Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 3. (Read 10577 times)

sr. member
Activity: 812
Merit: 455
March 24, 2024, 11:06:55 PM
Proverb: Elephant pikin no go be dwarf.

Meaning: Like father like son.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
March 14, 2024, 04:04:03 PM
Proverb: Wen sugar no dey again, all the ants go disappear
Meaning: People will leave you when they cannot get anything from you or benefit from their relationship with you.
member
Activity: 168
Merit: 77
March 13, 2024, 11:50:09 AM
Lol, proverbs dey full of wisdom and some dey parable, I like to dey talk dey speak proverb join and some really dey funny ah swear and e dey carry lesson join and e go dey make help us in times we dey face problem or wen we dey depressed or frustrated. Make I follow talk my own too..
* Akara and moi moi get same parents but na wetin them pass through na make them different.
Meaning: How you start doesn't matter but what matters is how you finish.

* Leave matter for Mathias and sabi for Sabinus
Meaning : Give everyone what they deserve.

* The difference between kpekere and plantain chips na packaging.
Meaning: Don't judge on appearance alone.

* The water dem use take make eba can never be recovered.
Meaning: Don't cry over spilled milk.

* Table no dey turn, na who get sense dey change chair
Meaning: Take charge of your destiny.

* If trust dey, water for no boil fish.
Meaning: Trust no one.

* Na strong head make February no complete.
Meaning: Listen to advice, suggestions or opinions at times.
Make I stop here because wetin dey my head, plenty well well, as e be say I start to dey learn proverbs even idioms wen I still dey primary school.
member
Activity: 126
Merit: 12
March 13, 2024, 10:54:26 AM
Proverb ~ Custard na pap wey jand
Just like corned beef na cow wey travel abroad, ba 🤪

Nas look brother no be small proverbs wey full for here nija
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
March 12, 2024, 05:35:57 PM
Proverb ~ Custard na pap wey jand
Just like corned beef na cow wey travel abroad, ba 🤪
member
Activity: 126
Merit: 12
March 12, 2024, 04:57:17 PM
Proverb ~ Custard na pap wey jand

Meaning - Looks can be deceiving. Stay sharp.

Proverb ~ Man wey naked no dey put hand for pocket:

Meaning - Stop capping. Be honest about your true situation.

Proverb ~ Who dey purge no dey select toilet:

Meaning - Basically, beggars can’t be choosers.

Proverb ~ E don tey wey yansh dey for back:

There’s nothing new under the sun.

Proverb ~ Rice wey dey bottom pot today go dey on top cooler tomorrow:

No condition is permanent.
sr. member
Activity: 476
Merit: 337
March 12, 2024, 03:12:03 PM
Proverb: Face of goat wey dey frown no go fit stop em owner wey wan carry am go market.

Meaning: No matter how you think a person is not able to do something because of a disability you will be shocked with their victory some day.
Bros, dis ur interpretation get small k-leg oh.


Dem nor dey take morning know bad market.
Meaning: You don't dismiss a thing by rushing into conclusion based on first incident.
   I also get one obonge African proverbs we I won add here, although many of us fit also done know am since but make I just talk am sha.
   Restless feet fit waka enter inside snake pit– This one means say person wey no get any better things wey em dey use em life dey do fit carry em leg waka enter where bad things them plenty.
   My advice for this talk be say make we find better things out our hand so that we no go enter trouble, them also talk am say an idle man nah devil's workshop, . As this country dey badh everyday make person also do meaningful things wey go provide money for ram.
   Nah only person wey no get jobs dey talk watin em next neighbor do wey no dey good.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
March 12, 2024, 07:49:44 AM
My people I greet una, e come be like say our elders here don go on holidays but as I dey think am I come understand say now na raining season our elders don go do farm work so that dem go rush come back before rain start. Make I drop one proverb abeg make here for hot small abeg make we no forget say na here we dey learn all the better word dem to take guide our children for our families.

Proverb: Pikin wey no get papa and mama no supposed dey cry of hunger dey go house.
Meaning: If you are the bread winner in your family, you don't need to depend on anyone else in your family for survival because the burden is already on your shoulders.
sr. member
Activity: 812
Merit: 455
February 25, 2024, 08:37:01 PM
Proverb: If life don beat you well well and your face don swell up, just dy smile and behave like fat man.

Meaning: In life always try to make the best out of it no matter what.
member
Activity: 75
Merit: 16
February 24, 2024, 10:50:47 AM
Though me I no grow up for village sha o but sometimes when my uncle's them de advice me e get some adage and proverbs them wey Dem dey use for me and e plenty of which I don't know whether people don already mention am because people wey reply to this thread plenty well well but make I drop this two:

××An apple doesn't fall far from the tree ---- meaning say Pikin dey get the same character and behavior like the parents.

××It's only when you near a tree that you would know the kind of fruits it bears ------ meaning say Na when you reach person body naim you go know the kind of person wey them be
full member
Activity: 364
Merit: 44
Unlimited 50% Deposit Bonus at JokerBet.biz
February 23, 2024, 01:30:13 AM
Rat wey dey house they invite outside rat say food dey
Meaning: person wey get some na em exposed him self
A child in the parents shoulder never know the distance they are going
Meaning child under parents don't know life is not easy
Old woman that throw away basket on play ground invited public
Meaning: tabling your problem gives people room for opinion including your enemies
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
February 23, 2024, 01:10:18 AM
Proverb: Face of goat wey dey frown no go fit stop em owner wey wan carry am go market.

Meaning: No matter how you think a person is not able to do something because of a disability you will be shocked with their victory some day.
Bros, dis ur interpretation get small k-leg oh.


Dem nor dey take morning know bad market.
Meaning: You don't dismiss a thing by rushing into conclusion based on first incident.
sr. member
Activity: 812
Merit: 455
February 15, 2024, 05:46:46 PM
Proverb: Face of goat wey dey frown no go fit stop em owner wey wan carry am go market.

Meaning: No matter how you think a person is not able to do something because of a disability you will be shocked with their victory some day.
jr. member
Activity: 41
Merit: 1
February 12, 2024, 06:20:55 AM
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.

— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.

Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.

Make I kick start am with some Warri flavour. Area!

Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.

Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations.



Pikin wey wash him hand well go follow elder chop for the same plate
Meaning: pikin wey get sence dy follow elders do things
sr. member
Activity: 812
Merit: 455
February 11, 2024, 06:13:44 AM
Proverb: Person wey sleep with nyash (anus) wey dey scratch am must wake up with fingers wey dey smell.

Meaning: There's nothing dirty that you do privately that won't come out in the open.
member
Activity: 73
Merit: 13
February 11, 2024, 05:56:46 AM
Proverb: monkey smart monkey smart, na because tree near tree
Meaning: you can only be smart in what you know best to do.

Proverb: aboki bring suya.. aboki bring suya.. na cow body dey suffer am
Meaning: it is only ignorant that will make someone not to understand that excessive demand is hurting the person bringing it.

Proverb: indomie dey easy to cook but people dey Cook bean pass indomie without considering the time. Because if E don E go bellefull pass indomie.
Meaning: better things take time to achieve.
jr. member
Activity: 38
Merit: 9
February 11, 2024, 05:26:55 AM
Let me start by saying, who hasn't used proverbs in their speech at some point in time? We all have ! Proverbs are an integral part of our daily communication. Having a strong knowledge of proverbs we not only help you in increasing communication skills but would also help you do well in various competitive areas.

Proverb: Better soup na money kill am
Meaning: The good things in life don't come cheap.

Proverb: Rice way dey bottom pot today go dey on top cooler tomorrow.
Meaning: No condition is permanent.

Proverb: One day breeze go blow and fowl yansh go open
Meaning: Nothing stays hidden for ever.
member
Activity: 132
Merit: 50
February 09, 2024, 12:10:37 PM
Wow, dis thread wey you start dey really interesting. Wetin I dey see here na something wey I no dey hear everyday. E dey quite diverse and e all dey make sense. E dey surprise me say no matter how much we dey advance for life, many of us still dey hold onto our traditions.

And I also like how the new faces dey join the group and also me.
sr. member
Activity: 812
Merit: 455
February 09, 2024, 06:13:01 AM
Proverb: If you no fit look ahead, you go always remain blind.

Meaning: You should always know what you want to achieve in future.

Dis one enter well as na beta word wey we dey see as e dey happen on a steady for our everyday life, na like the word wey our elders say if you fall to plan then you plan to fall i believe say your proverb make sense well well.

One sad truth wey I don realize now be say even when people know wetin Dem want to achieve am na wahala because for we county naija the only thing wey dey work currently na our local garri market. I good like add small thing here,  e no go work out to know wetin person want just like that but make people dey try work hard to make sure say dem achieve wetin Dem want.

My Oga, piple dy work hard for this contri but when things no dey always go dia way e go b like say your efforts no follow. E dey also make plenty piple dey discouraged and dem no go wan like to try again and if some piple wey dia own don better see person wey don give up e go be like the person never try to make things better for am.
The contri strong like karnel, this our naija alone nah discouragement ma no lie for you, only God nai dy help us and again, if e better for any of una today help the next man of you feel like.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
February 08, 2024, 01:22:45 PM
Proverb: If you no fit look ahead, you go always remain blind.

Meaning: You should always know what you want to achieve in future.

Dis one enter well as na beta word wey we dey see as e dey happen on a steady for our everyday life, na like the word wey our elders say if you fall to plan then you plan to fall i believe say your proverb make sense well well.

One sad truth wey I don realize now be say even when people know wetin Dem want to achieve am na wahala because for we county naija the only thing wey dey work currently na our local garri market. I good like add small thing here,  e no go work out to know wetin person want just like that but make people dey try work hard to make sure say dem achieve wetin Dem want.
Pages:
Jump to: