Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 4. (Read 10577 times)

sr. member
Activity: 812
Merit: 455
February 08, 2024, 06:02:40 AM
Proverb: If you no fit look ahead, you go always remain blind.

Meaning: You should always know what you want to achieve in future.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
January 16, 2024, 05:37:10 PM

Pokapoka, my man. E don tey oh. I nor sure sey I dey even see your brakelight for forum as a whole sef. I bin dey think sey you don retire here. Anyway, good to read from you again.
Pepsin still dey hang boot for forum lol. E just get one or two wey ah dey package based on the outside life nai just dey chop my attention. I still dey shook face here when I get breathing space for office. Small time ah go resume fully. I greet you bros.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 16, 2024, 10:06:24 AM
~snipped~
Pokapoka, my man. E don tey oh. I nor sure sey I dey even see your brakelight for forum as a whole sef. I bin dey think sey you don retire here. Anyway, good to read from you again.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
January 15, 2024, 06:07:57 PM
Proverb: life nor be film if not part 2 for dey.
Meaning: You only get one shot at life.


Proverb: person wey shit dey catch nor dey waka anyhow.
Meaning: You are careful not to make mistakes when you are clear on your plans.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
January 15, 2024, 11:56:31 AM
I greet my fellow elders for here@ Chief Mpa, I say make I remind you say as we enter new year you supposed use one strong proverb take motivate us so that we no go misbehave but meanwhile make I motivate our elders with dis proverb wey I hear our elder for villa talk as I visit dem for our cultural day celebration.

Dem say rat wey get one hole dey die quick.
Meaning: Don't depend on one source of income for survival if you want to remain financially relevant.


Normally na new year be dis and we don map out our new year resolutions but I wam use dis opportunity encourage us say make we dey try dey do other things wey go bring income to us, anything fit happen any time for one thing wey we take dey get hope and if we no get back up e go worry, make we see dis talk as advise as elders wey we be and make we make good use of am well even as we remember say we need good health to live good life.
member
Activity: 308
Merit: 32
January 11, 2024, 05:11:45 AM
Proverb: Na Gather gather they form shit,
Meaning: insults starts in a day


Proverb: person wey no Sabi swim no supposed go where water deep

Meaning: if you are not equal to the task don't bother taking the risk.
hero member
Activity: 1316
Merit: 379
WOLFBET.COM - Exclusive VIP Rewards
January 10, 2024, 02:43:14 PM
Person wey dey think big all time no dey work or show say wetin him plan go come true, check him don already thief.

Meaning: It's only a lazy man or woman that keeps procrastinating, Hence doesn't make any effort in life to succeed rather taking what doesn't belong to them.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
January 10, 2024, 01:27:10 PM
Dem say make kettle no dey call pot black.
Meaning: Remove the log in your eyes before helping someone else.
newbie
Activity: 8
Merit: 1
January 10, 2024, 08:02:09 AM
PROVERB: IF YOU SABI POUND, POUND INSIDE MORTER MAKE EVERYBODY CHOP AM. BUT IF YOU NO SABE POUND, POUND FOR GRAND MAKE ONLY YOU CHOP AM.


MEANING: What is worth doing is worth doing well.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
January 10, 2024, 07:50:49 AM
PROVERB: FOWL SAY WHY HIM NO GO SHEET WEDA NAH HIM DEA PACK AM?
MEANING: small pikin wey no know say tins hard nah him go dea waste food because no be him dea feed himself

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 10, 2024, 06:01:15 AM
Dem sey if the cheeks no see anything chew, e dey vex ear.
Meaning: A hungry man is an angry man.
full member
Activity: 420
Merit: 126
January 09, 2024, 05:35:41 PM
Proverb: Wetin elderly person don see even if small pikin climb tree im no go fit see am

Meaning :The wisdom an elderly person possess is far beyond that of a young person.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
January 06, 2024, 04:40:15 PM
Man wey dey beat him wife na wetin him dey eat him dey pour sand sand put.
Meaning: You don't do things that will be to your detriment, no matter how angry you're.

My chief normally dis particular proverb dey self explanatory as oyibo people use talk am because any man wey dey beat em wife dey also beat em self since our holy book( Bible) talk say husband and wife go be one. On a norm any man wey dey beat em wife na big mistake em dey do because laslas em go still dey affected knownly or unknownly so my advice be say make no man beat em wife no matter the offense why she commit.
member
Activity: 308
Merit: 32
January 05, 2024, 03:12:37 PM
1. Proverb: No gree for anybody ooo.
Meaning: say no to oppression

2. Proverb:  Success be like pregnancy you no know how many times the man sleep with the woman

Meaning: you don't know the efforts, and sacrifices behind every successful man.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 04, 2024, 07:04:17 AM
Man wey dey beat him wife na wetin him dey eat him dey pour sand sand put.
Meaning: You don't do things that will be to your detriment, no matter how angry you're.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
January 02, 2024, 10:38:55 AM
Verse 1

Proverb: No call forest wey give you shelter jungle...

Meaning: Never insult anybody who takes care of your responsibility...

Verse 2

Proverb: Hot anger no go fit cook yam...

Meaning: No matter how someone has angered you it must surely come down...
Haba, my sister dis one you drop verse, abeg you for tell us say you be musician nah Grin.. regardless, all you drop nah beta yarn and I fit relate with some of them. Especially as you mention hot temper because weda we like or not, hot temper no dey solve anything, e no dey even win award so before we carry temperament spoil beta tin, e wise to just take ice water calm ourselves.
 I really happy say place like this dey to help us keep in touch with proverbs wey our parents bin dey sama us with. These wise sayings of our parents be like torch to take guide our paths so I dey happy. Make I drop this one here, person fit don tok am but the understanding fit differ.

Proverbs; Pikin fit play with him mama breast but no fot play with him papa testicles
Meaning ; It's not everything that is for child's play; just because there are things that a within reach doesn't mean you have to joke with it.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
January 02, 2024, 10:23:20 AM
What goes around comes around.

Zillamos, you go try step up your game nah, as you don try locate this our corner, first of all you need to start from the beginning read and learn from wetin oda people write so  you fit learn from them. This corner na African proverbs in pidgin, wetin you need to do na just to write your proverbs in pidgin then you fit use big big grammar come interpret the meaning of your Proverbs.

Make I also use this medium advise you to stop to dey drop one one line write up e rit no worry you now but later e go fit affect your account, you fit gum body with person wey show you dis corner make em fit give you small expo on how this area dey be or you just take small time go round only our naija board make you fit observe how things dey go here. No forget say pikin wey go sabi something no dey waste time take correction so try sleep four side make you observe as things dey go.
newbie
Activity: 7
Merit: 0
January 02, 2024, 02:10:13 AM
What goes around comes around.
full member
Activity: 714
Merit: 174
December 31, 2023, 05:29:17 PM
E don try wey I visit this thread and I no really go through the previous replies
But my people talk say No Matter How teeth decay, tongue go still lick am
meaning: No matter how bad a child is, the family will still accept him and this parable suppose be one of the major things wey suppose to Dey guide us here as to try cover our yans, that one no mean say people go do anyhow or wan spam the board with shit post as my people also talk sayPikin wey say mama no go sleep, him too no go sleep
Nor be small things I dun read for here ooo, my head just dey burst! Idey very impressed, body dey sweet me. Wisdom Choke from different people side oooo. I go like add my own.
PROVERB- The same traffic wey dey vex driver, nai dey sweet who dey hawk gala.
E mean say something wey  nor favour another person, fit favour you if you put hand.
jr. member
Activity: 34
Merit: 14
December 30, 2023, 05:51:27 AM
My people talk say; them go look big heaps finish, plant am big yam
Meaning: Before a task be given to you, you're already equal to the task

Dog go dey chop shit, goat teeth go dey decay
Meaning: you're enjoying your life, people are busy castigating you

Eagle perch, kite perch. The one wey say the other one no go perch, em feather go break
Meaning: you can't oppress any one of your kind and go scot free

Pikin wey him father send thief dey use leg break door
Meaning: no child is scare having the backup of his father no matter how wrong he may be.

Person wey me and am follow dey hunt antelope done say my leg look like antelope own
Meaning: betrayal

Chicken feather no dey ever lack for kite nest
Meaning: something does not lack where it's suppose to be

I wish I can say more 😺

Pages:
Jump to: