Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 243. (Read 1032218 times)

hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
RIP to one of our own Becky666: https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732
~Snipped

Omo. I saw this news earlier today for our telegram channel but I say I go take time out to read through. Mehn, I just dey short of words like this. All through his time on the forum, me and Becky never get any problems. He been always dey supportive of our community and our goal of getting our very own local board. It's sad he had to go. Too bad. I wonder why the good guys keep going. He will be great missed - on and off the forum. Goodbye bro.

~Snipped

I know say we pass 10 wey dey active for here and wey dey campaigns too..
$20
$25
$30
These na the money I for like make each of us contribute so I go leave for the house to deliberate on it.

Brainboss endorsed the idea so make I see wetin una think.

I'm all in, I go dey follow up the thread to see when contribution go start   Cry
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
What a bad news to hear, the inactiveness of becky been worry me, I immediately know say something dey wrong with am, I asked about am for telegram group but I no get positive response, cause nobody dey close to am. I remember when I pm am ask am about him health and why him never come forum for sometimes, and e take am two weeks to give me response, make I bring him reply come public.

Brotherly, i was sick that made me inactive bro.
It wasn't fine bro but fine now, thanks for all your concerns.

One love!.

E dey pain me, after the message, he was still struggling to post and complete him post count, I no know say him time don dey reach.
RIP Becky666

I have created a thread about his dismiss on reputation board, here https://bitcointalk.org/index.php?topic=5336580.new#new
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Little Contribution to The Deceased Family(Becky666)

Death is inevitable; as a community who care for ourselves as foe suggest say make we put head together contribute little support to the family of Becky666 since we no go fit meetup the funeral, at least make him family members know say Becky get better friends for the forum him been dey work. Our pipo talk say rain nodey fall ontop one roof, my wish nobe say we go contribute money for only funerals,  No!!. Some of us fit get wedding, Birthday, child dedication wey as a community we go support too, like it or not we are family now..

My suggestions
I know say we pass 10 wey dey active for here and wey dey campaigns too..
$20
$25
$30
These na the money I for like make each of us contribute so I go leave for the house to deliberate on it.

Brainboss endorsed the idea so make I see wetin una think.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
RIP to one of our own Becky666: https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732

Death na bastard, our brother wey been dey handle this account wey I write above don just go like dat. When I hear am I no believe, I try to reach am but e number no dey connect again, I check e WhatsApp and account for forum and dem no dey active again.

RIP brother.

Chaiii, watin be this na,,, watin be this! Death na bustard Big pant like this! E just weak me just now, for the struggle way we dey too, dey try escape government make we for dey solve matter with the small thing we dey gather from here. Nah, e no gel at all. Na very big lose to in immediate and acquired family way be en people and we for the forum. This one na person way identify wella and e dey represent. No be small short one don reach us so, chai!

I fit re all when we been dey ask of the guy for telegram group chat, no of us know say, e get watin been dey worry am. Na big fvck up. My sincere condolence for the family way e live behind and to the Nigerian hangout, en kind we no go see again.

RIP Becky666
member
Activity: 672
Merit: 29
It's very pathetic say dis kind thing go happen to one of our own dis time around but anyhow em be, life goes on, and God knows the best.
I pray d next news wey we go hear na success from all angles.
My condolence goes to the family and well-wishers (sobs)
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
May be na me go even feel dis thing pass sef as my guy tick me with dat ogbonge trust sey I correct pass Mr Honesty. Na every time wey I check dat area I go dey see my guy.

Chai! Death, why you cheat us like dis na...😭😭

Becky, make God give the family wey you leave behind iron heart to bear dis thing. RIP, bro.

I go suggest sey make we wear this RIP for Becky for our avatar for people wey dem campaign allow.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Chai meh I dey para which kind news be this na I know say for long time him never dey active Omo death na beast. This is terrible I don't know how old he was, we never had personal contact I pray he rest in power in the bosom of the Lord.

Death is not the end Becky666  Angry
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I realize say him later no make am for roobet and is like I saw he wore another signature or so, I been think say him don dey ok.
Me self think him illness don go down little when Hhampuz accepted him for Rollbit, me fuck up as I no contact him at the time after he called me during WhatsApp conversation between him and I. As I hear say him do leave us, I no go lie I dey bad mood and feel like weeping.

RIP BECKY666. it saddens.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
I'm really in tears for this guy honestly. I remember when I been ask am why him dey skip post with roobet when hhampuz dey asterisk am one week off and the next on, the guy tell me say him dey struggle with health issues say I no go understand. I realize say him later no make am for roobet and is like I saw he wore another signature or so, I been think say him don dey ok. Chai chai chai.... I'm really in tears

Rest in peace BECKY666. You are a soldier.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
We just lost a soldier. Condolences to the family and the entire Nigerian Bitcointalk forum Community members. May he find rest where he is.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
RIP to one of our own Becky666: https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732

RIP brother.
Jezz!!!

Oh! This is terrible! Gosh!

Nor be dis type of news persin wan to dey hear oh! Kai, so na like dis Becky take waka go? Na wa oh. Dis life sef, e nor get head at all. And that my guy bin sick one time, na d time wey im still dey Roobet with us but BM remove am as e nor dey active. Im come back and quick quick get another campaign sharperly and we jolly as dat wan happen. E neva reach 2months na wey all dis thing happen. Na wa oh. So, d bastard sickness return again to claim awa persin.

Gosh! I nor just wan believe sey dis thing na true oh!
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
RIP to one of our own Becky666: https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732

Death na bastard, our brother wey been dey handle this account wey I write above don just go like dat. When I hear am I no believe, I try to reach am but e number no dey connect again, I check e WhatsApp and account for forum and dem no dey active again.

Quote from:   date=08/05/2021
Good morning sir, I lost my elder brother day before yesterday 😭 I don't know how to get your contact now so that we can talk well sir, this is my phone number 🙏

As the message come, I no believe then now I recieved another message na e I know say the mata don serious and no be joke again. I sabi Becky666 (as account) well well. I know when e start to dey hustle for the growth of the account. E dey pain me say e just go like dat. E family (children and wife) go don here about me and everybody here because e sabi talk good about the forum and how e don help am.

Abeg if anybody fit reach e family for here make dem send mine and our condolences, our prayers and love dey for dem. I go still try reach e family and if we fit organized any small thing for the family e go make sense.

Quote from: date=10/05/2021
Good day Bros, sad to bring to your notice the demise of my friend and former colleague  whom I introduced here in this forum and he is your good friend here too.

The owner of Becky666 https://bitcointalksearch.org/user/becky666-2526732 died last week Tuesday at Wuse General Hospital Abuja.

I just go through our chat come remember this message,
 
RIP brother.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
<...>
The thing be say e no easy as we never been given the local board we dey request for, I know say ginger go come if local board dey. There are many of us wey get the zeal to build the local board but dem no wan give us. There are a lot of discussion threads we need to create but which can not fit in for here.
The thing be say, I hear abi make I say, I see sometimes ago say, how busy the thread be na criteria too to get watin we dey fine and this one way the thread don dey trun watin we go dey see person post, no be everybody o but, 1 person post only 1 time a day na em dey weak me. The ginger no be like before again. Check am na, imagine when CryptopreneurBrainboss open this thread some months way don carry waka go back how the place been busy. Abi na the coolele water way been follow dey pour some kind people that time been be the motivation abi na the joy way been follow say we get corner to drop our Pigin been be the matter.

On how e be eh, we suppose dey carry eye see this place like say, na the local board be dis cef. E no make much difference if not, if we no fit carry here way be say, we get small local freedom to dey do as e be us for body, na so even if them give us local board cef, e go hard us to dey do one or two's. The way the ginger carry die via this side way we get now, na so e go tire us kwa when everywhere burst like logos. Na so e just be!
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Paxful dey expect more volume in crypto trading for Nigeria to pass 2020

You know sey CBN in beginning of February this year ban crypto trading, this can make some Nigerians to dey think crypto trading volume fit drop for the country, but me no think so. And we even dey see more increase in trading volume, I believe say Paxful CEO, Ray Youssef no just talk this thing:

The Chief Executive Officer, Paxful, Ray Youssef, had said, “We’re on track for an over 20 per cent increase in volume this year. We are seeing growth in all our markets and especially among groups or in countries where there’s a real need for cryptocurrencies: where the traditional financial system is failing people, whether that’s because of extreme volatility, strict capital controls, or high transaction costs.

The company talk say that them dey on track to have 36 percent more bank transfer volume on their platform than he had last year.

Waiting I being dey think about this matter be say no be only Paxful this kind thing dey happen, na every exchange (p2p precisely for now) Nigerians dey use go experience this kind of trading volume increase.

Waiting you people think about this?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
The thing be say e no easy as we never been given the local board we dey request for, I know say ginger go come if local board dey. There are many of us wey get the zeal to build the local board but dem no wan give us. There are a lot of discussion threads we need to create but which can not fit in for here. But I know say nothing no dey possible, we can get local board one day. To even pin this thread for us na wahala for moderator, pinning this local thread alone self go cause ginger.

But make we just no give up, if I see waiting I believe go fit for here, me go post ham. And as you know, I dey active as always.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Here cold o. Na so we don loose motivation reach abi we cef no con be proudly naija people again, lol. No be say we pride in the nation shah but then, we for dey try dey make this area busy so, we fit dey gather benefit from watin the thing we dey fine go bring come. Na better o, man no dey run from better o and better no fit come without suffer first. Abeg, make we no tire so soon. If na talk way we go dey yarn about, omo talk way be Charlie, man way get update dey with us and e ready to dey drop something from time to time way be say, watin to talk no for dey finish. This one way, e con be like say, we don make money finish, me no con understand abi na hope we don loose in the struggle or we no get loose for the thing again.

Anyhow e be shah, na say make we for dey grow con really get sweet mind follow ourselves this thing for bring for us. Make we try dey visit the corner, e no sweet as e be like this.

I greet una my people.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I hope this will pass enough message across.
https://punchng.com/why-pantami-must-resign-or-be-sacked/?amp
Some of this revelation dey shock person becuase, you no go see goat, you carry yam give am. Imagine the kind high post way them carry give that kind person, person way be say, e dey so deep inside the violence part of en religion. The part way be say, anybody way no agree with them or no be as them be as per religion side, the person no deserve to breath air at all. Air way be say na free, e go con be say, some people feel say because, you no dey serve with them, you no suppose live. Na to tell you say you no get choice to choose be that na. Na that kind person na em our Oga at the top carry power give,,, watin we go expect!
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Play-ppqy eh, this our corner dull die. In fact, the place don die finish o, you fit imagine say, if I no talk something or Charlie or Traderbtc talk something, ba em be say, nothing go come board for here via discussion o. E wayh me just now say today like this, e no dey anybody body to write or talk anything for this our corner make e for be like say e active small. E con be like say, all our mouth and talk talk na for telegram e end, e no reach for forum as na there we con get bole for hand finish.

E no go well na, we way dey fine something con be like say, na watin them for award us with just by small trier! No be so na, na continued effort fit make something come out this our struggle o. Abeg, if we dey sleep, make we try wake else, our aim don cast finish.
I dey notice the dullness sha, but I understand say most times people dey forget to stop by here, even me sometimes I dey forget tbh, but anyhow e be I believe say our guys for here probably dey busy na make dem no dey reach here that much again, we fit still continue to keep the place lively till them dey free then them go join us yarn for here. And we go still try to achieve the main goal of getting our own local board, na just time e go take but one day we go surely get am.
I hope this will pass enough message across.
https://punchng.com/why-pantami-must-resign-or-be-sacked/?amp

Quote
A brewing storm over sensitive allegations unveiling Isa Pantami, the Minister of Communications and Digital Economy, as a fervent supporter of extremist Islamist sects, who preached their violent cause should not be overlooked. The minister is under fire for vociferously espousing the violent Jihadist narrative of al-Qaeda and the Taliban before he was appointed minister by the President, Major General Muhammadu Buhari (retd.).

Quote
Essentially, Pantami’s past is catching up with him. Although he claims that he has “repented” of his Salafist ideology, his violent preaching of those days is damagingly chilling. Among other things, he said, “Oh God, give victory to the Taliban and to al-Qaeda,” and, “This jihad is an obligation for every single believer, especially in Nigeria.”

Quote
In 2012, Goodluck Jonathan, the President, claimed that sympathisers of Boko Haram had infiltrated his government. “Some of them are in the executive arm of government, some of them are in the parliamentary/legislative arm of government, while some of them are even in the judiciary…Some are also in the armed forces, the police and other security agencies,” he had said.
Honestly this country na wa sef, how people way we elect put for office go dey pray for the downfall off of the country, truly na some of this people we put for office dey sponsor this boko haram group, I just weak for the country like this, I wonder how we go do, this buhari na weakling, so much for the fighting of corruption dey fight corruption dey forget boko haram, the country dey for God hand na to just dey pray say things go get better for this failed state💔.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I believe say one day things go better, but we seriously need to eliminate the boko haram terrorist group

Jump to: