cryptocurrencies share all the characteristics of traditional tax havens — the pseudonymity of accounts, and insufficient fiscal oversight or weak enforcement.

Continue reading; https://punchng.com/un-urges-nigeria-others-on-crypto-regulation/

So I just dey scroll for internet as usual to see the latest development for cryptocurrency matter for we continent and this Nigeria own catch my interest. Make una read am and see if u fit drop small knowledge for the question wey I ask because me just thinking I dey see say with cryptocurency you fit avoid plenty tax and even store your profits for stablecoin and you no go dey affected by the volatility of the market. Wetin you dey think, make wey govern begin dey tasks exchange or any centralized service providers so our tax money no go waste.

Ps: Abeg if person raise topic no go rush to dey raised another one, give small time (maybe 1-3 days) until no ongoing discussion for the topic so thread no go dey careless.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Una good evening ooo, I just join this forum and I just say make I observe this our local board see wetin dey sup for here.
As me na new member na I say make i let the house know say new person don join una for here.
I welcome you to the forum, i no go come dy go over the same thing like the rules/merit/activity and all because you don they here for a few months now, and you go sabi am, though i no sure say you care because i don check your post history like this so, e be like say na bounty carry you come for forum, i no go talk say e bad oh, but the thing be say this forum they more enjoyable if you go fit enter other better sections join discussions with other users, before you know it, you sev go begin learn how to they constructive with your own posts; i also notice say you like to make posts in the off-topic board, the thing no too make sense as nothing too productive they happen for there.
member
Activity: 756
Merit: 30
Lol, I wan believe say na sarcasm you dey try put here. Na Biden wey dey vacation now or putin wey dey fight war na him d guy wan involve for the matter? Any person wey go believe say all these western folks dey reason Naija just dey deceive himself. The only time when dem fit reason Naija na when their interest dey threatened. So, if na wetin the guy dey try do with him part 1- 3 post, na already dead on arrival be that.
The truth be say the person sef no get idea of wetin him Post. The content of the post dey different from the topic sha. Na me first reply am say that place is not proper for that him post make he move am. And the funny thing be say I no see part 1&2 and booom part 3 Don comot like say na series  Grin
Na true you talk sha Nobody and no country send Nigeria Mata for this world ooo dem dey happy sef as we dey suffer cuz e dey favor them.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Una no fit know everything finish o. Maybe our guy want take style involve everybody for the world into the matter make the strike kuku spoil finish as Buhari and his corrupt politicians no want to settle the matter. Our brother want to drag Biden and Putin inside so the issue go quickly resolve na. But na this one weh him deh make am part 3, na series for Nollywood? The thing funny, I no go lie o.
Lol, I wan believe say na sarcasm you dey try put here. Na Biden wey dey vacation now or putin wey dey fight war na him d guy wan involve for the matter? Any person wey go believe say all these western folks dey reason Naija just dey deceive himself. The only time when dem fit reason Naija na when their interest dey threatened. So, if na wetin the guy dey try do with him part 1- 3 post, na already dead on arrival be that.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
My broda and very own person, I dey aware of watin happen to you and I dey very sorry. Dis kind thing wa you experience no be watin person dey wish for and person still no fit say no when e come. True true, e pass our power to overcome but the matter be say, e dey happen and e no big pass us. We go sock am up small small but, e no fit live us finish. Na so e just be. You go try na, make you dey maintain and be the strength to yourself and your people most especially. Life no easy for anybody and the God way allow this rain to fall for your zinc today, e go give you the strength to use see am through. Sympathy bro.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
In other news, my pipo abeg some of the newbies wey dey this forum need some kind orientation because I nor understand why this user, Muzzyart wey I believe say na Nigerian go post this kind topic ASUU STRIKE PART 3 for Economy board.  E nor make sense at all. Any person wey introduce am need to give am proper orientation if him wan enjoy the forum.

Una no fit know everything finish o. Maybe our guy want take style involve everybody for the world into the matter make the strike kuku spoil finish as Buhari and his corrupt politicians no want to settle the matter. Our brother want to drag Biden and Putin inside so the issue go quickly resolve na. But na this one weh him deh make am part 3, na series for Nollywood? The thing funny, I no go lie o.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
Brother Agbe so sorry for your loss. Losing a loved one is not easy. I pray God grants you the fortitude to bear the loss. And may her soul RIP.

In other news, my pipo abeg some of the newbies wey dey this forum need some kind orientation because I nor understand why this user, Muzzyart wey I believe say na Nigerian go post this kind topic ASUU STRIKE PART 3 for Economy board.  E nor make sense at all. Any person wey introduce am need to give am proper orientation if him wan enjoy the forum.

My brother sorry for your lose oo. Na so the live take be, make you no kill yourself because soon you will get back to live and pick yourself up. Sorry.

Okay my friend @ Davidvictorson, about your complain on the person wey go carry strike matter put for economy board, meself been make small post there and later telling the person say mod fit shift the post enter Off-topic or Politics and Society. I think say newbie suppose focus on reading little little things from beginner board before jumping into the real work here proper at least dat one go guide dem on the kind of post wey dey go where e dey go. Again this thing about gunning for merit dey follow cause some of it. The rush for pure water dey make am be like dat, during our time, this kind of help no even dey. Make we take am wayolly we go reach where we dey go.
member
Activity: 742
Merit: 30

In other news, my pipo abeg some of the newbies wey dey this forum need some kind orientation because I nor understand why this user, Muzzyart wey I believe say na Nigerian go post this kind topic ASUU STRIKE PART 3 for Economy board.  E nor make sense at all. Any person wey introduce am need to give am proper orientation if him wan enjoy the forum.
Ahh, this post na this thread e suppose they now, but some times those newbies no they notice say we get our own local thread because if them know them fore come here come discuss the matter.
Una good evening ooo, I just join this forum and I just say make I observe this our local board see wetin dey sup for here.
As me na new member na I say make i let the house know say new person don join una for here.
Welcome to Nija Unofficial Thread @Stable090, for here I asure u any question wey u get ask am 4 here and our senior men them go answer you.
One more thing is that you should avoid plagiarism because na big crime for the forum.
sr. member
Activity: 756
Merit: 439
Una good evening ooo, I just join this forum and I just say make I observe this our local board see wetin dey sup for here.
As me na new member na I say make i let the house know say new person don join una for here.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Finally our brother don create room for us.
Me nah Rivers Pikin.
Ogba 1stson..

Make we carry this thread hold body.
Welcome guy man, you be new timer for this thread? If so e get as we Dey Lay-out introductory post just like the one you been one make now. Check the beginning of the thread also before I forget this thread wasn’t just opened now we no use style tay, so welcome to a center where we Nigerian Dey take rapport with each other, my advice to you is read before you right, this go even help you in other boards of this forum, welcome again.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Something happened to me 2day. If no bi campaign. I 4 no post 2day bcos as I dey like dis I dey very week. I don tell some pipo weti happened 2 me.
Brother Agbe so sorry for your loss. Losing a loved one is not easy. I pray God grants you the fortitude to bear the loss. And may her soul RIP.

In other news, my pipo abeg some of the newbies wey dey this forum need some kind orientation because I nor understand why this user, Muzzyart wey I believe say na Nigerian go post this kind topic ASUU STRIKE PART 3 for Economy board.  E nor make sense at all. Any person wey introduce am need to give am proper orientation if him wan enjoy the forum.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Agbe once again sorry for your lost and accept my condolences, na so the life be sometime you win some and other time you lose some. Your sister lost the battle to the cold hand of death but am sure she is spending eternity in the bosom of God,

This life self, na wa o. Death na the real joy spoiler for every home. Sorry Agbe. God go give you the heart to bear the pain.

as @CryptopreneurBrsinboss write for him profile: there is nothing like death, only a better place after Earth.

Ok, now I come understand wetin make CryptopreneurBrainboss put that comment for him avatar space. I read that text like four times when I see am some hours ago and e make feel somehow without understanding it. But I understand am well now.
member
Activity: 742
Merit: 30

Thank you for d correction @Coyster @GiftedMAN. Sorry I been notice d mistake afta I don post am finish, I no go do such lyk dat again and go adjust for future purpose. Na why dey say no place lyk home, I dey happy to be part of dis family. Gracias 🙏🏽
E de sweet me as u Don notice am and u take correction. Thanks to all those senior men them for the correction, me self learn from una, and I know say many beginners wey dey here too don learn as well
hero member
Activity: 910
Merit: 686
@Asiska02, abeg try read wetin our senior man Coyster drop now so that you no go dey do that mistake again, on how you drop your own contribuction, you no need to drop another one thesame time until another person drop em own too. I no say we dey learn everyday abeg no see dis my yarning like insult. When me I first locate dis our naija side I been do dis same mistake but na our oga kpatakpata correct me come still use one water cool my head. Na em name dey down so.

CryptopreneurBrainboss

Jump to: